Deuteronômio 24

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs VC

Sair da comparação
VC Versão Católica
1 Wen man marry woman and e nor like am, bikos e don si one bad karata for en body, e fit rite divorce paper give di woman, den tell am make e komot from en house.
1 Se um homem, tendo escolhido uma mulher, casar-se com ela, e vier a odiá-la por descobrir nela qualquer coisa inconveniente, escreverá uma letra de divórcio, lha entregará na mão e a despedirá de sua casa.
2 Wen di woman komot di house, e fit marry anoda man.
2 Se ela, depois de ter saído de sua casa, desposar outro homem,
3 But if di sekond husband still get problem with di same woman kon divorce am or di man die,
3 e este também a odiar, escrevendo e dando-lhe na mão uma letra de divórcio e despedindo-a de sua casa, ou então, se este segundo marido vier a falecer,
4 di first husband nor go marry am again, bikos di woman nor dey klean and dis tin nor dey good for God eye. Make una nor bring problem kom di land wey di Oga una God dey give una.
4 não poderá o primeiro marido, que a repudiou, tomá-la de novo por mulher depois de ela se contaminar, porque isso é uma abominação aos olhos do Senhor e não deves comprometer com esse pecado a terra que te dá em herança o Senhor, teu Deus.
5 Make una nor put man wey just marry among di sojas or gi-am any oda work. E must dey free to spend one year for en house, so dat di wife go dey happy.
5 Quando um homem se tiver casado recentemente, não irá à guerra e não se lhe imporá cargo algum. Durante; um ano estará livremente em seu lar para tornar feliz a mulher que ele desposou.
6 Wen una borrow pesin money, make una nor take en grindin stone as shorti, bikos dat na di only tin wey di family take dey chop.
6 Não se tomarão como Senhor as duas pedras do moinho, nem que seja somente a pedra móvel, porque seria tomar como penhor a própria vida.
7 If una katch pesin wey kidnap anoda Israel pesin kon dey trit am like slave or sell am, di pesin wey kidnap anoda pesin, must die. Like dis, una go remove bad-bad tins from among una.
7 Se se encontrar um homem que tenha raptado um de seus irmãos israelitas, para fazer dele seu escravo, e o vender, esse raptor será punido de morte. Assim, tirarás o mal do meio de ti.
8 As una dey do as di priest sey make una do, make una dey kareful about bad diziz. Make una obey all di kommand wey I don give una.
8 Toma precauções contra a praga da lepra, observando e praticando cuidadosamente tudo o que te ensinarem os sacerdotes levíticos. Cumpre fielmente tudo o que ordenei a esse respeito.
9 Make una remember wetin di Oga una God do to Miriam as una dey kom out from Egypt.
9 Lembra-te do que o Senhor, teu Deus, fez a Maria, quando saíste do Egito.
10 If una borrow anytin give una neighbour, make una nor enter en house kon take wetin e use as shorti.
10 Se fizeres ao teu próximo um empréstimo qualquer, não entrarás em sua casa para tomar {algum} penhor.
11 Una go wait for outside den e go enter en house go bring am for una.
11 Esperarás fora; é ali que o teu devedor te trará esse penhor.
12 If una neighbour na poor man and e kon give una en klot as shorti for di money wey e borrow, make una nor keep dat klot till di next day.
12 Se ele for pobre, o penhor não pernoitará em tua casa,
13 Make una take di klot go give who get am wen evening rish, so dat en body go dey warm for nite and e go bless una, den di Oga una God go si una as pipol wey dey do good.
13 mas tornarás a dar-lho antes que o sol se ponha, a fim de que ele possa dormir com o seu manto e te abençoe, e isso te será contado como um benefício pelo Senhor, teu Deus.
14 Make una nor opress poor pipol and doz wey dey work for una; weda dem bi Israel pipol or strenjas wey dey stay with una.
14 Não prejudicarás o assalariado pobre e necessitado, quer seja um de teus irmãos, quer seja um estrangeiro que mora numa das cidades de tua terra.
15 Una must pay dem for dia work evriday wen evening rish, bikos dem poor and dey wait dat money. If una nor pay dem, dem fit kry give God and di sin go dey una head.
15 Dar-lhe-ás o seu salário no mesmo dia, antes do pôr-do-sol, porque é pobre e espera impacientemente a sua paga. Do contrário clamaria contra ti ao Senhor, e serias culpado de um pecado.
16 Make una nor kill papa or mama, bikos of di sin wey dia shidren kommit, or kill shidren bikos of wetin dia papa and mama do; if una go kill pesin at-all, e must bi for en own sin.
16 Não morrerão os pais pelos filhos, nem os filhos pelos pais. Cada um morrerá pelo seu próprio pecado.
17 Una must judge well for di strenjas wey dey with una; doz wey nor get papa and mama and woman wey en husband don die. Make una nor ever take dia klot as shorti for debt.
17 Não violarás o direito do estrangeiro nem do órfão, e não tomarás como penhor o vestido de uma viúva.
18 Make una always remember sey una bi slave for Egypt, before di Oga una God kon save una. Na dis make mi give una dis kommand.
18 Lembra-te de que foste escravo no Egito e de que o Senhor, teu Deus, te libertou. Por isso te dou esta ordem.
19 Wen una harvest una plant kon leave some for di farm, make una nor go back go gada dem. Make una leave doz ones for strenjas; doz wey nor get papa and mama and doz wey dia husband don die, den di Oga una God go bless una for all di work wey una dey do.
19 Quando segares a messe no teu campo e deixares por esquecimento algum feixe, não voltarás para levá-lo. Deixá-lo-ás para o estrangeiro, o órfão e a viúva, a fim de que o Senhor, teu Deus, abençoe todas as empresas de tuas mãos.
20 Wen una dey plok olive fruit from en tree, di ones wey remain bilong to doz wey bi strenjas; wey nor get papa and mama and doz wey dia husband don die.
20 Quando sacudires tuas oliveiras, não voltarás a colher o resto que ficou nos galhos; isso será para o estrangeiro, o órfão e a viúva.
21 Wen una dey gada grape for una vineyard, make una nor go back again go gada wetin remain; bikos doz ones na for doz wey bi strenjas; wey nor get papa and mama and doz wey dia husband don die.
21 Quando tiveres vindimado a tua vinha, não voltarás a colher os cachos que ficaram; deixá-los-ás para o estrangeiro, o órfão e a viúva.
22 Make una remember sey una bi slave for Egypt before and na dis make mi dey kommand una to do all dis tins.
22 Lembra-te de que foste escravo no Egito: eis por que te dou esta ordem.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Deuteronômio 24, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.