Deuteronômio 21

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NVT

Sair da comparação
NVT Nova Versão Transformadora
1 Wen una dey di land wey di Oga una God dey give una, una fit si pesin wey dem kill for di field and una nor know who kill-am.
1 “Quando estiverem na terra que o S enhor , seu Deus, lhes dá, e alguém for encontrado morto no campo e não se saiba quem o matou,
2 For dat kind matter, una eldas and judge go measure from where dem for kill di pesin go rish di town wey dey near der.
2 as autoridades e os juízes medirão a distância do local onde está o cadáver até as cidades vizinhas.
3 Di eldas for di town wey dey near where dem for kill di pesin, go take one small melu wey dem neva tish anytin or use work at-all.
3 Quando se determinar qual é a cidade mais próxima, as autoridades da cidade escolherão do rebanho uma novilha que nunca tenha sido usada para trabalhar no campo e nunca tenha puxado um arado.
4 Dem go escort am go di valley wey dem neva plant or klear before and wey wota dey rush pass. Wen dem rish di valley, dem go break di melu neck for der.
4 Levarão a novilha a um vale que não tenha sido lavrado nem semeado e pelo qual passe um ribeiro. Ali, no vale, quebrarão o pescoço da novilha.
5 Den di Levi priest go kon front (bikos di Oga una God don choose dem to serve am and to bless una with en name). Na dem go dey judge both good and bad kase for di town.
5 Os sacerdotes levitas se aproximarão, pois o S enhor , seu Deus, os escolheu para servirem diante dele e pronunciarem bênçãos em seu nome. Cabe a eles decidir todos os casos legais e criminais.
6 Di eldas for dat town must wosh dia hand on-top di small melu wey dem don break en neck.
6 “As autoridades daquela cidade lavarão as mãos sobre a novilha cujo pescoço foi quebrado
7 Den dem go sey, “Awa hand and leg nor dey for dis pesin deat and wi nor si am wen dem dey kill-am.
7 e dirão: ‘Nossas mãos não derramaram o sangue dessa pessoa, nem vimos o crime acontecer.
8 So God go forgive en pipol Israel wey E save and E nor go ponish dem sey na dem kill pesin wey nor do anytin.” Den di sin nor go dey dia head at-all.
8 Ó S enhor , perdoa o teu povo, Israel, o qual libertaste. Não culpes o teu povo pela morte de um inocente’. Assim, serão absolvidos da culpa pelo sangue da pessoa.
9 If una follow dis kommand, una go do wetin dey rite for God eye and una go dey save from dis sin.
9 Desse modo, vocês removerão do seu meio a culpa pela morte da vítima e farão o que é certo aos olhos do S enhor .”
10 Wen una dey go fight una enemies and di Oga una God make una win kon katch some of dem as una prisona
10 “Quando vocês saírem para guerrear contra seus inimigos e o S enhor , seu Deus, entregá-los em suas mãos e vocês os fizerem prisioneiros,
11 and among di pipol wey una take so, una si fine woman for inside wey una like marry,
11 pode acontecer de algum de vocês vir uma mulher bonita entre os cativos, sentir-se atraído por ela e desejar casar-se com ela.
12 una fit karry am go una house. Di woman must shave en head, kut en finger
12 Nesse caso, leve-a para casa, onde ela raspará a cabeça, cortará as unhas
13 burn di klot wey e wear wen dem katch am, den kon stay una house. E go take one mont take mourn for en papa and mama wey die. Den una fit marry am as una wife.
13 e trocará as roupas que estava usando quando foi capturada. Ela ficará em sua casa, mas você deixará que ela fique de luto pelo pai e pela mãe por um mês inteiro. Depois disso, você se casará com ela. Passará a ser seu marido, e ela será sua esposa.
14 But if una marry am and e nor dey do as una wont make e do, make una let am go free. Since una force and sleep with di woman, una nor go fit trit am like slave kon sell am.
14 Se depois do casamento ela não o agradar, liberte-a. Não a venda nem a trate como escrava, pois você a humilhou.”
15 If man get two wife and e love won pass di oda, den di two wife born boy pikin, If di first-born na from di wife wey e nor love,
15 “Se um homem tiver duas esposas e amar apenas uma delas, mas ambas lhe derem filhos homens, e o filho mais velho for da esposa que ele não ama,
16 wen di man dey divide en propaty, make e nor give di biggest part to di yonga one wey e love en mama, bikos nor bi en dem first-born.
16 quando dividir sua herança o homem não poderá dar a porção maior ao filho da esposa amada, como se este fosse o filho mais velho.
17 E must give di first pikin wetin bi en own, even doh e nor love di mama. E must gi-am times two of wetin e give di sekond pikin, bikos na di first son bi en papa pawa and honor.
17 Terá de reconhecer os direitos do filho mais velho, da esposa não amada, dando-lhe porção dobrada. Ele é o primeiro filho do vigor de seu pai, e os direitos do filho mais velho lhe pertencem.”
18 If pesin get sturbon son wey nor dey listin to en papa and mama even doh dem ponish am,
18 “Se um homem tiver um filho teimoso e rebelde, que não obedece ao pai nem à mãe, apesar de eles o disciplinarem,
19 make en papa and mama seize am kom meet di eldas for di town gate.
19 o pai e a mãe levarão o filho até a porta da cidade e dirão às autoridades ali reunidas:
20 Dem go tell di eldas for di town sey, “Awa pikin too sturbon and e nor dey hear word, e dey chop and drink anyhow.”
20 ‘Este nosso filho é teimoso e rebelde e se recusa a obedecer. É mau-caráter e vive bêbado’.
21 Den, all di men for di town go stone di pikin die. Like dis, una go remove all di wiked pipol wey dey among una and wen evribody for Israel hear wetin happen, fear go katch dem.
21 Então todos os homens da cidade o executarão por apedrejamento. Desse modo, vocês eliminarão o mal do seu meio, e todo o Israel ficará sabendo disso e temerá.”
22 If pesin do wetin go make dem kill-am and dem hang am for tree make e die,
22 “Se alguém cometeu um crime que merece a pena de morte e, por isso, foi executado e pendurado numa árvore,
23 make di body nor dey di tree till di next day. Na dat same day una go beri di body, bikos en body wey dem hang, na curse for God eye. Make una nor dirty di land wey di Oga una God dey give una.
23 não deverá permanecer pendurado ali durante a noite. Enterrem o corpo no mesmo dia, pois todo aquele que é pendurado é maldito aos olhos de Deus. Desse modo, vocês evitarão a contaminação da terra que o S enhor , seu Deus, lhes dá como herança.”

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Deuteronômio 21, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.