Deuteronômio 10

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARIB

Sair da comparação
ARIB Almeida Revisada Imprensa Bíblica
1 For dat time, God kon tell mi, “Make yu kut two stones like di first ones den kom meet mi for di mountin; make yu still make box with wood for yorsef.
1 Naquele mesmo tempo me disse o Senhor: Alisa duas tábuas de pedra, como as primeiras, e sobe a mim ao monte, e faze uma arca de madeira.
2 Di same word wey dey di stones wey yu break, I go rite dem put for dis ones and yu must put dem for di box.”
2 Nessas tábuas escreverei as palavras que estavam nas primeiras tábuas, que quebras-te, e as porás na arca.
3 So I use akasia wood take make box kon kut two stone like di first ones. Den I klimb go di mountin with di two stones for my hand.
3 Assim, fiz ume arca de madeira de acácia, alisei duas tábuas de pedra, como as primeiras, e subi ao monte com as duas tábuas nas mãos.
4 So di same word wey bi di ten kommandment wey E tell mi for di mountin and from di fire wen una gada go meet am, God kon rite dem put for dis ones as E bin rite am for di first stones.
4 Então o Senhor escreveu nas tábuas, conforme a primeira escritura, os dez mandamentos, que ele vos falara no monte, do meio do fogo, no dia da assembléia; e o Senhor mas deu a mim.
5 Den I kom down from di mountin kon put di two stones for di box wey I make, just as God kommand mi and di stones still dey der.
5 Virei-me, pois, desci do monte e pus as tábuas na arca que fizera; e ali estão, como o Senhor me ordenou.
6 For dat time, Israel pipol travel from Beerot Bene Jaakan go Mosera. Aaron die for der and dem beri am and en pikin Eleazar kon take-ova as priest.
6 {Ora, partiram os filhos de Israel de Beerote-Bene-Jaacã para Mosera. Ali faleceu Arão e foi sepultado; e Eleazar, seu filho, administrou o sacerdócio em seu lugar.
7 From der, dem travel go Gudgodah kon from der travel go Jotbatah where wota for dey flow.
7 Dali partiram para Gudgoda, e de Gudgoda para Jotbatá, terra de ribeiros de águas.
8 For dat time, God separate Levi tribe sey make dem karry God Kovenant Box kon stand for God present to serve am and na dem go dey bless pipol with en name and na so e bi till today.
8 Por esse tempo o Senhor separou a tribo de Levi, para levar a arca do pacto do Senhor, para estar diante do Senhor, servindo-o, e para abençoar em seu nome até o dia de hoje.
9 Dat na why Levi pipol nor get propaty or land among di oda tribes for Israel. Na God ensef bi dia propaty, just as di Oga una God tok.
9 Pelo que Levi não tem parte nem herança com seus irmãos; o Senhor é a sua herança, como o Senhor teu Deus lhe disse.}
10 But for mi, I stay for di mountin just as I do for di first time for forty days and forty nite. For dat time, God still listin to mi kon sey E nor go distroy una.
10 Também, como antes, eu estive no monte quarenta dias e quarenta noites; e o Senhor me ouviu ainda essa vez; o Senhor não te quis destruir;
11 Den E tell mi, “Make yu and di pipol start una journey, so dat dem go-go kollect di land wey I promise dia grand-grand papa.”
11 antes disse-me o Senhor: Levanta-te, põe-te a caminho diante do povo; eles entrarão e possuirão a terra que com juramento prometi a seus pais lhes daria.
12 Naw, Israel pipol, wetin di Oga una God wont from unasef? E wont make una dey fear am kon dey live di kind life wey E wont make una live. E wont make una love, respet and serve am with all una soul and heart.
12 Agora, pois, ó Israel, que é que o Senhor teu Deus requer de ti, senão que temas o Senhor teu Deus, que andes em todos os seus caminhos, e o ames, e sirvas ao Senhor teu Deus de todo o teu coração e de toda a tua alma,
13 Una must always obey God kommand and law wey I dey give una today, so dat evritin go dey well with una.
13 que guardes os mandamentos do Senhor, e os seus estatutos, que eu hoje te ordeno para o teu bem?
14 Di heavens, di heavens wey high pass, plus di eart and evritin wey dey inside am, na God get all of dem.
14 Eis que do Senhor teu Deus são o céu e o céu dos céus, a terra e tudo o que nela há.
15 Yet God show en love to una grand-grand papa dem. And E choose una wey bi dia grand-shidren above evry oda pipol, as all of us dey si am today.
15 Entretanto o Senhor se afeiçoou a teus pais para os amar; e escolheu a sua descendência depois deles, isto é, a vós, dentre todos os povos, como hoje se vê.
16 So make una shange una heart and stop to dey do strong head.
16 Circuncidai, pois, o prepúcio do vosso coração, e não mais endureçais a vossa cerviz.
17 Bikos di Oga una God na God of all gods and Oga of all ogas. Na en bi di great Oga God, di God wey dey do wonders, God wey nor dey do wayo and nobody fit bribe am.
17 Pois o Senhor vosso Deus, é o Deus dos deuses, e o Senhor dos senhores, o Deus grande, poderoso e terrível, que não faz acepção de pessoas, nem recebe peitas;
18 Doz wey nor get papa and mama and doz wey nor get husband again, E dey make sure sey E fight for dem. E dey show love to strenjas wey dey stay with una kon give dem food and klot to wear.
18 que faz justiça ao órfão e à viúva, e ama o estrangeiro, dando-lhe pão e roupa.
19 So una too must show love to strenjas, bikos unasef bi strenja for Egypt before.
19 Pelo que amareis o estrangeiro, pois fostes estrangeiros na terra do Egito.
20 Una must fear di Oga una God kon woship and love am. Wen una swear, e go must bi with en name.
20 Ao Senhor teu Deus temerás; a ele servirás, e a ele te apegarás, e pelo seu nome; jurarás.
21 Na only en bi God; di only one wey wi go dey praiz; di Pesin wey don do many wonderful mirakles wey una don si with una own eyes.
21 Ele é o teu louvor e o teu Deus, que te fez estas grandes e terríveis coisas que os teus olhos têm visto.
22 Wen una grand-grand papa dem go Egypt, dem bi only seventy. But naw, di Oga una God don make una plenty like di stars for sky!
22 Com setenta almas teus pais desceram ao Egito; e agora o Senhor teu Deus te fez, em número, como as estrelas do céu.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Deuteronômio 10, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.