Deuteronômio 22
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs VC
1 Wen una si una neighbour animal dey waka lost, make una nor trowey una eye; una must riton am go give di owner.
1 Se vires extraviado o boi ou a ovelha de teu irmão, não te desviaras mas reconduzi-los-ás ao teu irmão.
2 If di owner nor dey stay near una or una nor know who e bi, make una take am go una house until di owner go kom find am, den una must gi-am back en animal.
2 Se este habitar longe, ou se não o conheceres, levarás o animal para a tua casa e ele aí ficará até que seja reclamado pelo teu irmão: então lho entregarás.
3 Na di same tin una go do to donkey, klot or any oda tin wey una neighbour lost wey una si. Make una dey ready to always help una neighbour.
3 O mesmo farás com o seu jumento, com o seu manto e com qualquer objeto perdido por teu irmão e encontrado por ti. Não te desviarás desse objeto.
4 Wen una si una neighbour donkey or melu dey faint for road, make una nor trowey una eye or waka pass am; instead make una make sure sey una help di animal.
4 Se vires o jumento ou o, boi de teu irmão caídos no caminho, não voltarás os olhos para o lado, mas ajudá-lo-ás a levantá-los.
5 Make woman nor wear klot wey bi man own and make man nor wear woman klot, bikos anybody wey dey do dis kind tin, dey make di Oga una God vex.
5 A mulher não se vestirá de homem, nem o homem se vestirá de mulher: aquele que o fizer será abominável diante do Senhor, seu Deus.
6 If una si bird house for tree or for groun and yong birds or eggs dey inside with dia mama for der, make una nor take di mama from en shidren.
6 Se encontrares no caminho, sobre uma árvore ou na terra, o ninho de uma ave, e a mãe posta sobre os filhotes ou sobre os ovos, não a apanharás com os filhotes.
7 Make una free di mama, but una fit take di shidren. Make una do like dis, so dat e go dey well with una and una go get long life.
7 Deixarás partir a mãe e só tomarás os filhotes, para que se prolonguem os teus dias felizes.
8 If una build new house, make una build guide round di roof, so dat dem nor go sey una kill pesin in kase pesin fall from di top.
8 Quando construíres uma casa nova, farás uma balaustrada em volta do teto, para que não se derrame sangue sobre a tua casa, se viesse alguém a cair lá de cima.
9 Make una nor plant two difren seed for una vineyard; if not, all di fruit and di seed wey una plant, go skata.
9 Não semearás em tua vinha várias espécies de sementes, para que se não considere tudo consagrado: o grão semeado e o produto da vinha.
10 Make una nor klear una farm with donkey and melu togeda.
10 Não lavrarás com um boi e um jumento atrelados juntos.
11 Make una nor wear klot wey dem use wool and linen take make.
11 Não trarás sobre ti uma veste de diferentes tecidos: lã e linho misturados.
12 Una must fold una kover klot for di four korna.
12 Porás no manto com que te cobrires borlas nos seus quatro cantos.
13 If anybody marry woman kon sleep with am den
13 Se um homem, depois de ter desposado uma mulher e a ter conhecido, vier a odiá-la,
14 e porshu am for publik kon sey, “Na wen I marry dis woman, I know sey e nor bi virgin.”
14 e, imputando-lhe faltas desonrosas, se puser a difamá-la, dizendo: desposei esta mulher e, ao aproximar-me dela, descobri que ela não era virgem,
15 Den di woman papa and mama must bring proof kon give di eldas for di town gate sey, dia pikin na virgin.
15 então o pai e a mãe da donzela tomarão as provas de sua virgindade e as apresentarão aos anciães da cidade, à porta.
16 Di girl papa go tell dem, “I give my pikin to dis man as en wife and naw, e don rijet am.
16 O pai dirá aos anciães: dei minha filha por mulher a este homem, mas porque ele lhe tem aversão,
17 E dey curse di girl sey, ‘I don know sey yu nor bi virgin.’ But dis klot show sey my pikin na virgin, before e marry am.” Den, dem go spread di girl bed shit for di eldas front.
17 eis que agora lhe imputa faltas desonrosas, pretendendo não ter encontrado nela as marcas da virgindade. Ora, eis aqui as provas da virgindade de minha filha. E estenderão diante dos anciãos da cidade a veste de sua filha.
18 Di eldas go take di man kon ponish am.
18 E os anciãos da cidade tomarão aquele homem e fá-lo-ão castigar,
19 Dem go still tell am make e pay 100 silva to di woman papa, bikos na for publik e for curse di woman sey e nor bi virgin. Den di woman go still bi di man wife and e nor go fit sey make di woman pak komot from en house.
19 impondo-lhe, além disso, uma multa, de cem siclos de prata, que eles darão ao pai da jovem em reparação da calúnia levantada contra uma virgem de Israel. E ela continuará sua mulher sem que ele jamais possa repudiá-la.
20 But if wetin di man tok na true and e show sey di woman nor bi virgin,
20 Se, porém, o fato for verídico e não se tiverem comprovado as marcas de virgindade da jovem,
21 den dem go take di woman go en papa door-mot. For der, di men for di town go stone am die. E don kommit bad sin for Israel, bikos e dey sleep with difren men wen e dey en papa house. Like dis, una go remove evil from among una.
21 esta será conduzida ao limiar da casa paterna, e os habitantes de sua cidade a apedrejarão até que morra, porque cometeu uma infâmia em Israel, prostituindo-se na casa de seu pai. Assim, tirarás o mal do meio de ti.
22 If dem katch anybody dey sleep with anoda man wife, both of dem must die; like dis, una go remove evil from Israel.
22 Se se encontrar um homem dormindo com uma mulher casada, todos os dois deverão morrer: o homem que dormiu com a mulher, e esta da mesma forma. Assim, tirarás o mal do meio de ti.
23 If virgin don dey engage to one man and anoda man for di town kon sleep with am,
23 Se uma virgem se tiver casado, e um homem, encontrando-a na cidade, dormir com ela,
24 una must bring di two of dem kom di town gate kon stone dem die. Una go stone di girl die, bikos e nor kry wen di man dey sleep with am and una go kill di man, bikos e sleep with di woman wey en broda suppose marry; like dis, una go remove evil from among una.
24 conduzireis um e outro à porta da cidade e os apedrejareis até que morram: a donzela, porque, estando na cidade, não gritou, e o homem por ter violado a mulher do seu próximo. Assim, tirarás o mal do meio de ti.
25 But if di man meet di woman for outside di town kon force and rape am, den na only di man go die.
25 Mas se foi no campo que o homem encontrou a jovem e lhe fez violência para dormir com ela, nesse caso só ele deverá morrer,
26 Una must nor do anytin to di woman, bikos e nor do anytin wey go make dem kill-am. Dis one na di same tin as wen pesin attack and kill anoda pesin,
26 e nada fareis à jovem, que não cometeu uma falta digna de morte, porque é um caso similar ao do homem que se atira sobre o seu próximo e o mata:
27 bikos di man meet am for field and di woman kon dey shaut, but nobody dey der to save am.
27 foi no campo que o homem a encontrou; a jovem gritou, mas não havia ninguém que a socorresse.
28 If one man si virgin wey dey engage kon force and rape am and dem katch dem.
28 Se um homem encontrar uma jovem virgem, que não seja casada, e, tomando-a, dormir com ela, e forem apanhados,
29 Di man wey rape di woman go pay 50 silva give di woman papa and di woman go bi en wife, bikos e don dis-virgin am. E nor go ever fit porshu di woman komot en house till e die.
29 esse homem dará ao pai da jovem cinqüenta siclos de prata, e ela tornar-se-á sua mulher. Como a deflorou, não poderá repudiá-la em todos os dias de sua vida.
30 Make nobody marry en papa former wife, bikos dat na disgrace to en papa.
30 Ninguém desposará a mulher de seu pai, nem levantará a cobertura do leito paterno.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Deuteronômio 22, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.