Deuteronômio 19

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARIB

Sair da comparação
ARIB Almeida Revisada Imprensa Bíblica
1 Wen di Oga una God don distroy di pipol wey E won give dia land to una, una go take di land kon stay for dia towns and house.
1 Quando o Senhor teu Deus desarraigar as nações cuja terra ele te dá, e tu as desapossares, e morares nas suas cidades e nas suas casas,
2 Den for di centre for di land wey God dey give una, make una keep three town for der.
2 designarás para ti no meio da terra que o Senhor teu Deus te dá para a possuíres, três cidades;
3 For di aria for di land wey God dey give una as una own, una go measure and divide am into three, so dat pesin wey kill anoda pesin fit run go der.
3 preparar-lhe-ás caminhos, e partirás em três os termos da tua terra, que o Senhor teu Deus te dará em herança; isto será para que todo homicida se acolha nessas cidades.
4 If pesin kill anoda pesin by mistake, without sey dem kworel or dey fight before, di pesin fit run go any of di town go stay.
4 Este, pois é o caso no tocante ao homicida que se acolher ali para que viva: aquele que involuntariamente matar o seu próximo, a quem dantes não odiava;
5 For ezample, may bi pesin go forest with en neighbour go kut wood. Den one of dem kon karry di axe make e kut di tree and di axe head komot from di wood wey hold am kon kill di oda pesin. For dis matter, dat pesin wey kill di pesin fit run go one of dis towns and e go dey save.
5 como, por exemplo, aquele que entrar com o seu próximo no bosque para cortar lenha e, pondo força na sua mão com o machado para cortar a árvore, o ferro saltar do cabo e ferir o seu próximo de sorte que venha a morrer; o tal se acolherá a uma dessas cidades, e viverá;
6 Bikos if di town too far for am, before e go run rish der, di pesin wey dey vex sey dem kill en pesin fit porshu di pesin kon kill-am. Dis pesin deat nor good, bikos na mistake e take kill pesin.
6 para que o vingador do sangue não persiga o homicida, enquanto estiver abrasado o seu coração, e o alcance, por ser comprido o caminho, e lhe tire a vida, não havendo nele culpa de morte, pois que dantes não odiava o seu próximo.
7 Na dis make mi sey, make una keep three town wey pesin go run go and e go dey save.
7 Pelo que eu te deu esta ordem: Três cidades designarás para ti.
8 And if di Oga una God don make una land big, just as E promise una grand-grand papa kon give una all di land wey E promise dem
8 E, se o Senhor teu Deus dilatar os teus termos, como jurou a teus pais, e te der toda a terra que prometeu dar a teus pais
9 and una dey obey all di kommand wey I dey give una today (wey bi to love di Oga una God and always do as E tok), dat time, make una add three towns join di first three.
9 {quando guardares, para o cumprires, todo este mandamento que eu hoje te ordeno, de amar o Senhor teu Deus e de andar sempre nos seus caminhos}, então acrescentarás a estas três, mais três cidades;
10 Una must nor kill innocent pesin for di land wey di Oga una God won give una, bikos dat go make una dey guilty.
10 para que não se derrame sangue inocente no meio da tua terra, que o Senhor teu Deus te dá por herança, e não haja sangue sobre ti.
11 But if pesin hate en neighbour kon hide for korna dey wait am, so dat e go attack and kill-am, den run go dis towns,
11 Mas se alguém, odiando a seu próximo e lhe armando ciladas, se levantar contra ele e o ferir de modo que venha a morrer, e se acolher a alguma destas cidades,
12 di pesin wey old pass for en family go sey make dem bring am kom, so dat dem go kill-am too.
12 então os anciãos da sua cidade, mandando tirá-lo dali, o entregarão nas mãos do vingador do sangue, para que morra.
13 Make una nor sorry for dat kind pesin! Pipol wey dey kill pipol wey nor do anytin, make una komot dem from Israel, den evritin go dey well with una.
13 O teu olho não terá piedade dele; antes tirarás de Israel o sangue inocente, para que te vá bem.
14 Wen una rish di land wey di Oga una God dey give una, make una nor ever tif anoda pesin land or komot di boundary stone for where una grand-grand papa sey make dem put am.
14 Não removerás os marcos do teu próximo, colocados pelos teus antecessores na tua herança que receberás, na terra que o Senhor teu Deus te dá para a possuíres.
15 Make una nor hold anybody sey e do bad, if na only one pesin bi witness. Di trut for di matter bi sey, two or three pesin must sey dem si wetin happen.
15 uma só testemunha não se levantará contra alguém por qualquer iniqüidade, ou por qualquer pecado, seja qual for o pecado cometido; pela boca de duas ou de três testemunhas se estabelecerá o fato.
16 If pesin kom outside kon tok wetin e nor si about anoda pesin,
16 Se uma testemunha iníqua se levantar contra alguém, para o acusar de transgressão,
17 den, both who tok and who dem dey tok about go kom God present kon tok before di priest and di judge wey dey der.
17 então aqueles dois homens que tiverem a demanda se apresentarão perante o Senhor, diante dos sacerdotes e dos juízes que houver nesses dias.
18 Den di judge go handle di matter well-well. If di oda pesin lie for en broda head,
18 E os juízes inquirirão cuidadosamente; e eis que, sendo a testemunha falsa, e falso o testemunho que deu contra seu irmão,
19 den di deat wey e won make e broda die, na en go die-am. Like dis, una go remove all dis bad pipol among una.
19 far-lhe-ás como ele cuidava fazer a seu irmão; e assim exterminarás o mal do meio de ti.
20 Den di rest pipol go hear wetin happen and dem go kon dey fear to do doz kind bad tins.
20 Os restantes, ouvindo isso, temerão e nunca mais cometerão semelhante mal no meio de ti.
21 Anybody wey dey guilty, make una nor sorry for am! Una matter must bi life-for-life, eye-for-eye, tit-for-tit, hand-for-hand and leg-for-leg.
21 O teu olho não terá piedade dele; vida por vida, olho por olho, dente por dente, mão por mão, pé por pé.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Deuteronômio 19, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.