Ester 9

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs VC

Sair da comparação
VC Versão Católica
1 Wen di thirtint day for di twelft mont (wey bi Adar mont) rish, di day wey dem suppose do wetin di king tok. Na dis day Jew enemies tink sey dem go distroy Jew pipol finish. Instead na Jew pipol kon distroy dia enemies.
1 No duodécimo mês, que é o de Adar, no dia treze do mês, data em que entrava em vigor a ordem e o edito do rei, no mesmo dia em que os inimigos dos judeus contavam fazer-lhes mal, aconteceu tudo ao contrário, e os judeus dominaram seus inimigos.
2 For anywhere wey Jew pipol dey start for di town, dem kon gada demsef to fight anybody wey won fight dem. Pipol for evriwhere dey fear dem and nobody gri near dem at-all.
2 Estavam reunidos em suas respectivas cidades, em todas as províncias do rei Assuero para levantarem a mão contra aqueles que desejavam sua perda. Ninguém pôde resistir-lhes, porque o terror se tinha apoderado de todos os povos.
3 All di oga for di arias, di shiefs, di govnors and doz wey dey work for di king kon dey assist Jew pipol, bikos dem dey fear Mordekai.
3 Todos os senhores das províncias, os sátrapas, os governadores, os funcionários do rei tomaram o partido dos judeus, por temor de Mardoqueu.
4 Dem kon know Mordekai for evriwhere, bikos en pawa for di palis, dey strong evriday.
4 Porque este ocupava um alto lugar no palácio real e sua fama se espalhava em todas as províncias, onde sua influência não cessava de crescer.
5 So Jew pipol attack all dia enemies with swod kon kill dem well-well. Dem do wetin dem like with dia enemies.
5 Os judeus, pois, feriram todos os seus inimigos a golpes de espada: massacre e extermínio de seus opressores, aos quais trataram como quiseram.
6 Jew pipol kill five hundred men inside Shushan wey bi di main town.
6 Em Susa, na capital, mataram quinhentos homens.
7 Dem still kill Parshandata, Dalfon, Aspatah,
7 Fizeram igualmente perecer Farsandata, Delfon, Esfata,
8 Porata, Adalia, Aridatah,
8 Forata, Adalia, Aridata,
9 Parmashta, Arisai, Aridai, and Vaizata.
9 Fermesta, Arisai, Aridai e Jesata,
10 Dis na Haman wey Hammedata born, wey bi Jew pipol enemy, ten sons. But even as Jew pipol dey do all dis tins, dem nor ever tif or karry any propaty.
10 os dez filhos de Amã, filho de Amedata, o opressor dos judeus. Mas se abstiveram de toda pilhagem.
11 For dat same day, dem kon go tell di king about di pipol wey dem kill for Shushan.
11 Nesse mesmo dia fizeram conhecer ao rei o número das vítimas em Susa, a capital.
12 Den di king tell Kween Estha, “For only Shushan, Jew pipol don kill five hundred men and Haman ten sons! How many dem go don kill for oda aria? So wetin yu still wont? Make yu tell mi and I go do am for yu.”
12 E o rei disse a Ester: Em Susa, na capital, os judeus mataram quinhentos homens e os dez filhos de Amã. Que não terão feito nas outras províncias do rei! {Entretanto}, tens ainda algum pedido? Ser-te-á concedido. Tens algum desejo? Será satisfeito.
13 Estha ansa, “If di king go agri, tumoro, make Jew pipol for Shushan still do wetin dem do today kon hang Haman ten sons body.”
13 Se parecer bem ao rei, respondeu Ester, seja permitido ainda amanhã, aos judeus de Susa, agir conforme ao decreto de hoje, e que se suspendam numa forca os dez filhos de Amã.
14 Di king kon orda sey make dem do am and dem read di law for Shushan, den dem hang Haman sons body.
14 O rei deu ordem para que assim se fizesse. O edito foi publicado em Susa e suspenderam na forca os dez filhos de Amã.
15 For di fourteent day for di twelft mont wey bi Adar, Jew pipol wey dey Shushan kon gada go kill anoda three hundred pipol for di town, but dem nor tosh or tif dia propaty.
15 Os judeus de Susa se reuniram de novo no dia quatorze do mês de Adar, e mataram na cidade trezentos homens, sem entretanto dar-se à pilhagem.
16 Di Jew pipol for di oda aria still gada defend demsef kon kill 75,000 of dia enemies, but dem nor tif or karry dia propaty.
16 Os outros judeus que estavam disseminados pelas províncias do rei se juntaram para defender suas vidas e se pôr a salvo dos ataques de seus inimigos. Massacraram setenta e cinco mil, sem entretanto entregar-se à pilhagem.
17 Dis tin happen for di thirtint day for di twelft mont wey bi Adar. Den, dem stop to kill for di fourteent day kon do party.
17 Era o dia treze do mês de Adar. No dia quatorze repousaram e fizeram um dia de banquete de alegria.
18 Di Jew pipol for Shushan kon rest for di Fifteent day, bikos dem take di thirtint and fourteent day take kill dia enemies.
18 Quanto aos judeus de Susa, que se juntaram no dia treze e catorze do mesmo mês, repousaram no dia quinze, fazendo-o um dia de alegre banquete
19 Dis na why Jew pipol wey dey stay small-small town dey celebrate di fourteent day for di twelft mont wey bi Adar mont, as betta holy day to give gift, food and oda betta tins.
19 Eis por que os judeus do campo, que habitam nas cidades não fortificadas, fazem no dia catorze do mês de Adar, um dia de festa com banquetes de alegria, dia em que mandam presentes uns aos outros.
20 Mordekai rite dis tins kon send am to all Jew pipol wey dey di kingdom, weda dem dey near or far sey,
20 Mardoqueu consignou por escrito todos esses acontecimentos. Enviou cartas a todos os judeus das províncias do rei Assuero, próximas ou longínquas,
21 “For evry year, make una take holy day and celebrate for di fourteent and Fifteent day for Adar, wey bi di twelft mont,
21 para lhes ordenar que celebrassem cada ano o dia catorze e o dia quinze do mês de Adar,
22 bikos na doz days Jew pipol take win dia enemies. Na den dia problem and wahala turn to smile and happiness.” Doz days go bi wen Jew pipol free diasef from dia enemies, so dem go share gifts among demsef and dash poor pipol gifts too.
22 como sendo dias em que tinham sido postos a salvo dos ataques de seus inimigos, e mês em que sua angústia tinha sido trocada em alegria e sua dor em felicidade. Deviam, pois, nesses dias oferecer alegres banquetes, dar-se presentes e praticar generosidade com os pobres.
23 So Jew pipol obey Mordekai and dis celebrashon kon bi tradishon.
23 Os judeus erigiram em costume o que tinham feito na primeira vez e o que Mardoqueu lhes tinha mandado.
24 Haman wey Hammedata from Agag born wey bi Jew pipol enemy, bin make plans to distroy Jew pipol. E don trow dice to choose day wen dem go kill and distroy dem.
24 Porque Amã, filho de Amedata, o agagita, o opressor dos judeus, tinha resolvido perdê-los, e lançado {contra eles} o pur, isto é, a sorte, para exterminá-los e destruí-los.
25 But Estha go meet di king and di king give orda make Haman use en own head karry di wiked plan wey e make. So dem kon hang Haman and en sons.
25 Mas quando Ester se apresentou diante do rei, este ordenou por escrito que a perversa maquinação, tramada contra os judeus, recaísse sobre a cabeça de seu autor e que este e seus filhos fossem suspensos à forca.
26 Dis na why dem dey koll di holy day “Purim” wey mean, “To trow dice.” So, bikos of Mordekai leta and wetin don happen to dem,
26 É por isso que se chamam esses dias Purim, da palavra pur. Assim, conforme o conteúdo dessa carta, conforme o que eles mesmos tinham visto e o que lhes tinha acontecido,
27 Jew pipol kon make law for demsef, dia shidren-shidren and any oda pesin wey go turn to Jew sey, for di rite time for evry year, dem must observe dis two days akordin to wetin Mordekai rite.
27 os judeus instituíram e estabeleceram para si, para sua posteridade e para seus adeptos, o costume irrevogável de celebrar anualmente esses dois dias, segundo a forma prescrita e no tempo marcado.
28 Dem agri sey evribody wey bi Jew for di kingdom must obey dis kommand about “Purim” from one generashon go anoda.
28 Esses dias deviam ser recordados e celebrados de geração em geração, em cada família, em cada província e em cada cidade. Jamais poderiam ser abolidos esses dias dos Purim entre os judeus, nem sua recordação se apagar entre seus descendentes.
29 Den Kween Estha wey bi Abihail dota, still support evritin wey Mordekai rite about “Purim.”
29 A rainha Ester, filha de Abigail, e o judeu Mardoqueu escreveram uma segunda vez com insistência para confirmar a carta sobre os Purim.
30 Dem send di kommand go give Jew pipol for di 127 aria wey King Zazes dey rule. Di kommand na to let Jew pipol know sey dem go get peace and dey save
30 Depois enviaram a todos os judeus das cento e vinte e sete províncias do rei Assuero cartas com palavras de paz,
31 and make dia shidren-shidren obey “Purim law” for di korrect time, just as dem dey follow di fasting and mourning laws. Na Mordekai and Kween Estha kommand dem like dis.
31 e a recomendação de celebrarem fielmente esses dias dos Purim no tempo marcado, como o judeu Mardoqueu e a rainha Ester os tinham instituído, e como eles tinham estabelecido, tanto para si mesmos, como para seus descendentes, com os jejuns e as lamentações.
32 Evritin wey Estha kommand about Purim law, dem rite am for di offisial book.
32 Desse modo, a ordem de Ester confirmou a instituição dos Purim, e tudo isso foi consignado num livro.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Ester 9, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.