Daniel 5
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NVT
1 King Belshazzar do party for en royal men wey rish 1,000 and e kon drink wine togeda with dem.
1 Muitos anos depois, o rei Belsazar deu um grande banquete para mil de seus nobres e bebeu vinho com eles.
2 As dem dey drink, King Belshazzar orda sey make dem bring all di gold, silva and bowl wey en papa Nebukadnezzar karry kom from God temple for Jerusalem. Di king sey make dem bring dem kom, so dat en, en ofisas, en wife and girl-friends go use dem drink wine.
2 Enquanto Belsazar tomava vinho, ordenou que trouxessem as taças de ouro e prata que seu antecessor, Nabucodonosor, havia tirado do templo em Jerusalém. Queria beber nessas taças com seus nobres, suas esposas e suas concubinas.
3 So, dem bring di gold cup and di bowl kom and dem use am take drink wine
3 Então trouxeram as taças de ouro do templo, a casa de Deus em Jerusalém, e o rei e seus nobres, suas esposas e concubinas beberam nelas.
4 kon dey praiz dia god wey dem make with gold, silva, bronze, iron, wood and stone.
4 Enquanto tomavam o vinho, louvavam seus ídolos feitos de ouro, prata, bronze, ferro, madeira e pedra.
5 At wons, one finger appear kon dey rite for di palis wall near where di lamp for dey shine well-well and di king si di hand wey dey rite for di wall.
5 De repente, viram dedos de mão humana escreverem no reboco da parede do palácio real, perto do candelabro. O próprio rei viu a mão enquanto ela escrevia,
6 Bikos e dey fear, en face kon dey red and all en body kon dey shake.
6 e seu rosto ficou pálido de medo. Seus joelhos batiam um contra o outro, e suas pernas vacilavam.
7 Di king kon sey make dem go koll all di wise men, pipol wey dey si vishon and majishan kom. Den e tell dem, “If anybody fit read wetin dem rite for di wall kon tok wetin e mean, dem go wear am purpol royal garment kon gi-am gold shain wey get honor, den e go bi di nomba three pesin wey get pawa pass for dis kingdom.”
7 Aos gritos, o rei mandou chamar os encantadores, os astrólogos e os adivinhos. Disse aos sábios da Babilônia: “Quem conseguir ler esta inscrição e me disser o que ela significa será vestido com um manto vermelho, e em seu pescoço será colocada uma corrente de ouro. Ele se tornará o terceiro em importância em meu reino!”.
8 So di wise men kom, but dem nor fit read wetin dem rite or tell di king wetin e mean.
8 Quando todos os sábios do rei chegaram, nenhum deles foi capaz de ler a inscrição nem de dizer o que ela significava.
9 Dat time, King Belshazzar kon dey fear well-well and shake anyhow, but en royal men nor even know wetin dem go do.
9 O rei ficou muito assustado, e seu rosto, ainda mais pálido. Seus nobres também ficaram abalados.
10 Bikos of di many nois wey dem dey make, di king mama enter di hall kon sey, “My king, yu go live forever! Abeg nor let dis tin shake yor mind and make yu nor fear!
10 A rainha-mãe soube do que estava acontecendo ao rei e seus nobres e foi depressa à sala de banquetes. Disse ela a Belsazar: “Que o rei viva para sempre! Não fique tão pálido e assustado.
11 E get one man for dis yor kingdom wey get di holy gods spirit inside am. Di time wey yor papa, Nebukadnezzar bi king, naim dey kommand all di wise men for Babilon.
11 Há em seu reino um homem que tem nele o espírito dos santos deuses. Durante o reinado de Nabucodonosor, esse homem demonstrou percepção, entendimento e sabedoria como a dos deuses. Seu antecessor, o rei Nabucodonosor, o nomeou chefe de todos os magos, encantadores, astrólogos e adivinhos da Babilônia.
12 E get one kind pawa with knowledge and wisdom. E dey solve problem wey pesin nor know. E go tell yu wetin dream or vishon mean; so make yu send for dis man, dem dey koll am Daniel wey di king shange en name to Belteshazzar and e go tell yu wetin di writing mean.”
12 Esse homem, Daniel, a quem o rei deu o nome de Beltessazar, tem inteligência extraordinária e é cheio de conhecimento e entendimento. É capaz de interpretar sonhos, explicar enigmas e resolver problemas difíceis. Mande chamar Daniel, e ele lhe dirá o que significa a inscrição”.
13 So dem bring Daniel kom meet di king. Den di king ask am, “Na yu bi di Daniel wey my papa bring kom from Judah?
13 Daniel foi levado à presença do rei, que lhe perguntou: “Você é Daniel, um dos exilados trazidos de Judá por meu antecessor, o rei Nabucodonosor?
14 I don hear about yu; how di holy gods spirit dey inside yu and yor knowledge, wisdom and undastandin.
14 Soube que o espírito dos deuses está em você, e que é cheio de percepção, entendimento e sabedoria.
15 Si, dem bring di wise men and majishan kom here make dem read wetin dey di wall kon tell mi wetin e mean, but dem nor fit read am tok-less of to know di meaning.
15 Meus sábios e encantadores tentaram ler as palavras na parede e me dizer o que significam, mas não conseguiram.
16 Naw, I don hear sey yu dey fit tok meaning and esplain wetin pesin nor undastand. If yu fit read dis writing kon tell mi wetin e mean, yu go wear royal purpol; dem go put gold shain for yor neck and na yu go bi nomba three man for dis kingdom.”
16 Soube que você é capaz de interpretar e resolver problemas difíceis. Se conseguir ler as palavras e disser o que significam, será vestido com um manto vermelho, e em seu pescoço será colocada uma corrente de ouro. Você se tornará o terceiro em importância em meu reino”.
17 But Daniel ansa, “My king! Make yu keep yor gifts kon honor anoda pesin. But I go read wetin dey di wall kon tell yu wetin e mean.
17 Daniel respondeu ao rei: “Guarde seus presentes ou entregue-os a outra pessoa; mas eu lhe direi o que significa a inscrição.
18 Di Most High God make yor papa Nebukadnezzar get kingdom wey strong well-well and E give yor papa respet, honor and majesty.
18 Ó rei, o Deus Altíssimo deu soberania, majestade, glória e honra a seu antecessor, Nabucodonosor.
19 Yor papa great well-well, sotey all di pipol, nashon and language dey shake and fear am. E dey kill who e won kill kon honor who e like honor or disgrace who e won disgrace.
19 Ele o engrandeceu de tal modo que povos de todas as raças, nações e línguas estremeciam de medo diante dele. Matava quem ele queria matar e poupava quem ele queria poupar; honrava quem ele queria honrar e humilhava quem ele queria humilhar.
20 But e kom dey karry body up, dey sturbon and pride kon full en spirit, so God remove am from en throne and e kom lost en respet.
20 Quando, porém, seu coração e sua mente se encheram de arrogância, ele foi tirado de seu trono e despojado de sua glória.
21 Dem porshu am komot for where human being dey. En mind kom bi like animal own and e kon dey follow wiked donkeys dey stay. E dey chop grass like sey e bi melu kon dey sleep for bush and e nor get anytin to take kover en body from dew wey dey fall. Na so e bi until e kom bilive sey na God dey rule ova human being and dey give leadership to anybody wey E like.
21 Foi expulso do convívio humano. Sua mente se tornou como a de um animal, e ele viveu entre os jumentos selvagens. Passou a comer capim, como os bois, e foi molhado pelo orvalho do céu, até entender que o Deus Altíssimo domina sobre todos os reinos do mundo e nomeia quem ele quer para governar sobre eles.
22 “But yu, Belshazzar wey bi Nebukadnezzar pikin, neva gri respet God, even doh sey yu know all dis tins wey happen.
22 “Ó Belsazar, o senhor é sucessor dele e sabia de tudo isso, mas mesmo assim não se humilhou.
23 Instead, yu dey against God wey get heaven and eart. Yu bring all di tins from di temple, den yu and yor men, plus yor wife and yor girl-friends kon use dem dey drink wine. Yu dey praiz di gods wey dem make with gold, silva, bronze, iron, wood and stone; gods wey nor even fit si, hear or undastand! But yu neva ever praiz God wey dey kontrol yor life and ways!
23 Desafiou o Senhor dos céus e mandou trazer essas taças do templo. O rei, seus nobres, suas esposas e suas concubinas beberam vinho dessas taças enquanto louvavam deuses de prata, ouro, bronze, ferro, madeira e pedra, deuses que não veem, não ouvem, nem sabem coisa alguma. Mas o rei não honrou ao Deus que lhe dá fôlego de vida e controla seu destino.
24 Na dis make God send di hand kom rite all dis words for di wall.
24 Por isso Deus enviou a mão que escreveu a mensagem.
25 “Dis na wetin di hand rite: MENE, MENE, TEKEL and FARSIN (E mean, NOMBA, NOMBA, WEIGH, DIVISION).
25 “Esta é a mensagem que foi escrita: Mene, Mene, Tequel e Parsim.
26 And dis na wetin e mean: mene (nomba) mean sey: ‘God don nomba di days wey yu go rule and E go end am.’
26 E este é o significado das palavras:
27 Tekel (weigh) mean sey: ‘God don weigh yu for skale kon si sey yu dey lite.’
27 Tequel : Você foi pesado na balança e não atingiu o peso necessário.
28 Farsin (division) mean sey: ‘Dem go divide yor kingdom give Mede and Persia pipol.’ ”
28 Parsim : Seu reino será dividido e entregue aos medos e aos persas”.
29 Just as di king tok, dem kon wear royal purpol klot give Daniel; put gold shain for en neck kon make am di nomba three man for Babilon.
29 Então, por ordem de Belsazar, vestiram Daniel com um manto vermelho, colocaram em seu pescoço uma corrente de ouro e o declararam o terceiro em importância no reino.
30 So for dat nite, dem kon kill Belshazzar wey bi Babilon king.
30 Naquela mesma noite, Belsazar, rei da Babilônia, foi morto.
31 Darius wey bi Media pipol king kon take-ova di kingdom and dat time, e bi sixty-two years.
31 E Dario, o medo, tinha 62 anos quando se apoderou do reino.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Daniel 5, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.