Deuteronômio 18
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NTLH
1 Make una remember sey Levi pesin wey bi priest, plus di whole Levi tribe nor get any propaty or land among di oda tribes for Israel. Instead di priest and Levi pipol go chop from di special gift wey di oda tribes go give God, bikos na dat bi dia share.
1 Moisés disse ao povo: — A
2 Dem nor get any land for diasef for Israel. Na God bi dia propaty, just as E don tell dem.
2 Eles não terão terras; conforme o Senhor Deus prometeu, a parte dessa tribo é o direito de os homens servirem como sacerdotes do Senhor .
3 Di tins wey di priests go take as dia own share, na di animals and oda tins wey di oda tribes bring kom as ofrin: dem go take di animals shoulder, jaw and belle.
3 — Quando alguém oferecer touros ou bodes em sacrifício a Deus, os sacerdotes receberão o quarto dianteiro, as queixadas e o bucho.
4 Di first share for una harvest, new wine, olive oil and di wool wey una kollect wen una dey shear di sheep, make una give dem to di priest.
4 Receberão também o que for colhido ou preparado primeiro, sejam cereais, ou vinho, ou azeite, ou lã.
5 Bikos na di Oga una God choose Levi tribe out of all di tribes wey dey Israel to serve am forever.
5 Pois o Senhor , nosso Deus, os escolheu entre todas as tribos de Israel para que eles e os seus descendentes o sirvam como sacerdotes para sempre.
6 And if one Levi pesin kom from any town for Israel kon sey e dey go where God don choose sey make dem woship am,
6 — Se um levita que estiver morando numa das cidades de Israel desejar ir ao lugar de adoração escolhido pelo Senhor Deus, poderá ir quando quiser.
7 e fit serve for der with God name, just like evry oda Levi wey bi priest wey dey serve God for der.
7 Ele servirá como sacerdote do Senhor , nosso Deus, como fazem os outros levitas que estão ali.
8 Dem go give di same food like di oda priests and e fit keep anytin wey en family send kom gi-am.
8 E receberá a mesma quantidade de alimentos que os outros sacerdotes recebem; além disso, poderá ficar com tudo o que a sua família mandar.
9 Wen una enter di land wey di Oga una God dey give una, make una nor learn wetin di oda kountries for der dey do.
9 — Quando vocês tomarem posse da terra que o Senhor , nosso Deus, está dando a vocês, não imitem os costumes nojentos dos povos de lá.
10 For ezample, make una nor burn una shidren as sakrifice. And make nobody learn how to dey tell pipol dia future;
10 Não ofereçam os seus filhos em sacrifício , queimando-os no altar. Não deixem que no meio do povo haja adivinhos ou pessoas que tiram sortes; não tolerem feiticeiros,
11 learn to use juju; how to tok to oda spirit or witch spirit.
11 nem quem faz despachos, nem os que invocam os espíritos dos mortos.
12 Anybody wey dey do dis kind tin, dey make God vex. Na bikos of dis tins wey di oda kountries do, na-im make God porshu dem komot from di land for una.
12 O Senhor Deus detesta os que praticam essas coisas nojentas e por isso mesmo está expulsando da terra esses povos, enquanto vocês vão tomando posse dela.
13 But make una serve di Oga una God well-well, so dat E nor go si any fault for una body.
13 Em todas as coisas sejam fiéis ao Senhor , nosso Deus.
14 Di pipol wey una won porshu dey do dis tins, but di Oga una God dey sey make una nor do dis kind tin.
14 Moisés disse ao povo: — Os povos da terra que vai ser de vocês seguem os conselhos dos que adivinham o futuro e dos que tiram sortes; mas o
15 Di Oga una God go raiz profet like mi from among una and e go bi una own kountry man and make una listin to am.
15 Do meio de vocês Deus escolherá para vocês um profeta que será parecido comigo, e vocês vão lhe obedecer.
16 Bikos dis na wetin una ask di Oga una God by unasef wen una gada go meet am for Mount Sinai. Una sey, “God, make Yu nor let us hear yor vois again or si di big fire again, bikos wi go die.”
16 Lembrem que naquele dia em que estavam reunidos ao pé do monte Sinai, vocês oraram ao Senhor assim: “Ó Deus, não nos obrigues a ouvir de novo a tua voz, nem a ver outra vez este grande fogo, para que não morramos.”
17 God kon tell mi, “Wetin dem tok dey good.
17 Então o Senhor me disse: “Esse pedido do povo é justo.
18 From among dia own pipol, I go raiz one profet like yu. I go put my word for en mout and e go tell dem anytin wey I kommand.
18 Do meio deles escolherei para eles um profeta que será parecido com você. Darei a esse profeta a minha mensagem, e ele dirá ao povo tudo o que eu ordenar.
19 Anybody wey nor gri listin to wetin di profet tok, na mi go ponish am with my own hand.
19 Eu castigarei quem não obedecer às ordens que esse profeta der em meu nome.”
20 But any profet wey tok wetin I nor send am or tok about any oda god, go die.
20 E Moisés continuou dizendo ao povo: — O
21 “But una fit ask unasef, ‘How wi won take know sey, dat message nor bi from God?’
21 Mas vocês vão ficar pensando assim: “Como é que vamos saber que aquilo que o profeta diz não é mensagem de Deus, o Senhor ?”
22 Wen any profet dey tok with God name and wetin e tok nor kon happen at-all, una go know sey nor bi God send am, but di profet just dey tok on en own, so make una nor listin, bilive or fear am.”
22 Fiquem sabendo que, se um profeta falar em nome de Deus, mas se o que disser não acontecer, então o que disse não foi mensagem de Deus. Esse profeta foi atrevido, e vocês não precisam ter medo dele.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Deuteronômio 18, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.