Deuteronômio 30
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs BKJ
1 I don give una choice to choose between di blessing and di curse. Wen all dis tins don happen to una and una dey stay for di nashons where di Oga una God skata una go, una go remember di choice wey I give una.
1 E acontecerá, quando todas essas coisas vierem sobre ti, a maldição e a bênção, que pus diante de ti, e te lembrares delas entre todas as nações a que o SENHOR teu Deus te levou,
2 If una and una shidren-shidren turn kom meet God kon obey all en kommand wey I dey give una today, with una heart and soul,
2 e retornares ao SENHOR teu Deus, e obedeceres à sua voz, conforme tudo o que te ordeno hoje, tu e os teus filhos, com todo o teu coração, e com toda a tua alma,
3 den di Oga una God go sorry for una. E go bring una kom back from di kountries wey E bin skata una go kon make una prosper again.
3 então o SENHOR teu Deus reverterá o teu cativeiro, e terá compaixão de ti, e voltará e te congregará dentre todas as nações para onde o SENHOR teu Deus te tiver dispersado.
4 Even if una skata for evriwhere for di eart, di Oga una God go gada and bring una kom back to una land.
4 Se algum dos teus for levado às partes extremas dos céus, dali o SENHOR teu Deus te congregará, e dali te tomará;
5 Di Oga una God go take una enter di land wey E give una grand-grand papa, so dat e go bi una own too. E go make una prosper and many pass una grand-grand papa dem.
5 e o SENHOR teu Deus te trará à terra que teus pais possuíram, e a possuirás; e ele te fará bem, e te multiplicará mais do que a teus pais.
6 Di Oga una God go sekonsaiz una and una shidren heart by ensef, so dat una go love am with all una heart and soul, den una go get betta life.
6 E o SENHOR teu Deus circuncidará o teu coração, e o coração da tua semente, para que ames ao SENHOR teu Deus com todo o teu coração, e com toda a tua alma, para que possas viver.
7 But di Oga una God go put all dis curse for una enemies head and doz wey dey won kill una.
7 E o SENHOR teu Deus porá todas essas maldições sobre os teus inimigos, e sobre aqueles que te odeiam, que te perseguiram.
8 Den una go obey God vois kon keep all en kommand wey I dey kommand una today.
8 E voltarás e obedecerás à voz do SENHOR, e cumprirás todos os seus mandamentos, que te ordeno neste dia.
9 For all di work wey una go do with una hand, God go make una prosper. Una and una animals go get plenty pikin and una plant go produce plenty food. Bikos God go dey happy to make una prosper, just as E dey happy wen una grand-grand papa dey prosper.
9 E o SENHOR teu Deus te fará abundante em toda obra de tua mão, no fruto de teu corpo, e no fruto de teu gado, e no fruto de tua terra, para o bem, porque o SENHOR teu Deus se alegrará contigo, para o bem, como se alegrou com os teus pais,
10 Dis tin go happen wen una obey di Oga una God vois kon keep all en law and kommand wey dem rite for di Law Book, bikos una don turn kom meet God with all una heart and soul.
10 se ouvires a voz do SENHOR teu Deus, e guardares os seus mandamentos e os seus estatutos, que estão escritos neste livro da lei, e se te converteres ao SENHOR teu Deus com todo o teu coração, e com toda a tua alma.
11 Di way wey I dey kommand una today, nor dey too strong for una and e nor too mush.
11 Porque este mandamento, que te ordeno hoje, não está oculto de ti, nem está distante.
12 E nor dey for heaven so make nobody sey, “Who go-go heaven go bring di kommand kom for us, so dat wi go hear and do am?”
12 Não está nos céus, para que digas: Quem subirá por nós aos céus, e o trará a nós, para que possamos ouvi-lo e cumpri-lo?
13 Di kommand nor dey for di oda side for di river, so una nor nid to ask, “Na who go cross di river go bring am for us, so dat wi go hear and obey am?”
13 Tampouco está além do mar, para que digas: Quem irá além do mar por nós, e o trará a nós, para que possamos ouvi-lo e cumpri-lo?
14 But di word and kommand dey here with una. Una know am and una fit read am, so make una obey am.
14 Mas a palavra está muito próxima de ti, na tua boca, e no teu coração, para que possas cumpri-la.
15 Make una know sey, “I dey give una choice between good and bad; life and deat.
15 Vê, eu coloco diante de ti neste dia a vida e o bem, e a morte e o mal;
16 If una obey di Oga una God kommand wey I dey give una today so, den una kon love di Oga una God; dey do as E tok; dey keep en rules, law and kommand, una go get long life kon dey many more-more and di Oga una God go bless una for di land wey una won enter as una own.
16 por isso, te ordeno hoje, que ames ao SENHOR teu Deus, que andes nos seus caminhos, e que guardes os seus mandamentos, e os seus estatutos, e os seus juízos, para que possas viver e te multiplicar; e o SENHOR teu Deus te abençoará na terra que vais possuir.
17 “But if una turn against God and E kommand kon dey woship juju and oda gods,
17 Mas se o teu coração se desviar, de modo que não quiseres dar ouvidos, mas fores atraídos a adorar outros deuses, e os servires,
18 I dey tell una today sey una go die! Una nor go stay tey for di land wey una dey cross Jordan River go take as una own.
18 eu vos denuncio hoje, que certamente perecereis e que não prolongareis os vossos dias sobre a terra, a qual cruzaste o Jordão para ir e possuir.
19 “I koll heaven and eart make dem bi witness against una today sey, I don give una choice between life and deat, blessing and curse. So make una choose life, so dat una with una shidren go get long life.
19 Chamo os céus e a terra para registrar hoje, contra vós, que coloquei diante de vós a vida e a morte, a bênção e a maldição; portanto escolhe a vida, para que a tua semente possa viver;
20 Den una go love di Oga wey bi una God kon dey obey en vois and hold am strong, bikos God go give una long life for di land wey E promise to give una grand-grand papa Abraham, Isaak and Jakob.”
20 para que possas amar ao Senhor teu Deus, e para que possas obedecer à sua voz, e para que possas te apegar a ele; porque ele é a tua vida, e a duração dos teus dias; para que possas habitar na terra que o Senhor jurou aos teus pais, a Abraão, a Isaque e a Jacó, que lhes daria.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Deuteronômio 30, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.