Deuteronômio 6
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NTLH
1 Dis na di kommandment, statutes and ordinances wey Oga God give mi make I tish una and una must obey and do dem for di land where una dey go.
1 Moisés disse ao povo: — São esses os mandamentos e as
2 Una go make sure sey una respet Oga God and obey all en statutes and kommandments wey I dey give una – una, una shidren and grand-shidren – go obey am with all una life so dat una go get long life.
2 Temam o Senhor , nosso Deus, vocês, os seus filhos e os seus netos, e cumpram sempre todos os mandamentos e leis que eu lhes estou dando e assim vocês viverão muitos anos.
3 Make una pay attenshon, Israel pipol, and dey kareful to do dis, so dat una go stay well kon plenty more-more – as God, una papa-papa Oga tell una and una go inherit di land where milk and honey plenty well-well.
3 Povo de Israel, tenha o cuidado de cumprir a lei de Deus. Então, conforme disse o Senhor , o Deus dos nossos antepassados, tudo correrá bem para vocês, e vocês se tornarão numerosos naquela terra boa e rica onde vão viver.
4 Israel pipol! Make una listin! Di Oga na awa God and God na one!
4 — Escute, povo de Israel! O Senhor , e somente o Senhor , é o nosso Deus.
5 So una must love di Oga una God with all una heart, all una soul and all una pawa.
5 Portanto, amem o Senhor , nosso Deus, com todo o coração, com toda a alma e com todas as forças.
6 Dis word wey I dey kommand una about today so, una must keep am for una mind
6 Guardem sempre no coração as leis que eu lhes estou dando hoje
7 and una must tish una shidren kon tok about am as una sidan for house; dey waka for road; dey sleep or wen una wake-up.
7 e não deixem de ensiná-las aos seus filhos. Repitam essas leis em casa e fora de casa, quando se deitarem e quando se levantarem.
8 Make una tie dem for una hand kon wear dem for una fore head, so dat una go dey remember dem.
8 Amarrem essas leis nos braços e na testa, para não as esquecerem;
9 Make una write dem for una gate and door-mot.
9 e as escrevam nos batentes das portas das suas casas e nos seus portões.
10 Den wen di Oga una God take una enter di land wey E promise una grand-grand papa, Abraham, Isaak and Jakob sey E go give una; di land wey get big and fine-fine towns wey una nor build at-all
10 Moisés continuou: — O
11 and house where betta tins full, tins wey una nor buy with una hand. For di land, una go fetch wota from well wey una nor dig and una go chop from vineyards and olive trees wey una nor plant,
11 há casas cheias de objetos de valor, que vocês não ajuntaram; poços de água, que vocês não cavaram; e plantações de uvas e de azeitonas, que vocês não plantaram. Quando o Senhor os levar para essa terra, e vocês tiverem comida à vontade,
12 so make una dey kareful, so dat una nor go forget God wey take una komot Egypt.
12 tenham o cuidado de não esquecerem Deus, que os tirou do Egito, onde vocês eram escravos.
13 Una must fear di Oga una God kon serve am. Una must use only en name take swear.
13 Temam o Senhor , seu Deus, sirvam somente a ele e jurem só pelo nome dele.
14 Una must nor woship any of una neighbour gods apart from God ensef,
14 Não adorem outros deuses, os deuses dos povos vizinhos.
15 bikos di Oga una God wey dey here with una, dey jealous well-well and en vexnashon go kill and porshu evry oda tin, until E go distroy wiked pipol and sinnas komot from dis eart.
15 Pois o Senhor , nosso Deus, está com vocês e ele não tolera outros deuses. Se vocês os adorarem, o Senhor ficará irado com vocês e destruirá vocês completamente.
16 Make una nor test di Oga una God, just as una do wen una dey for Massah.
16 — Não ponham à prova o Senhor , seu Deus, como o puseram à prova em Massá.
17 Make una make sure sey una dey obey dis kommand well kon keep all di laws wey E give una.
17 Obedeçam cuidadosamente a todos os mandamentos e leis que ele lhes deu.
18 Make una always dey do wetin dey rite and good for God eye, so dat evritin go dey well with una, den una go enter and stay for di good land wey God promise sey E go give una grand-grand papa.
18 Façam aquilo que Deus acha bom e certo, e assim tudo correrá bem para vocês, e vocês entrarão e tomarão posse da boa terra que o Senhor jurou dar aos nossos antepassados.
19 Just as God sey make una do, all di enemies wey dey stay der, una go porshu dem komot.
19 E, conforme prometeu, ele expulsará todos os inimigos que vocês enfrentarem.
20 Tumoro wen una shidren go ask una sey, “Dis law, kommand and rules wey di Oga awa God give us, wetin dem mean?”
20 — No futuro os seus filhos perguntarão: “Por que foi que o Senhor , nosso Deus, nos deu estes mandamentos e estas leis?”
21 Den una go tell dem, “Wi bin dey Egypt as Fero slaves, but God take us komot from Egypt with en own strong hand.
21 Aí vocês responderão: “Nós éramos escravos do rei do Egito, mas o Senhor , com o seu grande poder, nos tirou de lá.
22 God do many mirakle, signs and wonders for awa front, bikos E kause betta wahala for Egypt, Fero and en pipol.
22 Nós vimos com os nossos próprios olhos os grandes milagres e as coisas espantosas que Deus fez contra os egípcios e contra o seu rei e toda a gente do seu palácio.
23 E take us komot from Egypt, so dat E go give us dis land wey E don promise awa grand-grand papa.
23 E Deus nos tirou do Egito para nos trazer aqui e nos dar esta terra, como havia jurado aos nossos antepassados.
24 Na di Oga awa God kommand us to obey and fear all en kommand, so dat E go kontinue to bless and guide awa life, as E dey do since kon rish today.
24 Ele nos mandou obedecer a todas estas leis e sempre temer o Senhor , nosso Deus. Se fizermos isso, ele nos guardará de todo mal, como tem feito até hoje, e tudo sempre correrá bem para nós.
25 Wi go dey good for en eye if wi obey all dis kommand wey di Oga awa God give us.”
25 E, se tivermos o cuidado de obedecer a todas estas leis que o Senhor , nosso Deus, nos deu, a nossa vida agradará a ele.”
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Deuteronômio 6, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.