Êxodo 13

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs VC

Sair da comparação
VC Versão Católica
1 God kon tell Moses:
1 O Senhor disse a Moisés:
2 “Make yu dedikate all di first-born wey bi man for Israel give mi, weda na human being or animals.”
2 "Consagrar-me-ás todo primogênito entre os israelitas, tanto homem como animal: ele será meu."
3 So Moses tell di pipol, “Make una remember today wey una komot from Egypt where una for bi slave. Dis na di day wey di Oga una God take una komot with en great pawa. So make nobody chop bread wey get yist.
3 Moisés disse ao povo: "Conservareis a memória deste dia, em que saístes do Egito, da casa da servidão, porque foi pelo poder de sua mão que o Senhor vos fez sair deste lugar; não comereis pão fermentado.
4 Una komot from Egypt for Abib mont.
4 Vós saís hoje do Egito, no mês das espigas.
5 Afta God don take una enter Kanaan, Hit, Amor, Hiv and Jebus pipol land; di place wey E promise una grand-grand papa sey E go give dem, land wey good well-well, den una go dey celebrate dis feast for di first mont for evry year.
5 Assim, pois, quando o Senhor te houver introduzido na terra dos cananeus, dos hiteus, dos amorreus, dos heveus e dos jebuseus, que jurou a teus pais te dar, terra que mana leite e mel, observarás este rito neste mesmo mês.
6 For seven days, make una chop bread wey nor get yist and for di sevent day, una go do feast for di Oga una God.
6 Durante sete dias comerás pães sem fermento, e no sétimo dia haverá uma festa em honra do Senhor.
7 Una go chop bread wey nor get yist for seven days and make una nor keep any bread wey get yist for una house.
7 Comer-se-ão pães sem fermento durante sete dias. Não se verão em tua casa, em toda a extensão do território, nem pães fermentados nem fermento.
8 “Make una tell una shidren for dat day sey, ‘All dis tins wey wi dey do so, na bikos of wetin awa God do for us wen wi komot from Egypt.’
8 Explicarás então a teu filho: isso é em memória do que o Senhor fez por mim, quando saí do Egito.
9 Dis go bi like sign wey una put for una hand and fore head, so dat Oga God law go dey una mout, bikos na with en strong hand E take karry una komot Egypt.
9 Será isso para ti como um sinal sobre tua mão, como uma marca entre os teus olhos, a fim de que tenhas na boca a lei do Senhor, porque foi graças à sua poderosa mão que o Senhor te fez sair do Egito.
10 Una must celebrate dis feast for di rite time for di year.
10 Observarás a cada ano essa prescrição no tempo prescrito.
11 “Wen di Oga una God don take una enter Kanaan pipol land as E promise una and una grand-grand papa,
11 "Quando o Senhor te houver introduzido na terra dos cananeus, como ele jurou a ti e a teus pais, e te houver dado essa terra,
12 una must give all di first-born wey bi man, both human being and animals to Oga God.
12 consagrarás ao Senhor todo primogênito; mesmo os primogênitos de teus animais, os machos, serão do Senhor.
13 Una fit take donkey first-born from God if una gi-am one lamb or yong goat. But if una nor kollect am back, una must break en neck. But una must buy una first son back.
13 Entretanto, resgatarás com um cordeiro todo primogênito do jumento; do contrário, quebrar-lhe-ás a nuca. Todo primogênito dos homens entre teus filhos, resgatá-lo-ás igualmente.
14 “Wen una son ask una for future sey, ‘Wetin dis tin mean?’ Una go ansa, ‘Na with mighty pawa God take komot us from Egypt where wi for bi slaves.
14 E, quando teu filho te perguntar um dia o que isso significa, dir-lhe-ás: é que o Senhor nos tirou do Egito com sua mão poderosa, da casa da servidão.
15 Wen Fero nor gri free us, di Oga awa God kon kill all di first sons for Egypt, both human being and animal. Dis na di rizin why wi dey sakrifice all di first-born son give God, but wi dey buy dem back.’
15 E, como o faraó se obstinasse em não nos deixar partir, o Senhor matou todos os primogênitos do Egito, desde os primogênitos dos homens até os dos animais. Eis por que sacrifico ao Senhor todos os primogênitos machos dos animais, e devo resgatar todo primogênito entre meus filhos.
16 Dis matter go bi like sign for una hand and fore head, so dat una go remember as di Oga God take karry us komot from Egypt with en mighty pawa.”
16 Isso será como um sinal sobre tua mão e como uma marca entre teus olhos, porque foi pelo poder de sua mão que o Senhor nos tirou do Egito".
17 Wen Fero free di pipol, God nor take dem pass Filistia pipol land even doh, na dat side near pass, bikos God sey, “Make di pipol nor go shange dia mind wen dem si war kon sey, ‘Wi won go back to Egypt.’ ”
17 Tendo o faraó deixado partir o povo, Deus não o conduziu pelo caminho da terra dos filisteus, que é, no entanto, o mais curto, pois disse: "Talvez o povo possa arrepender-se, no momento em que tiver de enfrentar um combate e voltar para o Egito".
18 So God lead di pipol pass di wildaness wey face di Red Sea. And Israel pipol prepare demsef for war as dem dey komot from Egypt.
18 Por isso, Deus fez com que o povo desse uma volta pelo deserto, para o lado do mar Vermelho. Os israelitas partiram do Egito em boa ordem.
19 Moses pak Josef bones, bikos Josef don make Israel pipol swear wen e sey, “God go kom save una and una must karry my bones komot from dis place.”
19 Moisés levou consigo os ossos de José, porque este fizera os filhos de Israel jurarem: "Quando Deus vos visitar, levareis daqui os meus ossos convosco".
20 So dem travel from Sukkot go Etam for di wildaness korna.
20 Tendo partido de Socot, acamparam em Etão, na extremidade do deserto.
21 Naw, God dey lead dem with kloud for day time, den for nite, E dey lead dem with fire, so dat dem go fit travel both for day and nite.
21 O Senhor ia adiante deles: de dia numa coluna de nuvens para guiá-los pelo caminho; e de noite numa coluna de fogo para alumiá-los; de sorte que podiam marchar de dia e de noite.
22 Oga God nor remove di kloud for day time or di fire for nite.
22 Nunca a coluna de nuvens deixou de preceder o povo durante o dia, nem a coluna de fogo durante a noite.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Êxodo 13, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.