Deuteronômio 31

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARA

Sair da comparação
ARA Almeida Revista e Atualizada 1993
1 Den Moses tell Israel pipol dis word.
1 Passou Moisés a falar estas palavras a todo o Israel
2 “I don rish one hundred and twenty years naw and I nor go fit still bi una leader again. God don tell mi sey, ‘Yu nor go follow dem cross Jordan River.’
2 e disse-lhes: Sou, hoje, da idade de cento e vinte anos. Já não posso sair e entrar, e o Senhor me disse: Não passarás o Jordão.
3 Na di Oga una God bi di Pesin wey go cross before una. E go distroy all di oda kountries for una and una go porshu dem komot. Oga God sey na Joshua go lead una cross Jordan River.
3 O Senhor , teu Deus, passará adiante de ti; ele destruirá estas nações de diante de ti, e tu as possuirás; Josué passará adiante de ti, como o Senhor tem dito.
4 God go ponish dis kountries just as E do to Amor pipol kings, Sihon and Og kon distroy dia land.
4 O Senhor lhes fará como fez a Seom e a Ogue, reis dos amorreus, os quais destruiu, bem como a sua terra.
5 God go put dem for una hand and na wetin I kommand una, una must do to dem.
5 Quando, pois, o Senhor vos entregar estes povos diante de vós, então, com eles fareis segundo todo o mandamento que vos tenho ordenado.
6 Make una dey strong and make una heart nor shake; make una nor fear dem at-all, bikos na di Oga una God dey go with una. E nor go leave or forget una.”
6 Sede fortes e corajosos, não temais, nem vos atemorizeis diante deles, porque o Senhor , vosso Deus, é quem vai convosco; não vos deixará, nem vos desamparará.
7 Den Moses koll Joshua kom out for all di pipol present kon sey, “Make yu dey strong and make yor heart nor shake, bikos na yu go lead dis pipol go di land wey God promise dia grand-grand papa and na yu go make dem get am.
7 Chamou Moisés a Josué e lhe disse na presença de todo o Israel: Sê forte e corajoso; porque, com este povo, entrarás na terra que o Senhor , sob juramento, prometeu dar a teus pais; e tu os farás herdá-la.
8 God go-go for yor front. E go dey with yu; E nor go leave or forget yu. Make fear nor katch yu and make di work nor taya yu.”
8 O Senhor é quem vai adiante de ti; ele será contigo, não te deixará, nem te desamparará; não temas, nem te atemorizes.
9 Moses rite all dis law kon gi-am to di priest, Levi shidren wey karry God Kovenant Box and e still give di law to all di eldas for Israel.
9 Esta lei, escreveu-a Moisés e a deu aos sacerdotes, filhos de Levi, que levavam a arca da Aliança do Senhor , e a todos os anciãos de Israel.
10 Moses kommand dem: “For di last day for evry seven years, for di rite time for di year wey dem dey kansol pipol debt, durin di time wey dem dey do Shelta First,
10 Ordenou-lhes Moisés, dizendo: Ao fim de cada sete anos, precisamente no ano da remissão, na Festa dos Tabernáculos,
11 wen Israel pipol go kom before di Oga una God for di place wey E choose, yu must read dis law for dem make dem hear.
11 quando todo o Israel vier a comparecer perante o Senhor , teu Deus, no lugar que este escolher, lerás esta lei diante de todo o Israel.
12 Make una gada all di pipol: men, wimen and shidren, plus all di strenjas among una, so dat dem go hear, learn and know how to fear di Oga una God kon obey all en law.
12 Ajuntai o povo, os homens, as mulheres, os meninos e o estrangeiro que está dentro da vossa cidade, para que ouçam, e aprendam, e temam o Senhor , vosso Deus, e cuidem de cumprir todas as palavras desta lei;
13 Den dia shidren wey know di law, go still hear, learn and fear di Oga una God as long as una dey di land wey una dey cross Jordan River go stay.”
13 para que seus filhos que não a souberem ouçam e aprendam a temer o Senhor , vosso Deus, todos os dias que viverdes sobre a terra à qual ides, passando o Jordão, para a possuir.
14 Den God tell Moses, “Di time wey yu go die don near well-well. Make yu koll Joshua kom di Tabanako, so dat I go fit tell am wetin e go do.” So Moses and Joshua go di Tabanako where di pipol gada put.
14 Disse o Senhor a Moisés: Eis que os teus dias são chegados, para que morras; chama Josué, e apresentai-vos na tenda da congregação, para que eu lhe dê ordens. Assim, foram Moisés e Josué e se apresentaram na tenda da congregação.
15 God appear to dem like kloud for di door-mot.
15 Então, o Senhor apareceu, ali, na coluna de nuvem, a qual se deteve sobre a porta da tenda.
16 Den God tell Moses, “Yu go soon die, den di pipol go kon dey sin with strenj gods for di land where dem dey go. Dem go rijet mi kon break my kovenant wey I make with dem.
16 Disse o Senhor a Moisés: Eis que estás para dormir com teus pais; e este povo se levantará, e se prostituirá, indo após deuses estranhos na terra para cujo meio vai, e me deixará, e anulará a aliança que fiz com ele.
17 For dat time, I go vex for dem well-well kon leave and hide my face from dem until dia enemies kill dem finish. Many wahala and trobol go ovakom dem and dem go sey, ‘Dis wahala don finish us, bikos God no dey with us again.’
17 Nesse dia, a minha ira se acenderá contra ele; desampará-lo-ei e dele esconderei o rosto, para que seja devorado; e tantos males e angústias o alcançarão, que dirá naquele dia: Não nos alcançaram estes males por não estar o nosso Deus no meio de nós?
18 But dat time, I go really hide my face, bikos of all di wikedness wey dem don do as dem dey serve oda gods.
18 Esconderei, pois, certamente, o rosto naquele dia, por todo o mal que tiverem feito, por se haverem tornado a outros deuses.
19 “But make yu rite dis song for yorsef kon tish evribody for Israel. Make sure sey dem know am, so dat dis song go bi my witness against dem!
19 Escrevei para vós outros este cântico e ensinai-o aos filhos de Israel; ponde-o na sua boca, para que este cântico me seja por testemunha contra os filhos de Israel.
20 Bikos afta I don bring dem kom di land wey I promise dia grand-grand papa; di land wey get milk and honey; where dem go chop beleful kon get body, dem go turn go serve anoda god kon rijet and break my kovenant.
20 Quando eu tiver introduzido o meu povo na terra que mana leite e mel, a qual, sob juramento, prometi a seus pais, e, tendo ele comido, e se fartado, e engordado, e houver tornado a outros deuses, e os houver servido, e me irritado, e anulado a minha aliança;
21 Den wen wahala and sofa fall for dia head, dis song go bi witness against dem, bikos dia shidren-shidren nor go forget am. I know wetin dem dey tink for dia mind today, even before I take dem go di land wey I promise dem.”
21 e, quando o tiverem alcançado muitos males e angústias, então, este cântico responderá contra ele por testemunha, pois a sua descendência, sempre, o trará na boca; porquanto conheço os desígnios que, hoje, estão formulando, antes que o introduza na terra que, sob juramento, prometi.
22 So for dat day, Moses rite di song kon tish evribody for Israel
22 Assim, Moisés, naquele mesmo dia, escreveu este cântico e o ensinou aos filhos de Israel.
23 and God kon make Joshua, Nun pikin leader for Israel sey, “Make yu dey strong and nor fear, bikos yu go take Israel, my pipol go di land wey I promise dem and I go dey with yu.”
23 Ordenou o Senhor a Josué, filho de Num, e disse: Sê forte e corajoso, porque tu introduzirás os filhos de Israel na terra que, sob juramento, lhes prometi; e eu serei contigo.
24 Wen Moses rite finish for dia present,
24 Tendo Moisés acabado de escrever, integralmente, as palavras desta lei num livro,
25 e kon kommand Levi pipol wey dey karry God Kovenant Box sey,
25 deu ordem aos levitas que levavam a arca da Aliança do Senhor , dizendo:
26 “Make una take di Law Book kon put am near di Oga una God Kovenant Box. E go dey der as witness against una,
26 Tomai este Livro da Lei e ponde-o ao lado da arca da Aliança do Senhor , vosso Deus, para que ali esteja por testemunha contra ti.
27 bikos I know as una sturbon rish. True-true, as I stay among una kon rish today, una still dey disobey God; so how una sturbones go kon bi wen I don die?
27 Porque conheço a tua rebeldia e a tua dura cerviz. Pois, se, vivendo eu, ainda hoje, convosco, sois rebeldes contra o Senhor , quanto mais depois da minha morte?
28 Make all di tribes kom meet mi; una eldas and ofisas, so dat I go tok to dem by mysef about dis tins kon koll di heavens and eart to bi witness against dem.
28 Ajuntai perante mim todos os anciãos das vossas tribos e vossos oficiais, para que eu fale aos seus ouvidos estas palavras e contra eles, por testemunhas, tomarei os céus e a terra.
29 Bikos I know sey wen I don die, una go spoil unasef kon turn from dis way wey I kommand una. Wahala go kom meet una dat time, bikos una don do bad tins wey go make God vex.”
29 Porque sei que, depois da minha morte, por certo, procedereis corruptamente e vos desviareis do caminho que vos tenho ordenado; então, este mal vos alcançará nos últimos dias, porque fareis mal perante o Senhor , provocando-o à ira com as obras das vossas mãos.
30 Den Moses sing di words for di song from biginnin go rish di end, so dat evribody wey dey Israel, go hear am.
30 Então, Moisés pronunciou, integralmente, as palavras deste cântico aos ouvidos de toda a congregação de Israel:

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Deuteronômio 31, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.