Deuteronômio 17

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARA

Sair da comparação
ARA Almeida Revista e Atualizada 1993
1 Make una nor sakrifice any animal wey nor well or get problem give di Oga una God, bikos dat kind tin dey make am vex.
1 Não sacrificarás ao Senhor , teu Deus, novilho ou ovelha em que haja imperfeição ou algum defeito grave; pois é abominação ao Senhor , teu Deus.
2 Wen una don dey stay di town wey di Oga una God go give una, if one man or woman among una do bad tin for God eye kon go against en kovenant,
2 Quando no meio de ti, em alguma das tuas cidades que te dá o Senhor , teu Deus, se achar algum homem ou mulher que proceda mal aos olhos do Senhor , teu Deus, transgredindo a sua aliança,
3 bikos e go serve anoda god or woship di sun, moon, star or di pawas for heaven, tins wey I sey make una nor do,
3 que vá, e sirva a outros deuses, e os adore, ou ao sol, ou à lua, ou a todo o exército do céu, o que eu não ordenei;
4 wen una hear about dat kind tin, make una shek di matter well-well. If na true sey dem do dis bad tins for Israel,
4 e te seja denunciado, e o ouvires; então, indagarás bem; e eis que, sendo verdade e certo que se fez tal abominação em Israel,
5 den make una take di man or woman wey kommit dis sin go outside di town gate kon stone am die.
5 então, levarás o homem ou a mulher que fez este malefício às tuas portas e os apedrejarás, até que morram.
6 But make una nor ever kill pesin, bikos of wetin one pesin tok. Two or three pesin must tok di same tin, before una go fit stone pesin die.
6 Por depoimento de duas ou três testemunhas, será morto o que houver de morrer; por depoimento de uma só testemunha, não morrerá.
7 Di pipol wey tok about di tins wey di pesin do, na dem go first stone di pesin, before oda pipol go join dem. Like dis, una go stop wiked and evil tins among una.
7 A mão das testemunhas será a primeira contra ele, para matá-lo; e, depois, a mão de todo o povo; assim, eliminarás o mal do meio de ti.
8 If matter too strong for una to judge; matter like to kill pesin or matter wey koncern propaty or wahala for village, make una karry doz kind matter go di place wey di Oga una God don choose.
8 Quando alguma coisa te for difícil demais em juízo, entre caso e caso de homicídio, e de demanda e demanda, e de violência e violência, e outras questões de litígio, então, te levantarás e subirás ao lugar que o Senhor , teu Deus, escolher.
9 Una go-go meet di Levi priest or di judge wey dey on duty. Dem go hear di kase kon give judgement.
9 Virás aos levitas sacerdotes e ao juiz que houver naqueles dias; inquirirás, e te anunciarão a sentença do juízo.
10 Una must do as dem judge for di place wey God choose. Una must do just as dem tok.
10 E farás segundo o mandado da palavra que te anunciarem do lugar que o Senhor escolher; e terás cuidado de fazer consoante tudo o que te ensinarem.
11 Afta dem don read di law kon pass judgement, una must do anytin wey dem tok; make una nor try to shange wetin dem tok at-all.
11 Segundo o mandado da lei que te ensinarem e de acordo com o juízo que te disserem, farás; da sentença que te anunciarem não te desviarás, nem para a direita nem para a esquerda.
12 Anybody wey nor gri obey wetin di judge or di priest wey dey ripresent di Oga una God tok, una must kill dat pesin. Like dis, una go end bad and wiked tins for Israel.
12 O homem, pois, que se houver soberbamente, não dando ouvidos ao sacerdote, que está ali para servir ao Senhor , teu Deus, nem ao juiz, esse morrerá; e eliminarás o mal de Israel,
13 Den wen all di pipol hear am, dem go fear to do wiked tins.
13 para que todo o povo o ouça, tema e jamais se ensoberbeça.
14 Wen una rish di land wey di Oga una God dey give una and una don take and dey stay inside, den una sey, “Like all di kountries wey dey around us, na so too wi go selet king for awasef,”
14 Quando entrares na terra que te dá o Senhor , teu Deus, e a possuíres, e nela habitares, e disseres: Estabelecerei sobre mim um rei, como todas as nações que se acham em redor de mim,
15 Una must selet di king wey di Oga una God go choose. Una go choose king from among unasef. Make una nor choose pesin wey nor kom from Israel.
15 estabelecerás, com efeito, sobre ti como rei aquele que o Senhor , teu Deus, escolher; homem estranho, que não seja dentre os teus irmãos, não estabelecerás sobre ti, e sim um dentre eles.
16 Make di king nor build big house where e go put horse, or make di pipol go back to Egypt go buy horse, bikos God don sey, “Make una nor go back to Egypt.”
16 Porém este não multiplicará para si cavalos, nem fará voltar o povo ao Egito, para multiplicar cavalos; pois o Senhor vos disse: Nunca mais voltareis por este caminho.
17 Make di king nor marry many wife for ensef, bikos dem go turn en heart from di Oga una God. Make e nor gada money, silva or gold for ensef.
17 Tampouco para si multiplicará mulheres, para que o seu coração se não desvie; nem multiplicará muito para si prata ou ouro.
18 Wen e sidan for di throne as king, make e kopy dis kommand put for book for di Levi priest present.
18 Também, quando se assentar no trono do seu reino, escreverá para si um traslado desta lei num livro, do que está diante dos levitas sacerdotes.
19 Make e always keep dat kopy with am evriday as long as e dey alive. Like dat, e go learn how to fear di Oga en God as e dey obey all di laws and kommand.
19 E o terá consigo e nele lerá todos os dias da sua vida, para que aprenda a temer o Senhor , seu Deus, a fim de guardar todas as palavras desta lei e estes estatutos, para os cumprir.
20 As e dey read am evriday, e nor go dey proud and e nor go do like sey e important pass evribody. Dis nor go let am turn from dis kommand at-all. And e go make en and en shidren-shidren reign as king for Israel forever.
20 Isto fará para que o seu coração não se eleve sobre os seus irmãos e não se aparte do mandamento, nem para a direita nem para a esquerda; de sorte que prolongue os dias no seu reino, ele e seus filhos no meio de Israel.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Deuteronômio 17, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.