Deuteronômio 23
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ACF
1 If anybody wound or dem kut en private part komot, make una nor let am kom God present.
1 Aquele a quem forem trilhados os testículos, ou cortado o membro viril, não entrará na congregação do SENHOR.
2 Make una nor let pesin wey nor know en papa kom God present; even to en tent generashon, make nor of dem enter where God dey.
2 Nenhum bastardo entrará na congregação do Senhor; nem ainda a sua décima geração entrará na congregação do Senhor.
3 Make no Ammon or Moab pesin enter God present; even to dia tent generashon, make nor of dem enter where God dey.
3 Nenhum amonita nem moabita entrará na congregação do Senhor; nem ainda a sua décima geração entrará na congregação do Senhor eternamente.
4 Dis pipol nor welkom una with food and wota wen una kom out from Egypt. Instead dem hire Balaam wey en papa bi Beor from Petor wey dey Aram Naharaim sey make e curse una.
4 Porquanto não saíram com pão e água, a receber-vos no caminho, quando saíeis do Egito; e porquanto alugaram contra ti a Balaão, filho de Beor, de Petor, de mesopotâmia, para te amaldiçoar.
5 But di Oga una God nor gri listin to Balaam. Di curse wey Balaam suppose curse una, e turn am to blessing bikos di Oga una God love una.
5 Porém o Senhor teu Deus não quis ouvir Balaão; antes o Senhor teu Deus trocou em bênção a maldição; porquanto o Senhor teu Deus te amava.
6 As long as una dey dis life, make una nor ever pray for peace or betta tin for dem.
6 Não lhes procurarás nem paz nem bem em todos os teus dias para sempre.
7 Make una nor hate Edom or Egypt pipol, bikos Edom pipol na una brodas and una stay as strenjas for Egypt.
7 Não abominarás o edomeu, pois é teu irmão; nem abominarás o egípcio, pois estrangeiro foste na sua terra.
8 Di third generashon for Edom and Egypt pipol fit enter God present.
8 Os filhos que lhes nascerem na terceira geração, cada um deles entrará na congregação do Senhor.
9 Wen una dey go fight una enemies, make una guide unasef against anytin wey nor klean.
9 Quando o exército sair contra os teus inimigos, então te guardarás de toda a coisa má.
10 If anybody dey among una wey nor dey klean, bikos of wetin e do with en body for nite, e must komot di kamp and e nor go enter for sometaim.
10 Quando entre ti houver alguém que, por algum acidente noturno, não estiver limpo, sairá fora do arraial; não entrará no meio dele.
11 Wen evening don rish, make e wosh ensef with wota, den wen sun don go down, e fit enter di kamp again.
11 Porém será que, declinando a tarde, se lavará em água; e, em se pondo o sol, entrará no meio do arraial.
12 Una must get somewhere outside di kamp where pipol go for dey piss or shit.
12 Também terás um lugar fora do arraial, para onde sairás.
13 Una must get shovel among evry oda tin wey una get, so dat wen una shit for outside di kamp, una go dig groun with di shovel den pour di shit for der kon kover am.
13 E entre as tuas armas terás uma pá; e será que, quando estiveres assentado, fora, então com ela cavarás e, virando-te, cobrirás o que defecaste.
14 Bikos di Oga una God dey waka for di kamp to diliver una kon kill una enemies. So una kamp must dey holy, so dat E nor go si anytin wey go make am turn from una.
14 Porquanto o Senhor teu Deus anda no meio de teu arraial, para te livrar, e entregar a ti os teus inimigos; pelo que o teu arraial será santo, para que ele não veja coisa feia em ti, e se aparte de ti.
15 Any slave wey run leave en masta kom meet una, una must nor take am go back.
15 Não entregarás a seu senhor o servo que, tendo fugido dele, se acolher a ti;
16 Make dem stay with una for any town wey dem choose and make una nor opress dem.
16 Contigo ficará, no meio de ti, no lugar que escolher em alguma das tuas portas, onde lhe agradar; não o oprimirás.
17 Make nobody for Israel, weda na man or woman, turn ashawo for di temple.
17 Não haverá prostituta dentre as filhas de Israel; nem haverá sodomita dentre os filhos de Israel.
18 Wen una dey bring una vow ofrin, make una nor bring any ashawo pesin ofrin kon give di Oga una God, weda na man or woman, bikos dat kind tin dey make di Oga una God vex.
18 Não trarás o salário da prostituta nem preço de um sodomita à casa do Senhor teu Deus por qualquer voto; porque ambos são igualmente abominação ao Senhor teu Deus.
19 If una give money, food or any oda tin to una fellow brodas for Israel, make una nor put intrest at-all.
19 A teu irmão não emprestarás com juros, nem dinheiro, nem comida, nem qualquer coisa que se empreste com juros.
20 Una fit borrow with intrest give strenja, but nor bi to una own fellow Israel broda and if una keep dis kommand, di Oga una God go bless una for evritin wey una dey do for di land wey una go soon take as una own.
20 Ao estranho emprestarás com juros, porém a teu irmão não emprestarás com juros; para que o Senhor teu Deus te abençoe em tudo que puseres a tua mão, na terra a qual vais a possuir.
21 Wen una make promise give di Oga una God, make e nor tey before una do wetin una promise, if not, God go hold una sey una don sin.
21 Quando fizeres algum voto ao Senhor teu Deus, não tardarás em cumpri-lo; porque o Senhor teu Deus certamente o requererá de ti, e em ti haverá pecado.
22 But e nor go bi sin, if pesin nor make promise or vow at-all.
22 Porém, abstendo-te de votar, não haverá pecado em ti.
23 Anytin wey una promise, una must dey kareful sey una do am. And di promise wey una make to di Oga una God must kom from una free mind.
23 O que saiu dos teus lábios guardarás, e cumprirás, tal como voluntariamente votaste ao Senhor teu Deus, declarando-o pela tua boca.
24 If una enter una neighbour vineyard, una fit chop as many grapes as una wont, but make una nor take any one komot from di vineyard.
24 Quando entrares na vinha do teu próximo, comerás uvas conforme ao teu desejo até te fartares, porém não as porás no teu cesto.
25 And wen una enter una neighbour grain field, una fit plok di grain head with una hand, but make una nor kut am with knife.
25 Quando entrares na seara do teu próximo, com a tua mão arrancarás as espigas; porém não porás a foice na seara do teu próximo.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Deuteronômio 23, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.