Ester 3
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs VC
1 Afta, King Zazes kon promote Haman wey bi Hammedata pikin from Agag town. E make en pozishon high pass evry oda pozishon for di kingdom.
1 Depois desses acontecimentos, o rei Assuero elevou em dignidade Amã, filho de Amedata, o agagita, e lhe deu um lugar acima de todos os grandes que o rodeavam.
2 Bikos of dis, all di king savants wey dey for di king gate kon dey bow and respet Haman, bikos di king don kommand sey make e bi like dat. But, Mordekai nor gri bow or gi-am respet.
2 Todos os servos do rei, que estavam à sua porta, dobravam o joelho e prostravam-se diante de Amã, por ordem expressa do rei; entretanto, Mardoqueu não queria nem dobrar o joelho, nem prostrar-se.
3 So di king savants wey dey di palis gate kon ask Mordekai, “Wetin make yu dey go against di king kommand?”
3 Por que, pois, lhe diziam os servos que estavam à porta real, desobedeces assim à ordem do rei?
4 And wen dem tok to Mordekai well-well and e nor ansa dem, dem kon tell Haman wetin Mordekai dey do, so dat dem go hear wetin Heman go tok, bikos Mordekai don tell dem sey en na Jew.
4 E como lhe repetissem isso todos os dias, sem que ele fizesse conta, denunciaram-no a Amã, para ver se esse Mardoqueu persistia em sua resolução, pois ele lhes havia dito que era judeu.
5 Wen Haman si sey Mordekai nor gri bow or gi-am respet, e vex well-well
5 Amã viu que Mardoqueu não queria nem inclinar-se, nem prostrar-se diante dele e isso o pôs em cólera.
6 and since e don know naw sey Mordekai na Jew, e kon sey e go ponish am well-well. E kon dey plan to kill all di Jew wey dey di kingdom.
6 Mas teve como pouco vingar-se só de Mardoqueu, cuja raça conhecia, e procurou um meio de exterminar a nação de Mardoqueu, todos os judeus do reino de Assuero.
7 For di twelft year wen King Zazes dey rule, for di first mont wey bi Nisan, Haman kon sey make dem trow dice (na Purim dem dey koll am), so dat e go know di rite day and mont to do wetin e plan. E kon agri to do en plan for di thirtint day for di twelft mont, wey bi Adar.
7 No primeiro mês, chamado Nisã, do ano duodécimo do reinado de Assuero, foi lançado o pur, isto é, a sorte, diante de Amã, para cada dia e para cada mês, até o duodécimo mês, isto é, Adar.
8 So Haman tell di king, “E get one tribe wey dem full evriwhere for dis yor kingdom wey get difren law. Dem nor dey follow di king law. So e nor dey good for di king to allow dem live.
8 Então Amã disse ao rei Assuero: Há em todas as províncias do teu reino uma nação dispersa e separada das outras; suas leis são diferentes das dos demais povos e se nega a observar as leis do rei. Não convém aos interesses do rei deixar essa gente em paz.
9 So my oga, if yu wont, make yu kommand make dem kill all dis pipol. If yu do like dat, den I go get like 10,000 big sak for silva for di royal pus for di kingdom.”
9 Se ao rei lhe parece bem, dê-se ordem de fazê-los perecer, e eu pesarei dez mil talentos de prata nas mãos dos funcionários, para que os recolham ao tesouro real.
10 Di king kon remove en ring wey dem take dey stamp law, so dat e go get pawa kon gi-am to Haman wey bi Hammedata pikin from Agag and dis Haman na Jew enemy.
10 Tirando o anel de seu dedo, o rei o entregou a Amã, filho de Amedata, o agagita, o opressor dos judeus.
11 Di king tell am, “Make yu nor worry about di money, just go do wetin yu like with di pipol.”
11 Eu te entrego, lhe disse, esse dinheiro e ao mesmo tempo esse povo; faze dele o que quiseres.
12 So for di thirtint day for di first mont, Haman koll di king seketry kon sey make e rite dis kommand for all di language for di kingdom kon send am go meet all di rulers, govnors and ofisas for di kingdom. Dem rite am with King Zazes name kon stamp am with en ring.
12 No dia treze do primeiro mês foram convocados os escribas reais. Foram escritas pontualmente todas as ordens do rei aos sátrapas do rei, aos governadores de cada província e aos príncipes de cada nação, a cada província segundo sua escritura e a cada nação em sua língua própria. O edito estava assinado com o nome de Assuero e levava o selo real.
13 Di messenjas take di kommand go all di aria for di kingdom. And di law wey dey inside sey for di thirtint day for Adar mont, dem must kill all Jew pipol; weda dem yong or old, both wimen and shidren kon take all dia propaty.
13 Foram expedidas cartas, por correios, para todas as províncias do rei, a fim de destruir, matar e exterminar todos os judeus, jovens, velhos, crianças e mulheres, num só dia, no dia treze do duodécimo mês chamado Adar e a fim de entregar ao saque os seus despojos.
14 Dem must read dis kommand to evribody for di kingdom, so dat dem go dey ready wen dat day go rish.
14 Uma cópia do edito, que devia ser promulgado em cada província, foi enviada a todos os povos, para que todos estivessem preparados para o dia marcado.
15 Just as di king kommand, dem kon tok evritin for di main town for Shushan and di messenjas karry am go evriwhere for di kingdom. Di king and Haman dey drink and enjoy diasef, while evribody for Shushan town, dey run up-and-down.
15 Por ordem do rei, os correios partiram a toda a pressa. O edito fora publicado primeiro em Susa, a capital, e enquanto o rei bebia acompanhado de Amã, a consternação reinava na cidade de Susa.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Ester 3, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.