Deuteronômio 4
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NVI
1 Israel pipol, make una listin to di rules and law wey I won tish una naw. Make una obey dis law, so dat una go get betta life kon enter and stay di land wey awa grand-grand papa God promise sey E go give us.
1 E agora, ó Israel, ouça os decretos e as leis que lhes estou ensinando a cumprir, para que vivam e tomem posse da terra, que o Senhor, o Deus dos seus antepassados, dá a vocês.
2 Make una nor add join or remove from dis kommand wey I dey give una. Make una just obey di Oga una God kommand wey I dey give una.
2 Nada acrescentem às palavras que eu lhes ordeno e delas nada retirem, mas obedeçam aos mandamentos do Senhor, o Deus de vocês, que eu lhes ordeno.
3 All of una si wetin God do for Baal-Peor. How E distroy di pipol wey serve juju for der.
3 Vocês viram com os próprios olhos o que o Senhor fez em Baal-Peor. O Senhor, o seu Deus, destruiu do meio de vocês todos os que seguiram a Baal-Peor,
4 But all of una wey dey faithful to God still dey alive till today.
4 mas vocês, que permaneceram fiéis ao Senhor, o Deus de vocês, estão hoje todos vivos.
5 Si! I don tish una di rules and law, just as God tell mi, so dat una go dey do dem for di land wey una won enter go stay.
5 Eu lhes ensinei decretos e leis, como me ordenou o Senhor, o meu Deus, para que sejam cumpridos na terra na qual vocês estão entrando para dela tomar posse.
6 So make una dey sure sey una dey do dem, bikos dis tins go show how una get sense rish among di pipol wey go hear am and dem go sey, “True-true, dis great kountry get pipol wey wise well-well.”
6 Vocês devem obedecer-lhes e cumpri-los, pois assim os outros povos verão a sabedoria e o discernimento de vocês. Quando eles ouvirem todos estes decretos dirão: "De fato esta grande nação é um povo sábio e inteligente".
7 In-short, e nor get any oda kountry wey dia gods dey klose to dem like di Oga awa God wey dey ansa wen ever wi koll am.
7 Pois, que grande nação tem um Deus tão próximo como o Senhor, o nosso Deus, sempre que o invocamos?
8 Na wish oda great kountry get rules and law like di ones wey I tell una today?
8 Ou, que grande nação tem decretos e preceitos tão justos como esta lei que estou apresentando a vocês hoje?
9 But make una look well! Make una dey kareful, so dat una nor go forget wetin una don take una eyes si. As long as una dey life, make una nor let dis tins komot from una mind! Make una make sure sey una tell una shidren and grand-shidren about dis tins.
9 Apenas cuidado! Muito cuidado, para que vocês nunca se esqueçam das coisas que os seus olhos viram; conservem-nas na memória por toda a sua vida. Contem-nas a seus filhos e a seus netos.
10 Make una nor forget di day wey una stand before di Oga una God for Mount Horeb where E for tell mi sey, “Gada all di pipol kom meet mi, so dat I go tell dem my kommand. Den dem go learn to dey fear mi as long as dem dey alive and dem go tish dia shidren to dey fear mi too.”
10 Houve um dia em que vocês estiveram diante do Senhor, o seu Deus, em Horebe, quando o Senhor me disse: "Reúna o povo diante de mim para ouvir as minhas palavras, a fim de que aprendam a me temer enquanto viverem sobre a terra, e as ensinem a seus filhos".
11 Una waka kom stand near di mountin as di smoke from di mountin dey shot enter sky, but di mountin dark, bikos of di tick kloud.
11 Vocês se aproximaram e ficaram ao pé do monte. O monte ardia em chamas que subiam até o céu, e estava envolvido por uma nuvem escura e densa.
12 Den God tok to una from inside di fire. Una hear pesin dey tok, but una nor si anytin.
12 Então o Senhor falou a vocês do meio do fogo. Vocês ouviram as palavras, mas não viram forma alguma; apenas se ouvia a voz.
13 E give una en kovenant. E kommand sey make una dey obey di ten kommandment wey dem rite for two stone.
13 Ele lhes anunciou a sua aliança, os Dez Mandamentos. E escreveu-os sobre duas tábuas de pedra e ordenou que os cumprissem.
14 Na den God kommand mi sey, make I tish una dis rules and law, so dat una go obey dem for di land wey una won enter go stay.
14 Naquela ocasião, o Senhor mandou-me ensinar-lhes decretos e leis para que vocês os cumprissem na terra da qual vão tomar posse.
15 But make una dey kareful, bikos una nor know as God bi even wen E dey tok to una for Mount Sinai from inside di fire.
15 No dia em que o Senhor lhes falou do meio do fogo em Horebe, vocês não viram forma alguma. Portanto, tenham muito cuidado,
16 I dey tok like dis, so dat una nor go make juju kon kause wahala for unasef. Dis mean sey weda di juju bi like man or woman,
16 para que não se corrompam e não façam para si um ídolo, uma imagem de qualquer forma semelhante a homem ou mulher,
17 any animal, bird wey dey fly,
17 ou a qualquer animal da terra ou a qualquer ave que voa no céu,
18 anytin wey dey crawl for groun or any fish for wota.
18 ou a qualquer criatura que se move rente ao chão ou a qualquer peixe que vive nas águas debaixo da terra.
19 Wen una look di sky kon si di sun, moon and stars and as evritin bi for heaven, make una nor let anytin move una to woship or serve dem, bikos di Oga una God don give dem to di pipol for di eart.
19 E para que, ao erguerem os olhos ao céu e virem o sol, a lua e as estrelas, todos os corpos celestes, vocês não se desviem e se prostrem diante deles, e prestem culto àquilo que o Senhor, o seu Deus, distribuiu a todos os povos debaixo do céu.
20 Make una remember sey di Oga wey bi una God, save and take una komot from Egypt, so dat una go bi en own pipol wey E go guide and na so una bi till today.
20 A vocês, o Senhor tomou e os tirou da fornalha de fundir ferro, do Egito, para serem o povo de sua herança, como hoje se pode ver.
21 But God dey vex for mi, bikos of una and E swear sey I nor go ever cross Jordan River or enter di good land wey E go soon give us.
21 O Senhor irou-se contra mim por causa de vocês e jurou que eu não atravessaria o Jordão e não entraria na boa terra que o Senhor, o seu Deus, está lhes dando por herança.
22 So I must die for dis land; I nor go cross Jordan River. But una go cross ova kon take di land wey God promise us.
22 Eu morrerei nesta terra; não atravessarei o Jordão. Mas vocês atravessarão e tomarão posse daquela boa terra.
23 So make una dey kareful, so dat una nor go break di kovenant wey una make with di Oga una God. Make una nor make any juju for unasef, bikos una God nor like am.
23 Tenham o cuidado de não esquecer da aliança que o Senhor, o seu Deus, fez com vocês; não façam para si ídolo algum com a forma de qualquer coisa que o Senhor, o seu Deus, proibiu.
24 Di Oga una God na strong fire wey dey burn anytin and E dey jealous well-well.
24 Pois o Senhor, o seu Deus, é Deus zeloso; é fogo consumidor.
25 Afta una don born shidren and grand-shidren and una don tey for di land well-well, if una spoil unasef kon make juju and do yeye tins wey go make una Oga God vex,
25 Quando vocês tiverem filhos e netos, e já estiverem a muito tempo na terra, e se corromperem e fizerem ídolos de qualquer tipo, fazendo o que o Senhor, o seu Deus, reprova, provocando a sua ira,
26 I koll heaven and eart as witness today against una. If una break di kommand wey God give una thru mi, una go die for di land wey una won cross Jordan River enter. Una go stay der small; den God go distroy una finish.
26 invoco hoje o céu e a terra como testemunhas contra vocês de que vocês serão rapidamente eliminados da terra, da qual estão tomando posse ao atravessar o Jordão. Vocês não viverão muito ali; serão totalmente destruídos.
27 God go skata una among di pipol and una nor go many for di kountries wey God go drive una go.
27 O Senhor os espalhará entre os povos, e restarão apenas alguns de vocês entre as nações às quais o Senhor os levará.
28 For der, una go woship gods wey pesin take hand make; wood and stones wey nor go ever fit si, hear, chop or smell.
28 Lá vocês prestarão culto a deuses de madeira e de pedra, deuses feitos por mãos humanas, deuses que não podem ver, nem ouvir, nem comer, nem cheirar.
29 But if una turn to God from der, E go kom help una, dat na if una really turn kom meet am with all una heart and soul.
29 E lá procurarão o Senhor, o seu Deus, e o acharão, se o procurarem de todo o seu coração e de toda a sua alma.
30 For dat time, wen una dey trobol and all dis tins don happen to una, una go turn kom meet di Oga una God kon obey all en kommand
30 Quando vocês estiverem sofrendo e todas essas coisas tiverem acontecido com vocês, então, em dias futuros, vocês voltarão para o Senhor, o seu Deus, e lhe obedecerão.
31 (bikos E dey sorry for pipol), E nor go let una fall or distroy una, bikos E nor fit forget di kovenant wey E make with una grand-grand papa dem.
31 Pois o Senhor, o seu Deus, é Deus misericordioso; ele não os abandonará, nem os destruirá nem se esquecerá da aliança que com juramento fez com os seus antepassados.
32 True-true, make una look as e bi before, from di time wey God kreate pipol for dis eart kon rish naw and una look from where di heaven start go rish di end, anytin wey dey great like dis don ever happen or sey pipol si am before?
32 Perguntem, agora, aos tempos antigos, antes de vocês existirem, desde o dia em que Deus criou o homem sobre a terra. Perguntem de um lado ao outro do céu: Já aconteceu algo tão grandioso ou já se ouviu algo parecido?
33 Any kountry don ever hear God vois dey tok to dem from inside fire as una hear kon survive to tell pipol about am?
33 Que povo ouviu a voz de Deus falando do meio do fogo, como vocês ouviram, e continua vivo?
34 Or God don ever try to diliver one kountry from anoda kountry with judgement, signs, wonders, war, strent, pawa or any oda tin wey dey make pesin fear like di ones wey God do for Egypt for una own eyes?
34 Ou que deus decidiu tirar uma nação do meio de outra para lhe pertencer, com provas, sinais, maravilhas e lutas, com mão poderosa e braço forte, e com feitos temíveis e grandiosos, conforme tudo o que o Senhor fez por vocês no Egito, como vocês viram com os seus próprios olhos?
35 E show una dis tins, so dat una go know sey na di Oga God bi God and no oda pesin or tin, big rish am.
35 Tudo isso foi mostrado a vocês para que soubessem que o Senhor é Deus; e que não há outro além dele.
36 E let una hear en vois from heaven, so dat E go fit tell una wetin una go do. E make una si en great fire for eart here, so dat E go tok to una from der.
36 Do céu ele fez com que vocês ouvissem a sua voz, para discipliná-los. Na terra, mostrou-lhes o seu grande fogo, e vocês ouviram as suas palavras vindas do meio do fogo.
37 Bikos E love una grand-grand papa, E kon choose to bless dia shidren-shidren and na en own hand E take komot una from Egypt with all di wonders wey E do.
37 E porque amou os seus antepassados e escolheu a descendência deles, ele foi em pessoa tirá-los do Egito com o seu grande poder,
38 E porshu kountries wey strong pass una komot from dia land, so dat una go fit take di land kon stay der forever.
38 para expulsar diante de vocês nações maiores e mais fortes, a fim de fazê-los entrar e possuir como herança a terra deles, como hoje se vê.
39 So make una remember dis tins kon keep am well for una heart: Na di Oga God bi God, both for heaven and for eart and know oda god, dey.
39 Reconheçam isso hoje, e ponham no coração que o Senhor é Deus em cima nos céus e embaixo na terra. Não há nenhum outro.
40 If una obey all di laws and kommand wey I dey give una today, e go betta for una and una shidren. I dey give una dis kommand, so dat una go get long life for di land wey di Oga una God dey give una forever.
40 Obedeçam aos seus decretos e mandamentos que hoje eu lhes ordeno, para que tudo vá bem com vocês e com seus descendentes, e para que vivam muito tempo na terra que o Senhor, o seu Deus, lhes dá para sempre.
41 Den Moses selet three town for Jordan River east.
41 Então Moisés separou três cidades a leste do Jordão,
42 Anybody wey by mistake kill pesin wen e bi sey dem nor get wahala or kworel before, fit run go one for dis towns and e go dey save.
42 para onde poderia fugir quem tivesse matado alguém sem intenção e sem premeditação. O perseguido poderia fugir para uma dessas cidades a fim de salvar a vida.
43 Dis towns na: Beza wey dey di wildaness high land for Reuben tribe; Ramot for Gilead wey bi Gad tribe own and Golan for Bashan wey bi Manasseh tribe own.
43 As cidades eram as seguintes: Bezer, no planalto do deserto, para a tribo de Rúben; Ramote, em Gileade, para a tribo de Gade; e Golã, em Basã, para a tribo de Manassés.
44 Dis na di law wey Moses give Israel pipol.
44 Esta é a lei que Moisés apresentou aos israelitas.
45 All dis na di law, rules and kommand wey Moses tell Israel pipol afta e don lead dem komot from Egypt
45 Estes são os mandamentos, os decretos e as ordenanças que Moisés promulgou como leis para os israelitas quando saíram do Egito,
46 and as dem dey kamp for di valley near Bet-Peor wey dey east for Jordan River. (Amor pipol wey dia king bi Sihon wey bin rule form Heshbon, na dem get dis place before. But Moses and Israel pipol kom from Egypt kon distroy di king and en pipol.
46 do outro lado do Jordão, no vale fronteiro a Bete-Peor, na terra de Seom, rei dos amorreus, que habitava em Hesbom, a quem Moisés e os israelitas derrotaram quando saíram do Egito.
47 Israel pipol take di land and King Og for Bashan own too and na di two kings for Amor get am.
47 Eles tomaram posse da terra dele e da terra de Ogue, rei de Basã, os dois reis amorreus que viviam a leste do Jordão.
48 So Israel pipol take all di aria wey dey for Aroer near Arnon Gorge go rish Mount Sion, wey dem still dey koll Mount Hermon.
48 Essa terra estendia-se desde Aroer, na margem do ribeiro do Arnom, até o monte Siom, isto é, o Hermom,
49 Israel pipol still win all di wotaside for Jordan River east go rish di sout for di Deat Sea, under Pisgah aria.)
49 e incluía toda a região da Arabá, a leste do Jordão, até o mar da Arabá, abaixo das encostas do Pisga.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Deuteronômio 4, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.