Daniel 7

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs VC

Sair da comparação
VC Versão Católica
1 Di first year wen Belshazzar bi king for Babilon, Daniel dream one kind dream kon si plenty vishon wen e dey sleep, so e rite di dreams for book.
1 No primeiro ano do reinado de Baltazar, rei de Babilônia, Daniel, estando em seu leito, teve um sonho e visões surgiram em seu espírito. Consignou por escrito esse sonho e a substância dos fatos.
2 Daniel sey: “As I dey dream dat nite, I kon si breeze dey blow from di four korna for di eart and di sea dey make strong nois.
2 Assim se manifestou: Via, no transcurso de minha visão noturna, os quatro ventos do céu precipitarem-se sobre o Grande Mar.
3 Den four big beast kom out from di sea and dem dey difren from each oda.
3 Surgiram das águas quatro grandes animais, diferentes uns dos outros.
4 “Di first one bi like lion wey get eagle feada. As I dey look am, dem remove di feadas kon karry am komot groun. Dem make am stand with two leg like human being kon gi-am human being mind.
4 O primeiro parecia-se com um leão, mas tinha asas de águia. Enquanto o olhava, suas asas foram-lhe arrancadas, foi levantado da terra e erguido sobre seus pés como um homem, e um coração humano lhe foi dado.
5 “Di sekond beast bi like bear. Dem karry am for one side. E get three rib for en mout and dem dey en tit centre. So I hear wen one vois tell am, ‘Get up make yu go chop pipol until yu beleful.’
5 Apareceu em seguida outro animal semelhante a um urso; erguia-se sobre um lado e tinha à boca, entre seus dentes, três costelas. Diziam-lhe: Vamos! Devora bastante carne!
6 “Afta all dis tins, as I dey look, anoda beast wey bi like leopard kon kom out with four feada for en back, di feada bi like bird own. Dis beast get four head and dem kom gi-am pawa to rule.
6 Depois disso, vi um terceiro animal, idêntico a uma pantera, que tinha nas costas quatro asas de pássaro; tinha ele também quatro cabeças. O império lhe foi atribuído.
7 “As I still dey look for di vishon, di nomba four beast kom out: E get pawa, e wall-wall and pipol dey fear am well-well. En tit dem na iron. E dey distroy and skata anytin kon use en leg take skata wetin remain. E dey difren from all di beast wey first kom and e get ten horn.
7 Finalmente, como eu contemplasse essas visões noturnas, vi um quarto animal, medonho, pavoroso e de uma força excepcional. Possuía enormes dentes de ferro; devorava, depois triturava e pisava aos pés o que sobrava. Ao contrário dos animais precedentes, ostentava dez chifres.
8 “As I still dey look di horn, I si anoda small horn dey kom out from di big wons and three of di former horn kom skata make dis ones for fit kom out. Dis horn get eye wey bi like human being own and mout wey e take dey tok anyhow.
8 Como estivesse ocupado em observar esses chifres, eis que surgiu, entre eles outro chifre menor, e três dos primeiros foram arrancados para dar-lhe lugar. Este chifre tinha olhos idênticos aos olhos humanos e uma boca que proferia palavras arrogantes.
9 “As I still dey look, dem kom set throne and Oga God wey nor dey die kon sidan put. En klot dey white like snow and en hair bi like lamb skin. En throne dey bring fire like sey di wheel dey burn.
9 Continuei a olhar, até o momento em que foram colocados os tronos e um ancião chegou e se sentou. Brancas como a neve eram suas vestes, e tal como a pura lã era sua cabeleira; seu trono era feito de chamas, com rodas de fogo ardente.
10 River with fire dey kom out from di throne. Pipol wey dey woship am, many well-well. Many-many pipol still dey wait to kom woship am. Den dem open di book, bikos dem won start to judge kase.
10 Saído de diante dele, corria um rio de fogo. Milhares e milhares o serviam, dezenas de milhares o assistiam! O tribunal deu audiência e os livros foram abertos.
11 “I still dey look as di horn dey tok wiked-wiked words. I dey look until dem kill di beast kon distroy en body, den trow am inside di fire wey dey kom out from di throne.
11 Olhei então, devido à balbúrdia causada pelos discursos arrogantes do chifre, olhei até o momento em que o animal foi morto, seu corpo subjugado e a fera jogada ao fogo.
12 Dem take di remainin beast pawas, but dem sey make doz beast still dey live for sometaim.
12 Quanto aos outros animais, o domínio lhes foi igualmente retirado, mas a duração de sua vida foi fixada até um tempo e uma data.
13 As I still dey look for di vishon for nite, I si wetin bi like human being. E dey waka kom with kloud wey dey round am, den e go show ensef give di Pesin wey dey live forever.
13 Olhando sempre a visão noturna, vi um ser, semelhante ao filho do homem, vir sobre as nuvens do céu: dirigiu-se para o lado do ancião, diante de quem foi conduzido.
14 Dem gi-am authority, honor and pawa to rule. Evribody, nashon and pipol from difren tribe, go serve am. En pawa go last forever and nobody go fit distroy en kingdom.
14 A ele foram dados império, glória e realeza, e todos os povos, todas as nações e os povos de todas as línguas serviram-no. Seu domínio será eterno; nunca cessará e o seu reino jamais será destruído.
15 “Di vishon wey I si dey disturb mi.
15 Quanto a mim, Daniel, senti minha alma desfalecer dentro de mim, e fiquei perturbado por essas visões de meu espírito.
16 So I go meet one of dem wey stand for der kon tell am make e tell mi wetin e mean. Den e tell mi di meaning.
16 Aproximando-me de um dos assistentes, perguntei-lhe sobre a realidade de tudo isso. Respondeu-me dando a explicação seguinte:
17 E sey, ‘Di four big beast na four kingdom wey go soon kom di eart.
17 esses grandes animais, {disse}, em número de quatro, são quatro reis que se levantarão da terra.
18 And di pipol wey dey serve di Most High God go get royal pawa wey go dey forever and ever.’
18 Mas os santos do Altíssimo receberão a realeza e a conservarão por toda a eternidade.
19 “Den, I won kon know more about di nomba four beast wey nor bi like any of di oda beast; di beast wey dey make pesin fear; wey dey kill and skata wetin e fit skata with en bronze finger and iron tit.
19 Quis então saber exatamente o que representava o quarto animal, diferente dos demais, pavoroso em extremo, cujos dentes eram de ferro e as garras de bronze, que devorava, depois triturava e calcava aos pés o que sobrava.
20 I still won know about di ten horns for en head; di horns wey grow kom out leta; di three horns wey fall wey get eye and mout wey dey tok anyhow and en face dey make pesin fear pass any of di oda beast dem own.
20 Quis ser informado sobre os dez chifres que tinha na cabeça, bem como a respeito desse outro chifre que havia surgido e diante do qual três chifres haviam caído, esse chifre que tinha olhos e uma boca que proferia palavras arrogantes, e parecia maior do que os outros.
21 As I still dey look, di horn kon dey fight and distroy God pipol,
21 Tinha visto esse chifre fazer guerra aos santos e levar-lhes vantagem, até o momento em que veio o ancião,
22 until God wey dey live forever kon judge and favor all en holy shidren. Den di time kom rish for God to take-ova di kingdom.
22 quando foi feita justiça aos santos do Altíssimo e quando lhes chegou a hora de obterem a realeza.
23 “Dis na wetin e tell mi: ‘Di nomba four beast mean sey di eart go get four kingdom wey go difren from all di kingdoms wey dey before. Dem go skata and distroy di eart.
23 Ele me respondeu: o quarto animal é um quarto reino terrestre, diferente de todos os demais, que devorará, calcará e aniquilará o mundo.
24 “ ‘Di ten horns mean di ten kings wey go kom from dat kingdom. Anoda king go kom afta dem, but e go dey difren from all di former kings. E go ova-trow three kings.
24 Os dez chifres indicam dez reis levantando-se nesse reino. Mas depois deles surgirá outro, diferente, que destronará três.
25 E go tok against God kon opress anybody wey dey serve God. E go try to shange laws, festivals and di pipol wey dey serve God, go dey under am for three and half years.
25 Proferirá insultos contra o Altíssimo, e formará o projeto de mudar os tempos e a lei; e os santos serão entregues ao seu poder durante um tempo, tempos e metade de um tempo.
26 “ ‘But di kourt for heaven go sidan judge am kon take en pawa komot for en hand, den dem go distroy am finish.
26 Mas realizar-se-á o julgamento e lhe será arrancado seu domínio, para destruí-lo e suprimi-lo definitivamente.
27 Di pawa and great tins wey di world get, God kom gi-am to pipol wey dey serve am. Dia royal pawa nor go ever end and rulers go serve and respet dem.’
27 A realeza, o império e a suserania de todos os reinos situados sob os céus serão devolvidos ao povo dos santos do Altíssimo, cujo reino é eterno e a quem todas as soberanias renderão seu tributo de obediência.
28 “Na like dis di matter take end. But for mi, Daniel, my mind kon dey disturb mi well-well and I kon kover my face bikos I dey fear. But I still keep evritin to mysef.”
28 Aqui terminou o discurso {a mim dirigido}. Quanto a mim, Daniel, meus pensamentos transtornaram-me a ponto de me mudar de cor. Mas conservei tudo isso em meu coração.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Daniel 7, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.