Êxodo 10
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NAA
1 Den God kon tell Moses, “Make yu go meet Fero, bikos I don make en and en savants heart strong, so dat I go fit show dem all dis my mirakles.
1 O Senhor disse a Moisés: — Vá falar com Faraó, porque lhe endureci o coração e o coração de seus oficiais, para que eu faça estes meus sinais no meio deles,
2 All dis tins dey happen, so dat yu go fit tell yor shidren and grand-shidren how I take fool Egypt pipol with my mirakles, make dem for know sey na mi bi God.”
2 e para que você possa contar aos seus filhos e aos filhos de seus filhos como zombei dos egípcios e quantos sinais fiz no meio deles, e para que vocês saibam que eu sou o Senhor .
3 So Moses and Aaron go meet Fero kon tell am, “God wey bi Hibru pipol God sey: ‘Na how long e go take yu before yu go honbol yorsef for where I dey? Make yu let my pipol go woship mi!
3 Moisés e Arão apresentaram-se a Faraó e lhe disseram: — Assim diz o
4 But if yu nor gri let dem go, I go make lokust full yor kountry tumoro.
4 Se você não deixar o meu povo ir, eis que amanhã trarei gafanhotos ao seu território.
5 Di lokust dem go plenty well-well kon kover evriwhere and nobody go si ordinary groun. Dem go chop all di tins wey remain from wetin di ice-blok rain distroy and dem go chop all di trees for field.
5 Eles cobrirão de tal maneira a face da terra que não será possível ver o chão. Comerão o restante que escapou, o que restou depois da chuva de pedras, e comerão todas as árvores que crescem no campo.
6 Di lokust dem go full yor house, yor savants house and all Egypt pipol house and e go plenty pass wetin una papa and grand-grand papa don ever si since wen dem dey di land kon rish today!’ ” Den Moses turn kon waka leave Fero.
6 Os gafanhotos encherão as suas casas, as casas de todos os seus oficiais e as casas de todos os egípcios, como nunca viram os seus pais, nem os seus antepassados desde o dia em que se estabeleceram na terra até o dia de hoje.” Moisés virou-se e saiu da presença de Faraó.
7 Fero savants ask am, “Na how long dis man go dey trobol us? Make yu free di pipol make dem go serve di Oga wey bi dia God. Yu nor know sey Egypt don distroy finish?”
7 Então os oficiais de Faraó disseram: — Até quando este homem será um perigo para nós? Deixe essa gente ir, para que adorem o
8 So dem bring Moses and Aaron kom back kon si Fero and e tell dem, “Make una go serve di Oga una God. But na wish pipol dey follow una go?”
8 Então Moisés e Arão foram conduzidos à presença de Faraó, e este lhes disse: — Vão e adorem o
9 Moses ansa am, “Wi go-go with awa yong and old pipol; all awa shidren and all awa animals, bikos wi dey travel go do sakrifice to take honor di Oga awa God.”
9 Moisés respondeu: — Iremos com os nossos jovens, com os nossos velhos, com os filhos, com as filhas, com os nossos rebanhos e com os nossos gados. Iremos, porque temos de celebrar uma festa ao
10 Den Fero tell dem, “I swear with God sey, I nor go let una take una wimen and shidren follow body! E klear sey yu really get wiked plan!
10 Então Faraó disse: — Que o
11 So make only di men go serve Oga God, bikos dat na wetin yu wont.” Den Fero drive Moses and Aaron komot for en front.
11 Mas não é assim que vai ser. Vão somente vocês, os homens, e adorem o Senhor , pois é isso o que vocês estão pedindo. E os expulsaram da presença de Faraó.
12 God tell Moses, “Make yu stresh yor hand face Egypt, so dat di lokust go kom kover evriwhere and dem go chop all di plants wey dey grow wey di ice-blok distroy remain.”
12 Então o Senhor disse a Moisés: — Estenda a mão sobre a terra do Egito, para que venham gafanhotos sobre a terra do Egito e comam toda a vegetação da terra, tudo o que a chuva de pedras não destruiu.
13 So Moses stresh di stik wey dey en hand face Egypt. At wons, Oga God make one strong breeze from east blow kom Egypt, both for day and nite. For morning, di breeze from east don karry lokust enter di land.
13 Moisés estendeu o seu bordão sobre a terra do Egito, e o Senhor trouxe sobre a terra um vento leste todo aquele dia e toda aquela noite. Quando amanheceu, o vento leste tinha trazido os gafanhotos.
14 Di lokust kover evriwhere for Egypt, plus di arias wey dey near der. Di wahala strong well-well and dem neva si any lokust like dat before and dem nor go ever si any lokust like dat again.
14 E os gafanhotos se espalharam por toda a terra do Egito e pousaram sobre todo o seu território. Eram muito numerosos. Antes destes, nunca houve tantos gafanhotos, nem depois deles virão outros assim.
15 Di lokust kover di groun kon make am black, den chop all di plants and fruits wey dey for di tree wey di ice-blok distroy remain. No leaf remain for di tree and all di plants and grass, die finish for Egypt.
15 Porque cobriram a superfície de toda a terra, de modo que a terra se escureceu. Devoraram toda a vegetação da terra e todo fruto das árvores que a chuva de pedras não havia destruído. E não restou nada verde nas árvores, nem na vegetação do campo, em toda a terra do Egito.
16 Den Fero kwik-kwik sey make dem koll Moses and Aaron and e tell dem, “I don sin against di Oga una God and against una!
16 Então Faraó se apressou em chamar Moisés e Arão e lhes disse: — Pequei contra o
17 Make una forgive mi for dis last time and pray to di Oga una God, so dat E go remove dis sofa from mi.”
17 Agora peço que me perdoem o pecado ainda esta vez e que orem ao Senhor , seu Deus, para que tire de mim esta praga mortal.
18 So Moses komot from Fero front kon go pray to Oga God.
18 Moisés saiu da presença de Faraó e orou ao Senhor .
19 Den God send anoda strong breeze from di sea and e karry all di lokust enter di Red Sea. No lokust remain for Egypt again.
19 Então o Senhor fez soprar um vento oeste muito forte, que levantou os gafanhotos e os lançou no mar Vermelho. Não restou um só gafanhoto em todo o território do Egito.
20 But God still make Fero heart strong and e nor gri free Israel pipol.
20 O Senhor , porém, endureceu o coração de Faraó, e este não deixou ir os filhos de Israel.
21 Den God tell Moses, “Make yu stresh yor hand go heaven, so dat darkness go kover Egypt and dem go feel am, bikos e go tick well-well.”
21 Então o Senhor disse a Moisés: — Estenda a mão para o céu, e virão trevas sobre a terra do Egito, trevas que se possam apalpar.
22 So Moses stresh en hand go heaven and for three days, tick darkness kon dey evriwhere for Egypt.
22 Moisés estendeu a mão para o céu, e houve trevas espessas sobre toda a terra do Egito durante três dias.
23 Nobody fit si each oda and nobody fit stand up komot for where e dey for three days. But Israel pipol get lite for where dem dey.
23 Os egípcios não podiam ver uns aos outros, e ninguém se levantou do seu lugar durante três dias. Porém todos os filhos de Israel tinham claridade nas suas casas.
24 Den Fero send for Moses kon tell am, “Make una go serve di Oga una God, both una and una family, but una animals go dey here for Egypt.”
24 Então Faraó chamou Moisés e lhe disse: — Vão e adorem o
25 But Moses ask am, “Yu go give us di animals wey wi go take do sakrifice and burnt ofrin to di Oga wey bi awa God?
25 Moisés respondeu: — Então você teria de nos providenciar os animais para os sacrifícios e holocaustos que queremos oferecer ao
26 All awa animal must go with us and no one go remain. Wi must take di animals go serve awa God. Until wi rish der, wi nor go fit know wetin to take serve awa God.”
26 Por isso os nossos rebanhos irão conosco. Nem um casco de animal ficará para trás, porque temos de escolher alguns para oferecer em sacrifício ao Senhor , nosso Deus. E, enquanto não chegarmos lá, não saberemos com que animais teremos de adorar o Senhor .
27 But God still make Fero heart strong and e nor gri free dem.
27 O Senhor , porém, endureceu o coração de Faraó, e este não quis deixá-los ir.
28 So Fero tell Moses, “Make yu komot from where I dey and nor ever kom si mi again, bikos any day wey yu si my face again, yu go die!”
28 Faraó disse a Moisés: — Saia da minha presença e tenha cuidado para nunca mais aparecer aqui. Porque, no dia em que você tornar a ver o meu rosto, será morto.
29 Moses ansa, “Make e bi as yu tok! I nor go si yor face again.”
29 Moisés respondeu: — Como queira! Nunca mais tornarei a ver o seu rosto.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Êxodo 10, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.