Ester 4

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs BKJ

Sair da comparação
1 Wen Mordekai hear evritin wey dey happen, e tear en klot kon wear sak, pak ashes for en head; den e go di town centre kon dey kry.
1 Quando Mardoqueu percebeu tudo o que fora feito, Mardoqueu rasgou as suas vestes, e vestiu-se de pano de saco com cinzas, e saiu para o meio da cidade, e clamou com grande e amargo clamor;
2 But e nor waka pass di king gate: bikos nobody wey wear sak klot go fit pass der.
2 e chegou bem na frente do portão do rei; porque ninguém poderia entrar no portão do rei vestido com pano de saco.
3 And for evry aria where dem for read dis law, Jew pipol wey dey der, dey kry, fast, wear sak klot kon pak ashes for dia head.
3 E em cada província, onde quer que o mandamento do rei e o seu decreto chegavam, havia um grande lamento entre os judeus, e jejum, e choro, e lamúrias; e muitos estavam deitados em pano de saco e em cinzas.
4 Wen Estha savants tell am wetin dey happen, e vex well-well kon sey make dem go remove Mordekai sak klot kon wear am betta klot, but Mordekai nor gri.
4 Assim, as criadas de Ester e os seus camareiros vieram e contaram-lhe isto. Então, a rainha ficou mui angustiada; e ela mandou vestes para vestir a Mardoqueu e tirar-lhe o pano de saco; ele porém não a recebeu.
5 Den Estha koll Hatak, one offisa for di palis wey di king sey make e dey serve am kon send am go ask Mordekai, make e tell am wetin dey happen.
5 Então, Ester chamou Hataque, um dos camareiros do rei, a quem ele havia indicado para atendê-la, e deu-lhe mandado para Mardoqueu, para saber o que era aquilo e porque era.
6 Hatak go meet Mordekai for di town centre for di palis gate.
6 Assim Hataque saiu até Mardoqueu, à rua da cidade, que estava diante do portão do rei.
7 Mordekai tell am evritin wey dey happen and all di money wey Haman sey di kingdom go get, wen dem don kill all Jew pipol.
7 E Mardoqueu lhe contou sobre tudo o que lhe havia acontecido, e sobre a soma de dinheiro que Hamã havia prometido pagar aos tesouros do rei pelos judeus, para destruí-los.
8 E give Hatak one kopy for di kommand wey dem read for Shushan, sey make dem kill all Jew pipol. Mordekai sey make e go give and tell Estha evritin, so dat e go beg di king make e sorry for en pipol.
8 Além disso, ele lhe deu uma cópia do escrito do decreto que foi entregue em Susã para destruí-los, para que a mostrasse a Ester, e a fizesse saber e para lhe ordenar que adentrasse ao rei, para lhe fazer súplica, e lhe pedisse e suplicasse diante dele pelo seu povo.
9 Hatak do as Mordekai tell am,
9 E Hataque veio e contou a Ester as palavras de Mardoqueu.
10 den Estha sey make e go give Mordekai dis message:
10 Mais uma vez Ester falou a Hataque, e deu-lhe um mandamento para Mardoqueu:
11 “If anybody, weda na man or woman enter di inna kourtyard go si di king without sey e koll am, dat pesin must die. Dat na di law; evribody from doz wey dey advise di king go rish evriwhere for di kingdom, know sey na so e bi. But na only one way wi fit take break dis law: if di king show pesin en gold rod, den dem nor go kill dat pesin. But e don rish one mont since di king sey make dem koll mi kom.”
11 Todos os servos do rei, e o povo das províncias do rei, sabem que para qualquer um, seja homem ou mulher, que entrar no átrio interno a ter com o rei sem ser chamado, existe uma lei para levá-lo à morte, exceto aqueles para quem o rei estender o seu cetro de ouro, para que possa viver; mas eu não fui chamada a adentrar ao rei nestes trinta dias.
12 Wen Mordekai hear Estha message,
12 E eles contaram a Mardoqueu as palavras de Ester.
13 e kon sey make dem go warn am, “Make yu nor feel sey yu dey save pass any oda Jew pesin, bikos yu dey stay for palis.
13 Então, Mardoqueu ordenou que se respondesse a Ester: Não imagines que, estando na casa do rei, escaparás só tu entre todos os judeus.
14 If yu keep kwayet for dis time, God go send help kon from heaven and wi go dey save, but yu go die and yor papa family go end. Yu know weda na bikos of dis tin, na-im make yu bi kween!”
14 Pois se de todo te calares agora, de outra parte se levantará socorro e livramento para os judeus, mas tu e a casa de teu pai perecereis; quem sabe se não foste elevada a rainha para tal tempo como este?
15 So Estha ansa Mordekai:
15 Então, Ester mandou que eles retornassem a Mardoqueu esta resposta:
16 “Go gada all Jew pipol for Shushan, den make una fast and pray for mi. Make una nor chop or drink anytin for three days and nites. Mi and my savants go do di same tin. Afta di fasting, I go-go meet di king, even doh dat kind tin dey against di law. If na dat one go make mi die, den make I die.”
16 Vai, reúne todos os judeus que estão presentes em Susã, e jejuai por mim, e não comais nem bebais por três dias, noite ou dia; da mesma maneira também eu e as minhas criadas jejuaremos; e assim adentrarei à presença do rei, o que está em desacordo com a lei; e se eu perecer, pereço eu.
17 So Mordekai kon go do evritin wey Estha tell am.
17 Assim, Mardoqueu seguiu o seu caminho, e fez segundo tudo o que Ester lhe havia ordenado.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Ester 4, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.