Êxodo 11
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARA
1 God kon tell Moses, “I go bring di last wahala to take ponish Fero and Egypt pipol and afta dis one, e go free una. E go drive una komot with evritin wey una get.
1 Disse o Senhor a Moisés: Ainda mais uma praga trarei sobre Faraó e sobre o Egito. Então, vos deixará ir daqui; quando vos deixar, é certo que vos expulsará totalmente.
2 So make yu go tell Israel pipol make dem ask dia neighbour for silva and gold.”
2 Fala, agora, aos ouvidos do povo que todo homem peça ao seu vizinho, e toda mulher, à sua vizinha objetos de prata e de ouro.
3 (Naw, God don make Egypt pipol love Israel pipol. Even sef Moses kon bi one very big pesin for Egypt and Fero savants and Egypt pipol dey respet am.)
3 E o Senhor fez que o seu povo encontrasse favor da parte dos egípcios; também o homem Moisés era mui famoso na terra do Egito, aos olhos dos oficiais de Faraó e aos olhos do povo.
4 Moses sey, “Oga God sey for mid-nite, I go waka pass evriwhere inside Egypt
4 Moisés disse: Assim diz o Senhor : Cerca da meia-noite passarei pelo meio do Egito.
5 and all di first-born son for Egypt, go die. I go start from Fero first-born wey go take-ova en papa throne, go rish di first-born wey en slave girls wey dey grind korn born and all di first-born among en animals.
5 E todo primogênito na terra do Egito morrerá, desde o primogênito de Faraó, que se assenta no seu trono, até ao primogênito da serva que está junto à mó, e todo primogênito dos animais.
6 Strong kry go dey evriwhere for Egypt; pipol neva kry like dat before and dem nor go ever kry like dat again.
6 Haverá grande clamor em toda a terra do Egito, qual nunca houve, nem haverá jamais;
7 But for Israel pipol side, peace go dey well-well, even dog nor go bark for anybody or animal, den yu go know sey Oga God don separate Israel pipol from Egypt pipol.
7 porém contra nenhum dos filhos de Israel, desde os homens até aos animais, nem ainda um cão rosnará, para que saibais que o Senhor fez distinção entre os egípcios e os israelitas.
8 All dis yor savants go kom meet and bow for mi sey, ‘Make yu and all di pipol wey dey follow yu komot for here’ and afta dis, I go komot for here too.” With vexnashon, Moses kon waka leave Fero.
8 Então, todos estes teus oficiais descerão a mim e se inclinarão perante mim, dizendo: Sai tu e todo o povo que te segue. E, depois disto, sairei. E, ardendo em ira, se retirou da presença de Faraó.
9 God kon tell Moses, “Fero nor go gri listin to yu, so dat I go fit do my plenty wonders for Egypt.”
9 Então, disse o Senhor a Moisés: Faraó não vos ouvirá, para que as minhas maravilhas se multipliquem na terra do Egito.
10 So Moses and Aaron do all dis wonders wey Fero si, but God make Fero heart strong, so dat e nor go let Israel pipol komot from Egypt.
10 Moisés e Arão fizeram todas essas maravilhas perante Faraó; mas o Senhor endureceu o coração de Faraó, que não permitiu saíssem da sua terra os filhos de Israel.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Êxodo 11, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.