Deuteronômio 7

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARA

Sair da comparação
ARA Almeida Revista e Atualizada 1993
1 Wen di Oga una God take una enter di land wey una go-go stay, E go porshu many kountries komot for una. Kontries like: Hit, Girgash, Amor, Kanaan, Periz, Hiv and Jebus pipol. (Di pipol for dis seven kountries get pawa pass una.)
1 Quando o Senhor , teu Deus, te introduzir na terra a qual passas a possuir, e tiver lançado muitas nações de diante de ti, os heteus, e os girgaseus, e os amorreus, e os cananeus, e os ferezeus, e os heveus, e os jebuseus, sete nações mais numerosas e mais poderosas do que tu;
2 Wen di Oga una God don give dis kountry to una and una don konker dem, una must distroy dem finish. Make una nor enter agriment with dem.
2 e o Senhor , teu Deus, as tiver dado diante de ti, para as ferir, totalmente as destruirás; não farás com elas aliança, nem terás piedade delas;
3 Make una nor even marry from dem. Make una nor let una pikin marry dia pikin,
3 nem contrairás matrimônio com os filhos dessas nações; não darás tuas filhas a seus filhos, nem tomarás suas filhas para teus filhos;
4 bikos dem go take una shidren from mi kon let dem go woship anoda god. Den God go vex for una well-well kon kwik distroy una.
4 pois elas fariam desviar teus filhos de mim, para que servissem a outros deuses; e a ira do Senhor se acenderia contra vós outros e depressa vos destruiria.
5 Dis na wetin una go do. Una must skata di pagans altar kon distroy all dia juju pilas. Make una kut dia Asherah pole for groun kon burn dia juju.
5 Porém assim lhes fareis: derribareis os seus altares, quebrareis as suas colunas, cortareis os seus postes-ídolos e queimareis as suas imagens de escultura.
6 Bikos una dey holy and na di Oga una God bi una papa. From all di pipol wey dey di eart, di Oga una God don choose una to bi en own special pipol.
6 Porque tu és povo santo ao Senhor , teu Deus; o Senhor , teu Deus, te escolheu, para que lhe fosses o seu povo próprio, de todos os povos que há sobre a terra.
7 God nor choose una from en heart, bikos una plenty pass oda kountries or small pass oda kountries!
7 Não vos teve o Senhor afeição, nem vos escolheu porque fôsseis mais numerosos do que qualquer povo, pois éreis o menor de todos os povos,
8 But na bikos God love una and dey keep di promise wey E make with una grand-grand papa. Na dis make God save una with en strong hand wen una dey serve as slave for King Fero hand for Egypt.
8 mas porque o Senhor vos amava e, para guardar o juramento que fizera a vossos pais, o Senhor vos tirou com mão poderosa e vos resgatou da casa da servidão, do poder de Faraó, rei do Egito.
9 So make una undastand sey, di Oga una God na en really bi God. Na en bi di God wey dey keep en kovenant for tazon generashon kon dey show en love wey nor dey end to doz wey love and dey obey en kommand.
9 Saberás, pois, que o Senhor , teu Deus, é Deus, o Deus fiel, que guarda a aliança e a misericórdia até mil gerações aos que o amam e cumprem os seus mandamentos;
10 But E nor dey waste time to ponish and distroy doz wey rijet am.
10 e dá o pago diretamente aos que o odeiam, fazendo-os perecer; não será demorado para com o que o odeia; prontamente, lho retribuirá.
11 So una must obey all dis kommand, law and rules wey I dey give una today.
11 Guarda, pois, os mandamentos, e os estatutos, e os juízos que hoje te mando cumprir.
12 If una listin to dis rules kon obey dem with all una heart, di Oga una God go really keep en kovenant wey E promise una grand-grand papa.
12 Será, pois, que, se, ouvindo estes juízos, os guardares e cumprires, o Senhor , teu Deus, te guardará a aliança e a misericórdia prometida sob juramento a teus pais;
13 E go love and bless una kon make una plenty and E go give una many shidren. E go bless evritin wey una plant and una animals. Wen una rish di land wey E promise sey E go give una grand-grand papa, una go harvest many korn, new wine, olive oil and many kattle, sheep and goats.
13 ele te amará, e te abençoará, e te fará multiplicar; também abençoará os teus filhos, e o fruto da tua terra, e o teu cereal, e o teu vinho, e o teu azeite, e as crias das tuas vacas e das tuas ovelhas, na terra que, sob juramento a teus pais, prometeu dar-te.
14 For all di kountries for di eart, na una God go bless pass. Evry man and woman among una go get shidren and una animals go dey born too.
14 Bendito serás mais do que todos os povos; não haverá entre ti nem homem, nem mulher estéril, nem entre os teus animais.
15 God go protet una from any kind sickness. E nor go let una sofa from di bad-bad diziz wey una si for Egypt, but E go make una enemies sofa dis diziz!
15 O Senhor afastará de ti toda enfermidade; sobre ti não porá nenhuma das doenças malignas dos egípcios, que bem sabes; antes, as porá sobre todos os que te odeiam.
16 All di kountries wey di Oga una God dey give una, una must distroy all of dem finish. Make una nor sorry for dem at-all and make una nor woship dia gods, if not dem go trap una.
16 Consumirás todos os povos que te der o Senhor , teu Deus; os teus olhos não terão piedade deles, nem servirás a seus deuses, pois isso te seria por ciladas.
17 Una fit tink and ask, “Dis kountries many pass us, so how wi go take distroy dem?”
17 Se disseres no teu coração: Estas nações são mais numerosas do que eu; como poderei desapossá-las?
18 Make una nor fear. Make una remember wetin di Oga una God do to Fero and Egypt pipol;
18 Delas não tenhas temor; lembrar-te-ás do que o Senhor , teu Deus, fez a Faraó e a todo o Egito;
19 di betta judgement wey una si, di signs and wonders wey God do; en strent and pawa wey E use take-take us komot der and na so di Oga una God go do to all dis pipol wey una dey fear.
19 das grandes provas que viram os teus olhos, e dos sinais, e maravilhas, e mão poderosa, e braço estendido, com que o Senhor , teu Deus, te tirou; assim fará o Senhor , teu Deus, com todos os povos, aos quais temes.
20 Den di Oga una God go send fear go porshu doz wey neva die wey dey hide and E go do am until di very last one wey dey hide from una, go die!
20 Além disso, o Senhor , teu Deus, mandará entre eles vespões, até que pereçam os que ficarem e se esconderem de diante de ti.
21 So make una nor fear doz kountries, bikos di Oga una God dey with una and E bi God wey dey great and wonderful.
21 Não te espantes diante deles, porque o Senhor , teu Deus, está no meio de ti, Deus grande e temível.
22 Di Oga una God go-go for una front and na small-small E go take porshu doz pipol komot di land for una, until dem go finish. E nor go porshu all of dem at wons, if not wild animals go kon too kwik plenty for di land before una rish der.
22 O Senhor , teu Deus, lançará fora estas nações, pouco a pouco, de diante de ti; não poderás destruí-las todas de pronto, para que as feras do campo se não multipliquem contra ti.
23 Di Oga una God go give dem to una; E go make dem fear well-well until una go distroy dem finish.
23 Mas o Senhor , teu Deus, tas entregará e lhes infligirá grande confusão, até que sejam destruídas.
24 E go put dia kings for una hand and una go remove dia names from dis eart. Nobody go fit fight una and una go distroy all of dem.
24 Entregar-te-á também nas mãos os seus reis, para que apagues o nome deles de debaixo dos céus; nenhum homem poderá resistir-te, até que os destruas.
25 Una go burn dia juju for fire and una must nor like dia gold or silva. Una must nor take dem, if not dem go bi trap for una, bikos dem nor dey good to di Oga una God.
25 As imagens de escultura de seus deuses queimarás; a prata e o ouro que estão sobre elas não cobiçarás, nem os tomarás para ti, para que te não enlaces neles; pois são abominação ao Senhor , teu Deus.
26 Any propaty wey God nor like, make una nor take am enter una house, bikos if una do so, God go distroy una just as E do to doz pipol. Make una make sure sey una nor do dat kind tin, bikos God go distroy dem.
26 Não meterás, pois, coisa abominável em tua casa, para que não sejas amaldiçoado, semelhante a ela; de todo, a detestarás e, de todo, a abominarás, pois é amaldiçoada.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Deuteronômio 7, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.