Efésios 1

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NAA

Sair da comparação
NAA Nova Almeida Atualizada 2017
1 Dis leta na from Paul, wey bi Jesus Christ apostle, bikos na so God wont am. I dey rite to God pipol wey dey for Efesus, di ones wey dey follow Jesus Christ with faith.
1 Paulo, apóstolo de Cristo Jesus pela vontade de Deus, aos santos que vivem em Éfeso e são fiéis em Cristo Jesus.
2 Make di grace and peace wey dey kom from God awa papa and from awa Oga God Jesus Christ, dey with una.
2 Que a graça e a paz de Deus, nosso Pai, e do Senhor Jesus Cristo estejam com vocês.
3 I bless God wey bi awa Oga God Jesus Christ Papa; wey don bless us with difren spiritual blessing from heaven, bikos of Christ.
3 Bendito seja o Deus e Pai de nosso Senhor Jesus Cristo, que nos abençoou com todas as bênçãos espirituais nas regiões celestiais em Cristo.
4 Before God kreate di world, E choose us thru Christ bikos E love us, so dat for en front, wi nor go get any fault and wi go dey holy.
4 Antes da fundação do mundo, Deus nos escolheu, nele, para sermos santos e irrepreensíveis diante dele. Em amor
5 Before, God don already decide thru Jesus Christ sey, wi go bi en shidren, bikos na so E wont am.
5 nos predestinou para ele, para sermos adotados como seus filhos, por meio de Jesus Cristo, segundo o propósito de sua vontade,
6 So, make all praiz and glory bi en own, bikos of en free grace wey E give us, thru en pikin wey E love well-well.
6 para louvor da glória de sua graça, que ele nos concedeu gratuitamente no Amado.
7 Na thru Christ blood wi take get salvashon and na dis blood make God dey forgive us awa sins, bikos en grace big well-well.
7 Nele temos a redenção, pelo seu sangue, a remissão dos pecados, segundo a riqueza da sua graça,
8 Di grace wey E give us, get plenty wisdom, sense and undastandin.
8 que Deus derramou abundantemente sobre nós em toda a sabedoria e entendimento.
9 E do like dis wen E show us di sekret plan wey E get and di good mind wey E show evribody, thru Christ.
9 Ele nos revelou o mistério da sua vontade, segundo o seu propósito, que ele apresentou em Cristo,
10 God go komplete en plan wen di time don rish, den E go gada evritin wey dey heaven and eart togeda under Christ, wey bi di head.
10 de fazer convergir nele, na dispensação da plenitude dos tempos, todas as coisas, tanto as do céu como as da terra.
11 All tins dey happen as God wont am and thru Christ, E choose us to bi en own pipol, bikos na so E plan am from di time wen E kreate di world,
11 Em Cristo fomos também feitos herança, predestinados segundo o propósito daquele que faz todas as coisas conforme o conselho da sua vontade,
12 so dat wi wey first bilive Christ, go dey gi-am praiz and glory.
12 a fim de sermos para louvor da sua glória, nós, os que de antemão esperamos em Cristo.
13 Since una don hear di trut kon bilive Christ, God don give una di Holy Spirit as special mark to show sey naim get una.
13 Nele também vocês, depois que ouviram a palavra da verdade, o evangelho da salvação, tendo nele também crido, receberam o selo do Espírito Santo da promessa.
14 God deposit dis Holy Spirit for di tins wey wi go inherit, until di time wen E go save en pipol, so dat all praiz and glory go bi en own.
14 O Espírito é o penhor da nossa herança, até o resgate da sua propriedade, em louvor da sua glória.
15 So, since I hear about una faith for Christ and how una love all God pipol,
15 Por isso, também eu, tendo ouvido a respeito da fé que vocês têm no Senhor Jesus e do amor para com todos os santos,
16 I nor dey stop to tank God for una, wen ever I dey pray.
16 não cesso de dar graças por vocês, mencionando-os nas minhas orações.
17 I pray make God, awa Oga God Jesus Christ Papa wey get glory, give una spiritual wisdom and revelashon, wey go make una know am well-well.
17 Peço ao Deus de nosso Senhor Jesus Cristo, o Pai da glória, que conceda a vocês espírito de sabedoria e de revelação no pleno conhecimento dele.
18 Una eye don open to undastand di grace wey God koll una kom enter and una don si how di blessing wey E promise en pipol, plenty rish.
18 Peço que ele ilumine os olhos do coração de vocês, para que saibam qual é a esperança da vocação de vocês, qual é a riqueza da glória da sua herança nos santos
19 Una don si how en pawa big rish, bikos una bilive am. Dis na di pawa wey dey do big-big tins for us.
19 e qual é a suprema grandeza do seu poder sobre nós, os que cremos, segundo a eficácia da força do seu poder.
20 E show dis pawa thru Christ, wen E raiz am from deat, kon make am sidan for en rite hand for heaven;
20 Ele exerceu esse poder em Cristo, ressuscitando-o dentre os mortos e fazendo-o sentar à sua direita nas regiões celestiais,
21 di place wey far well-well, wey high pass where wiked pipol dey rule; wey strong pass evry pawa wey dey dis world; big pass evry name wey dey for dis world and di ones wey dey kom.
21 acima de todo principado, potestade, poder, domínio e de todo nome que se possa mencionar, não só no presente século, mas também no vindouro.
22 God put evritin under Christ leg kon make am head for di church and Oga God for evritin.
22 E sujeitou todas as coisas debaixo dos pés de Cristo e, para ser o cabeça sobre todas as coisas, o deu à igreja,
23 Na di church bi Christ body and naim dey make evritin for evriwhere full and komplete.
23 a qual é o seu corpo, a plenitude daquele que a tudo enche em todas as coisas.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Efésios 1, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.