Deuteronômio 8

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NVI

Sair da comparação
NVI Nova Versão Internacional
1 Make una make sure sey una dey obey all di kommandment wey I dey give una today. Den una go get long life kon many as una enter and stay for di land wey God promise sey E go give una grand-grand papa.
1 Tenham o cuidado de obedecer toda a lei que eu hoje lhes ordeno, para que vocês vivam, multipliquem-se e tomem posse da terra que o Senhor prometeu, com juramento, aos seus antepassados.
2 Make una remember how di Oga una God guide una pass di wildaness for dis forty years, so dat E go fit honbol and test una to si if una go fit keep en kommand or not.
2 Lembre-se de como o Senhor, o seu Deus, os conduziu por todo o caminho no deserto, durante estes quarenta anos, para humilhá-los e pô-los à prova, a fim de conhecer suas intenções, se iriam obedecer aos seus mandamentos ou não.
3 True-true! E make una dey honbol thru honga kon dey give una food wey una nor know (manna) make una chop. E do dis to tish una sey human being nor nid only food, but dem still dey alive bikos of wetin God tok.
3 Assim, ele os humilhou e os deixou passar fome. Mas depois os sustentou com maná, que nem vocês nem os seus antepassados conheciam, para mostrar-lhe que nem só de pão viverá o homem, mas de toda palavra que procede da boca do Senhor.
4 For dis forty years, una klot nor even tear and una leg nor get sore at-all.
4 As roupas de vocês não se gastaram e os seus pés não incharam durante esses quarenta anos.
5 Make una tink am well. Just as papa and mama dey ponish dia pikin, na so too di Oga una God ponish una for una own good.
5 Saibam, pois, em seu coração que, assim como um homem disciplina o seu filho, da mesma forma o Senhor, o seu Deus, os disciplina.
6 So make una obey di kommand wey di Oga una God give una kon do as E tok and always dey fear am.
6 Obedeçam aos mandamentos do Senhor, o seu Deus, andando em seus caminhos e dele tendo temor.
7 Bikos di Oga una God dey take una enter one betta land; land wey get betta river and wota, with fountain wey dey flow for di valley and hill.
7 Pois o Senhor, o seu Deus, os está levando a uma boa terra, cheia de riachos e tanques de água, de fontes que jorram nos vales e nas colinas;
8 Betta land wey get wheat, barley, vines, fig trees, pomegranates, olive oil and honey;
8 terra de trigo e cevada, videiras e figueiras e romãzeiras, azeite de oliva e mel;
9 land where una go for chop as una like and una go get evritin. Betta land where stones bi like iron and una go fit make koppa from en hills.
9 terra onde não faltará pão e onde não terão falta de nada; terra onde as rochas têm ferro e onde você poderá escavar cobre nas colinas.
10 Una go chop beleful kon praiz di Oga una God, bikos of di good land wey E give una.
10 Depois que tiverem comido até ficarem satisfeitos, louvem ao Senhor, o seu Deus, pela boa terra que lhe deu.
11 Make una make sure sey una nor forget di Oga una God. Make una dey keep en kommand and law wey I dey give una today.
11 Tenham o cuidado de não se esquecer do Senhor, do seu Deus, deixando de obedecer aos seus mandamentos, às suas ordenanças e aos seus decretos que hoje lhes ordeno.
12 Bikos wen una go don get propaty well-well kon build many fine house to stay
12 Não aconteça que, depois de terem comido até ficarem satisfeitos, de terem construído boas casas e nelas morado,
13 and get many animals and many silva and gold, plus evry oda tin,
13 de aumentarem os seus rebanhos, a sua prata e o seu ouro, e todos os seus bens,
14 make una nor kon dey do like sey una too important, den forget di Oga una God wey bring una kom out from Egypt where una for bi slaves before.
14 o seu coração fique orgulhoso e vocês se esqueçam do Senhor, do seu Deus, que os tirou do Egito, da terra da escravidão.
15 Na dis God take una pass di wildaness wey get wiked snakes and skorpions; place where wota nor dey. But God make wota flow for una from rock kon
15 Ele os conduziu pelo imenso e pavoroso deserto, por aquela terra seca e sem água, de serpentes e escorpiões venenosos. Ele tirou água da rocha para vocês,
16 feed una for di wildaness with manna (food wey una grand-grand papa nor ever know), so dat E go honbol and test una, den make una betta pipol.
16 e o sustentou no deserto com maná, que os seus antepassados não conheciam, para humilhá-los e prová-los, a fim de que tudo fosse bem com vocês.
17 E do all dis tins, so dat una nor go kon dey tell unasef sey, “Na my own pawa and work, I take get all dis tins.”
17 Não digam, pois, em seu coração: "A minha capacidade e a força das minhas mãos ajuntaram para mim toda esta riqueza".
18 Una must remember di Oga una God, bikos na en dey give pipol di pawa to make money. If una obey am, di kovenant wey E make with una grand-grand papa, E go make am happen for una life.
18 Mas, lembrem-se do Senhor, do seu Deus, pois é ele que lhes dá a capacidade de produzir riqueza, confirmando a aliança que jurou aos seus antepassados, conforme hoje se vê.
19 But if una forget di Oga una God for evritin kon dey follow oda gods, dey woship and bow for dem, I go tell una today sey, God go really distroy una.
19 Mas se vocês se esquecerem do Senhor, do seu Deus, e seguirem outros deuses, prestando-lhes culto e curvando-se diante deles, asseguro-lhes hoje que vocês serão destruídos.
20 Just like di pipol wey God won distroy for una, na so too E go do to una, bikos una nor gri follow en kommand.
20 Por não obedecerem ao Senhor, ao seu Deus, vocês serão destruídos como o foram as outras nações que o Senhor destruiu perante vocês.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Deuteronômio 8, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.