Deuteronômio 1
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NVI
1 Dis na wetin Moses tell Israel pipol for di wildaness for Jordan River near Arabah opposite Suf, between Paran and Tofell, Laban, Hazerot and Dizahab.
1 Estas são as palavras ditas por Moisés a todo o Israel no deserto, a leste do Jordão, na Arabá, defronte de Sufe, entre Parã e Tofel, Labã, Hazerote e Di-Zaabe.
2 Na eleven days journey e suppose bi from Horeb to Kadesh Barnea wen dem pass thru Mount Seir.
2 Em onze dias se vai de Horebe a Cades-Barnéia pelo caminho dos montes de Seir.
3 Forty years afta Israel pipol don komot Egypt, for di first day for di elevent mont, Moses kon tell Israel pipol evritin wey God kommand am.
3 No quadragésimo ano, no primeiro dia do décimo primeiro mês, Moisés proclamou aos israelitas todas as ordens do Senhor acerca deles.
4 Dis tin happen for Edrei, afta dem win King Sihon for Amor, wey en soja oga na Heshbon and King Og for Bashan wey en sojas oga na Ashtarot.
4 Isso foi depois que ele derrotou Seom, rei dos amorreus, que habitava em Hesbom, e em Edrei derrotou Ogue, rei de Basã, que habitava em Asterote.
5 So, wen Israel pipol dey for Moab land wey dey Jordan River, na der Moses for tell dem dis law:
5 A leste do Jordão, na terra de Moabe, Moisés tomou sobre si a responsabilidade de expor esta lei:
6 Oga God tok to us for Horeb sey, “Una don too tey for dis mountin.
6 O Senhor, o nosso Deus, disse-nos em Horebe: "Vocês já ficaram bastante tempo nesta montanha.
7 So make una get up kon kontinue una journey go Amor kountries for di hill; all di arias wey dey near der, di high lands, di Shefelah, di Negev, all di lowland, Kanaan and Lebanon, still e rish di great River Eufrates.
7 Levantem acampamento e avancem para a serra dos amorreus; vão a todos os povos vizinhos na Arabá, nas montanhas, na Sefelá, no Neguebe e ao longo do litoral, à terra dos cananeus e ao Líbano, até o grande rio, o Eufrates.
8 Look! I don already give di land to una. So make una go kollect di land wey mi God promise to give una grand-grand papa Abraham, Isaak, Jakob and dia shidren.”
8 "Ponho esta terra diante de vocês. Entrem e tomem posse da terra que o Senhor prometeu sob juramento dar aos seus antepassados, Abraão, Isaque e Jacó, e aos seus descendentes".
9 Moses still sey, “For dat time, I sey, ‘Una wahala too mush for only mi.
9 Naquela ocasião eu lhes disse: "Não posso levá-los sozinho.
10 God don make una many well-well like stars for sky!
10 O Senhor, o seu Deus, os fez multiplicar de tal modo que hoje vocês são tão numerosos quanto as estrelas do céu.
11 So make God wey bi una grand-grand papa God bless una well-well, just as E promise!
11 Que o Senhor, o Deus dos seus antepassados, os multiplique mil vezes mais e os abençoe, conforme lhes prometeu!
12 But una wahala too mush to bear! How I wont take handle all una wahala and trobols?
12 Mas como poderei levar sozinho os seus problemas, as suas cargas e as suas disputas?
13 Make una choose some men from each tribe wey wise, get wisdom and I go make dem una leaders.’
13 Escolham homens sábios, criteriosos e experientes de cada uma de suas tribos, e eu os colocarei como chefes de vocês".
14 “Den una sey, ‘Wetin yu tell us so, dey good well-well.’
14 Vocês me disseram que essa era uma boa proposta.
15 “So I take di men wey una selet by unasef kon make dem judge and ofisas ova una. Some dey lead 1,000 pipol, some hundred, some fifty, while some na only ten pipol.
15 Então convoquei os chefes das tribos, homens sábios e experientes, e os designei como chefes de mil, de cem, de cinqüenta e de dez, além de oficiais para cada tribo.
16 For dat time, I tell di judge dem sey, ‘Una must listin to una pipol and doz wey bi strenjas, den make una judge well.
16 Naquela ocasião ordenei aos juízes de vocês: "Atendam as questões de seus irmãos e julguem com justiça, não só as questões entre os seus compatriotas como também entre um israelita e um estrangeiro.
17 Make una nor favor anybody and na as una take listin to rish man kase, na so too una go take listin to poor man own. Make una nor fear anybody, bikos na God dey judge evribody. Any kase wey una nor fit judge, make una bring am kom meet mi.’ ”
17 Não sejam parciais no julgamento! Atendam tanto o pequeno como o grande. Não se deixem intimidar por ninguém, pois o veredicto pertence a Deus. Tragam-me os casos mais difíceis e eu os ouvirei.
18 For dat time, I kommand una about all di tins wey una go do.
18 Naquela ocasião eu lhes ordenei tudo o que deveriam fazer".
19 Den just as God kommand us, wi komot from Mount Horeb kon travel pass di great wildaness wey dey make pesin fear, just as unasef go remember, den wi face Amor pipol kountries. Wen wi rish Kadesh Barnea,
19 Depois, conforme o Senhor, o nosso Deus, nos tinha ordenado, partimos de Horebe e fomos para a serra dos amorreus, passando por todo aquele imenso e terrível deserto que vocês viram, e assim chegamos a Cades-Barnéia.
20 I kon sey, “At last wi don rish Amor pipol kountry wey di Oga awa God don give us.
20 Então eu lhes disse: "Vocês chegaram à serra dos amorreus, a qual o Senhor, o nosso Deus, nos dá.
21 Si! E don put di land for una front. So make una go take am, just as God promise una. Make una nor fear anytin! Make una heart strong!
21 Vejam, o Senhor, o seu Deus, põe diante de vocês esta terra. Entrem na terra e tomem posse dela, conforme o Senhor, o Deus dos seus antepassados, lhes disse. Não tenham medo nem se desanimem".
22 “So all of una waka kom meet mi sey, ‘Make wi first send some men go si di land, so dat dem go kom back kon tell us as e bi. Dem go tell us di best way or town wey wi go take enter and attack di kountry.’
22 Vocês todos vieram dizer-me: "Mandemos alguns homens à nossa frente em missão de reconhecimento da região, para que nos indiquem por qual caminho subiremos e a quais cidades iremos".
23 “I tink sey wetin una tok dey good, so I kon choose twelf men, one form each tribes.
23 A sugestão pareceu-me boa; por isso escolhi doze de vocês, um homem de cada tribo.
24 Dem go di hill kountry until dem rish Eshkol Valley kon look am well-well.
24 Eles subiram a região montanhosa, chegaram ao vale de Escol e o exploraram.
25 Dem pick some fruits for der kon meet us. Dem sey, ‘Di land wey awa Oga God don give us, good well-well.’ ” Two spies dey karry fruits from di promised land go meet Moses|alt="Two spies carrying a bunch of grapes back to Moses from the promised land" src="CO00856B.TIF" size="col" loc="DEUT 1:23-25" copy="Cook" ref="1:25"
25 Trouxeram alguns frutos da região, com o seguinte relato: "Essa terra que o Senhor, o nosso Deus, nos dá é boa".
26 Una nor ready to go, instead una kon dey tok against di Oga awa God kommand.
26 Vocês, contudo, não quiseram ir, e se rebelaram contra a ordem do Senhor, o seu Deus.
27 Una dey komplain for korna sey, “Na bikos God hate us na-im make am take us komot Egypt, so dat Amor pipol go distroy us!
27 Queixaram-se em suas tendas, dizendo: "O Senhor nos odeia; por isso nos trouxe do Egito para nos entregar nas mãos dos amorreus e destruir-nos.
28 Na wetin go happen to us? Awa own brodas don make us dey fear, bikos dem sey, ‘Di pipol wey dey di land big well-well pass us; dia kountry dey big and dem fence am rish heaven. Wi still si Anak shidren-shidren for der too.’ ”
28 Para onde iremos? Nossos compatriotas nos desanimaram quando disseram: O povo é mais forte e mais alto do que nós; as cidades são grandes, com muros que vão até o céu. Vimos ali os enaquins".
29 So I ansa una sey, “Make una nor fear dem at-all!
29 Então eu lhes disse: Não fiquem apavorados; não tenham medo deles.
30 Di Oga una God go first go fight for una, just as una si evritin wey E do for Egypt
30 O Senhor, o seu Deus, que está indo à frente de vocês, lutará por vocês, como fez no Egito, diante de seus próprios olhos.
31 and for di wildaness where E for karry us like man wey dey karry en pikin. Na like dis E dey do for evriwhere wey una go until una rish dis place.”
31 Também no deserto vocês viram como o Senhor, o seu Deus, os carregou, como um pai carrega seu filho, por todo o caminho que percorreram até chegarem a este lugar.
32 But even afta evritin wey E do, una nor gri trust di Oga wey bi una God,
32 Apesar disso, vocês não confiaram no Senhor, o seu Deus,
33 di Pesin wey dey always go find betta place for una, even before una rish der. E dey appear to una thru fire for nite and inside kloud for day time, so dat E go show una di way wey una go-go.
33 que foi à frente de vocês, numa coluna de fogo de noite e numa nuvem de dia, para procurar lugares para vocês acamparem e para mostrar-lhes o caminho que vocês deviam seguir.
34 Wen God hear as una dey komplain, E vex well-well kon swear sey:
34 Quando o Senhor ouviu o que vocês diziam, irou-se e jurou:
35 “Nobody for dis una wiked generashon nor go si or enter di good land wey I promise una grand-grand papa dem!
35 "Ninguém desta geração má verá a boa terra que jurei dar aos seus antepassados,
36 Di only pesin wey I go allow na Kaleb, Jefunneh pikin wey follow di odas go shek di land and na wetin God wont make e do, na-im e do. I go give en and en shidren-shidren some part for di land wey e bin go look.”
36 exceto Calebe, filho de Jefoné. Ele a verá, e eu darei a ele e a seus descendentes a terra em que pisou, pois seguiu o Senhor de todo o coração".
37 And God sef still vex for mi, bikos of una. E tell mi sey, “Even yu, Moses nor go enter di land wey I promise una!
37 Por causa de vocês o Senhor irou-se contra mim e me disse: "Você também não entrará na terra.
38 But na Nun pikin Joshua wey dey assist yu go enter. So make Yu enkourage am, bikos na en go lead Israel pipol enter di land.
38 Mas o seu auxiliar, Josué, filho de Num, entrará. Encoraje-o, pois ele fará com que Israel tome posse dela.
39 Una shidren wey una feel sey go die for road, di ones wey nor know good from bad, na dem I go give di land to. I go give dem di land and e go bi dia own forever.
39 Mas as crianças que vocês disseram que seriam levadas como despojo, os seus filhos que ainda não distinguem entre o bem e o mal, eles entrarão na terra. Eu a darei a eles, e eles tomarão posse dela.
40 But una go turn back go di wildaness towards di Red Sea.”
40 Mas quanto a vocês, dêem meia-volta e partam para o deserto pelo caminho do mar Vermelho".
41 Den una ansa mi, “Wi don really sin against God. Naw, wi dey ready to fight doz pipol, just as awa Oga God don kommand.” So each of una wear una war klot kon ready to go fight.
41 Então vocês responderam: "Pecamos contra o Senhor. Nós subiremos e lutaremos, conforme tudo o que o Senhor, o nosso Deus, nos ordenou". Cada um de vocês preparou-se com as suas armas de guerra, achando que seria fácil subir a região montanhosa.
42 But God tell mi, “Make yu tell di pipol sey, ‘Make una nor go fight, bikos I nor go dey with una and una enemies go kill una well-well.’ ”
42 Mas o Senhor me disse: "Diga-lhes que não subam nem lutem, porque não estarei com vocês. Vocês serão derrotados pelos seus inimigos".
43 I tell una, but una nor gri listin. Instead una go against God kommand kon go fight.
43 Eu lhes disse isso, mas vocês não me deram ouvidos, rebelaram-se contra o Senhor e, com presunção, subiram a região montanhosa.
44 Amor pipol wey dey stay dat aria kom fight and porshu una, just as wiked bee dey do and dem kill una from Seir go rish Hormah.
44 Os amorreus que lá viviam os atacaram, os perseguiram como um enxame de abelhas e os arrasaram desde Seir até Hormá.
45 Den wen una kom back, una kom dey kry for God present, but God nor listin to una at-all.
45 Vocês voltaram e choraram perante o Senhor, mas ele não ouviu o seu clamor nem lhes deu atenção.
46 Bikos of dis, una kon stay for Kadesh tey well-well.
46 Então vocês ficaram em Cades, onde permaneceram muito tempo.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Deuteronômio 1, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.