Efésios 2

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs BKJ

Sair da comparação
1 Before-before, na sturbones and sin dey kontrol una life,
1 E vos vivificou, estando mortos em transgressões e pecados,
2 bikos una dey do wetin di world wont. Una dey obey wiked pawas wey dey rule di air and kontrol sturbon shidren.
2 nos quais, no passado, caminhastes, conforme o curso deste mundo, conforme o príncipe das potestades do ar, do espírito que, agora, opera nos filhos da desobediência;
3 All of us dey live dis kind life before. Wi dey do difren tins wey awa body and mind wont. Dat time, wi bi shidren wey God won ponish like oda sinnas.
3 entre os quais também todos nós vivíamos, em tempos passados, nos desejos da nossa carne, fazendo a vontade da carne e da mente; e éramos por natureza filhos da ira, como os outros também.
4 Bikos God love us well-well, E don show us plenty mesi
4 Mas Deus, que é rico em misericórdia, pelo seu grande amor com que nos amou,
5 (aldo sin dey kontrol awa life before), E kon give us life thru Christ, den E save us with en grace!
5 estando nós ainda mortos em nossos pecados, nos vivificou juntamente com Cristo (pela graça sois salvos),
6 E raiz us up with Christ kon make us sidan with am for heaven.
6 e nos ressuscitou juntamente com ele, e nos fez assentar nos lugares celestiais, em Cristo Jesus;
7 E do dis, to show evribody for di world wey dey kom sey, en grace wey dey show us kindness thru Jesus Christ, big well-well.
7 para mostrar nas épocas vindouras as abundantes riquezas da sua graça, pela sua benignidade para conosco através de Cristo Jesus.
8 God save una with en grace, bikos una get faith (as una don bilive Christ), nor bi with una own pawa, but na God give una.
8 Pois pela graça sois salvos por meio da fé; e isso não é de vós mesmos; isso é o dom de Deus.
9 E nor save una bikos of di work wey una do, so make nobody dey boast.
9 Não de obras, para que nenhum homem se glorie.
10 God kreate us thru Jesus Christ as di good work wey E don prepare down before, so dat wi go dey do as E plan.
10 Porque somos feitura sua, criados em Cristo Jesus para as boas obras, as quais Deus estabeleceu para que andássemos nelas.
11 Make una remember sey before-before una bi Gentile pipol wey dey do wetin di flesh wont and Jew pipol dey koll una, “pipol wey dem neva sekonsaiz” like di way dem dey sekonsaiz human being.
11 Portanto, lembrai-vos de que vós, no passado, éreis gentios na carne e chamados incircuncisão pelos que, na carne, se chamam circuncisão feita por mãos;
12 Dat time, una dey without di Mezaya and una nor get share for Israel blessings and since una nor get hope and una dey without God for dis world, una kon bi strenja to God kovenant wey E promise Israel pipol.
12 que, naquele tempo, estáveis sem Cristo, separados da comunidade de Israel e estranhos aos pactos da promessa, não tendo esperança e sem Deus no mundo.
13 But thru Jesus Christ blood, una wey bin dey far, God don draw una near ensef,
13 Mas agora em Cristo Jesus, vós, que antes estáveis longe, chegastes perto pelo sangue de Cristo.
14 bikos na Christ bi awa peace. Na Christ make Jew and Gentile pipol bi one. E don break di wall wey divide and separate dem as enemies.
14 Porque ele é a nossa paz, o qual de ambos fez um; e, derrubou a parede do meio da separação entre nós,
15 E don kansol Jew pipol law with all en kommand and rules, so dat e go fit make Jew and Gentile pipol to bi one with am and like dis, peace go dey among dem.
15 abolindo na sua carne a inimizade, isto é, a lei dos mandamentos, que consistia em ordenanças para fazer em si mesmo de dois um novo homem, fazendo assim a paz;
16 E use di sofa wey e sofa for cross take end dia kworel kon make dem one body as dem dey serve God.
16 e reconciliar ambos com Deus em um corpo pela cruz, matando com ela a inimizade.
17 And e prish peace to una wey dey far and near,
17 E, vindo, ele pregou a paz a vós que estáveis longe e aos que estavam perto.
18 so dat thru am, all of us with one Spirit, go fit rish where awa Papa dey for heaven.
18 Porque, por ambos temos acesso em um mesmo Espírito ao Pai.
19 So, una nor go bi strenja and pipol wey nor get share for Israel blessings again, but una go bi God shidren with all di pipol wey dey en house.
19 Assim que já não sois estrangeiros, nem forasteiros, mas concidadãos com os santos e da família de Deus;
20 Dis na bikos, God don build una on-top di apostles and profets foundashon and na Jesus Christ bi di nomba one stone wey God take lay di foundashon.
20 e sois edificados sobre a fundação dos apóstolos e dos profetas, de que Jesus Cristo é a principal pedra da esquina;
21 Na for inside Christ di whole building for join togeda kon grow as one holy Temple for God and
21 no qual todo o edifício, bem ajustado, cresce para templo santo no ­Senhor,
22 thru am, God don build una togeda as where E go dey stay thru di Spirit.
22 no qual também vós juntamente sois edificados para habitação de Deus através do Espírito.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Efésios 2, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.