Deuteronômio 3

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARC

Sair da comparação
ARC Almeida Revista e Corrigida 2009
1 Den wi turn kon dey go Bashan and King Og for Bashan kon gada en sojas kom fight us for Edrei.
1 Depois, nos viramos e subimos o caminho de Basã; e Ogue, rei de Basã, nos saiu ao encontro, ele e todo o seu povo, à peleja em Edrei.
2 But God tell mi, “Make una nor fear, bikos I don give una viktory ova King Og and all en sojas and I go give una all en land. Make una do to am, just as una do to King Sihon for Heshbon town inside Amor.”
2 Então, o Senhor me disse: Não o temas, porque a ele, e a todo o seu povo, e a sua terra tenho dado na tua mão; e far-lhe-ás como fizeste a Seom, rei dos amorreus, que habitava em Hesbom.
3 So God make us win King Og for Bashan and all en sojas, den wi kill dem finish.
3 E também o Senhor , nosso Deus, nos deu na nossa mão a Ogue, rei de Basã, e a todo o seu povo; de maneira que o ferimos, até que ninguém lhe ficou de restante.
4 For dat time, wi kollect all di towns wey e get. E nor get any town wey wi nor take from dem. Wi take sixty towns and all di aria for Argob wey bi Bashan main kingdom.
4 E, naquele tempo, tomamos todas as suas cidades; nenhuma cidade houve que lhe não tomássemos: sessenta cidades, toda a borda da terra de Argobe e o reino de Ogue, em Basã.
5 Dem guide all dis towns with high walls, big gates kon lock dem with betta iron key and dem still get many village.
5 Todas essas cidades eram fortificadas com altos muros, portas e ferrolhos; além de outras muitas cidades sem muros.
6 Wi judge dem well, both wimen and shidren, just as wi judge King Sihon for Heshbon.
6 E destruímo-las, como fizemos a Seom, rei de Hesbom, destruindo todas as cidades, homens, mulheres e crianças.
7 But wi keep all di animal and evry oda tin wey wi karry from di town.
7 Porém todo o gado e o despojo das cidades tomamos para nós por presa.
8 So for dat time, wi take di two king for Amor land for (Trans-Jordan) go rish River Arnon and Mount Hermon
8 Assim, naquele tempo, tomamos a terra da mão daqueles dois reis dos amorreus, que estavam dalém do Jordão: desde o rio Arnom até ao monte Hermom
9 (Sidon pipol dey koll am Hermon Sirion, why Amor pipol dey koll am Senir),
9 (os sidônios a Hermom chamam Siriom; porém os amorreus lhe chamam Senir),
10 all di towns wey dey di high lands, all di lands for Gilead and Bashan go rish Salekah and Edrei, di towns wey bi King Og for Bashan, own.
10 todas as cidades da terra plana, e todo o Gileade, e todo o Basã até Salca, e Edrei, cidades do reino de Ogue, em Basã.
11 For all Refah pipol, na only King Og for Bashan remain. (Na iron dem take make en bed and e still dey for Rabbah wey dey Ammon. Akordin to how dem dey measure, di bed long rish thirteen and half fit and e wide rish six fit.)
11 (Porque só Ogue, rei de Basã, ficou do resto dos gigantes; eis que o seu leito, um leito de ferro, não está porventura em Rabá dos filhos de Amom? De nove côvados o seu comprimento, e de quatro côvados a sua largura, pelo côvado de um homem.)
12 Dis na di land wey wi kollect den: Di aria from Aroer go River Arnon and half for Gilead hill kountries with dia towns, I give dem to Reuben and Gad tribe.
12 Tomamos, pois, esta terra em possessão naquele tempo; desde Aroer, que está junto ao ribeiro de Arnom, e a metade da montanha de Gileade, com as suas cidades, tenho dado aos rubenitas e gaditas.
13 Di remainin one for Gilead and di land for Bashan and King Og kingdom, I give dem to half for Manasseh tribe. (All di aria for Argob, dat is, all Bashan wey dem dey koll Refah land.
13 E o resto de Gileade, como também todo o Basã, o reino de Ogue, dei à meia tribo de Manassés. (Toda aquela borda da terra de Argobe, por todo o Basã, se chamava a terra dos gigantes.
14 Manasseh pikin, Jair take Argob aria go rish Geshur and Maakat pipol borda (wey bi Bashan), den e shange di town name to en name. And na Havvot-Jair dem dey koll am till today.)
14 Jair, filho de Manassés, alcançou toda a porção da terra de Argobe, até ao termo dos gesuritas e maacatitas, e a chamou pelo seu nome, Basã-Havote-Jair, até este dia.)
15 I give Gilead to Makir.
15 E a Maquir dei Gileade.
16 Di aria from Gilead go rish River Arnon (Di main centre) go rish River Jabbok, wey dey Ammon pipol borda, I still give dem to Reuben and Gad tribe.
16 Mas aos rubenitas e gaditas dei desde Gileade até ao ribeiro de Arnom, o meio do ribeiro e o termo; e até ao ribeiro de Jaboque, o termo dos filhos de Amom,
17 Arabah and Jordan River na still borda for Kinneret Sea go rish Arabah Sea (dat is, di Salt Sea), under di low land for Pisgah go rish di east.
17 como também a campina e o Jordão com o termo: desde Quinerete até ao mar da campina, o mar Salgado, abaixo de Asdote-Pisga para o oriente.
18 For dat time, I tell dem sey: “Di Oga wey bi una God don give una dis land as una own. Una sojas wey don ready for war go cross first, before Israel pipol go follow for back.
18 E vos mandei mais, no mesmo tempo, dizendo: O Senhor , vosso Deus, vos deu esta terra, para possuí-la; passai, pois, armados vós, todos os homens valentes, adiante de vossos irmãos, os filhos de Israel.
19 But una wifes, shidren and animals (Bikos I know sey dem many), make dem stay for di towns wey I give una.
19 Tão somente vossas mulheres, e vossas crianças, e vosso gado (porque eu sei que tendes muito gado) ficarão nas vossas cidades que já vos tenho dado,
20 Una must fight until God make una pipol win, just as E do for una and dem go kollect di land wey God give dem for di oda side for Jordan River. Den una fit go back to una own land wey I don give una.”
20 até que o Senhor dê descanso a vossos irmãos como a vós, para que eles herdem também a terra que o Senhor , vosso Deus, lhes há de dar dalém do Jordão; então, voltareis cada qual à sua herança, que já vos tenho dado.
21 I still kommand Joshua sey, “Yu don si evritin wey di Oga yor God do to doz two kings; E go still do di same tin to all di kingdoms wey yu go-go.
21 Também dei ordem a Josué, no mesmo tempo, dizendo: Os teus olhos veem tudo o que o Senhor , vosso Deus, tem feito a estes dois reis; assim fará o Senhor a todos os reinos, a que tu passarás.
22 So make una nor fear, bikos di Oga una God go fight for una by ensef.”
22 Não os temais, porque o Senhor , vosso Deus, é o que peleja por vós.
23 So for dat time, I beg God,
23 Também eu pedi graça ao Senhor , no mesmo tempo, dizendo:
24 “My Oga God, yu don start to show mi yor pawa and how Yu strong rish. (Na wish god for heaven or eart go fit do wetin Yu dey do so?)
24 Senhor Jeová , já começaste a mostrar ao teu servo a tua grandeza e a tua forte mão; porque, que deus há nos céus e na terra, que possa fazer segundo as tuas obras e segundo a tua fortaleza?
25 Abeg make Yu let mi cross with Israel pipol, so dat I go si di land wey Yu promise awa grand-grand papa dem for di oda side for Jordan River, wey get betta kountries for di hill and Lebanon!”
25 Rogo-te que me deixes passar, para que veja esta boa terra que está dalém do Jordão, esta boa montanha e o Líbano.
26 But God vex for mi, bikos of una and E nor gri listin to mi. Instead, E tell mi, “E don do! Make yu nor tok to mi about dat matter again!
26 Porém o Senhor indignou-se muito contra mim, por causa de vós, e não me ouviu; antes, o Senhor me disse: Basta; não me fales mais neste negócio.
27 But klimb go Pisgah and make yu look di east, nort, sout and west well-well, bikos I nor go let yu cross Jordan River.
27 Sobe ao cume de Pisga, e levanta os teus olhos ao ocidente, e ao norte, e ao sul, e ao oriente, e vê com os teus olhos, porque não passarás este Jordão.
28 But yu go make Joshua di leader kon enkourage am, bikos na-im go take dis pipol cross kon make dem get di land wey yu go si.”
28 Manda, pois, a Josué, e esforça-o, e conforta-o; porque ele passará adiante deste povo e o fará possuir a terra que apenas verás.
29 So wi stay for Bet-Peor Valley.
29 Assim, ficamos neste vale defronte de Bete-Peor.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Deuteronômio 3, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.