Deuteronômio 9
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARC
1 Israel pipol, make una listin! Today una won cross Jordan River kon go take doz strong pipol wey get pawa pass una, land. Dem dey stay for towns wey di wall rish di sky!
1 Ouve, ó Israel, hoje, passarás o Jordão, para entrares a possuir nações maiores e mais fortes do que tu; cidades grandes e muradas até aos céus;
2 Di pipol strong well-well and dem tall; dem bi Anak shidren-shidren. Una hear wen dem sey, “Na who go fit fight Anak pipol?”
2 um povo grande e alto, filhos de gigantes, que tu conheces e de que já ouviste: Quem pararia diante dos filhos dos gigantes?
3 But make una undastand today sey, di Oga una God wey dey waka for una front na fire wey dey burn anytin; E go win dem kon make dem bi like mumu for una front. Just as God tell una, na so una go kwik-kwik konker and distroy dem finish.
3 Sabe, pois, hoje, que o Senhor , teu Deus, que passa diante de ti, é um fogo que consome, e os destruirá, e os derrubará de diante de ti; e tu os lançarás fora e cedo os desfarás, como o Senhor te tem dito.
4 Afta di Oga una God don do all dis tins for una, make una nor tok for una heart sey, “God give us dis land bikos wi good well-well!” Nor bi bikos una good make God give una, but na di wikedness wey dis oda pipol dey do, na-im make God porshu dem komot for una.
4 Quando, pois, o Senhor , teu Deus, os lançar fora, de diante de ti, não fales no teu coração, dizendo: Por causa da minha justiça é que o Senhor me trouxe a esta terra para a possuir, porque, pela impiedade destas nações, é que o Senhor as lança fora, de diante de ti.
5 Una nor dey enter and stay dis land, bikos una dey good or get sense. Di Oga una God go porshu dis pipol komot for una, bikos of di wikedness wey dem dey do and to fulfil di promise wey E make with una grand-grand papa, Abraham, Isaak and Jakob.
5 Não é por causa da tua justiça, nem pela retidão do teu coração que entras a possuir a sua terra, mas, pela impiedade destas nações, o Senhor , teu Deus, as lança fora, de diante de ti; e para confirmar a palavra que o Senhor , teu Deus, jurou a teus pais, Abraão, Isaque e Jacó.
6 So make una undastand naw sey nor bi bikos una good make di Oga una God dey give una dis land, bikos una nor good and una bi sturbon pipol.
6 Sabe, pois, que não é por causa da tua justiça que o Senhor , teu Deus, te dá esta boa terra para possuí-la, pois tu és povo obstinado.
7 Make una remember and nor ever forget how una make di Oga una God vex for di wildaness. From di day wey una komot Egypt kon rish naw, una dey always sin against God.
7 Lembra-te e não te esqueças de que muito provocaste à ira o Senhor , teu Deus, no deserto; desde o dia em que saístes do Egito até que chegastes a esse lugar, rebeldes fostes contra o Senhor ;
8 Even for Mount Sinai, una make God vex well-well sotey E won kon distroy una.
8 pois, em Horebe, tanto provocastes à ira o Senhor , que o Senhor se acendeu contra vós para vos destruir.
9 Dis tin happen wen I go di mountin go kollect di ten kommandment wey God make for una. I dey der for forty days and forty nite and I nor chop or drink anytin.
9 Subindo eu ao monte a receber as tábuas de pedra, as tábuas do concerto que o Senhor fizera convosco, então fiquei no monte quarenta dias e quarenta noites; pão não comi e água não bebi.
10 God give mi two stones and all di kommandment wey E tell una from inside di fire wen una gada go meet am for di mountin, E use en own hand take rite dem put for di stones.
10 E o Senhor me deu as duas tábuas de pedra, escritas com o dedo de Deus; e nelas tinha escrito conforme todas aquelas palavras que o Senhor tinha falado convosco no monte, do meio do fogo, no dia da congregação.
11 Wen di forty days don finish, God give mi di two stones wey E rite di kovenant put.
11 Sucedeu, pois, que, ao fim dos quarenta dias e quarenta noites, o Senhor me deu as duas tábuas de pedra, as tábuas do concerto.
12 Den God sey, “Make yu get up! Just dey go at wons, bikos di pipol wey yu bring out from Egypt don dey sin. Dem kwik-kwik forget kon komot from di way wey I sey make dem dey live dia life! Dem don melt gold take make juju for demsef!”
12 E o Senhor me disse: Levanta-te, desce depressa daqui, porque o teu povo, que tiraste do Egito, já se tem corrompido; cedo se desviou do caminho que eu lhe tinha ordenado; imagem de fundição para si fez.
13 God still sey, “I don si sey dis pipol sturbon well-well!
13 Falou-me mais o Senhor , dizendo: Atentei para este povo, e eis que ele é povo obstinado.
14 So make yu leave mi make I distroy all of dem komot from dis eart. Den I go make strong and mighty pipol from yor shidren-shidren.”
14 Deixa-me que os destrua e apague o seu nome de debaixo dos céus; e te faça a ti nação mais poderosa e mais numerosa do que esta.
15 So I turn komot di mountin as di fire still dey burn and di two kovenant stones dey my hand.
15 Então, virei-me e desci do monte; e o monte ardia em fogo, e as duas tábuas do concerto estavam em ambas as minhas mãos.
16 Wen I rish where una dey, I si sey una don really sin against di Oga una God and una don make juju for unasef; una don kwik-kwik turn komot from di way wey God kommand una!
16 E olhei, e eis que havíeis pecado contra o Senhor , vosso Deus; vós tínheis feito um bezerro de fundição; cedo vos desviastes do caminho que o Senhor vos ordenara.
17 So I take di two kovenant stones wey di kommandment dey kon skata dem for una front.
17 Então, peguei das duas tábuas, e as arrojei de ambas as minhas mãos, e as quebrei aos vossos olhos.
18 Den I go stay for God present for anoda forty days and forty nite; I nor chop or drink anytin bikos of all di sins wey una don kommit wen una dey do wiked tins wey go make God vex well-well.
18 E me lancei perante o Senhor , como dantes; quarenta dias e quarenta noites, não comi pão e não bebi água, por causa de todo o vosso pecado que havíeis pecado, fazendo mal aos olhos do Senhor , para o provocar à ira.
19 I dey fear God vexnashon, bikos E sey E go distroy una. But dis time, E still listin to mi again.
19 Porque temi por causa da ira e do furor com que o Senhor tanto estava irado contra vós, para vos destruir; porém, ainda por esta vez, o Senhor me ouviu.
20 God vex well-well for Aaron and E won kon distroy am too. But I pray for Aaron and God kon sorry for am.
20 Também o Senhor se irou muito contra Arão para o destruir; mas também orei por Arão ao mesmo tempo.
21 I take una sin; di juju wey una make kon melt and grind am till e bi like san-san. Den I pour am for wota wey dey flow kom from di mountin.
21 Porém eu tomei o vosso pecado, o bezerro que tínheis feito, e o queimei a fogo, e o pisei, moendo-o bem, até que se desfez em pó; e o seu pó lancei no ribeiro que descia do monte.
22 And una still make God vex for Taberah, Massah and Kibrot Hattaavah.
22 Também em Taberá, e em Massá, e em Quibrote-Hataavá provocastes muito a ira do Senhor .
23 Den wen E send una from Kadesh Barnea kon sey, “Make una go take di land wey I don give una,” una still sin against di Oga una God, bikos una nor bilive or obey am.
23 Quando também o Senhor vos enviou desde Cades-Barneia, dizendo: Subi e possuí a terra que vos tenho dado, rebeldes fostes ao mandado do Senhor , vosso Deus, e não o crestes, e não obedecestes à sua voz.
24 Una don dey sin against di Oga una God rite from di first day wey I know una!
24 Rebeldes fostes contra o Senhor , desde o dia em que vos conheci.
25 I liedan for groun for God present for forty days and forty nite, bikos E sey E go distroy una.
25 E prostrei-me perante o Senhor aqueles quarenta dias e quarenta noites em que estava prostrado; porquanto o Senhor dissera que vos queria destruir.
26 I pray to am, “My Oga God, make Yu nor distroy yor pipol wey bi yor betta propaty; pipol wey Yu save with yor own pawa kon take dem komot from Egypt with yor strent.
26 E eu orei ao Senhor , dizendo: Senhor Deus, não destruas o teu povo e a tua herança, que resgataste com a tua grandeza, que tiraste do Egito com mão forte.
27 Make Yu remember yor savant, Abraham, Isaak and Jakob; den nor look as dis pipol sturbon, wiked and di sins wey dem dey kommit.
27 Lembra-te dos teus servos Abraão, Isaque e Jacó; não atentes para a dureza deste povo, nem para a sua impiedade, nem para o seu pecado,
28 Bikos if Yu distroy dem, Egypt pipol go sey, ‘God nor fit karry dem go rish di land wey E promise dem and bikos God hate dem well-well, E take dem komot here go kill for di wildaness.’
28 para que o povo da terra donde nos tiraste não diga: Porquanto o Senhor os não pôde introduzir na terra de que lhes tinha falado e porque os aborrecia, os tirou para os matar no deserto.
29 Dem bi yor pipol, yor betta propaty wey Yu take komot Egypt with yor great strent and pawa.”
29 Todavia, são eles o teu povo e a tua herança que tu tiraste com a tua grande força e com o teu braço estendido.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Deuteronômio 9, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.