Deuteronômio 5

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NTLH

Sair da comparação
NTLH Nova Tradução na Linguagem de Hoje 2000
1 Den Moses koll Israel pipol kon sey:
1 Moisés mandou que o povo se reunisse e falou assim: — Povo de Israel, preste atenção nas
2 Di Oga awa God make kovenant with us for Mount Sinai.
2 O Senhor , nosso Deus, fez uma aliança conosco no monte Sinai.
3 E nor make dis kovenant with awa grand-grand papa dem, but na with all of us wey dey alive today.
3 Não foi com os nossos pais que ele fez essa aliança, mas foi conosco, foi com todos os que hoje estamos aqui vivos.
4 God tok to us face-to-face for di mountin from inside fire.
4 Do meio do fogo ali no monte o Senhor Deus falou com vocês face a face.
5 (Dat time I stand between God and una, so dat I go tell una God message, bikos una dey fear di fire, so una nor fit klimb di mountin.)”
5 Vocês ficaram com medo do fogo e não subiram o monte; por isso eu me coloquei entre o Senhor Deus e vocês. E ele disse:
6 God sey, “Na mi bi di Oga wey bi una God, di One wey take una komot from Egypt where una for bi slave.
6 “Meu povo, eu, o Senhor , sou o seu Deus. Eu o tirei do Egito, a terra onde você era escravo.
7 Make una nor serve any oda god escept mi.
7 — “Não adore outros deuses; adore somente a mim.
8 Make una nor make any juju with anytin wey dey heaven; eart or for inside wota.
8 — “Não faça imagens de nenhuma coisa que há lá em cima no céu, ou aqui embaixo na terra, ou nas águas debaixo da terra.
9 Make una nor woship or serve dem, bikos mi wey bi una God dey jealous well-well. I go ponish una shidren and shidren-shidren for di sin wey dia papa kommit,
9 Não se ajoelhe diante de ídolos, nem os adore, pois eu, o Senhor , sou o seu Deus e não tolero outros deuses. Eu castigo aqueles que me odeiam e castigo também os seus descendentes, até os seus bisnetos e trinetos.
10 but I go show my mesi thru di kovenant to doz wey choose, obey and keep my kommand.
10 Porém sou bondoso com aqueles que me amam e obedecem aos meus mandamentos e abençoo os seus descendentes por milhares de gerações .
11 Make una nor use di Oga una God name take make yeye, bikos God nor go sorry for anybody wey use en name anyhow.
11 — “Não use o meu nome sem o respeito que ele merece, pois eu sou o Senhor , o Deus de vocês, e castigo aqueles que desrespeitam o meu nome.
12 Una must obey di Sabat Day, just as di Oga una God kommand una.
12 — “Guarde o sábado, que é um dia santo, como eu, o Senhor Deus, mandei.
13 Una fit work and do evritin wey una won do for six days,
13 Faça todo o seu trabalho durante seis dias da semana;
14 but for di sevent day, una must nor do any work. Dis mean sey, both unasef, una shidren, una savants, una animals or di strenjas wey dey with una, evribody must rest for dat day.
14 mas o sétimo dia da semana é o dia de descanso, dedicado a mim, o seu Deus. Não faça nenhum trabalho nesse dia, nem você, nem os seus filhos, nem as suas filhas, nem os seus escravos, nem as suas escravas, nem os seus animais, nem os estrangeiros que vivem na terra de você. Assim como você descansa, os seus escravos também devem descansar.
15 Remember sey una bi savant for Egypt and na di Oga una God take una komot der with en strong pawa. Na dis make God sey make una dey keep di Sabat Day.
15 Lembre que você foi escravo no Egito e que eu, o Senhor , seu Deus, o tirei de lá com a minha força e com o meu poder. É por isso que eu mando que você guarde o sábado.
16 Make una honor una papa and mama, just as di Oga una God don kommand una, so dat una go get long life and e go dey well with una for di land wey E won give una.
16 — “Respeite o seu pai e a sua mãe, como eu, o seu Deus, estou ordenando, para que você viva muito tempo, e tudo corra bem para você na terra que estou lhe dando.
17 Make una nor kill.
17 — “Não mate.
18 Make una nor sleep with who nor bi una husband or wife.
18 — “Não cometa adultério.
19 Make una nor tif.
19 — “Não roube.
20 Make una nor lie for pesin head.
20 — “Não dê testemunho falso contra ninguém.
21 Make una nor dey like anoda pesin wife or husband, or sey yu like to take pesin house, land, savants, animal or any oda tin.”
21 — “Não cobice a mulher de outro homem. Não cobice nada que seja de outro homem: a sua casa, as suas terras, os seus escravos, os seus animais ou qualquer outra coisa que seja dele.”
22 God tell una dis tins from inside di fire as una gada for di mountin. E shaut tok from di fire wey kloud and darkness kover. Dis na all di tins wey E tok dat time and E rite dem for two stones kon give dem to mi.
22 E Moisés disse: — São esses os mandamentos que o
23 But wen una hear en vois from di tick darkness as di mountin dey katch fire, all di eldas and leaders for una tribes kom meet mi.
23 E Moisés continuou, dizendo: — O fogo queimava no alto do monte, e vocês ouviram a voz falar do meio da escuridão. Então os chefes das
24 Dem kon sey, “Di Oga awa God don show us as en glory big rish and wi don hear am tok from inside di fire. Naw wi don know sey God fit tok to human being and dem go still dey alive.
24 e me disseram: “O Senhor , nosso Deus, nos mostrou a sua glória e o seu poder, e nós o ouvimos falar do meio do fogo. Hoje nós vimos que é possível Deus falar com uma pessoa e ela continuar viva.
25 But naw, why wi go won die again? Bikos if di Oga awa God tok to us again, den wi go really die! If wi kontinue to dey hear awa Oga God vois, wi go die!
25 Porém não queremos arriscar a vida outra vez. Esse grande fogo pode nos destruir, e, se nós ouvirmos a voz do Senhor , nosso Deus, sem dúvida morreremos.
26 E get anybody for dis whole world wey hear God vois from inside fire as wi hear am kon still dey alive like us?
26 Nunca houve alguém que continuasse a viver depois de ter ouvido, como nós ouvimos, o Deus vivo falando do meio do fogo.
27 Make una go by unasef kon listin to wetin God dey tok. Den make una kon tell us evritin wey E tell una and wi go listin and obey.”
27 Moisés, volte para o monte e escute o que o Senhor Deus quer dizer, e depois venha e nos conte tudo aquilo que ele disser. Nós ouviremos com atenção e obedeceremos.”
28 Wen God hear una dey tok to mi, E kon tell mi sey, “I hear wetin di pipol tell yu and dem tok well.
28 — O Senhor ouviu o que vocês disseram quando estavam falando comigo e me disse: “Eu ouvi o que o povo lhe falou, e tudo o que disseram está certo.
29 If to sey dem go just gri fear mi and obey all my kommand, e for dey well with dem and dia shidren-shidren forever.
29 Como seria bom se eles sempre pensassem assim, e me respeitassem, e sempre obedecessem a todos os meus mandamentos! Assim tudo daria certo para eles e para os seus descendentes para sempre.
30 “So make yu go tell dem, ‘Make dem go back to dia house!’
30 Vá, Moisés, e mande que o povo volte para as suas barracas.
31 But make yu nor follow dem go, yu go dey here with mi, so dat I go fit tell yu all di kommand, rules and law wey yu go tish dem, so dat dem go dey do dem for di land wey I go give dem.”
31 Mas você fique aqui comigo, e eu lhe direi todas as leis , ordens e mandamentos. Ensine-os ao povo a fim de que eles obedeçam a todas essas leis na terra que eu lhes estou dando para ser deles.”
32 So make una dey kareful kon do as di Oga una God kommand; make una nor turn go rite or left!
32 — Povo de Israel, faça tudo para cumprir todas as leis que o Senhor , nosso Deus, lhe deu. Nunca deixe de fazer exatamente o que Deus manda
33 Make una dey do just as E kommand una, so dat una nor go die; evritin go dey well with una and una go stay long for di land wey una dey go.
33 e nunca se desvie do caminho que ele lhe mostra. Assim tudo correrá bem para todos vocês, e vocês viverão muitos anos na terra que vão possuir.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Deuteronômio 5, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.