Êxodo 14
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs BKJ
1 Den God tell Moses,
1 E o SENHOR falou a Moisés, dizendo:
2 “Make yu tell Israel pipol sey make dem go stay for Pi Hahirot wey dey between Migdol and di Red Sea opposite Baal Baal-Zefon.
2 Dize aos filhos de Israel, para que voltem e acampem diante de Pi-Hairote, entre Migdol e o mar, diante de Baal-Zefom; diante dele acampareis junto ao mar.
3 Fero go tink sey Israel pipol konfuse kon dey waka up-and-down for di wildaness.
3 Porque Faraó dirá dos filhos de Israel: Eles estão encurralados na terra, o deserto os encerrou.
4 I go make Fero heart strong again and e go porshu una and una go honor mi, bikos of wetin I go do Fero and en sojas, den Egypt pipol go know sey na mi bi Oga God.” So Israel pipol do as Moses tell dem.
4 E eu endurecerei o coração de Faraó, para que ele os persiga. E eu serei honrado sobre Faraó, e sobre todo o seu exército, para que os egípcios saibam que eu sou o SENHOR. E assim eles fizeram.
5 Wen dem tell Fero sey Israel pipol don go, en heart and en savants heart kon turn against Israel pipol. So dem sey, “Wetin even make us do dis tin? Naw wey wi don free Israel pipol, na who go kon dey serve us?”
5 E se contou ao rei do Egito que o povo havia fugido. E o coração de Faraó e de seus servos virou-se contra o povo, e eles disseram: Por que fizemos isto, deixando que Israel saísse e deixasse de nos servir?
6 Di king kon ready en and en sojas shariot.
6 E aprontou a sua carruagem, e tomou o seu povo consigo,
7 Den e take six hundred of en best shariot and all di horse for Egypt and di sojas wey go ride dem.
7 e tomou seiscentas carruagens escolhidas, e todas as carruagens do Egito, e os capitães sobre todos eles.
8 God make Fero heart strong well-well, so e kon porshu Israel pipol. Naw Israel pipol just komot Egypt with betta mind.
8 E o SENHOR endureceu o coração de Faraó, rei do Egito, e ele perseguiu os filhos de Israel; e os filhos de Israel saíram com braço erguido.
9 Egypt sojas porshu dem with all dia shariot and Fero shariot and dem katch Israel pipol for dia kamp for Pi Hahirot and Baal Baal-Zefon wey dey near di Red Sea near.
9 Mas os egípcios os perseguiram com todos os cavalos e carruagens de Faraó, e seus cavaleiros, e seu exército, e os alcançaram acampados junto ao mar, perto de Pi-Hairote, diante de Baal-Zefom.
10 Israel pipol look up kon si Fero and Egypt sojas dey mash kom meet dem. Fear katch dem, so dem shaut kon kry to God.
10 E quando Faraó se aproximou, os filhos de Israel levantaram os seus olhos e eis que os egípcios estavam marchando atrás deles; e eles ficaram com medo, e os filhos de Israel clamaram ao SENHOR.
11 Den di pipol tell Moses, “Na bikos grave nor dey Egypt, naim make yu bring us kom inside dis wildaness, so dat wi go die for here? Na wetin make yu karry us komot from Egypt?
11 E disseram a Moisés: Porque não havia sepulcros no Egito nos levaste embora para morrermos no deserto? Por que agiste assim conosco para nos tirar do Egito?
12 Wi tell yu for Egypt sey, ‘Make yu leave us as wi dey serve Egypt pipol! E for betta sey wi dey serve Egypt pipol, dan to kom die inside dis wildaness o-o!’ ”
12 Não é esta a palavra que te falamos no Egito, dizendo: Deixa-nos sozinhos, para que sirvamos aos egípcios? Pois melhor nos seria servir aos egípcios do que morrermos no deserto.
13 Moses kon tell di pipol, “Make una nor fear! Make una get faith and una go si how God go take save una; bikos dis Egypt sojas wey una dey si today so, una nor go ever si dem again.
13 E Moisés disse ao povo: Não temais, aquietai-vos e vede a salvação do SENHOR, que ele hoje vos fará; porque aos egípcios que hoje vistes, nunca mais tornareis a ver.
14 God go fight for una, so make una nor worry.”
14 O SENHOR lutará por vós, e tereis vossa paz.
15 Den Oga God tell Moses, “Wetin make yu dey kry to mi? Tell di pipol make dem move go front.
15 E o SENHOR disse a Moisés: Por que clamas a mim? Dize aos filhos de Israel que avancem.
16 But make yu yorsef raiz yor stik kon take am divide di Red Sea, so dat Israel pipol go waka pass for dry groun.
16 Mas tu, levanta o teu cajado, e estende a tua mão sobre o mar, e divide-o, e os filhos de Israel irão por solo seco pelo meio do mar.
17 But I go make Egypt sojas heart strong, so dat dem go porshu una and pipol go honor mi, bikos of wetin I go do to Fero, en shariot and doz wey dey ride dem.
17 E eis que, eu endurecerei o coração dos egípcios, e eles os seguirão, e eu obterei honra sobre Faraó, e sobre todo o seu exército, sobre suas carruagens, e sobre os seus cavaleiros.
18 Den Egypt pipol go know sey na mi bi God wen I don kollect my glory for wetin I go do Fero, en shariot and doz wey dey ride dem.”
18 E os egípcios saberão que eu sou o SENHOR, quando eu tiver obtido honra sobre Faraó, sobre as suas carruagens, e sobre os seus cavaleiros.
19 God angel wey dey lead Israel pipol kon go dia back and di kloud move komot from dia front go dia back.
19 E o anjo de Deus, que ia adiante do acampamento de Israel, retirou-se e foi atrás deles, e a coluna foi de diante da face deles, e se colocou atrás deles,
20 Di kloud dey between Egypt pipol kamp and Israel pipol own. Di kloud make evriwhere dark for Egypt pipol, but give lite to Israel pipol, so dem nor fit near each oda till day break.
20 e se colocou entre o acampamento dos egípcios e o acampamento de Israel, e havia uma nuvem e escuridão para eles, mas clareava a noite para estes; de maneira que não se aproximou um do outro durante toda a noite.
21 So Moses stresh en hand face di sea and God kon divide di sea with strong breeze for nite, den di wota turn to dry land.
21 E Moisés estendeu a sua mão sobre o mar, e o SENHOR fez o mar voltar por meio de um forte vento oriental durante toda aquela noite, e fez do mar terra seca, e as águas foram divididas.
22 So Israel pipol waka pass di sea for dry groun; di wota kon form wall for dia rite and left side.
22 E os filhos de Israel entraram pelo meio do mar sobre a terra seca, e as águas eram para eles como um muro à sua direita, e à sua esquerda.
23 All Fero shariot and doz wey dey ride dem kon porshu Israel pipol enter di Red Sea for dry land.
23 E os egípcios seguiram, e entraram atrás deles até o meio do mar, com todos os cavalos de Faraó, as suas carruagens e os seus cavaleiros.
24 As day won break, God look Egypt sojas thru di fire and di kloud kon make dem konfuse.
24 E aconteceu que, na vigília da manhã, o SENHOR olhou para o exército dos egípcios por entre a coluna de fogo e de nuvem, e incomodou o exército dos egípcios,
25 E make dia shariot taya sink and dem nor fit ride fast, den Egypt sojas kon sey, “Make wi run go back from dis pipol, na God dey fight us bikos of dem.”
25 e torceu os eixos das rodas de suas carruagens, para que eles andassem pesadamente. Então disseram os egípcios: Fujamos da face de Israel, porque o SENHOR luta por eles contra os egípcios.
26 God kon tell Moses, “Make yu stresh yor hand face di sea, so dat di wota go fall kon kover all Egypt sojas, dia shariot and doz wey dey ride dem.”
26 E o SENHOR disse a Moisés: Estende a tua mão sobre o mar, para que as águas venham novamente sobre os egípcios, sobre as suas carruagens e sobre os seus cavaleiros.
27 So Moses stresh en hand face di sea and wen morning rish, di sea don go back to di way e bi before. For dis time, Egypt sojas try to run from di wota, but God kill all of dem inside di sea.
27 E Moisés estendeu a sua mão sobre o mar, e o mar voltou à sua força ao amanhecer, e os egípcios fugiram contra ele. E o SENHOR derrubou os egípcios no meio do mar.
28 Di wota fall kover di shariot with doz wey dey ride dem and all Fero sojas wey porshu Israel pipol enter di sea, kon die. Moses and Isreal pipol dey cross di Red Sea|alt="Moses is leading Israel to cross di Red Sea" src="cn02097b.tif" size="col" loc="EXO 14:28-31" copy="Cook" ref="14:28-31"
28 E as águas retornaram e cobriram as carruagens, e os cavaleiros, e todo o exército de Faraó que entrou no mar depois deles; não restou nenhum deles.
29 But Israel pipol waka pass di sea for dry groun and di wota form wall for dem, both for dia rite and left side.
29 Mas os filhos de Israel caminharam sobre terra seca no meio do mar; e as águas eram para eles como um muro à sua direita e à sua esquerda.
30 So for dat day, Oga God save Israel pipol from Egypt pipol hand. Leta, Israel pipol kon si Egypt pipol dead body for di wotaside.
30 Assim, naquele dia, o SENHOR salvou Israel da mão dos egípcios; e Israel viu os egípcios mortos na praia do mar.
31 Wen Israel pipol si how di Oga dia God take fight Egypt pipol with en mighty pawa, dem kon dey fear am. So, dem kon bilive God and en savant, Moses.
31 E Israel viu a grande obra que o SENHOR fez sobre os egípcios, e o povo temeu ao SENHOR e creu no SENHOR, e no seu servo Moisés.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Êxodo 14, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.