Deuteronômio 2
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NVI
1 Den wi turn kon travel pass di wildaness go di Red Sea, just as God kommand mi and wi kon dey waka anyhow round Mount Seir for many days.
1 Então demos meia-volta e partimos para o deserto pelo caminho do mar Vermelho, como o Senhor me havia ordenado. E por muitos anos caminhamos em redor dos montes de Seir.
2 At last, God kon tell mi,
2 Então o Senhor me disse:
3 “Una don too waka round dis mountin, so make una turn face nort.
3 "Vocês já caminharam bastante tempo ao redor destas montanhas; agora andem para o norte.
4 Make yu give dis kommand to di pipol: ‘Una go soon cross una pipol Edom kountry, wey una broda Esau bi dia grand-grand papa and dem dey stay for Seir. Edom pipol go dey fear una so make una dey kareful.
4 E diga ao povo: Vocês estão passando pelo território de seus irmãos, os descendentes de Esaú, que vivem em Seir. Eles terão medo de vocês, mas tenham muito cuidado.
5 Make una nor borda dem at-all, bikos I nor go give una any of dia land, bikos na di whole Mount Seir land I give Esau dia grand-grand papa.
5 Não os provoquem, pois não darei a vocês parte alguma da terra deles, nem mesmo o espaço de um pé. Já dei a Esaú a posse dos montes de Seir.
6 Una fit buy food chop from dem and wota to drink from dem too.
6 Vocês lhes pagarão com prata a comida que comerem e a água que beberem".
7 “ ‘Di Oga wey bi una God don bless una for evritin wey una dey do. Evry step wey una take for di great wildaness, I dey with una. For dis forty years wey una dey dis wildaness, God dey with una and una get evritin.’ ”
7 Pois o Senhor, o seu Deus, os tem abençoado em tudo o que vocês têm feito. Ele cuidou de vocês em sua jornada por este grande deserto. Nestes quarenta anos o Senhor, o seu Deus, tem estado com vocês, e não lhes tem faltado coisa alguma.
8 So wi nor kon follow Edom, Esau pipol kountry wey dey for Mount Seir. Wi nor pass thru Arabah Valley wey kom from Elat and Ezion-Geber, but wi travel pass Moab dirty land.
8 Assim, passamos ao largo de nossos irmãos, os descendentes de Esaú, que habitam em Seir. Saímos da rota da Arabá, de Elate e de Eziom-Geber. Voltamos e fomos pela rota do deserto de Moabe.
9 Den God tell mi, “Make una nor let Moab pipol wey bi Lot shidren-shidren vex. Make una nor kause wetin go make dem won fight una, bikos I nor go give una any of dia land, bikos I don give Ar to Lot shidren-shidren.
9 Então o Senhor me disse: "Não perturbem os moabitas nem os provoquem à guerra, pois não darei a vocês parte alguma da terra deles, pois já entreguei a região de Ar aos descendentes de Ló".
10 “(Emim pipol dey stay der before; pipol wey get betta pawa many well-well for der and dem tall like Anak pipol.
10 ( Antigamente os emins habitavam nessa terra; era um povo forte e numeroso, alto como os enaquins.
11 Na Refah and Anak dem still dey koll dis pipol; but Moab pipol dey koll dem Emim.
11 Como os enaquins, eles também eram considerados refains, mas os moabitas os chamavam emins.
12 Before-before, na Hor pipol dey stay for Seir, but Esau shidren-shidren drive and distroy dem, den kon stay der, just as Israel pipol do to di land wey dem take and na God give dem dis land.)”
12 Também em Seir antigamente habitavam os horeus. Mas os descendentes de Esaú os expulsaram e os exterminaram e se estabeleceram no seu lugar, tal como Israel fez com a terra que o Senhor lhe deu. )
13 God sey, “Naw, make una cross go River Zered.” So wi kon do as E tok.
13 "Agora levantem-se! Atravessem o vale de Zerede". Assim atravessamos o vale.
14 Na thirty-eight years e take us to cross from Kadesh Barnea go River Zered and dat time, all di sojas for dat generashon die finish, just as God tell dem.
14 Passaram-se trinta e oito anos entre a época em que partimos de Cades-Barnéia, até quando atravessamos o vale de Zerede, até que pereceu do acampamento toda aquela geração de homens de guerra, conforme o Senhor lhes havia jurado.
15 True-true, na God kill all of dem finish with en own hand for di kamp.
15 A mão do Senhor caiu sobre eles e por fim os eliminou completamente do acampamento.
16 So wen all di sojas don die finish among di pipol,
16 Depois que todos os guerreiros do povo tinham morrido,
17 God kon tell mi,
17 o Senhor me disse:
18 “Today, una go cross pass Moab pipol borda wey bi Ar land.
18 "Vocês estão prestes a passar pelo território de Moabe, pela região de Ar,
19 But wen una don near Ammon pipol, make una nor let dem vex won kon fight una, bikos I nor go give una any of dia land; bikos I don already gi-am to Lot shidren-shidren.
19 e vão chegar perto da fronteira dos amonitas. Não sejam hostis a eles, pois não darei a vocês parte alguma da terra dos amonitas, pois eu a entreguei aos descendentes de Ló".
20 “(Before-before, dem sey na Refah pipol dey stay der. Na Refah pipol really dey stay der; Ammon pipol dey koll dem Zamzum.
20 ( Essa região também era considerada terra dos refains, que ali habitaram no passado. Os amonitas os chamavam zanzumins.
21 Dem strong; many well-well and dem tall like Anak pipol. But God distroy Refah pipol, bikos of Ammon pipol, so dat dem go fit stay for der.
21 Eram fortes, numerosos e altos como os enaquins. O Senhor os exterminou, e os amonitas os expulsaram e se estabeleceram em seu lugar.
22 Dis na wetin E do for Esau shidren-shidren for Seir, wen E distroy Hor pipol, so dat dem go fit stay for der till today.
22 O Senhor fez o mesmo com os descendentes de Esaú que vivem em Seir, quando exterminou os horeus diante deles. Os descendentes de Esaú os expulsaram e se estabeleceram em seu lugar até hoje.
23 But for Avvim pipol wey kom form Krete and dey stay di west side for Gaza and Kaftor pipol aria, make una distroy and take dia land.)
23 Foi o que também aconteceu aos aveus, que viviam em povoados próximos de Gaza; os caftoritas, vindos de Caftor, os destruíram e se estabeleceram em seu lugar. )
24 “So make una cross go River Arnon. Si! I don already give una Sihon wey bi Amor king for Heshbon and all en land. So make una go fight and take di land from am!
24 "Vão agora e atravessem o ribeiro do Arnom. Vejam que eu entreguei em suas mãos Seom o amorreu, rei de Hesbom, e a terra dele. Comecem a ocupação, entrem em guerra contra ele.
25 From today, evribody wey dey di world, I go put fear for dia mind, bikos of una and even wen dem hear una name, fear go katch dem. Dem go fear nearly die wen dem hear sey una dey kom.”
25 Hoje mesmo começarei a infundir pavor e medo de vocês em todos os povos debaixo do céu. Quando ouvirem da fama de vocês, tremerão e ficarão angustiados".
26 So I send messenja from Kedemot wildaness go meet King Sihon for Heshbon with peace sey:
26 Do deserto de Quedemote enviei mensageiros a Seom, rei de Hesbom, oferecendo paz e dizendo:
27 “Make wi pass thru yor land and wi nor go tosh or take anytin from am; wi nor go even turn rite or left.
27 Deixa-nos passar pela tua terra. Iremos somente pela estrada; não nos desviaremos nem para a direita nem para a esquerda.
28 Yu go sell food and wota give us, so dat wi go chop and drink. Make yu just allow us waka pass,
28 Por prata nos venderás tanto a comida que comermos como a água que bebermos. Apenas deixe-nos passar a pé,
29 just as Esau shidren-shidren wey dey stay Seir and Moab pipol wey dey stay for Ar allow us pass. Make wi just pass until wi go cross Jordan River go rish di land wey di Oga awa God dey give us.”
29 como fizeram os descendentes de Esaú, que habitam em Seir, e os moabitas, que habitam em Ar. Assim chegarei ao Jordão, e, através dele, à terra que o Senhor, o nosso Deus, nos dá.
30 But King Sihon for Heshbon nor gri, bikos na so God wont make e bi, so dat E go fit give di land to us today.
30 Mas Seom, rei de Hesbom, não quis deixar-nos passar; pois o Senhor, o Deus de vocês, tornou-lhe obstinado o espírito e endureceu-lhe o coração, para entregá-lo nas mãos de vocês, como hoje se vê.
31 God tell mi sey, “Si! I don already give una King Sihon and en land. So make una take di land as una own.”
31 O Senhor me disse: "Estou entregando a você Seom e sua terra. Comece a ocupação, tome posse da terra dele! "
32 Wen King Sihon and all en sojas gada kon fight us for Jahaz,
32 Então Seom saiu à batalha contra nós em Jaza, com todo o seu exército.
33 di Oga awa God put dem for awa hand and wi kill dem, plus dia sons and evry oda pesin.
33 Mas o Senhor, o nosso Deus, entregou-o a nós, e o derrotamos, a ele, aos seus filhos e a todo o seu exército.
34 For dat time, wi take all di towns kon judge di pipol as God wont am, plus di wimen and shidren, den wi kon kill all of dem.
34 Naquela ocasião conquistamos todas as suas cidades e as destruímos totalmente, matando homens, mulheres e crianças, sem deixar nenhum sobrevivente.
35 But wi keep di animals for awasef.
35 Tomamos como presa somente os animais e o despojo das cidades que conquistamos.
36 From Aroer wey dey River Arnon korna (River town), go rish Gilead, e nor get any town wey fit fight us. Di Oga awa God give us all doz towns.
36 Desde Aroer, junto ao ribeiro do Arnom, e a cidade que fica no mesmo vale, até Gileade, não houve cidade de muros altos demais para nós. O Senhor, o nosso Deus, entregou-nos tudo.
37 Aldo wi nor go Ammon pipol land, River Jabbok, di town for di hill or any place wey God sey make wi nor go.
37 Somente da terra dos amonitas vocês não se aproximaram, ou seja, toda a extensão do vale do Rio Jaboque, e as cidades da região montanhosa, conforme o Senhor, o nosso Deus, tinha ordenado.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Deuteronômio 2, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.