Deuteronômio 16
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARC
1 Just to honor di Oga una God, make una dey celebrate di Passova evry year for Abib mont, bikos dat na di mont wey di Oga una God take karry una komot from Egypt for nite.
1 Guarda o mês de abibe e celebra a Páscoa ao Senhor , teu Deus; porque, no mês de abibe, o Senhor , teu Deus, te tirou do Egito, de noite.
2 Una Passova sakrifice go bi from di animal wey una get and una must sakrifice am give di Oga una God for di place wey E sey make una woship am; where E choose make dem honor en name.
2 Então, sacrificarás como oferta de Páscoa ao Senhor , teu Deus, ovelhas e vacas, no lugar que o Senhor escolher para ali fazer habitar o seu nome.
3 Make una chop am with bread wey dem nor make with yist and una go chop dis bread for seven days, just as e bi wen una rush dey komot from Egypt. Make una chop dis bread (bikos na-im una chop wen una dey sofa), so dat as long as una dey alive, una go remember di day wey una komot from Egypt.
3 Nela, não comerás levedado; sete dias nela comerás pães asmos, pão de aflição (porquanto apressadamente saíste da terra do Egito), para que te lembres do dia da tua saída da terra do Egito, todos os dias da tua vida.
4 Make dem nor si yist for anybody house for dis land thru-out di seven days. And wen una sakrifice di Passova lamb for evening for di first day, make una nor let any meat remain till morning.
4 Fermento não aparecerá contigo por sete dias em todos os teus termos; também da carne que matares à tarde, no primeiro dia, nada ficará até à manhã.
5 Una nor go just sakrifice di Passova lamb for any town wey God dey give una.
5 Não poderás sacrificar a Páscoa em nenhuma das tuas portas que te dá o Senhor , teu Deus;
6 Una go only sakrifice am for di place wey dem for dey woship God; di place wey di Oga una God choose sey dem go for honor en name. As di sun dey go down, una go sakrifice am der for evening to take celebrate and remember wen una komot from Egypt.
6 senão no lugar que escolher o Senhor , teu Deus, para fazer habitar o seu nome, ali sacrificarás a Páscoa à tarde, ao pôr do sol, ao tempo determinado da tua saída do Egito.
7 Make una roast and chop di lamb for di place wey una Oga God choose. Den, di next day, una fit go back to una house.
7 Então, a cozerás e comerás no lugar que escolher o Senhor , teu Deus; depois, sairás pela manhã e irás às tuas tendas.
8 For di next six days, make una nor chop any bread wey dem make with yist. Una go make di sevent day anoda holy day to honor di Oga una God and make nobody work for dat day.
8 Seis dias comerás pães asmos, e no sétimo dia é solenidade ao Senhor , teu Deus; nenhuma obra farás.
9 From di day wey una bigin harvest, make una kount seven weeks.
9 Sete semanas contarás; desde que a foice começar na seara, começarás a contar as sete semanas.
10 Den make una celebrate Harvest Feast to honor di Oga una God. Make una gi-am ofrin from una mind, akordin to how E bless una rish.
10 Depois, celebrarás a Festa das Semanas ao Senhor , teu Deus; o que deres será tributo voluntário da tua mão, segundo o Senhor , teu Deus, te tiver abençoado.
11 Dis na time to celebrate before di Oga una God for di place wey dem for dey woship am; di place wey E choose sey make dem honor en name. Make una celebrate with una shidren, all una savants, Levi pipol for una town, strenjas, shidren wey nor get papa and mama again and wimen wey dia husband don die wey dey stay with una.
11 E te alegrarás perante o Senhor , teu Deus, tu, e teu filho, e tua filha, e teu servo, e tua serva, e o levita que está dentro das tuas portas, e o estrangeiro, e o órfão, e a viúva, que estão no meio de ti, no lugar que escolher o Senhor , teu Deus, para ali fazer habitar o seu nome.
12 Make una remember sey na slave una bi for Egypt before, so make una obey all dis kommand with kare.
12 E lembrar-te-ás de que foste servo no Egito, e guardarás estes estatutos, e os farás.
13 Make una celebrate Shelta Feast for seven days for di time wen una dey harvest una plant and grapes.
13 A Festa dos Tabernáculos guardarás sete dias, quando colheres da tua eira e do teu lagar.
14 Wen una dey celebrate dis feast, make una happy with una shidren, all una savants, Levi pipol for una town, strenjas, shidren wey nor get papa and mama again and wimen wey dia husband don die, wey dey stay with una.
14 E na tua festa te alegrarás, tu, e teu filho, e tua filha, e teu servo, e tua serva, e o levita, e o estrangeiro, e o órfão, e a viúva, que estão das tuas portas para dentro.
15 Una must celebrate dis feast for seven days to honor di Oga una God for di place wey E choose, bikos na en bless una well-well kon make all una work, prosper. Dis feast go bi time for evribody to happy.
15 Sete dias celebrarás a festa ao Senhor , teu Deus, no lugar que o Senhor escolher, porque o Senhor , teu Deus, te há de abençoar em toda a tua colheita e em toda obra das tuas mãos; pelo que te alegrarás certamente.
16 For evry year, evry man for Israel go dey celebrate dis three feast: Bread wey nor get yist, Harvest Feast and Shelta Feast. For each feast, evribody must karry gift kom give di Oga una God for di place wey E choose.
16 Três vezes no ano, todo varão entre ti aparecerá perante o Senhor , teu Deus, no lugar que escolher, na Festa dos Pães Asmos, e na Festa das Semanas, e na Festa dos Tabernáculos; porém não aparecerá vazio perante o Senhor ;
17 Evribody must give God as dem fit do rish and na akordin to how di Oga God bless dem rish.
17 cada qual, conforme o dom da sua mão, conforme a bênção que o Senhor , teu Deus, te tiver dado.
18 For all di towns wey di Oga una God dey give una, make una pick doz wey fit judge from each tribe for Israel. Di judge dem must judge di pipol well.
18 Juízes e oficiais porás em todas as tuas portas que o Senhor , teu Deus, te der entre as tuas tribos, para que julguem o povo com juízo de justiça.
19 Make una nor judge anyhow or judge wetin una nor know. Make di judge dem nor take bribe from pipol, bikos bribe dey blind wise pesin eye kon spoil betta pipol mind.
19 Não torcerás o juízo, não farás acepção de pessoas, nem tomarás suborno, porquanto o suborno cega os olhos dos sábios e perverte as palavras dos justos.
20 Make una judge well, so dat una go stay long for di land wey di Oga una God dey give una.
20 A justiça, somente a justiça seguirás, para que vivas e possuas em herança a terra que te dará o Senhor , teu Deus.
21 Apart from di altar wey una build for di Oga wey bi una God, make una nor ever use wood take build house for Asherah juju.
21 Não plantarás nenhum bosque de árvores junto ao altar do Senhor , teu Deus, que fizeres para ti.
22 Make una nor ever build juju house kon woship dem, bikos di Oga una God nor like all dat kind tin.
22 Nem levantarás estátua, a qual o Senhor , teu Deus, aborrece.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Deuteronômio 16, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.