Deuteronômio 26

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs BKJ

Sair da comparação
1 Wen una enter di land wey di Oga una God won give una as una own and una don win evribody for der,
1 E será que, quando entrares na terra que o SENHOR teu Deus te dá como herança, e a possuíres, e nela habitares;
2 make una put some of di first fruits and plant wey una harvest inside one basket kon bring dem kom di place wey God don choose for woship and where dem go for honor en name.
2 que tomarás das primícias de todos os frutos da terra, que trarás da tua terra que o SENHOR teu Deus te dá, e as colocarás em um cesto, e irás ao lugar que o SENHOR teu Deus escolherá, para ali colocar o seu nome.
3 Make una go meet di priest wey dey der for dat time kon tell am, “With dis gift, wi won make di Oga awa God know sey wi don enter di land wey E promise awa grand-grand papa sey E go give us.”
3 E irás ao sacerdote que houver naqueles dias, e dirás a ele: Eu professo neste dia ao SENHOR teu Deus, que cheguei à terra que o SENHOR jurou aos nossos pais que nos daria.
4 Den di priest go take di basket from una hand kon go put am for di Oga una God altar.
4 E o sacerdote tomará o cesto da tua mão, e o colocará diante do altar do SENHOR teu Deus.
5 Den una go sey, “Awa papa Jakob waka from Aramean go stay for Egypt as strenja. En family for dat time, nor many, but wen dem dey komot Egypt, dem kon plenty and dem bi strong pipol naw.
5 E falarás, e dirás, diante do SENHOR teu Deus: Um sírio prestes a perecer foi meu pai, ele desceu ao Egito, e ali peregrinou com poucos, e se tornou uma nação, grande, poderosa e numerosa;
6 Wen Egypt pipol dey opress and ponish us as dia slaves,
6 e os egípcios nos maltrataram, e nos afligiram, e nos impuseram dura servidão;
7 wi kry to God wey bi awa grand-grand papa God. E hear awa kry kon si as wi dey sofa and as Egypt pipol dey ponish and trit us.
7 e, quando clamamos ao SENHOR Deus dos nossos pais, o SENHOR ouviu a nossa voz, e observou a nossa aflição, e o nosso trabalho, e a nossa opressão;
8 So God take us komot from Egypt with en pawa, en strong hand and all en pawaful signs and wonders.
8 e o SENHOR nos tirou do Egito com mão forte, e com braço estendido, e de maneira terrível, e com sinais, e com prodígios;
9 Den E bring us kom dis place kon give us dis land wey full with milk and honey!
9 e nos trouxe a este lugar, e nos deu esta terra, que é uma terra que mana leite e mel.
10 And naw, awa God, wi don bring di first fruit, plants and animal wey Yu give us for dis groun.” Make una put evritin for di Oga una God present, den bow woship am.
10 E eis que trago as primícias da terra, que tu, ó SENHOR, me deste. E as apresentarás, diante do SENHOR teu Deus, e adorarás diante do SENHOR teu Deus;
11 Afta una don woship am, una go celebrate bikos of all di good tins wey di Oga una God don give una and una family, di Levi and di strenjas wey dey stay among una.
11 e te alegrarás por todo o bem que o SENHOR, teu Deus, te tem dado a ti e a tua casa, tu, e o levita, e o estrangeiro que está no meio de ti.
12 Evry three years, una must offa special tithe for una plants. For dat year, una must give una tithe to Levi pipol, di strenjas, doz wey nor get papa and mama and wimen wey dia husband don die, so dat dem go dey si food chop for di town.
12 Quando tiveres terminado de oferecer todos os dízimos de tua produção, no terceiro ano, que é o ano do dízimo, então os dará ao levita, ao estrangeiro, ao órfão, e à viúva, para que possam comer dentro das tuas portas e se saciem;
13 Den for di Oga una God present, una go sey, “Wi don take di holy gift from awa house kon gi-am to Levi pipol, di strenjas, doz wey nor get papa and mama and wimen wey dia husband don die, just as Yu kommand us. Wi neva forget and wi don do evritin wey Yu kommand.
13 então dirás, diante do SENHOR teu Deus: Eu trouxe as coisas consagradas da minha casa, e também as dei ao levita, e ao estrangeiro, ao órfão, e à viúva, conforme todos os teus mandamentos que me ordenaste; não transgredi teus mandamentos, nem os esqueci;
14 Even wen wi dey mourn, wi nor chop any one; wen wi nor dey klean at-all, wi nor tosh am and wi neva offa any of am to dead body. Wi don obey di Oga awa God and wi don do evritin wey Yu kommand us.
14 não comi delas na minha tristeza, nem tirei nada delas para nenhum uso imundo, nem dei nada delas para os mortos; mas ouvi a voz do SENHOR meu Deus, e fiz conforme tudo o que me ordenaste.
15 Naw, make Yu look down from yor holy house for heaven kon bless Israel wey bi yor pipol and di land wey Yu promise awa grand-grand papa sey, Yu go give us. Di land wey full with milk and honey.”
15 Olha desde a tua santa habitação, desde os céus, e abençoa o teu povo, Israel, e a terra que nos deste, conforme juraste aos nossos pais, uma terra que mana leite e mel.
16 Today, di Oga una God don kommand una to obey all en laws and rules. So make una dey sure sey una dey obey dem with all una heart.
16 Neste dia, o SENHOR teu Deus te ordena que cumpras estes estatutos e juízos; portanto, tu os guardarás e os farás, com todo o teu coração, e com toda a tua alma.
17 Una don tok today sey na di Oga bi una God. And una don promise to do wetin E tok and obey en kommand, laws, rules and to do evritin wey E tell una.
17 Tu declaraste neste dia que o SENHOR será o teu Deus, e andarás nos seus caminhos, e guardarás os seus estatutos, e os seus mandamentos, e os seus juízos, e ouvirás a sua voz;
18 Today, God don sey una bi en pipol, en betta gift wey E value well-well, just as E promise, so una must obey en kommand.
18 e hoje o SENHOR te assegura que serás o seu povo peculiar, conforme ele te prometeu, e que tu deves cumprir todos os seus mandamentos;
19 If una obey am, E go karry una high pass evry oda pipol wey E kreate. Den una go get praiz, honor and evribody go dey tok good about una. Una go bi holy pipol to di Oga una God, just as E promise.
19 e te exaltarás acima de todas as nações que ele criou, em louvor, e em nome, e em honra; e poderás ser um povo santo para o SENHOR teu Deus, como ele bem falou.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Deuteronômio 26, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.