Deuteronômio 15

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARA

Sair da comparação
ARA Almeida Revista e Atualizada 1993
1 For di end of evry seven year, make una kancel di debt wey anybody dey owe una.
1 Ao fim de cada sete anos, farás remissão.
2 Dis na how una go dey do am. Evribody must kancel di debt wey dia fellow Israel broda dey hold dem. Dem must nor sey make dia neighbour or rilative pay dem back, bikos God time to free pipol, don rish.
2 Este, pois, é o modo da remissão: todo credor que emprestou ao seu próximo alguma coisa remitirá o que havia emprestado; não o exigirá do seu próximo ou do seu irmão, pois a remissão do Senhor é proclamada.
3 Dis freedom from debt na for only una brodas nor bi for di strenjas.
3 Do estranho podes exigi-lo, mas o que tiveres em poder de teu irmão, quitá-lo-ás;
4 Make poor pesin nor dey among una, bikos di Oga una God go really bless una for di land wey E dey give una as una own forever.
4 para que entre ti não haja pobre; pois o Senhor , teu Deus, te abençoará abundantemente na terra que te dá por herança, para a possuíres,
5 Una go receive dis blessing if una really obey dis kommand wey I dey give una.
5 se apenas ouvires, atentamente, a voz do Senhor , teu Deus, para cuidares em cumprir todos estes mandamentos que hoje te ordeno.
6 Bikos di Oga una God go bless una just as E promise; una go give to many kountries, but una nor go borrow from any one. Una go rule many kountries, but no kountry go rule una.
6 Pois o Senhor , teu Deus, te abençoará, como te tem dito; assim, emprestarás a muitas nações, mas não tomarás empréstimos; e dominarás muitas nações, porém elas não te dominarão.
7 But if anybody dey poor for Israel wen una rish di land wey di Oga una God dey give una, make una nor do strong head for am at-all.
7 Quando entre ti houver algum pobre de teus irmãos, em alguma das tuas cidades, na tua terra que o Senhor , teu Deus, te dá, não endurecerás o teu coração, nem fecharás as mãos a teu irmão pobre;
8 Una must make sure sey una dey good to am kon gi-am anytin wey e nid.
8 antes, lhe abrirás de todo a mão e lhe emprestarás o que lhe falta, quanto baste para a sua necessidade.
9 Make una dey kareful, if not wiked tins go full una mind, den una nor go give pesin money, bikos di seven years don dey near. If una nor gri give di pesin money and di pesin kon kry give God, dat mean sey una don kommit sin.
9 Guarda-te não haja pensamento vil no teu coração, nem digas: Está próximo o sétimo ano, o ano da remissão, de sorte que os teus olhos sejam malignos para com teu irmão pobre, e não lhe dês nada, e ele clame contra ti ao Senhor , e haja em ti pecado.
10 Make una dey give to poor pipol with happiness, bikos di Oga una God go bless una for evritin wey una dey do.
10 Livremente, lhe darás, e não seja maligno o teu coração, quando lho deres; pois, por isso, te abençoará o Senhor , teu Deus, em toda a tua obra e em tudo o que empreenderes.
11 E go always get some pipol for di land wey go dey poor. Dat na why I dey kommand una to dey give with happy mind to poor pipol and odas for Israel wey nid anytin.
11 Pois nunca deixará de haver pobres na terra; por isso, eu te ordeno: livremente, abrirás a mão para o teu irmão, para o necessitado, para o pobre na tua terra.
12 If una fellow Hibru sell ensef to bi una savant kon serve una for six years, for di sevent year, una must free di pesin.
12 Quando um de teus irmãos, hebreu ou hebreia, te for vendido, seis anos servir-te-á, mas, no sétimo, o despedirás forro.
13 Wen una dey free una savant, make una nor let dem go like dat.
13 E, quando de ti o despedires forro, não o deixarás ir vazio.
14 Make una give dem betta gift with happiness from una animal and from una wine. Make una give some of di blessing wey God give una.
14 Liberalmente, lhe fornecerás do teu rebanho, da tua eira e do teu lagar; daquilo com que o Senhor , teu Deus, te houver abençoado, lhe darás.
15 Make una remember sey una bi slave for Egypt until di Oga una God kon save una! Na dis make mi dey give una dis kommand.
15 Lembrar-te-ás de que foste servo na terra do Egito e de que o Senhor , teu Deus, te remiu; pelo que, hoje, isso te ordeno.
16 But if una savant sey, “I nor wont go,” bikos e love una and una family and e don serve una well.
16 Se, porém, ele te disser: Não sairei de ti; porquanto te ama, a ti e a tua casa, por estar bem contigo,
17 For dat kind kase, make una take sharp iron take press en ear join di door, den e go bi una savant forever. Una go do like dis both for una man and woman savant.
17 então, tomarás uma sovela e lhe furarás a orelha, na porta, e será para sempre teu servo; e também assim farás à tua serva.
18 Make una nor si am as big lost wen una free una savants. Make una remember sey, di work wey dem don work for una for six years, if una sey make una hire pesin make e do am, una go pay am times two. So di Oga una God go bless una for dis tin wey una do.
18 Não pareça aos teus olhos duro o despedi-lo forro; pois seis anos te serviu por metade do salário do jornaleiro; assim, o Senhor , teu Deus, te abençoará em tudo o que fizeres.
19 All di first male wey una animal born, una go give dem to God. Make una nor use dem take go klear una field and make una nor shear dem at-all.
19 Todo primogênito que nascer do teu gado ou de tuas ovelhas, o macho consagrarás ao Senhor , teu Deus; com o primogênito do teu gado não trabalharás, nem tosquiarás o primogênito das tuas ovelhas.
20 Instead, for evry year, una and una family go chop dem for di Oga una God present, for di place wey E choose.
20 Comê-lo-ás perante o Senhor , tu e a tua casa, de ano em ano, no lugar que o Senhor escolher.
21 But if di first pikin for di animal get problem like sey e nor fit waka or e blind or if any oda tin dey happen to am, make una nor sakrifice am give di Oga una God.
21 Porém, havendo nele algum defeito, se for coxo, ou cego, ou tiver outro defeito grave, não o sacrificarás ao Senhor , teu Deus.
22 Instead, make una use am take kook for una family for house. Anybody, weda e dey klean or e nor klean, fit chop from am, just as anybody fit chop deer or gazelle.
22 Na tua cidade, o comerás; o imundo e o limpo o comerão juntamente, como a carne do corço ou do veado.
23 But make una nor chop blood. Una must pour di blood for groun like wota.
23 Somente o seu sangue não comerás; sobre a terra o derramarás como água.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Deuteronômio 15, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.