Esdras 4

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NVI

Sair da comparação
NVI Nova Versão Internacional
1 Wen Judah and Benjamin enemies hear sey doz wey kom back from Babilon, dey ribuild di Oga wey bi Israel God Temple,
1 Quando os inimigos de Judá e de Benjamim souberam que os exilados estavam reconstruindo o templo do Senhor, o Deus de Israel,
2 dem go meet Zerubabel and di leaders kon tell dem, “Make una allow us join una ribuild di temple. Bikos wi dey woship di same God wey una dey woship and wi dey offa sakrifice to am ever since King Esarhaddon for Assyria send us kon stay here.”
2 foram falar com Zorobabel e com os chefes das famílias: "Vamos ajudá-los nessa obra porque, como vocês, nós buscamos o Deus de vocês e temos sacrificado a ele desde a época de Esar-Hadom, rei da Assíria, que nos trouxe para cá".
3 Den Zerubabel, Jeshua and di leaders kon tell dem, “Wi nor nid una help to ribuild di Oga awa God Temple. Wi go build am by awasef, just as King Cyrus for Persia sey make wi do.”
3 Contudo, Zorobabel, Jesua e os demais líderes das famílias de Israel responderam: "Não compete a vocês a reconstrução do templo de nosso Deus. Somente nós o construiremos para o Senhor, o Deus de Israel, conforme Ciro, o rei da Pérsia, nos ordenou".
4 Den di pipol wey dey stay di land before won kon try to diskorage and put fear for Judah pipol mind, so dat dem nor go build di temple.
4 Então a gente da região começou a desanimar o povo de Judá e a atemorizá-lo, para que não continuassem a construção.
5 Dem still go bribe Persia ofisas, so dat dem go attack Judah pipol. Dem kontinue to dey do like dis thru-out di time wey Cyrus dey rule and dem do am enter King Darius time.
5 Pagaram alguns funcionários para que se opusessem a eles e frustrassem o plano deles. E fizeram isso durante todo o reinado de Ciro até o reinado de Dario, reis da Pérsia.
6 Wen King Zazes start to rule, Judah enemies wey dey stay for Judah and Jerusalem kon go komplain against dem.
6 No início do reinado de Xerxes, apresentaram uma acusação contra o povo de Judá e de Jerusalém.
7 And wen King Atazazes dey rule for Persia, Bishlam, Mitredat, Tabeel and some pipol wey dey follow dem, rite leta go give di king. Dem rite di leta for Aramaik language, but dem go tok di meaning wen dem dey read am.
7 E nos dias de Artaxerxes, rei da Pérsia, Bislão, Mitredate, Tabeel e o restante dos seus companheiros escreveram uma carta a Artaxerxes. A carta foi escrita em aramaico, com caracteres aramaicos.
8 Rehum too wey bi di govnor and Shimshai, di aria seketry kon rite dis leta about Jerusalem go give King Atazazes sey:
8 O comandante Reum e o secretário Sinsai escreveram uma carta contra Jerusalém ao rei Artaxerxes nos seguintes termos:
9 “From Rehum wey bi di govnor and Shimshai di aria seketry; from di judge dem and all di ofisas from Erech, Babilon and Shushan wey dey Elam land,
9 O comandante Reum e o secretário Sinsai, e o restante de seus companheiros, os juízes e os oficiais de Trípoli, da Pérsia, de Ereque e da Babilônia, os elamitas de Susã,
10 with di pipol wey di great and pawaful Ashurbanipal karry from dia town go stay Samaria and West Eufrates aria.
10 e as outras nações a quem o grande e renomado Assurbanípal deportou e assentou na cidade de Samaria e noutros lugares a oeste do Eufrates,
11 “(Dis na wetin dem rite for di leta)
11 ( esta é uma cópia da carta que lhe enviaram ): "Ao rei Artaxerxes, De seus servos, que vivem a oeste do Eufrates:
12 Wi wont make di king know sey Jew pipol wey kom from yor oda aria, don dey stay for Jerusalem and dem dey build dat evil and yeye town back. Dem don start to build di wall and go soon finish am.
12 É bom o rei ficar sabendo que os judeus que chegaram a nós da tua parte vieram a Jerusalém e estão reconstruindo aquela cidade rebelde e má. Estão fazendo reparos nos muros e consertando os alicerces.
13 Awa oga, if dem build dis town back kon komplete di wall, di pipol go stop to pay tax and di money wey yu dey get for di palis bag, nor go rish again.
13 Além disso, é preciso que o rei saiba que, se essa cidade for reconstruída e os seus muros reparados, não mais se pagarão impostos, tributos ou taxas, e as rendas do rei sofrerão prejuízo.
14 Naw, bikos of di way wi dey loyal to yu, wi nor won si sey anybody disrespet di king, so wi dey sugest sey,
14 Agora, visto que estamos a serviço do palácio e não nos é conveniente ver a desonra do rei, estamos enviando esta mensagem ao rei,
15 make yu orda make dem search for di rekord wey yor grand-grand papa keep. If yu do am, yu go si sey, before-before, di town too like wahala and e don give kings, kingdoms and rulers, many trobol. Di pipol for der, dey hard to rule and na dis make dem distroy di town.
15 a fim de que se faça uma pesquisa nos arquivos de seus antecessores. Nesses arquivos o rei descobrirá e saberá que essa cidade é uma cidade rebelde, problemática para reis e províncias, um lugar de revoltas desde épocas antigas, motivo pelo qual foi destruída.
16 So wi bilive sey, if dem build di town back kon komplete di wall, awa oga nor go fit kontrol West Eufrates aria again.”
16 Informamos ao rei que, se essa cidade for reconstruída e seus muros reparados, nada lhe sobrará a oeste do Eufrates".
17 Di King kon ansa dem:
17 O rei enviou-lhes a seguinte resposta: "Ao comandante Reum, ao secretário Sinsai e aos seus demais companheiros que vivem em Samaria e em outras partes, a oeste do Eufrates: Saudações de paz!
18 Dem don translate and read di leta wey una send kon give mi and
18 A carta que vocês nos enviaram foi traduzida e lida na minha presença.
19 I don orda sey make dem find out and dem sey, na true sey Jerusalem dey go against royal authority before; na so-so trobol dem dey find and pipol wey nor dey obey di law, full der.
19 Sob minhas ordens fez-se uma pesquisa, e descobriu-se que essa cidade tem uma longa história de rebeldia contra os reis e que tem sido um lugar de rebeliões e revoltas.
20 Kings wey get pawa don rule for der before and dem rule di whole West Eufrates aria, dey kollect tax and oda money.
20 Jerusalém teve reis poderosos que governaram toda a região a oeste do Eufrates, aos quais se pagavam impostos, tributos e taxas.
21 So, make una stop to ribuild di town until I kommand make dem build am again.
21 Ordene agora a esses homens que parem a obra, para que essa cidade não seja reconstruída enquanto eu não mandar.
22 Naw, make una go do wetin I tok, so dat my kingdom go get peace.”
22 "Tenham cuidado, não sejam negligentes neste assunto, para que os interesses reais não sofram prejuízo".
23 As soon as dem just read di leta wey King Atazazes send go give Rehum, Shimshai and di pipol, dem kon rush go Jerusalem go force and stop Jew pipol to ribuild di town.
23 Lida a cópia da carta do rei Artaxerxes para Reum, para o secretário Sinsai e para os seus companheiros, eles foram depressa a Jerusalém e forçaram os judeus a parar a obra.
24 So dem stop to build di temple until di sekond year wen King Darius dey rule for Persia.
24 Assim a obra do templo de Deus em Jerusalém foi interrompida, e ficou parada até o segundo ano do reinado de Dario, rei da Pérsia.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Esdras 4, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.