Daniel 4
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs VC
1 King Nebukadnezzar send message go meet all di pipol for Babilon sey: “Make e betta for una!
1 Do rei Nabucodonosor a todos os povos, nações e pessoas de todas as línguas que habitam a terra, felicidade e prosperidade!
2 I dey happy to tell una di many signs and wonders wey God Almighty don do for mi.
2 Pareceu-me bom fazer-vos conhecer os milagres e prodígios que o Deus Altíssimo operou em mim.
3 “Di sign dem wey E show us dey great well-well!
3 Oh! como são grandes seus milagres e como são poderosos seus prodígios! Seu reinado é um reinado eterno, e sua dominação perdura de geração em geração.
4 Mi wey bi Nebukadnezzar dey live for peace for my palis, I dey enjoy betta tins.
4 Eu, Nabucodonosor, vivia tranqüilo em minha casa e próspero em meu palácio.
5 But I dream one bad dream wey make mi fear. Wetin I dey tink as I sleep for my bed and di vishon for my mind really make mi fear well-well.
5 Tive um sonho que me assustou; os pensamentos que perpassavam pelo meu espírito quando no meu leito, bem como minhas visões, perturbaram-me.
6 So I orda make dem koll all di wise men for Babilon, so dat dem go tell mi wetin di dream mean.
6 Dei ordem para que fizessem vir à minha presença todos os sábios de Babilônia, a fim de que me dessem a interpretação de meu sonho.
7 Wen di majishan, pipol wey dey si vishon, wise men and odas kom, I kon tell dem di dream, but nobody among dem fit tell mi wetin e mean.
7 Então acudiram os magos, os mágicos, os caldeus e os astrólogos, aos quais contei esse sonho, sem que eles todavia pudessem indicar-me o sentido.
8 Afta, Daniel (wey en name na Belteshazzar wey bi my god name and di holy gods spirit dey with) kon enter. So I tell am my dream sey:
8 Finalmente apresentou-se diante de mim Daniel, cognominado Baltazar, segundo o nome de meu deus, e em quem reside o espírito dos deuses santos. Narrei-lhe o sonho:
9 “Belteshazzar, na yu bi di majishan dem oga; I know sey di gods spirit dey inside yu and e nor get any dream or vishon wey yu nor know en meaning. I go tell yu my dream and yu go tell mi wetin e mean!
9 Baltazar, disse-lhe, chefe dos magos, sei que reside em ti o espírito dos deuses santos e que nenhum mistério te confunde. Dize-me então as visões que tive em sonho; dá-me a explicação.
10 Dis na di dream wey I dream: Wen I dey sleep for nite, I si one tree wey dey di land centre.
10 Tais eram as visões do meu espírito, quando no meu leito: eu via, no meio da região, uma árvore de alto porte.
11 “E tall rish di sky and yu go si am for anywhere wey yu dey for dis world.
11 Esta árvore cresceu, era vigorosa. O cimo tocava o céu, era avistada até nos confins da terra.
12 Di tree leaf fine well-well and fruits wey go beleful evribody, full am. Wild animals dey stay under am and birds dey stay for en branches dem. Evritin wey God kreate, dey chop from am.
12 Sua folhagem era bela, e seus abundantes frutos forneciam a todos o que comer. À sua sombra abrigavam-se os animais terrestres, nos seus ramos permaneciam os pássaros do céu e toda criatura tirava dela seu sustento!
13 Wen I still dey tink about dis dream, I kon si one angel dey kom down from heaven.
13 Nas visões de meu espírito, quando no meu leito, vi {também} um santo vigilante que descia do céu,
14 E shaut kon sey, ‘Make una kut di tree kon distroy en branches; remove en leaf and skata en fruits. Make una drive di animal komot from under am and di birds wey dey en branches!
14 e começou a gritar com voz possante; derrubai a árvore, desgalhai-a; fazei cair as folhas e dispersai seus frutos. Que os animais fujam de debaixo dela, que os pássaros abandonem seus ramos.
15 But leave di body for groun kon kover am with iron and bronze. Leave am for der with di grass; make dew wet am and make e stay with di animals and grass.
15 Entretanto, deixai permanecer na terra o tronco e as raízes, mas atados por correntes de ferro e de bronze. Que seja molhado pelo orvalho do céu e tenha seu quinhão de erva com os animais terrestres.
16 Make e stop to tink like human being. Make dem gi-am animal mind and e go dey like dat for seven years.
16 Que se mude seu espírito; que em lugar de um espírito humano lhe seja dado um espírito animal e sete tempos passem sobre ele!
17 Dis na di decision wey di angel make. So, make evribody wey dey di world know sey di Most High God get pawa ova evry kingdom and E dey gi-am to anybody wey E choose! Even to di pipol wey small pass!’
17 Esta sentença é um decreto dos vigilantes, esta resolução é uma ordem dos santos, a fim de que os vivos saibam que o Altíssimo domina sobre a realeza humana, e a confere a quem lhe apraz e pode a ela elevar o mais abjeto dos mortais.
18 “Dis na di dream wey mi, King Nebukadnezzar dream. So Belteshazzar, make yu tell mi wetin di dream mean, bikos nobody among di wise men fit tell mi wetin e mean apart from yu, bikos di holy gods spirit dey inside yu.”
18 Eis o sonho que tive, eu, o rei Nabucodonosor. Portanto tu, Baltazar, dá-me a interpretação dele, porque nenhum dos sábios de meu reino foi capaz de fazê-lo. Tu o podes, porque em ti habita o espírito dos deuses santos.
19 Den Daniel (wey en name na Belteshazzar) kon dey worry sotey e nor fit tok anytin. Di king kon tell am, “Belteshazzar, make yu nor let dis dream and en meaning worry yor mind.” Daniel ansa, “My king, e for betta sey dis dream na for yor enemy and wetin e mean, na for di pipol wey dey trobol yu!
19 Então Daniel {cognominado Baltazar} permaneceu alguns instantes perdido no tumulto de seus pensamentos, e o rei prosseguiu: Baltazar, este sonho e sua significação não devem perturbar-te! Meu senhor, replicou Daniel, possa o sonho ser para teus inimigos, e sua significação para teus adversários!
20 Di tree wey yu si, wey grow big and strong rish heaven, wey dem fit si from any part for di world.
20 A árvore que viste crescer e tornar-se bela, cujo cimo tocava o céu e era avistada dos confins da terra,
21 Tree wey get fine leaf and fruit wey go beleful evribody wey dey di world and where wild animals and birds dey stay,
21 esta árvore de bela folhagem, de frutos abundantes que a todos dava o que comer, sob a qual viviam os animais terrestres, e em cujos ramos abrigavam-se os pássaros do céu,
22 na yu, my king! Yu don dey big and strong; yu don big sotey yu dey rish di heaven and yor pawa rish di end for di world.
22 esta árvore, és tu senhor, que te tornaste grande e poderoso, cuja altura crescente atingiu os astros, cuja dominação estende-se até os confins da terra.
23 For di dream, yu si angel kom out from heaven kon sey, ‘Make una kut and distroy di tree, but make una leave di body for groun. Make una kover am with iron and bronze. Make una leave am for der with di grass, so dat dew wey dey fall from di sky go wet am, den make e stay with animals for bush.’ ”
23 Por outro lado, o rei viu um santo vigilante descer do céu e exclamar: derrubai a árvore, desgalhai-a; mas deixai na terra o tronco e as raízes, se bem que atadas por correntes de ferro e de bronze no meio da erva do campo. Que seja molhado pelo orvalho do céu e viva com os animais terrestres até que sete tempos hajam passado sobre ele. Eis o que isto significa:
24 Dis na wetin e mean, “My king! Na wetin di Most High God tok, dey happen so.
24 trata-se aí, ó rei, de um decreto do Altíssimo concernente ao rei, meu senhor:
25 Dem go drive yu komot from where human being dey stay and yu go stay with animals. Na seven years yu go take chop grass like melu and yu go sleep for open field where dew go fall for yor body, until yu go know sey na di Most High God get pawa ova evry kingdom and E dey gi-am to anybody wey E like.
25 Expulsar-te-ão de entre os homens para te fazer habitar com os animais do campo; pastarás ervas como os bois e serás molhado pelo orvalho do céu. Sete tempos passarão sobre ti, até que reconheças o domínio do Altíssimo sobre a realeza humana o qual a confere a quem lhe apraz.
26 Wen dem sey make dem leave di tree body for groun, e mean sey dem go give yu back yor kingdom wen yu don know sey na God bi Oga of all ogas for dis world.
26 Se foi ordenado deixar intatos o tronco da árvore e suas raízes, é que tua realeza te será restituída logo que reconheças a soberania do céu.
27 So, my king! Make yu follow my advise. Make yu turn from sin kom meet God; dey do good and sorry for poor pipol. Den yu go kontinue to prosper.”
27 Queiras então, ó rei, aceitar meu conselho: resgata teu pecado pela justiça, e tuas iniqüidades pela piedade para com os infelizes; talvez com isso haja um prolongamento de tua prosperidade.
28 So, all dis tins happen to King Nebukadnezzar.
28 Tudo isso aconteceu ao rei Nabucodonosor.
29 Afta twelf monts, as e dey waka for di roof for en palis for Babilon.
29 Doze meses mais tarde, o rei, passeando {nos terraços} do palácio real,
30 E kon sey: “Dis nor bi di great Babilon wey bi di royal town wey I build by mysef to show my pawa, strent, glory and honor?”
30 fazia esta reflexão: eis aí verdadeiramente a grande Babilônia, que construí para fazer dela uma mansão real por meu poder soberano, e para servir à glória de minha majestade!
31 As e still dey tok, one vois kom from heaven kon sey: “King Nebukadnezzar, make yu hear wetin I dey tok, God don komot yor kingdom from yor hand!
31 Falava ainda, quando uma voz baixou do céu: anunciam a ti, rei Nabucodonosor, que teu reino te foi arrebatado.
32 Dem go drive yu komot from where human being dey and yu go stay with animals. Na seven years yu go take chop grass like melu kon sleep for open field where dew go fall for yor body, until yu go know sey na di Most High God get pawa ova evry kingdom and E dey gi-am to anybody wey E like.”
32 Vão expulsar-te dentre os homens para te fazer viver entre os animais dos campos; pastarás ervas como os bois. Sete tempos passarão sobre ti, até que reconheças que o Altíssimo domina sobre a realeza humana e que a confere a quem lhe apraz.
33 So, di word wey God tok about Nebukadnezzar kon happen. Dem drive am komot from where human being dey and e kon go stay with animals. E chop grass like melu for seven years and dew fall for en body, until en hair kon long like eagle feada and en finger long like bird own.
33 No mesmo momento, o oráculo pronunciado sobre Nabucodonosor cumpriu-se; ele foi expulso dentre os homens e pastou ervas como os bois; seu corpo foi molhado pelo orvalho do céu. Seu pêlo cresceu como penas de águia e suas unhas, como unhas de pássaro.
34 But wen di seven years don pass, mi, Nebukadnezzar kon look heaven and my sense kom back to mi.
34 Ao terminar os dias marcados, eu, Nabucodonosor, levantei os olhos para o céu. A razão voltou-me e eu bendisse o Altíssimo; louvei e glorifiquei aquele que vive eternamente, cuja dominação é perpétua, cujo reino subsiste de idade em idade.
35 Yu nor fit kompare God
35 Diante dele nenhum habitante da terra tem importância; age como quer tanto em se tratando do exército celestial quanto em relação aos habitantes terrenos. Ninguém pode bater-lhe na mão e perguntar-lhe: Que fazeis aí?
36 Wen my mind don kom back to mi, dem kon give mi back my kingdom, pawa and glory. My ministers and royal men welkom mi back and dem give mi my royal pawa and di honor wey I kom get, big pass di first one.
36 Nesse mesmo instante a razão me foi restituída, com o brilho de minha realeza, minha majestade e meu esplendor. Meus conselheiros e meus nobres vieram procurar-me; fui reintegrado à frente do meu reino e meu poder achou-se aumentado.
37 Naw, mi Nebukadnezzar praiz, woship and hail di King wey dey heaven. Evritin wey E dey do dey rite and en ways dey pure. Pipol wey dey karry body up, E dey bring dem down.
37 Agora, eu, Nabucodonosor, louvo, exalto e glorifico o rei do céu, cujas obras são todas justas e cujos caminhos são retos, e que tem o poder de humilhar aqueles que procedem com orgulho.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Daniel 4, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.