Daniel 9

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NVI

Sair da comparação
NVI Nova Versão Internacional
1 For di first year wen Zazes pikin, Darius wey bi Media king, dey rule Babilon.
1 Dario, filho de Xerxes, de origem meda, foi constituído governante do reino babilônio.
2 For dat same year wen e dey rule, mi Daniel kom undastand di holy book wey sey na seventy years God tell Profet Jeremaya sey, Jerusalem pipol go skata for di world.
2 No primeiro ano do seu reinado, eu, Daniel, compreendi pelas Escrituras, conforme a palavra do Senhor dada ao profeta Jeremias, que a desolação de Jerusalém iria durar setenta anos.
3 So I wear sak klot, sidan for ashes den turn to God kon dey beg am as I dey pray and fast.
3 Por isso me voltei para o Senhor Deus com orações e súplicas, em jejum, em pano de saco e coberto de cinza.
4 I pray to God kon konfess all di bad tins wey wi don do sey:
4 Orei ao Senhor, ao meu Deus, e confessei: "Ó Senhor, Deus grande e temível, que mantém a sua aliança de amor com todos aqueles que o amam e obedecem aos seus mandamentos,
5 Wi don sin! Wi wiked well-well and wi dey do bad tins. Wi nor dey do wetin Yu kommand and wi don turn from yor korrect way.
5 nós temos pecado e somos culpados. Temos sido ímpios e rebeldes, e nos afastamos dos teus mandamentos e das tuas leis.
6 Wi nor gri listin to yor savants wey bi profets; di ones wey tell awa kings, rulers, grand-grand papa and all di nashon about Yu.
6 Não demos ouvido aos teus servos, os profetas, que falaram em teu nome aos nossos reis, aos nossos líderes e aos nossos antepassados, e a todo o povo desta terra.
7 “Awa God! Na only Yu dey do wetin dey rite, but dem dey disgrace us evriday, bikos Judah, Jerusalem and all di pipol wey Yu skata go evriwhere, nor gri listin to Yu.
7 "Senhor, tu és justo, e hoje estamos envergonhados. Sim, nós, o povo de Judá, de Jerusalém e de todo o Israel, tanto os que estão perto como os que estão distantes, em todas as terras pelas quais nos espalhaste por causa de nossa infidelidade para contigo.
8 My God! Wi dey sofa like dis, bikos awa king, rulers and grand-grand papa, don sin against Yu.
8 Ó Senhor, nós e nossos reis, nossos líderes e nossos antepassados estamos envergonhados por termos pecado contra ti.
9 But even with all di sin wey wi kommit, Yu still dey forgive and sorry for us.
9 O Senhor nosso Deus é misericordioso e perdoador, apesar de termos sido rebeldes;
10 Wi nor dey obey di Oga awa God, bikos wi nor dey live awa life as E sey make wi leave am. Wi even bilive sey di law wey E sey make en savants tell us, nor mean anytin.
10 não te demos ouvidos, Senhor, nosso Deus, nem obedecemos às leis que nos deste por meio dos teus servos, os profetas.
11 “All of us don break yor law and wi nor gri listin to wetin Yu tok. Wi don sin and na awa sins make Yu dey ponish us so, just as yor savant, Moses rite am for di law.
11 Todo o Israel tem transgredido a tua lei e se desviou, recusando-se a te ouvir. "Por isso as maldições e as pragas escritas na Lei de Moisés, servo de Deus, têm sido derramadas sobre nós, porque temos pecado contra ti.
12 Yu don do wetin Yu sey Yu go do wi and awa leaders. For all di towns wey dey for dis world, na Jerusalem Yu dey ponish pass.
12 Tu tens cumprido as palavras faladas contra nós e contra os nossos governantes, trazendo-nos grande desgraça. Debaixo de todo o céu jamais se fez algo como o que foi feito a Jerusalém.
13 Yu dey ponish us just as dem rite am for Moses Law. But as Yu ponish us rish, wi still dey kommit sin and wi nor gri do wetin Yu tok.
13 Assim como está escrito na Lei de Moisés, toda essa desgraça nos atingiu, e ainda assim não temos buscado o favor do Senhor, do nosso Deus, afastando-nos de nossas maldades e obedecendo à tua verdade.
14 Awa Oga God dey ready to ponish us and E really ponish us, bikos anytin wey E dey do, dey rite, yet wi nor gri listin to am.
14 O Senhor não hesitou em trazer desgraça sobre nós, pois o Senhor, o nosso Deus, é justo em tudo o que faz; ainda assim nós não o temos ouvido.
15 “Naw, awa God, na Yu take yor pipol komot from Egypt with yor mighty pawa kon make name for yorsef wey dem nor fit forget forever. Wi don sin and wi dey bihave like wiked pipol.
15 Ó Senhor, nosso Deus, que tiraste o teu povo do Egito com mão poderosa e que fizeste para ti um nome que permanece até hoje, nós temos pecado e somos culpados.
16 Before-before, Yu dey defend us. So make Yu nor vex for Jerusalem again, bikos na yor town and holy hill, e bi. Doz wey dey stay near us, dey look Jerusalem kon dey laf yor pipol, bikos of awa sin and di wiked tins wey awa grand-grand papa dem do.
16 Agora Senhor, conforme todos os teus feitos justos, afasta de Jerusalém, da tua cidade, do teu santo monte, a tua ira e a tua indignação. Os nossos pecados e as iniqüidades de nossos antepassados fizeram de Jerusalém e do teu povo motivo de zombaria para todos os que nos rodeiam.
17 “So naw, God, make Yu hear my prayer and as I dey beg Yu. Make Yu sorry for yor temple wey dem don distroy; so dat evribody go know sey na only Yu bi di God wey nor dey die.
17 Ouve, nosso Deus, as orações e as súplicas do teu servo. Por amor de ti, Senhor, olha com bondade para o teu santuário abandonado.
18 Abeg, God make Yu sorry for Jerusalem town wey Yu choose, nor bi bikos wi deserve am, but bikos of yor great love wey nor dey fail.
18 Inclina os teus ouvidos, ó Deus, e ouve; abre os teus olhos e vê a desolação da cidade que leva o teu nome. Não te fazemos pedidos por sermos justos, mas por causa da tua grande misericórdia.
19 So make Yu forgive us! Make Yu kwik hear and ansa us. Nor bi just for yor town and en pipol, but na to make pipol honor and praiz yor holy name.”
19 Senhor, ouve! Senhor, perdoa! Senhor, vê e age! Por amor de ti, meu Deus, não te demores, pois a tua cidade e o teu povo levam o teu nome".
20 As I still dey pray, dey konfess and beg God make E forgive mi and Israel pipol sin kon sorry for en holy temple,
20 Enquanto eu estava falando e orando, confessando o meu pecado e o pecado de Israel, meu povo, e fazendo o meu pedido ao Senhor, ao meu Deus, em favor do seu santo monte;
21 Angel Gabriel wey I don first si for my vishon before kon dey fly kom where I dey. Dat time, dem won offa di evening sakrifice.
21 enquanto eu ainda estava em oração, Gabriel, o homem que eu tinha visto na visão anterior, veio a mim, voando rapidamente para onde eu estava, à hora do sacrifício da tarde.
22 Di angel tell mi, “Daniel, I don kom make yu really undastand naw.
22 Ele me instruiu e me disse: "Daniel, agora vim para dar-lhe percepção e entendimento.
23 God don ansa yor prayer since di very first day wen yu start to pray and beg am and na di love wey E get for yu, make mi kom so. Naw, make yu listin well-well as I dey tok kon undastand di vishon:
23 Assim que você começou a orar, houve uma resposta, que eu lhe trouxe porque você é muito amado. Por isso, preste atenção à mensagem para entender a visão:
24 “God don set seventy weeks as di time wen E go take free yor pipol kon ribuild en temple. Una dey sofa, bikos of all di evil and wiked tins wey una do. Afta, E go forgive una sins and judge una well forever, so dat wetin E tok, go happen. Den E go anoint di holy temple again.
24 "Setenta semanas estão decretadas para o seu povo e sua santa cidade para acabar com a transgressão, para dar fim ao pecado, para expiar as culpas, para trazer justiça eterna, para cumprir a visão e a profecia, e para ungir o santíssimo.
25 “So make yu know and undastand sey, ‘From naw wen I tell yu dis message, till di time wen dem go ribuild Jerusalem and di leader wey God choose go kom, e go bi seven weeks and sixty-two weeks. Dem go build di town well again, but wahala go dey for dat time.
25 "Saiba e entenda que a partir da promulgação do decreto que manda restaurar e reconstruir Jerusalém até que o Ungido, o líder, venha, haverá sete semanas, e sessenta e duas semanas. Ela será reconstruída com ruas e muros, mas em tempos difíceis.
26 “ ‘Afta di sixty-two weeks, di Pesin wey God choose, go die and nor-tin go remain. Di ruler wey get pawa pass, go bring sojas kom distroy di town and di temple. Di end go rush kom like wota; e go bring war and distroshon, just as God plan am.
26 Depois das sessenta e duas semanas, o Ungido será morto, e já não haverá lugar para ele. A cidade e o lugar santo serão destruídos pelo povo do governante que virá. O fim virá como uma inundação: Guerras continuarão até o fim, e desolações foram decretadas.
27 “ ‘Dat ruler go enter agriment with many pipol for one week, den for di middle of dat week, e go stop all di sakrifice and ofrin. Den e go start one bad tin wey go kause wahala and tins go bi like dat, until di time wey God sey E won distroy di wayo pesin wey kause di wahala.’ ”
27 Com muitos ele fará uma aliança que durará uma semana. No meio da semana ele dará fim ao sacrifício e à oferta. E numa ala do templo será colocado o sacrilégio terrível, até que chegue sobre ele o fim que lhe está decretado".

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Daniel 9, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.