Êxodo 16
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NVI
1 Wen Israel pipol komot from Elim, dem kon go Sin Wildaness wey dey between Elim and Sinai for di Fifteent day for di sekond mont afta dem don komot from Egypt.
1 Toda a comunidade de Israel partiu de Elim e chegou ao deserto de Sim, que fica entre Elim e o Sinai. Foi no décimo quinto dia do segundo mês, depois que saíram do Egito.
2 So evribody for Israel kon dey komplain give Moses and Aaron inside di wildaness.
2 No deserto, toda a comunidade de Israel reclamou a Moisés e Arão.
3 Dem sey, “E for betta sey God kill us for Egypt, bikos wi even dey si food chop for der, but naw, E take us kom dis wildaness won kon kill us with honga!”
3 Disseram-lhes os israelitas: "Quem dera a mão do Senhor nos tivesse matado no Egito! Lá nos sentávamos ao redor das panelas de carne e comíamos pão à vontade, mas vocês nos trouxeram a este deserto para fazer morrer de fome toda esta multidão! "
4 Den Oga God tell Moses, “I go give una bread from heaven and di pipol go dey gada di ones wey go rish dem chop evriday, so dat I go fit test and know if dem go follow my kommandment.
4 Disse, porém, o Senhor a Moisés: "Eu lhes farei chover pão do céu. O povo sairá e recolherá diariamente a porção necessária para aquele dia. Com isso os porei à prova para ver se seguem ou não as minhas instruções.
5 But for di sixt day, make dem gada doubol of wetin dem bin dey gada.”
5 No sexto dia trarão para ser preparado o dobro do que recolhem nos outros dias".
6 So Moses and Aaron tell Israel pipol, “Dis evening, una go know sey na God take una komot from Egypt.
6 Assim Moisés e Arão disseram a todos os israelitas: "Ao entardecer, vocês saberão que foi o Senhor quem os tirou do Egito,
7 For morning, una go si God glory, bikos E don hear as una dey komplain against am. Na-im una dey komplain to, nor bi wi wey just bi ordinary human being.”
7 e amanhã cedo verão a glória do Senhor, porque o Senhor ouviu a queixa de vocês contra ele. Quem somos nós para que vocês reclamem a nós? "
8 So Moses sey, “Wen God give una meat chop for evening and bread for morning, den una go know sey, E don hear all una komplain. Wetin wi bi sef? Una komplain nor bi against us, but na against God.”
8 Disse ainda Moisés: "O Senhor lhes dará carne para comer ao entardecer e pão à vontade pela manhã, porque ele ouviu as suas queixas contra ele. Quem somos nós? Vocês não estão reclamando de nós, mas do Senhor".
9 Den Moses tell Aaron sey make e tell Israel pipol make dem kom meet God, bikos E don hear all dia komplain.
9 Disse Moisés a Arão: "Diga a toda a comunidade de Israel que se apresente ao Senhor, pois ele ouviu as suas queixas".
10 As Aaron dey tok to Israel pipol, dem turn look di wildaness kon si God glory wey appear inside di kloud.
10 Enquanto Arão falava a toda a comunidade, todos olharam em direção ao deserto, e a glória do Senhor apareceu na nuvem.
11 Den God tell Moses:
11 E o Senhor disse a Moisés:
12 “I don hear Israel pipol komplain, so go tell dem, ‘Una go chop meat for evening kon chop bread for morning until una beleful, den una go know sey na mi bi di Oga wey bi una God.’ ”
12 "Ouvi as queixas dos israelitas. Responda-lhes que ao pôr-do-sol vocês comerão carne, e ao amanhecer se fartarão de pão. Assim saberão que eu sou o Senhor seu Deus".
13 For evening, kwail bird kon fall full groun for di kamp and for morning dew gada evriwhere for di kamp.
13 No final da tarde, apareceram codornizes que cobriram o lugar onde estavam acampados; ao amanhecer havia uma camada de orvalho ao redor do acampamento.
14 Wen di dew don komot, small-small round tins wey white like ice-blok still dey groun for di wildaness.
14 Depois que o orvalho secou, flocos finos semelhantes a geada estavam sobre a superfície do deserto.
15 Wen Israel pipol si am, dem bigin ask each oda, “Wetin bi dis?” Bikos dem nor know wetin e bi.
15 Quando os israelitas viram aquilo, começaram a perguntar uns aos outros: "Que é isso? ", pois não sabiam do que se tratava. Disse-lhes Moisés: "Este é o pão que o Senhor lhes deu para comer.
16 Dis na wetin God kommand: ‘Make evribody take wetin e fit chop. One omer for one pesin; den una go gada akordin to di pipol wey dey una house.’ ”
16 Assim ordenou o Senhor: ‘Cada chefe de família recolha o quanto precisar: um jarro para cada pessoa da sua tenda’ ".
17 So Israel pipol do as God kommand. Some gada plenty, while odas gada small.
17 Os israelitas fizeram como lhes fora dito; alguns recolheram mais, outros menos.
18 Wen dem measure with one omer, di pesin wey gada plenty nor get pass who gada small: evribody gada wetin e go fit chop finish.
18 Quando mediram com o jarro, quem tinha recolhido muito não teve demais, e não faltou a quem tinha recolhido pouco. Cada um recolheu tanto quanto precisava.
19 So Moses tell dem, “Make nobody keep dem till tumoro.”
19 "Ninguém deve guardar nada para a manhã seguinte", ordenou-lhes Moisés.
20 But some nor gri listin to Moses, bikos dem still keep some till di next day. Di food wey dem keep kon get worm and e start to smell, so Moses kon dey vex for doz pipol.
20 Todavia, alguns deles não deram atenção a Moisés e guardaram um pouco até a manhã seguinte, mas aquilo criou bicho e começou a cheirar mal. Por isso Moisés irou-se contra eles.
21 So Israel pipol kon dey gada am evry morning; each pesin akordin to wetin e fit chop finish and wen sun don make evriwhere hot, di rest food go melt.
21 Cada manhã todos recolhiam o quanto precisavam, pois quando o sol esquentava, aquilo se derretia.
22 For di sixt day, dem gada doubol food, two omer for one pesin. Den di leaders for di kommunity kom ask Moses, “Why e bi like dat.”
22 No sexto dia recolheram o dobro: dois jarros para cada pessoa; e os líderes da comunidade foram contar isso a Moisés,
23 Moses ansa, “Dis na wetin God tok: ‘Tumoro na Sabat Day, so evribody must rest. Anytin wey una won bake or boil, make una bake and boil dem today and anytin wey remain, make una keep am till di next day wey bi Sabat Day.’ ”
23 que lhes explicou: "Foi isto que o Senhor ordenou: ‘Amanhã será dia de descanso, sábado consagrado ao Senhor. Assem e cozinhem o que quiserem. Guardem o que sobrar até a manhã seguinte’ ".
24 So dem keep am till di next day, just as Moses kommand and e nor spoil, smell or get worm.
24 E eles o guardaram até a manhã seguinte, como Moisés tinha ordenado, e não cheirou mal nem criou bicho.
25 Moses kon tell dem, “Make una chop am today, bikos today na awa God Sabat Day and una nor go si food chop for di field.
25 "Comam-no hoje", disse Moisés, "pois hoje é o sábado do Senhor. Hoje, vocês não o encontrarão no terreno.
26 Una go si gada for six days, but for di sevent day wey bi di Sabat Day, una nor go si any one gada or pick.
26 Durante seis dias vocês podem recolhê-lo, mas, no sétimo dia, o sábado, nada acharão. "
27 “For di sevent day, some pipol among una go won go gada, but dem nor go si anytin gada.”
27 Apesar disso, alguns deles saíram no sétimo dia para recolhê-lo, mas não encontraram nada.
28 So God tell Moses, “How long e go take before dis pipol go start to obey my kommandment?
28 Então o Senhor disse a Moisés: "Até quando vocês se recusarão a obedecer aos meus mandamentos e às minhas instruções?
29 Make una know sey na bikos God sey make una rest for Sabat Day naim make am dey give una doubol food for di sixt day. So make evribody stay en house; make nobody komot en house for di sevent day.”
29 Vejam que o Senhor lhes deu o sábado; e por isso, no sexto dia, ele lhes dá pão para dois dias. No sétimo dia, fiquem todos onde estiverem; ninguém deve sair".
30 So di pipol rest for di sevent day.
30 Então o povo descansou no sétimo dia.
31 Israel pipol koll di food “Manna.” Bikos e bi like korianda seed and e white and dey taste like biscuit wey dem do with honey.
31 O povo de Israel chamou maná àquele pão. Era branco como semente de coentro e tinha gosto de bolo de mel.
32 Den Moses sey, “Dis na wetin God kommand: ‘Make una keep one full omer wey go dey from one generashon go rish anoda, so dat dem go si di food wey I dey give una for di wildaness, afta I take una komot from Egypt.’ ”
32 Disse Moisés: "O Senhor ordenou-lhes que recolham um jarro de maná e guardem-no para as futuras gerações, para que vejam o pão que lhes dei no deserto, quando os tirei do Egito".
33 Moses kon tell Aaron, “Make yu measure one omer for manna with one kontaina, den put am for where Oga God Spirit dey, so dat E go take am dey remember di generashon wey dey kom for back.”
33 Então Moisés disse a Arão: "Ponha numa vasilha a medida de um jarro de maná, e coloque-a diante do Senhor, para que seja conservado para as futuras gerações".
34 Just as God kommand Moses, Aaron kon put am for di Kovenant Box front, so dat e go dey save.
34 Em obediência ao que o Senhor tinha ordenado a Moisés, Arão colocou o maná junto às tábuas da aliança, para ali ser guardado.
35 So Israel pipol chop manna for forty years until dem rish Kanaan land.
35 Os israelitas comeram maná durante quarenta anos, até chegarem a uma terra habitável; comeram maná até chegarem às fronteiras de Canaã.
36 (If yu divide efah into ten, na one part bi one omer.)
36 ( O jarro é a décima parte de uma arroba. )
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Êxodo 16, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.