Deuteronômio 20
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NVI
1 Wen una go fight una enemies and una si dia horse and dia sojas wey strong pass una own, make una nor fear. Di Oga una God wey bring una kom out from Egypt, dey with una!
1 Quando vocês forem à guerra contra os seus inimigos e virem cavalos e carros, e um exército maior do que o seu, não tenham medo, pois o Senhor, o seu Deus, que os tirou do Egito, estará com vocês.
2 Wen una dey ready for war, make di priest kom front kon tok to di sojas.
2 Quando chegar a hora da batalha, o sacerdote virá à frente e dirá ao exército:
3 E go tell dem, “Israel men, make una listin to mi! Today, as una dey go fight una enemies, make una nor fear at-all! Make una heart nor fail una or una kon dey shake for dia front like pikin wey nor well.
3 "Ouça, ó Israel. Hoje vocês vão lutar contra os inimigos. Não se desanimem nem tenham medo; não fiquem apavorados nem aterrorizados por causa deles,
4 Bikos di Oga una God dey go with una! E go fight una enemies for una kon make una win di war!”
4 pois o Senhor, o seu Deus, os acompanhará e lutará por vocês contra os inimigos, para lhes dar a vitória".
5 Den di soja oga go tok to di sojas sey, “E get anybody for here wey just build new house and e neva dedikate am? If na so, den yu fit go house, bikos dem fit kill yu for war and anoda pesin go dedikate yor house.
5 Os oficiais dirão ao exército: "Há alguém que construiu uma casa e ainda não a dedicou? Volte ele para sua casa, para que não morra na guerra e outro a dedique.
6 E get anybody for here wey just plant vineyard and neva chop anytin from am? If na so, yu fit go house, bikos dem fit kill yu for war and anoda pesin go chop di first fruit for yor harvest.
6 Há alguém que plantou uma vinha e ainda não desfrutou dela? Volte ele para sua casa, para que não morra na guerra e outro desfrute da vinha.
7 E get anybody for here wey just engage woman, but e neva marry am? If na so, yu fit go house go marry, bikos dem fit kill yu for war and anoda pesin go marry di woman.”
7 Há alguém comprometido para casar-se que ainda não recebeu sua mulher? Volte ele para sua casa, para que não morra na guerra e outro case-se com ela".
8 Den di soja oga go sey, “E get anybody among us wey dey fear or en heart dey shake? If na so, yu fit go house before yu go make anoda pesin, fear too.”
8 Por fim os oficiais acrescentarão: "Alguém está com medo e não tem coragem? Volte ele para sua casa, para que os seus irmãos israelitas também não fiquem desanimados".
9 Wen di oga don tok to dia sojas finish, dem go choose pesin wey go dey kommand each group.
9 Quando os oficiais terminarem de falar ao exército, designarão chefes para comandar as tropas.
10 As una near any town wey una won attack, make una first try to make peace with en pipol.
10 Quando vocês avançarem para atacar uma cidade, enviem-lhe primeiro uma proposta de paz.
11 If dem agri with una kon open di gate for una, den all di pipol for dia go serve una as una savants.
11 Se os seus habitantes aceitarem, e abrirem suas portas, serão seus escravos e se sujeitarão a trabalhos forçados.
12 But if dem nor gri open di gate for una and dem dey ready to fight, una must attack dat town.
12 Mas se eles recusarem a paz e entrarem em guerra contra vocês, sitiem a cidade.
13 Wen di Oga una God don give dat town to una, make una use una swod take kill all di men, yong boys or boy pikin for dat town.
13 Quando o Senhor, o seu Deus, entregá-la em suas mãos, matem ao fio da espada todos os homens que nela houver.
14 But una fit take all di wimen, shidren, animals and oda tins wey una fit take. Make una enjoy all di tins wey una take from una enemies land wey God dey give una.
14 Mas as mulheres, as crianças, os rebanhos e tudo o que acharem na cidade, será de vocês; vocês poderão ficar com os despojos dos seus inimigos dados pelo Senhor, o seu Deus.
15 But dis kommand na for only di towns wey dey far-far, nor bi for di towns inside di kountries wey una won stay.
15 É assim que vocês tratarão todas as cidades distantes que não pertencem às nações vizinhas de vocês.
16 For doz towns and kountries wey di Oga una God dey give una as where una go stay, make una distroy evritin wey dey inside dem.
16 Contudo, nas cidades das nações que o Senhor, o seu Deus, lhes dá por herança, não deixem vivo nenhuma alma.
17 Hit, Amor, Kanaan, Periz, Hiv and Jebus pipol, una must distroy dem finish, just as di Oga una God kommand.
17 Conforme a ordem do Senhor, o seu Deus, destruam totalmente os hititas, os amorreus, os cananeus, os ferezeus, os heveus e os jebuseus.
18 If una distroy dem finish, di pipol for di land nor go dey to tish una how to serve and woship dia own gods and juju wey go make una sin against di Oga una God.
18 Se não, eles os ensinarão a praticar todas as coisas repugnantes que eles fazem quando adoram os seus deuses, e vocês pecarão contra o Senhor, contra o seu Deus.
19 Wen una dey attack any town and di war nor dey end, make una nor use una axe take kut di trees. Una fit chop dia fruit, but make una nor kut dem. Na di trees bi una enemies wey make una won attack dem?
19 Quando sitiarem uma cidade por um longo período, lutando contra ela para conquistá-la, não destruam as árvores dessa cidade a golpes de machado, pois vocês poderão comer as suas frutas. Não as derrubem. Por acaso as árvores são gente, para que vocês as sitiem?
20 Di only tree wey una fit kut, na di ones wey nor good for food, den kon use dem take make tins wey una nid to take attack di enemies town until di town go fall.
20 Entretanto, poderão derrubar as árvores que vocês sabem que não são frutíferas, para utilizá-las em obras que ajudem o cerco, até que caia a cidade que está em guerra contra vocês.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Deuteronômio 20, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.