Deuteronômio 28

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARA

Sair da comparação
ARA Almeida Revista e Atualizada 1993
1 If una really obey God kon keep en kommand wey I dey give una today, di Oga una God go make una high pass all di pipol for di world.
1 Se atentamente ouvires a voz do Senhor , teu Deus, tendo cuidado de guardar todos os seus mandamentos que hoje te ordeno, o Senhor , teu Deus, te exaltará sobre todas as nações da terra.
2 Una go get all dis blessings if una obey di Oga una God.
2 Se ouvires a voz do Senhor , teu Deus, virão sobre ti e te alcançarão todas estas bênçãos:
3 God go bless una towns and una fields.
3 Bendito serás tu na cidade e bendito serás no campo.
4 God go bless una shidren and una plants. E go still bless una animals and dia pikin wey dem go born.
4 Bendito o fruto do teu ventre, e o fruto da tua terra, e o fruto dos teus animais, e as crias das tuas vacas e das tuas ovelhas.
5 E go bless una basket and una plate.
5 Bendito o teu cesto e a tua amassadeira.
6 Anywhere wey una go and anytin wey una dey do, God go bless am.
6 Bendito serás ao entrares e bendito, ao saíres.
7 God go make una win una enemies wen dem attack una. Dem go from one side attack una, but dem go skata and run from una for seven side!
7 O Senhor fará que sejam derrotados na tua presença os inimigos que se levantarem contra ti; por um caminho, sairão contra ti, mas, por sete caminhos, fugirão da tua presença.
8 God go kommand blessing for una aria and for evritin wey una dey do; yes, E go bless una for di land wey E dey give una.
8 O Senhor determinará que a bênção esteja nos teus celeiros e em tudo o que colocares a mão; e te abençoará na terra que te dá o Senhor , teu Deus.
9 If una obey di Oga una God kommand kon do as E tok, E go make una en holy pipol, just as E promise sey e go bi.
9 O Senhor te constituirá para si em povo santo, como te tem jurado, quando guardares os mandamentos do Senhor , teu Deus, e andares nos seus caminhos.
10 Den evribody for di eart go si sey una bilong to God and dem go respet una.
10 E todos os povos da terra verão que és chamado pelo nome do Senhor e terão medo de ti.
11 God go make una shidren, animal and plant many kon make una prosper for di land wey E promise una grand-grand papa sey, E go give una.
11 O Senhor te dará abundância de bens no fruto do teu ventre, no fruto dos teus animais e no fruto do teu solo, na terra que o Senhor , sob juramento a teus pais, prometeu dar-te.
12 God go send rain from en rish store kom meet una for di rite time and E go bless all di work wey una dey do. Una go dey give to many kountries, but una nor go ever borrow from dem.
12 O Senhor te abrirá o seu bom tesouro, o céu, para dar chuva à tua terra no seu tempo e para abençoar toda obra das tuas mãos; emprestarás a muitas gentes, porém tu não tomarás emprestado.
13 If una listin well to di Oga una God kommand and if una obey dem with kare, God go make una bi di head and nor bi tail and una go always dey on-top and nor dey under.
13 O Senhor te porá por cabeça e não por cauda; e só estarás em cima e não debaixo, se obedeceres aos mandamentos do Senhor , teu Deus, que hoje te ordeno, para os guardar e cumprir.
14 Make una nor turn from any of dis kommand wey I dey give una today or go follow and woship oda gods.
14 Não te desviarás de todas as palavras que hoje te ordeno, nem para a direita nem para a esquerda, seguindo outros deuses, para os servires.
15 But if una forget di Oga una God and una nor gri obey en kommand and laws wey I dey give una today, den all dis curse go kom meet una with full force:
15 Será, porém, que, se não deres ouvidos à voz do Senhor , teu Deus, não cuidando em cumprir todos os seus mandamentos e os seus estatutos que, hoje, te ordeno, então, virão todas estas maldições sobre ti e te alcançarão:
16 God go curse una towns and fields.
16 Maldito serás tu na cidade e maldito serás no campo.
17 E go curse una basket and una plate.
17 Maldito o teu cesto e a tua amassadeira.
18 God go curse una shidren and una plants. E go still curse una animals and dia pikin wey dem go born.
18 Maldito o fruto do teu ventre, e o fruto da tua terra, e as crias das tuas vacas e das tuas ovelhas.
19 Anywhere wey una go and anytin wey una dey do, God go curse am.
19 Maldito serás ao entrares e maldito, ao saíres.
20 Na God by ensef go send curse, problem, wahala, konfushon and E go dey fight una for evritin wey una dey do, until una skata and die finish, bikos of di wiked tins wey una dey do and bikos una don turn from am.
20 O Senhor mandará sobre ti a maldição, a confusão e a ameaça em tudo quanto empreenderes, até que sejas destruído e repentinamente pereças, por causa da maldade das tuas obras, com que me abandonaste.
21 God go send diziz kom meet una, until nor of una go remain for di land wey una go soon enter go stay.
21 O Senhor fará que a pestilência te pegue a ti, até que te consuma a terra a que passas para possuí-la.
22 God go kill una with bad diziz, fever, sore, kro-kro and kold. Dis diziz go attack una until una die finish.
22 O Senhor te ferirá com a tísica, e a febre, e a inflamação, e com o calor ardente, e a secura, e com o crestamento, e a ferrugem; e isto te perseguirá até que pereças.
23 Di sky on-top una head go strong like bronze and di eart under una leg go strong like iron.
23 Os teus céus sobre a tua cabeça serão de bronze; e a terra debaixo de ti será de ferro.
24 God go turn una rain wey dey fall for una land to powder and san-san; e go fall on-top una until una die finish.
24 Por chuva da tua terra, o Senhor te dará pó e cinza; dos céus, descerá sobre ti, até que sejas destruído.
25 God go still allow una enemies beat una; una go attack dem from one side, but una go run komot seven side, den all pipol for di eart go dey fear bikos of wetin hapun to una.
25 O Senhor te fará cair diante dos teus inimigos; por um caminho, sairás contra eles, e, por sete caminhos, fugirás diante deles, e serás motivo de horror para todos os reinos da terra.
26 Una dead body go bi food for di birds for sky and for wiked animal for di eart and nobody go fit porshu dem.
26 O teu cadáver servirá de pasto a todas as aves dos céus e aos animais da terra; e ninguém haverá que os espante.
27 God go ponish una with boil from Egypt, some part for una body go swell-up, eczema, ring worm and kro-kro go full una body and dem nor go fit cure una.
27 O Senhor te ferirá com as úlceras do Egito, com tumores, com sarna e com prurido de que não possas curar-te.
28 God go ponish una with madness, una eyes go blind and E go konfuse una mind.
28 O Senhor te ferirá com loucura, com cegueira e com perturbação do espírito.
29 For aftanoon, una go dey find road to pass like blind pipol and doz wey dey darkness and una go dey fail for evritin wey una dey do. Pipol go always dey tif una tin and opress una and nobody go save una.
29 Apalparás ao meio-dia, como o cego apalpa nas trevas, e não prosperarás nos teus caminhos; porém somente serás oprimido e roubado todos os teus dias; e ninguém haverá que te salve.
30 Di woman wey una dey won marry, anoda man go rape am. Una go build house, but una nor go fit stay inside. Una go plant vineyard, but una nor go chop dia fruit.
30 Desposar-te-ás com uma mulher, porém outro homem dormirá com ela; edificarás casa, porém não morarás nela; plantarás vinha, porém não a desfrutarás.
31 Dem go kill una melu for una own eye, but una nor go chop for inside. Dem go tif una donkey for una eye and dem nor go bring dem kom back. Dem go give all una sheep to una enemies and nobody go dey to save una.
31 O teu boi será morto aos teus olhos, porém dele não comerás; o teu jumento será roubado diante de ti e não voltará a ti; as tuas ovelhas serão dadas aos teus inimigos; e ninguém haverá que te salve.
32 God go give una shidren to oda pipol and even as una dey look dis tins, una nor go get pawa to do anytin.
32 Teus filhos e tuas filhas serão dados a outro povo; os teus olhos o verão e desfalecerão de saudades todo o dia; porém a tua mão nada poderá fazer.
33 Strenjas go kom chop di plants wey una sofa plant and dem go opress una still una die.
33 O fruto da tua terra e todo o teu trabalho, comê-los-á um povo que nunca conheceste; e tu serás oprimido e quebrantado todos os dias;
34 All dis tins wey dey happen go make una mad.
34 e te enlouquecerás pelo que vires com os teus olhos.
35 God go make boil wey dem nor fit cure, katch una knee and legs. In-short, di boil go kover una from head go rish una leg.
35 O Senhor te ferirá com úlceras malignas nos joelhos e nas pernas, das quais não te possas curar, desde a planta do pé até ao alto da cabeça.
36 God go karry una with di king go meet pipol wey una with una grand-grand papa neva hear of before and una go serve and woship gods wey dem make with wood and stone.
36 O Senhor te levará e o teu rei que tiveres constituído sobre ti a uma gente que não conheceste, nem tu, nem teus pais; e ali servirás a outros deuses, feitos de madeira e de pedra.
37 For di place where God go send una go, una go bi disgrace among di pipol for di eart.
37 Virás a ser pasmo, provérbio e motejo entre todos os povos a que o Senhor te levará.
38 Una go plant plenty seed, but na small tin una go harvest, bikos siti-siti go chop evritin wey una plant.
38 Lançarás muita semente ao campo; porém colherás pouco, porque o gafanhoto a consumirá.
39 Una go plant and kare for una vineyard, but una nor go drink di wine or chop di grapes, bikos worm go distroy evritin.
39 Plantarás e cultivarás muitas vinhas, porém do seu vinho não beberás, nem colherás as uvas, porque o verme as devorará.
40 Una go plant olive tree for una land, but una nor go ever use di olive oil, bikos di fruits go drop before e ripe.
40 Em todos os teus limites terás oliveiras; porém não te ungirás com azeite, porque as tuas azeitonas cairão.
41 Una go get shidren, but dem go die finish, bikos dem go katch dem as slaves go anoda kountry.
41 Gerarás filhos e filhas, porém não ficarão contigo, porque serão levados ao cativeiro.
42 Wiked insect go distroy una trees and plants.
42 Todo o teu arvoredo e o fruto da tua terra o gafanhoto os consumirá.
43 Di strenjas wey dey among una go dey strong well-well, while una go dey weak evriday.
43 O estrangeiro que está no meio de ti se elevará mais e mais, e tu mais e mais descerás.
44 Dem go dey borrow una money, but una nor go borrow anybody. Dem go bi head and una go bi tail!
44 Ele te emprestará a ti, porém tu não lhe emprestarás a ele; ele será por cabeça, e tu serás por cauda.
45 If una nor gri listin to di Oga una God or obey en kommand and law wey E give una, all dis curse go porshu una, until e distroy all of una.
45 Todas estas maldições virão sobre ti, e te perseguirão, e te alcançarão, até que sejas destruído, porquanto não ouviste a voz do Senhor , teu Deus, para guardares os mandamentos e os estatutos que te ordenou.
46 Di curse go bi sign against una and una shidren-shidren forever.
46 Serão, no teu meio, por sinal e por maravilha, como também entre a tua descendência, para sempre.
47 Bikos una nor gri serve di Oga una God with betta heart and mind for di good tins wey E do for una,
47 Porquanto não serviste ao Senhor , teu Deus, com alegria e bondade de coração, não obstante a abundância de tudo.
48 una go-go serve una enemies wey God go send against una. Una go dey hongry; una nor go si wota drink or get klot to wear and una nor go get anytin at-all. God go put load like iron for una neck wey go press una well-well until e don distroy una.
48 Assim, com fome, com sede, com nudez e com falta de tudo, servirás aos inimigos que o Senhor enviará contra ti; sobre o teu pescoço porá um jugo de ferro, até que te haja destruído.
49 God go bring some pipol from far against una and dem go kill una like vulture. And dem bi pipol wey una nor go undastand wetin dem dey tok;
49 O Senhor levantará contra ti uma nação de longe, da extremidade da terra virá, como o voo impetuoso da águia, nação cuja língua não entenderás;
50 pipol wey wiked well-well and dem nor go respet una old pipol or pity for una yong ones.
50 nação feroz de rosto, que não respeitará ao velho, nem se apiedará do moço.
51 Dem go chop una animals pikin and una plants, den dem go distroy una. Dem nor go leave any korn, new wine, olive oil or animals for una and una go hongry die.
51 Ela comerá o fruto dos teus animais e o fruto da tua terra, até que sejas destruído; e não te deixará cereal, mosto, nem azeite, nem as crias das tuas vacas e das tuas ovelhas, até que te haja consumido.
52 Dem go attack una towns until all di strong walls, (di walls wey una trust sey go protet una) go fall rish groun. Dem go attack all di towns for di land wey di Oga una God don give una.
52 Sitiar-te-á em todas as tuas cidades, até que venham a cair, em toda a tua terra, os altos e fortes muros em que confiavas; e te sitiará em todas as tuas cidades, em toda a terra que o Senhor , teu Deus, te deu.
53 Bikos of di honga and ponishment wey una enemies put una, una go dey chop una own shidren wey di Oga una God give una.
53 Comerás o fruto do teu ventre, a carne de teus filhos e de tuas filhas, que te der o Senhor , teu Deus, na angústia e no aperto com que os teus inimigos te apertarão.
54 Di man among una wey kwayet pass, go turn kon attack en broda, en wife and en shidren wey remain.
54 O mais mimoso dos homens e o mais delicado do teu meio será mesquinho para com seu irmão, e para com a mulher do seu amor, e para com os demais de seus filhos que ainda lhe restarem;
55 En own shidren flesh wey e dey chop, e nor go give anybody as nor-tin dey to chop, bikos of di wahala and honga wey di enemy put una for una own town.
55 de sorte que não dará a nenhum deles da carne de seus filhos, que ele comer; porquanto nada lhe ficou de resto na angústia e no aperto com que o teu inimigo te apertará em todas as tuas cidades.
56 Di woman wey dey kwayet and gentol among una, wey nor go even put en leg for groun, bikos of how e fine rish, go turn kon attack en husband and shidren
56 A mais mimosa das mulheres e a mais delicada do teu meio, que de mimo e delicadeza não tentaria pôr a planta do pé sobre a terra, será mesquinha para com o marido de seu amor, e para com seu filho, e para com sua filha;
57 and e go chop some since nor-tin dey to chop, bikos of di wahala and honga wey di enemies put una for una own town.
57 mesquinha da placenta que lhe saiu dentre os pés e dos filhos que tiver, porque os comerá às escondidas pela falta de tudo, na angústia e no aperto com que o teu inimigo te apertará nas tuas cidades.
58 “If una nor gri obey my law, di tins wey dem rite for dis book or una nor gri fear di Oga una God wonderful name,
58 Se não tiveres cuidado de guardar todas as palavras desta lei, escritas neste livro, para temeres este nome glorioso e terrível, o Senhor , teu Deus,
59 God go make una and una shidren-shidren ponishment many and di ponishment go tey well-well.
59 então, o Senhor fará terríveis as tuas pragas e as pragas de tua descendência, grandes e duradouras pragas, e enfermidades graves e duradouras;
60 E go give una all doz diziz wey una dey fear for Egypt and dem go trobol una forever.
60 fará voltar contra ti todas as moléstias do Egito, que temeste; e se apegarão a ti.
61 Di Oga una God go still ponish una with difren sickness wey nor dey join dis ones and E go dey bring dem kom, until una don die finish.
61 Também o Senhor fará vir sobre ti toda enfermidade e toda praga que não estão escritas no livro desta Lei, até que sejas destruído.
62 Even doh una many like di stars for sky, na only some of una go remain, bikos una nor gri listin to God.
62 Ficareis poucos em número, vós que éreis como as estrelas dos céus em multidão, porque não destes ouvidos à voz do Senhor , vosso Deus.
63 Just as e sweet God to prosper and make una plenty, na so too God go dey happy to distroy una.
63 Assim como o Senhor se alegrava em vós outros, em fazer-vos bem e multiplicar-vos, da mesma sorte o Senhor se alegrará em vos fazer perecer e vos destruir; sereis desarraigados da terra à qual passais para possuí-la.
64 bikos God go skata una among many kountries from one end for di eart go rish di oda end. For der, una go woship gods wey una or una grand-grand papa nor know before; gods wey dem make with wood and stones!
64 O Senhor vos espalhará entre todos os povos, de uma até à outra extremidade da terra. Servirás ali a outros deuses que não conheceste, nem tu, nem teus pais; servirás à madeira e à pedra.
65 For dat kountry, una nor go get peace or rest. And God go make una heart dey fear; una eye nor go dey si well and una soul go dey worry.
65 Nem ainda entre estas nações descansarás, nem a planta de teu pé terá repouso, porquanto o Senhor ali te dará coração tremente, olhos mortiços e desmaio de alma.
66 Na so-so fear una go dey fear both for day time and for nite, bikos una nor know wen una go die.
66 A tua vida estará suspensa como por um fio diante de ti; terás pavor de noite e de dia e não crerás na tua vida.
67 For morning time, una go sey, ‘If to sey na evening wi dey’ and for evening time, una go sey ‘If to sey na morning wi dey!’ Dis na bikos, di kind tins wey una go dey si around una go make una dey fear.
67 Pela manhã dirás: Ah! Quem me dera ver a noite! E, à noitinha, dirás: Ah! Quem me dera ver a manhã! Isso pelo pavor que sentirás no coração e pelo espetáculo que terás diante dos olhos.
68 Den God go put una for ship kon send una go back to Egypt, to di place wey E promise sey una nor go ever si again. Den for der, una go sell unasef give una enemies as slaves, but nobody go gri buy una.”
68 O Senhor te fará voltar ao Egito em navios, pelo caminho de que te disse: Nunca jamais o verás; sereis ali oferecidos para venda como escravos e escravas aos vossos inimigos, mas não haverá quem vos compre.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Deuteronômio 28, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.