Êxodo 12
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NVI
1 God tell Moses and Aaron for Egypt,
1 O Senhor disse a Moisés e a Arão, no Egito:
2 “Dis mont na di first mont for di year for una.
2 "Este deverá ser o primeiro mês do ano para vocês.
3 Make una tell Israel pipol sey, ‘For di tent day for dis mont, all di men go choose one yong sheep or goat for en family.
3 Digam a toda a comunidade de Israel que no décimo dia deste mês todo homem deverá separar um cordeiro ou um cabrito, para a sua família, um para cada casa.
4 If en family too small to chop one full animal, en and en neighbour wey dey stay near am go share one animal akordin to di pipol and how dem go fit chop rish.
4 Se uma família for pequena demais para um animal inteiro, deve dividi-lo com seu vizinho mais próximo, conforme o número de pessoas e conforme o que cada um puder comer.
5 Make di animal wey una choose dey okay; animal wey neva pass one year and e must bi man sheep or goat wey nor dey cripple or get sickness.
5 O animal escolhido será macho de um ano, sem defeito, e pode ser cordeiro ou cabrito.
6 “ ‘Una must kare for am until di fourteent day for dis mont, den for evening, di whole kommunity for Israel go kill all di animals.
6 Guardem-no até o décimo quarto dia do mês, quando toda a comunidade de Israel irá sacrificá-lo, ao pôr-do-sol.
7 Dem go take some of di blood put for di two door post and on-top di door for all di house wey dem go for chop di animal.
7 Passem, então, um pouco do sangue nas laterais e nas vigas superiores das portas das casas nas quais vocês comerão o animal.
8 For dat same nite, dem go roast and chop di meat with bitter leaf and bread wey nor get yist.
8 Naquela mesma noite comerão a carne assada no fogo, juntamente com ervas amargas e pão sem fermento.
9 Make una nor chop raw or meat wey dem boil, but make una roast am for fire well-well with en head, leg and all di parts for en body.
9 Não comam a carne crua, nem cozida em água, mas assada no fogo: cabeça, pernas e vísceras.
10 Una must chop evritin finish before day break kon burn anytin wey remain for morning.
10 Não deixem sobrar nada até pela manhã; caso isso aconteça, queimem o que restar.
11 “ ‘Na like dis una go take chop am: make una dress like who dey travel; wear una shoe kon hold una stik for hand. Make una rush chop am, bikos dis na Oga God Passova.
11 Ao comerem, estejam prontos para sair: cinto no lugar, sandálias nos pés e cajado na mão. Comam apressadamente. Esta é a Páscoa do Senhor.
12 Dat same nite, I go pass thru Egypt kon kill all di first-born son inside Egypt, both human being and animals, den I go judge all di gods for Egypt. Na mi bi di Oga una God.
12 "Naquela mesma noite passarei pelo Egito e matarei todos os primogênitos, tanto dos homens como dos animais, e executarei juízo sobre todos os deuses do Egito. Eu sou o Senhor!
13 Di blood go bi sign sey na una dey dat house, so dat wen I si di blood, I go waka pass and I nor go tosh una wen I dey ponish Egypt pipol.
13 O sangue será um sinal para indicar as casas em que vocês estiverem; quando eu vir o sangue, passarei adiante. A praga de destruição não os atingirá quando eu ferir o Egito.
14 Una go dey remember dis day and celebrate am to di Oga una God forever.
14 "Este dia será um memorial que vocês e todos os seus descendentes o comemorarão como festa ao Senhor. Comemorem-no como decreto perpétuo.
15 “ ‘For seven days, una must chop bread wey nor get yist. So for di first day, una must remove di yist wey dey una house, bikos if anybody chop bread wey get yist from di first day go rish di sevent day, I go kill-am.
15 Durante sete dias comam pão sem fermento. No primeiro dia tirem de casa o fermento, porque quem comer qualquer coisa fermentada, do primeiro ao sétimo dia, será eliminado de Israel.
16 For di first and sevent day, make una gada kom woship mi. Nobody go work for doz days, escept una won do wetin una go chop.
16 Convoquem uma reunião santa no primeiro dia e outra no sétimo. Não façam nenhum trabalho nesses dias, exceto o da preparação da comida para todos. É só o que poderão fazer.
17 “ ‘So make una kontinue to celebrate dis feast, bikos na di day wey I take una komot from Egypt and una go dey celebrate am forever.
17 "Celebrem a festa dos pães sem fermento, porque foi nesse mesmo dia que eu tirei os exércitos de vocês do Egito. Celebrem esse dia como decreto perpétuo por todas as suas gerações.
18 For evening for di fourteent day for di first mont, make una chop bread wey nor get yist, until di twenty-first day evening for di same mont.
18 No primeiro mês comam pão sem fermento, desde o entardecer do décimo quarto dia até o entardecer do vigésimo primeiro.
19 Yist must nor dey una house for seven days and anybody wey chop anytin wey get yist, nor go dey among Israel kommunity again. Weda na strenja or Israel pesin wey dem born for di land.
19 Durante sete dias vocês não deverão ter fermento em casa. Quem comer qualquer coisa fermentada será eliminado da comunidade de Israel, seja estrangeiro, seja natural da terra.
20 Make una nor chop anytin wey get yist and anywhere wey una go stay, una must nor chop bread wey get yist.’ ”
20 Não comam nada fermentado. Onde quer que morarem, comam apenas pão sem fermento".
21 Den Moses gada di eldas for Israel kon tell dem, “Make all di family kill one yong sheep or goat take celebrate di Passova.
21 Então Moisés convocou todas as autoridades de Israel e lhes disse: "Escolham um cordeiro ou um cabrito para cada família. Sacrifiquem-no para celebrar a Páscoa!
22 Make una deep di plant wey dem dey koll hyssop inside di blood, den take di blood rub di two pole for di door and di one wey cross dem for up. And make anybody nor komot from inside en house until morning.
22 Molhem um feixe de hissopo no sangue que estiver na bacia e passem o sangue na viga superior e nas laterais das portas. Nenhum de vocês poderá sair de casa até o amanhecer.
23 Bikos Oga God go waka pass Egypt kon kill pipol, but wen E si di blood for di up and two side for una door, E go waka pass and E nor go enter una house kon kill una.
23 Quando o Senhor passar pela terra para matar os egípcios, verá o sangue na viga superior e nas laterais da porta e passará sobre aquela porta; e não permitirá que o destruidor entre na casa de vocês para matá-los.
24 “Una and una shidren must kontinue to obey dis law forever.
24 "Obedeçam a estas instruções como decreto perpétuo para vocês e para os seus descendentes.
25 And wen una don enter di land wey di Oga una God go give una, just as E tok, una must do dis ofrin.
25 Quando entrarem na terra que o Senhor prometeu lhes dar, celebrem essa cerimônia.
26 Wen una shidren ask una sey, ‘Wetin dis ofrin mean?’
26 Quando os seus filhos lhes perguntarem: ‘O que significa esta cerimônia? ’,
27 Den una go ansa, ‘Na di Passova sakrifice for di Oga awa God, wen E kill Egypt pipol kon save wi and awa family.’ ” Den Israel pipol bow woship
27 respondam-lhes: É o sacrifício da Páscoa ao Senhor, que passou sobre as casas dos israelitas no Egito e poupou nossas casas quando matou os egípcios". Então o povo curvou-se em adoração.
28 kon do as God kommand dem thru Moses and Aaron.
28 Depois os israelitas se retiraram e fizeram conforme o Senhor tinha ordenado a Moisés e a Arão.
29 Dat nite, Oga God kill all di first-born son for Egypt and na from Fero first-born go rish doz wey dey prison and di animals first-born.
29 Então, à meia-noite, o Senhor matou todos os primogênitos do Egito, desde o filho mais velho do faraó, herdeiro do trono, até o filho mais velho do prisioneiro que estava no calabouço, e também todas as primeiras crias do gado.
30 Fero with all en savants and evribody for Egypt wake-up for nite bigin kry well-well, bikos e nor get any house where pesin nor for die.
30 No meio da noite o faraó, todos os seus conselheiros e todos os egípcios se levantaram. E houve grande pranto no Egito, pois não havia casa que não houvesse um morto.
31 Dat same nite, di king kon sey make dem go koll Moses and Aaron, den e tell dem, “Make yu and yor pipol komot from my kountry go woship di Oga una God, just as yu tok.
31 Naquela mesma noite o faraó mandou chamar Moisés e Arão e lhes disse: "Saiam imediatamente do meio do meu povo, vocês e os israelitas! Vão prestar culto ao Senhor, como vocês pediram.
32 Make yu still take una sheep, goat and kattles follow body. But bless mi too.”
32 Levem os seus rebanhos, como tinham dito, e abençoem a mim também".
33 Egypt pipol bigin enkourage Israel pipol, so dat dem go kwik komot, bikos dem dey sey, “All of us go die finish, if una nor komot for here.”
33 Os egípcios pressionavam o povo para que se apressasse em sair do país, dizendo: "Todos nós morreremos! "
34 So di pipol fill dia bakin pan with bread wey nor get yist, tie am join dia klot kon karry dem put for dia shoulder.
34 Então o povo tomou a massa de pão ainda sem fermento e a carregou nos ombros, nas amassadeiras embrulhadas em suas roupas.
35 Israel pipol kon do as Moses tell dem. Dem ask Egypt pipol for silva, gold and klot.
35 Os israelitas obedeceram à ordem de Moisés e pediram aos egípcios objetos de prata e de ouro, bem como roupas.
36 God make Egypt pipol favor en pipol and dem kon give Israel pipol evritin wey dem wont. Like dis, Israel pipol karry all di propaty for Egypt follow body.
36 O Senhor concedeu ao povo uma disposição favorável da parte dos egípcios, de modo que lhes davam o que pediam; assim eles despojaram os egípcios.
37 Israel pipol bigin travel with leg from Rameses go Sukkot. Israel men wey travel rish 600,000 (Dem nor kount wimen and shidren join am).
37 Os israelitas foram de Ramessés até Sucote. Havia cerca de seiscentos mil homens a pé, além de mulheres e crianças.
38 Many strenjas still follow Israel pipol komot from Egypt with all dia sheep, goat and kattle.
38 Grande multidão de estrangeiros de todo tipo seguiu com eles, além de grandes rebanhos, tanto de bois como de ovelhas e cabras.
39 Dem bake bread wey nor get yist with di bakin pan wey dem dey karry komot Egypt. Di bread nor get yist, bikos dem hurry dem komot from Egypt, so dem nor get time to prepare food for demsef.
39 Com a massa que haviam trazido do Egito, fizeram pães sem fermento. A massa não tinha fermentado, pois eles foram expulsos do Egito e não tiveram tempo de preparar comida.
40 Israel pipol stay for Egypt for four hundred and thirty years.
40 Ora, o período que os israelitas viveram no Egito foi de quatrocentos e trinta anos.
41 Israel pipol komot for Egypt for di day wey di four hundred and thirty years komplete.
41 No dia quando se completaram os quatrocentos e trinta anos, todos os exércitos do Senhor saíram do Egito.
42 Na dat nite God take save dem komot from Egypt and dem go dey dedikate dat nite to God from one generashon go rish anoda.
42 Assim como o Senhor passou em vigília aquela noite para tirar do Egito os israelitas, estes também devem passar em vigília essa mesma noite, para honrar ao Senhor, por todas as suas gerações.
43 So God tell Moses and Aaron, “Dis na di law wey follow di Passova. No strenja go chop from di Passova food.
43 Disse o Senhor a Moisés e a Arão: "Estas são as leis da Páscoa: Nenhum estrangeiro poderá comê-la.
44 But any slave wey yu buy wey dem sekonsaiz, fit chop am.
44 O escravo comprado poderá comer da Páscoa, depois de circuncidado,
45 Any strenja or worker wey dem hire must nor chop from am.
45 mas o residente temporário e o trabalhador contratado dela não comerão.
46 Evribody must chop am inside di house where dem for prepare am and make dem nor karry am from one house go anoda. Make una nor break any of di animals bone.
46 "Vocês a comerão numa só casa; não levem nenhum pedaço de carne para fora da casa, nem quebrem nenhum dos ossos.
47 Israel pipol must always dey celebrate dis feast.
47 Toda a comunidade de Israel terá que celebrar a Páscoa.
48 “Any strenja wey dey stay with una wey like to celebrate Oga God Passova, dem must sekonsaiz dia men, den una must si dem as Israel pipol.
48 "Qualquer estrangeiro residente entre vocês que quiser celebrar a Páscoa do Senhor terá que circuncidar todos os do sexo masculino da sua família; então poderá participar como o natural da terra. Nenhum incircunciso poderá participar.
49 Anybody, weda dem born as Israel pesin or strenja wey dey stay with una, must obey dis law.”
49 A mesma lei se aplicará ao natural da terra e ao estrangeiro residente".
50 So Israel pipol kon do as Moses and Aaron kommand dem.
50 Todos os israelitas fizeram como o Senhor tinha ordenado a Moisés e a Arão.
51 For dat day, Oga God take Israel pipol komot from Egypt akordin to der tribe.
51 No mesmo dia o Senhor tirou os israelitas do Egito, organizados segundo as suas divisões.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Êxodo 12, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.