Daniel 8

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs VC

Sair da comparação
VC Versão Católica
1 For di third year wey King Belshazzar dey rule, mi Daniel si anoda vishon apart from di ones wey I don si before.
1 No terceiro ano do reinado de Baltazar, eu, Daniel, tive uma visão, continuação daquela que eu tinha tido anteriormente.
2 For dis vishon, I si mysef for Shushan wey dey Elam aria. As I stand near Ulai river,
2 Nessa visão, eu me achava na fortaleza de Susa, na província de Elão, e eu me vi, sempre em visão, às margens do Ulai.
3 I look up kon si one ram wey get two horn and e stand near di river. Di two horn long, but one long pass di oda one. Di one wey long pass, kom out afta di short one.
3 Erguendo os olhos, eis que vi um carneiro, o qual se achava em frente ao rio. Tinha dois chifres, dois longos chifres, um dos quais era mais alto do que o outro. Esse chifre mais alto apareceu por último.
4 I si di ram dey waka with en horn dey go west, nort and sout-side. No animal fit stop am or eskape from en pawa. E dey do wetin e like and dey bihave anyhow.
4 Vi o carneiro dar chifradas em direção do oeste, do norte e do sul. Nenhum animal resistia diante dele, e ninguém conseguia escapar de seu poder. Fazia o que queria, e crescia.
5 As I still dey tink, one man goat kon dey kom from west side. E dey run fast-fast like sey en leg nor dey tosh groun. E get one horn between en two eyes.
5 Enquanto observava com atenção, eis que um bode robusto veio do ocidente e percorreu a terra inteira sem tocar o solo; tinha entre os dois olhos um chifre muito saliente.
6 E rush kon attack di ram wey I si before, wey stand near di river.
6 Foi até o carneiro de dois chifres, que eu tinha visto em frente ao rio, e avançou contra ele num excesso de fúria.
7 I dey look as e vex kon attack di ram, den e break di ram two horns and di ram nor get pawa to fight am back. Di goat trow di ram for groun kon dey mash am and nobody fit save am.
7 Eu o vi aproximar-se do carneiro e atirando-se com fúria sobre ele, espancá-lo e quebrar-lhe os dois chifres, sem que o carneiro tivesse força para sustentar o assalto. O bode jogou por terra o carneiro e o calcou aos pés, sem que alguém interviesse para subtraí-lo ao ataque de seu adversário.
8 Di goat kon dey strong more-more, but leta, en horns kon break. Den four horns kon grow kom out from where di two horns for break and each of di horns face difren direcshon.
8 Então o bode tornou-se muito grande. Mas, assim que se tornou poderoso, seu grande chifre quebrou-se e foi substituído por quatro chifres que cresciam em direção dos quatro ventos do céu.
9 From one of di horn, anoda small horn kon grow kom out. E grow big well-well kon face sout, east and di promise land.
9 De um deles saiu um pequeno chifre que se desenvolveu consideravelmente para o sul, para o oriente e para a jóia {dos países}.
10 E strong rish to attack God sojas for heaven; e even remove and trow some stars for groun kon stand on-top dem.
10 Cresceu até alcançar os astros do céu, do qual fez cair por terra diversas estrelas e as calcou aos pés.
11 E still dey praiz ensef pass di sojas for heaven. E stop di sakrifice wey dem dey offa give God evriday kon skata where dem for dey woship God.
11 Cresceu até o chefe desse exército de astros, cujo {holocausto} perpétuo aboliu e cujo santuário destruiu.
12 Instead of di normal sakrifice wey di pipol dey offa, dem kon start to sin, so dem forget God ways. Di horn dey enjoy evritin wey e dey do.
12 Por causa da infidelidade, além do holocausto perpétuo foi-lhe entregue um exército! A verdade foi lançada à terra. O pequeno chifre teve êxito na sua empreitada.
13 Den I hear one angel dey ask anoda one sey, “How long dis tin wey dey happen for dis vishon go kontinue? Dis wiked tin wey dem dey do go replace di sakrifice wey dem dey do evriday? How long di sojas wey dey heaven and di temple go dey under en leg?”
13 Ouvi um santo que falava, a quem outro santo respondeu: quanto tempo durará o anunciado pela visão a respeito do holocausto perpétuo, da infidelidade destruidora, e do abandono do santuário e do exército calcado aos pés?
14 I kom hear di oda angel sey, “Na 2,000 three hundred days, both for morning and evening and for dat time, dem nor go offa any sakrifice.”
14 Respondeu: duas mil e trezentas noites e manhãs. Depois disso o santuário será restabelecido.
15 As I still dey try to undastand wetin di vishon mean, I kon si pesin stand for my front.
15 Ora, enquanto eu contemplava essa visão e procurava o significado, vi, de pé diante de mim, um ser em forma humana,
16 Den I hear vois from Ulai river dey sey, “Gabriel, make yu tell am di meaning of wetin e si.”
16 e ouvi uma voz humana vinda do meio do Ulai: Gabriel, gritava, explica-lhe a visão.
17 Gabriel stand near mi, so bikos I dey fear, I kon fall face groun. Naim e sey, “Man pikin, make yu undastand wetin e mean. Di vishon dey show yu how di world go take end.”
17 Dirigiu-se então em direção ao lugar onde eu me achava. À sua aproximação, fiquei apavorado e caí com a face contra a terra. Filho do homem, disse-me ele, compreende bem que essa visão simboliza o tempo final.
18 As e dey tok to mi, I kon faint for groun. But e tosh mi and I get up.
18 Enquanto falava comigo, desmaiei, com o rosto em terra. Mas ele tocou-me e me fez ficar de pé.
19 So e sey, “I kom tell yu wetin go happen wen trobol go dey for di world. Dis vishon na about wen di world won end.
19 Eis, disse, vou revelar-te o que acontecerá nos últimos tempos da cólera, porque isso diz respeito ao tempo final.
20 Di ram wey yu si wey get two horn, na di two kings for Mede and Persia.
20 O carneiro de dois chifres, que viste, simboliza os reis da Média e da Pérsia.
21 Di man goat na Greece king and di big horn wey dey between en eyes, na di first king.
21 O bode valente é o rei de Javã; o grande chifre que ele tem entre os olhos é o primeiro rei.
22 Di horn wey break wey four oda horns kon grow kom out for en place, na di four oda kingdoms wey go kom from en nashon, but dem nor go get pawa like am.
22 Sua ruptura e o nascimento de quatro chifres em seu lugar significam quatro reinos saindo dessa nação, mas sem terem o mesmo poder.
23 Wen dia kingdom don dey won end and dia sin don plenty well-well, anoda wiked king wey sturbon and dey lie well-well, go kom ponish dem.
23 No fim do reinado deles, quando estiver cheia a medida dos infiéis, um rei surgirá, cheio de crueldade e fingimento.
24 E go dey strong, but nor bi by en own pawa. E go kause strong wahala kon prosper for evritin wey e dey do. E go distroy doz wey get pawa and pipol wey dey serve God.
24 Seu poder aumentará, nunca porém por si mesmo. Fará monstruosas devastações, terá êxito nas suas empresas, exterminará os poderosos e o povo dos santos.
25 With en wayo, e go prosper as e dey lie and deceive pipol. E go dey bihave anyhow kon distroy many pipol without sey e first warn dem. E go fight and win kings wey get strong pawa, but e go skata wen nobody tosh or fight am.
25 Graças à sua habilidade, fará triunfar sua perfídia, seu coração inchar-se-á de orgulho; mandará matar muita gente que não espera por isso, levantar-se-á contra o príncipe dos príncipes, mas será aniquilado sem a intervenção de mão humana.
26 Di vishon about morning and evening wey dem tell yu, korrect. But make yu keep di vishon for yor mind, bikos di time wey e go happen, neva rish.”
26 A visão que te foi apresentada sobre as noites e as manhãs é perfeitamente verídica. Mas tu, guarda esta visão em segredo, pois ela se refere a dias longínquos.
27 So I faint and I kon dey sick for some days. Den afta, I get up kon go do di work wey di king sey make I do. But di vishon still dey sopraiz mi, bikos I nor fit undastand wetin e mean.
27 Então, eu, Daniel, desfaleci. Estive doente durante muitos dias. Depois disso recomecei a trabalhar nos serviços do rei. Fiquei atônito com a visão que tive, completamente incompreensível para mim.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Daniel 8, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.