Deuteronômio 29

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NVI

Sair da comparação
NVI Nova Versão Internacional
1 Dis na di kovenant wey God kommand Moses sey make e make with Israel pipol wen dem dey Moab, plus di kovenant wey E make with dem for Mount Sinai.
1 São estes os termos da aliança que o Senhor ordenou que Moisés fizesse com os israelitas em Moabe, além da aliança que tinha feito com eles em Horebe.
2 Moses gada evribody for Israel kon tell dem, “Una don use una own eye take si evritin wey God do to Fero, all en savant and di whole Egypt.
2 Moisés convocou todos os israelitas e lhes disse: Os seus olhos viram tudo o que o Senhor fez no Egito ao faraó, a todos os seus oficiais e a toda a sua terra.
3 Una eye don si en great judgement, signs and wonders.
3 Com os seus próprios olhos vocês viram aquelas grandes provas, aqueles sinais e grandes maravilhas.
4 But till today, God neva make una undastand all dis tins or give una eyes wey fit si or ear wey dey hear!
4 Mas até hoje o Senhor não lhes deu mente que entenda, olhos que vejam, e ouvidos que ouçam.
5 I karry una thru di wildaness for forty years, but una klot or sandal nor tear.
5 "Durante os quarenta anos que os conduzi pelo deserto", disse ele, "nem as suas roupas, nem as sandálias dos seus pés se gastaram.
6 Una nor chop bread or drink wine or any oda drink, but E give una food, so dat una go know sey na-im bi di Oga una God.
6 Vocês não comeram pão, nem beberam vinho, nem qualquer outra bebida fermentada. Fiz isso para que vocês soubessem que eu sou o Senhor, o seu Deus. "
7 “Wen wi rish here, King Sihon for Heshbon and King Og for Bashan kom fight us, but wi win dem.
7 Quando vocês chegaram a este lugar, Seom, rei de Hesbom, e Ogue, rei de Basã, atacou-os, mas nós os derrotamos.
8 Wi take dia land kon gi-am to Reuben, Gad and half of Manasseh tribes as dia own.
8 Conquistamos a terra deles e a demos por herança as tribos de Rúben e de Gade e à metade da tribo de Manassés.
9 “So make una obey di words wey dey dis kovenant, so dat e go betta for una for evritin wey una dey do.
9 Sigam fielmente os termos desta aliança, para que vocês prosperem em tudo o que fizerem.
10 Today, all of una stand before di Oga una God, di head for di tribes, una eldas, una ofisas, evry man for Israel,
10 Hoje todos vocês estão na presença do Senhor, do seu Deus: os seus chefes e homens destacados, os seus líderes e oficiais, e todos os demais homens de Israel,
11 una small pikin, wifes and di strenjas wey dey stay with una, plus doz wey dey kut wood or karry wota,
11 juntamente com os seus filhos e as suas mulheres e os estrangeiros que vivem nos seus acampamentos cortando lenha e carregando água para vocês.
12 so dat una go asept di kovenant wey di Oga una God dey make with una today.
12 Vocês estão aqui presentes para entrar em aliança com o Senhor, o seu Deus, aliança que ele está fazendo com vocês hoje, selando-a sob juramento,
13 Today, God go sey una bi en pipol and na-im bi una God, bikos na-im promise una and una grand-grand papa Abraham, Isaak, Jakob.
13 para hoje confirmá-los como seu povo, para que ele seja o seu Deus conforme lhes prometeu e jurou aos seus antepassados, Abraão, Isaque e Jacó.
14 Nor bi only una I dey make dis kovenant with,
14 Não faço esta aliança, sob juramento, somente com vocês
15 but na with all di pipol wey stand with una for di Oga awa God present today, even with doz wey nor dey with us today.
15 que estão aqui conosco na presença do Senhor nosso Deus, mas também com aqueles que não estão aqui hoje.
16 “(Una know how wi dey live awa life wen wi dey Egypt and how wi take cross many nashons as wi dey travel.
16 Vocês mesmos sabem como vivemos no Egito e como passamos por várias nações até chegar aqui.
17 Una si di bad tins and di juju wey dem make with wood, stone, silva and gold.)
17 Vocês viram nelas as suas imagens e os seus ídolos detestáveis, feitos de madeira, de pedra, de prata e de ouro.
18 Make no man, woman, tribe or family among una leave di Oga una God kon go woship gods for oda kountries. Make nobody among una get any tree wey go bear fruit wey bitter or fit kill.
18 Cuidem que não haja entre vocês nenhum homem ou mulher, clã ou tribo cujo coração se afaste do Senhor, do nosso Deus, para adorar os deuses daquelas nações, e para que não haja no meio de vocês nenhuma raiz que produza esse veneno amargo.
19 “Make una make sure sey nobody among una wey dey hear dis tins today, bilive sey evritin dey okay with am, even doh e nor dey hear pipol word. Dis kind tin go skata all of una, weda una dey good or bad.
19 Se alguém, cujo coração se afastou do Senhor para adorar outros deuses, ouvir as palavras deste juramento, invocar uma bênção sobre si mesmo e pensar: "Estarei em segurança, muito embora persista em seguir o meu próprio caminho", trará desgraça tanto à terra irrigada quanto à terra seca.
20 God nor dey ready to forgive dat pesin. Instead, God vexnashon and jealousy go raiz for di pesin and all di curse wey dey dis book go bi en own.
20 O Senhor jamais se disporá a perdoá-lo; a sua ira e o seu zelo se acenderão contra tal pessoa. Todas as maldições escritas neste livro cairão sobre ela, e o Senhor apagará o seu nome de debaixo do céu.
21 God go pick and judge only di pesin from all di tribes for Israel akordin to all di curse wey dey dis Law Book.
21 O Senhor a separará de todas as tribos de Israel para que sofra desgraça, de acordo com todas as maldições da aliança escrita neste Livro da Lei.
22 “En shidren-shidren wey go kom afta una, plus di strenjas wey go kom from far place, all of dem go si di wahala for dat land and di sickness wey God go send for dia head.
22 Os seus filhos, os seus descendentes e os estrangeiros que vierem de terras distantes verão as desgraças que terão caído sobre a terra e as doenças com que o Senhor a terá afligido.
23 Fire and sulfur go kover di whole land. Dem nor go fit plant for der and nor-tin go grow for der. E go bi like Sodom and Gomorrah, Admah and Zeboiim, di towns wey God vex distroy.
23 A terra inteira será um deserto abrasador de sal e enxofre, no qual nada que for plantado brotará, onde nenhuma vegetação crescerá. Será como a destruição de Sodoma e Gomorra, de Admá e Zeboim, que o Senhor destruiu com ira e furor.
24 Den all di nashons go ask, ‘Wetin make God do all dis tins for dis land? Wetin make God dey vex like dis?’
24 Todas as nações perguntarão: "Por que o Senhor fez isto a esta terra? Por que tanta ira e tanto furor? "
25 “Den di pipol go sey, ‘Na bikos dem nor gri obey di kovenant wey God wey bi dia grand-grand papa God make with dem wen E bring dem kom out from Egypt.
25 E a resposta será: "Foi porque este povo abandonou a aliança do Senhor, o Deus dos seus antepassados, aliança feita com eles quando os tirou do Egito.
26 Dem kon go serve and woship oda gods wey dem nor even know and God sey make dem nor woship doz gods.
26 Eles se foram e adoraram outros deuses e se prostraram diante deles, deuses que eles não conheciam antes, deuses que o Senhor não lhes tinha dado.
27 Na dis tin make God dey vex for dem well-well for dis land and naim make am ponish dem with all di curse wey dey dis book.
27 Por isso a ira do Senhor acendeu-se contra esta terra, e ele trouxe sobre ela todas as maldições escritas neste livro.
28 So God don vex remove dem from dia land kon karry dem go anoda land and evribody dey si as e bi today.’ ”
28 Cheio de ira, indignação e grande furor, o Senhor os desarraigou da sua terra e os lançou numa outra terra, como hoje se vê".
29 Na di Oga awa God get all di sekret tins, but di tins wey E tell us, na for wi and awa shidren-shidren forever, so dat wi go fit obey all di words for dis law.
29 As coisas encobertas pertencem ao Senhor, ao nosso Deus, mas as reveladas pertencem a nós e aos nossos filhos para sempre, para que sigamos todas as palavras desta lei.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Deuteronômio 29, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.