Daniel 2
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NVT
1 For di sekond year wen Nebukadnezzar dey rule, e kon dream many dreams. Di dreams dey disturb en mind and e nor fit sleep,
1 Certa noite, no segundo ano de seu reinado, Nabucodonosor teve sonhos tão perturbadores que não conseguiu mais dormir.
2 so di king kon sey make dem koll all di majishan; doz wey dey si vishon and di wise men, so dat dem go tell am wetin en dream mean. Wen dem kom, dem kon tell di king make e tell dem di dream.
2 Chamou seus magos, encantadores, feiticeiros e astrólogos e exigiu que lhe dissessem o que ele havia sonhado. Quando se apresentaram ao rei,
3 But di king sey, “I nor fit remember wetin I dream and I nor know wetin di dream mean.”
3 ele disse: “Tive um sonho que muito me perturbou e preciso saber o que significa”.
4 Di wise men kon tell di king for Aramaik language sey: “Awa king, make yu live forever! Make yu tell yor savants di kind dream wey yu dream and wi go tell yu wetin e mean.”
4 Então os astrólogos responderam ao rei em aramaico: “Que o rei viva para sempre! Conte-nos o sonho e nós lhe diremos o que ele significa”.
5 Di king ansa di wise men, “I don tok for my mind sey una go tell mi my dream and wetin e mean. But if una nor fit tell mi di dream and wetin e mean, den I go make sure sey dem kut una to pieces kon skata una house!
5 O rei, porém, disse aos astrólogos: “Estou falando sério! Se não me disserem qual foi o sonho e o que ele significa, vocês serão despedaçados, e suas casas, transformadas em montes de escombros!
6 But if una fit tell mi di dream and wetin e mean, I go give una gifts. I go reward and honor una. So make una tell mi di dream and wetin e mean.”
6 Mas, se me disserem qual foi o sonho e o que ele significa, lhes darei muitos presentes, muitas recompensas e honras. Portanto, digam-me qual foi o sonho e o que ele significa!”.
7 Dem tell di king again, “Abeg! Make yu tell us yor dream and wi go tell yu wetin e mean.”
7 Eles disseram novamente: “Ó rei, conte-nos o sonho e então lhe diremos o que ele significa”.
8 Di king ansa, “I know sey una dey try to waste time, bikos una si sey I don tok wetin I go do.
8 O rei respondeu: “Sei o que estão fazendo! Estão tentando ganhar tempo, pois sabem que falo sério quando digo:
9 If una nor tell mi di dream naw, na only one tin go happen to una. Una dey plan to lie give mi, bikos una bilive sey I fit shange my mind leta. So make una tell mi di dream and I go know sey una fit tell mi wetin e mean.”
9 ‘Se não me contarem qual foi o sonho, estão condenados!’. Por isso, conspiraram para me dizer mentiras, na esperança de que mudarei de ideia. Digam-me, porém, qual foi o sonho e então saberei que podem explicar o que ele significa”.
10 Di wise men tell di king, “Nobody for dis world fit tell di king wetin e dream and know king don ever do dis kind tin to majishan, wise men or pipol wey dey si vishon.
10 Os astrólogos responderam ao rei: “Não há ninguém, em toda terra, capaz de dizer ao rei qual foi seu sonho! E nenhum rei, por maior e mais poderoso que fosse, pediu algo assim a um mago, encantador ou astrólogo!
11 Wetin di king dey ask for, nor dey eazy. Nobody for dis world fit tok di king dream escept di gods, but gods nor dey stay with human being!”
11 É impossível cumprir a exigência do rei. Ninguém, exceto os deuses, pode dizer qual foi seu sonho, e os deuses não vivem entre os mortais”.
12 Bikos wetin dem tok make di king vex, e kon sey make dem kill and distroy all di wise men wey dey for Babilon.
12 O rei ficou furioso e ordenou que todos os sábios da Babilônia fossem executados.
13 So dem make law to kill all di wise men and Daniel and en friends dey join doz wey dem won kill so.
13 E, por causa do decreto do rei, foram enviados homens para encontrar Daniel e seus amigos e matá-los.
14 Den, Daniel go meet Ariok wey dey kommand di king bodyguard and na-im won kill dem. So e tok to am with wisdom.
14 Quando Arioque, comandante da guarda do rei, veio matá-los, Daniel se dirigiu a ele com sabedoria e prudência.
15 E ask am, “Wetin make di king take dis kind wiked decision?” Den Ariok tell Daniel wetin happen.
15 Perguntou-lhe: “Por que o rei publicou um decreto tão severo?”, e Arioque lhe contou o que havia acontecido.
16 Den Daniel go tell di king sey make e gi-am time and e go tell di king di dream and en meaning.
16 Daniel foi ver o rei de imediato e pediu mais tempo para comunicar o significado do sonho.
17 Daniel go house go tell e friends, Hananaya, Mishael and Azaraya wetin dey happen.
17 Em seguida, Daniel voltou para casa e contou a seus amigos Hananias, Misael e Azarias o que havia acontecido.
18 E kon ask dem to pray to God wey dey heaven make E for sorry for dem kon show dem di dream and en meaning, so dat en and en friends nor go die with di oda-wise men for Babilon.
18 Pediu que suplicassem ao Deus dos céus que tivesse misericórdia deles e lhes revelasse o segredo, para que não fossem mortos com os outros sábios da Babilônia.
19 For nite, God show and tell Daniel evritin thru dream. Den Daniel praiz God wey dey heaven
19 Naquela noite, o segredo foi revelado a Daniel numa visão. Então Daniel louvou o Deus dos céus
20 kon sey,
20 e disse: “Louvado seja o nome de Deus para todo o sempre, pois a ele pertencem a sabedoria e o poder.
21 Na-im dey shange time and sizin;
21 Ele muda o curso dos acontecimentos; remove reis de seus tronos e põe outros no lugar. Dá sabedoria aos sábios e conhecimento aos eruditos.
22 All di sekret tins wey dem hide,
22 Revela coisas profundas e misteriosas e sabe o que está escondido nas trevas, embora ele seja cercado de luz.
23 I praiz and honor Yu,
23 Eu te agradeço e te louvo, ó Deus de meus antepassados, pois me deste sabedoria e força. Tu me mostraste o que te pedimos; revelaste o que o rei exigiu”.
24 So Daniel go si Ariok (wey di king don tell make e kill di wise men for Babilon). E kon tell am, “Make yu nor kill di wise men for Babilon! Just take mi go meet di king and I go tell am en dream and wetin e mean!”
24 Então Daniel foi falar com Arioque, a quem o rei havia ordenado que executasse os sábios da Babilônia. “Não mate os sábios”, disse. “Leve-me ao rei e eu interpretarei o sonho dele.”
25 So Ariok kwik-kwik take Daniel go meet di king kon sey, “I don si one man wey wi karry kom from Judah, e go tell yu yor dream and wetin e mean.”
25 Sem demora, Arioque levou Daniel ao rei e disse: “Encontrei um dos exilados de Judá que dirá ao rei o significado do sonho!”.
26 Den di king kon ask Daniel (wey en name na Belteshazzar), “Yu go fit tell mi di dream wey I dream and wetin e mean?”
26 O rei disse a Daniel (também chamado Beltessazar): “Você pode mesmo me dizer qual foi meu sonho e o que ele significa?”.
27 Daniel ansa, “Di dream wey di king dream so, na dat kind dream wey wise men, pesin wey dey si vishon and majishan, nor go fit tok.
27 Daniel respondeu: “Não existem sábios, encantadores, magos nem adivinhos capazes de revelar o segredo do rei.
28 But, e get one God wey dey for heaven wey dey open sekret and tell dreams. E don tell King Nebukadnezzar wetin go happen for future. Dis na di dream and vishon wey yu si:
28 Mas há um Deus nos céus que revela segredos, e ele mostrou ao rei Nabucodonosor o que acontecerá no futuro. Agora lhe direi qual foi o sonho e as visões que o rei teve enquanto estava deitado em sua cama.
29 “As yu dey sleep for yor bed, yu kom dey tink of di future. God wey dey show pipol dream, don show yu wetin go happen.
29 “Enquanto o rei dormia, sonhou com acontecimentos futuros. Aquele que revela segredos lhe mostrou o que acontecerá.
30 Naw, God tell mi dis dream nor bi bikos na mi wise pass, but na to make yu my king, undastand wetin yu dey tink for yor mind.
30 E eu sei o segredo de seu sonho não porque sou mais sábio que os outros, mas porque Deus deseja que o rei entenda o que se passava em seu coração.
31 “My king, for yor vishon, yu si one big image wey stand for yor front! E dey shine well-well and fear nor let yu look am.
31 “Em sua visão, ó rei, havia à sua frente uma enorme estátua brilhante, e a aparência dela era assustadora.
32 Na gold dem take make di image head; en chest and hand na silva, while from en belle go down, na bronze.
32 A cabeça da estátua era feita de ouro puro. O peito e os braços eram de prata, a barriga e os quadris eram de bronze,
33 En leg na iron, but en toe na both iron and san-san.
33 as pernas eram de ferro, e os pés, uma mistura de ferro e barro cozido.
34 As yu dey look, one hand wey nor bi human being own kon kut one stone. Di stone fall on-top di image iron leg and di image kon skata to pieces.
34 Enquanto o rei observava, uma pedra foi cortada de uma montanha, mas não por mãos humanas. Ela atingiu os pés de ferro e barro e os despedaçou.
35 Den all di iron, gold, silva and bronze kon bi like san-san for dry sizin. Breeze blow kon karry all of dem go and dem nor si dem again. But di stone wey skata di image, grow turn to mountin kon kover di eart.
35 Toda a estátua se desintegrou em minúsculos pedaços de ferro, barro, bronze, prata e ouro. Então o vento levou tudo, como se fosse palha na eira. Mas a pedra que derrubou a estátua se tornou uma grande montanha que cobriu toda a terra.
36 Dis na di dream. Naw I go tell my king wetin e mean:
36 “Esse foi o sonho. Agora, direi ao rei o que ele significa.
37 “My king, yu get pawa pass any oda king. God wey dey for heaven don make yu leader kon give yu pawa, strent and honor.
37 Ó rei, o senhor é o maior de todos os reis. O Deus dos céus lhe deu soberania, poder, força e honra.
38 E don make yu ruler ova human being, animals and birds for dis eart. Na yu bi di head among all gold.
38 Ele o fez governante de todo o mundo habitado e pôs até os animais selvagens e as aves debaixo de seu controle. O senhor é a cabeça de ouro.
39 But afta yu, anoda kingdom go kom, dem nor go get pawa rish yor own and afta dat one, di third kingdom wey bi bronze, wey go rule di whole eart, go kom.
39 “Quando, porém, seu reino chegar ao fim, outro reino, inferior ao seu, se levantará em seu lugar. Depois que esse reino tiver caído, o terceiro reino, representado pelo bronze, se levantará para governar o mundo.
40 Den, di nomba four kingdom go kom and e go strong like iron wey go skata evritin to pieces. E go skata and distroy all di kingdoms wey dey before.
40 Depois dele haverá o quarto reino, forte como o ferro. Esse reino esmagará e despedaçará todos os impérios anteriores, como o ferro esmaga e despedaça tudo que ele atinge.
41 Yorsef si di leg and di toe wey dem make with iron and san-san. Dis one mean kingdom wey divide into two. Some of en pawa go bi like iron, aldo dem mix di iron with san.
41 Os pés e os dedos que o rei viu, uma mistura de ferro e barro cozido, mostram que esse reino será dividido. Como ferro misturado com barro, ele terá um tanto da força do ferro.
42 Di toes wey dem make with iron and san mean sey, wen di kingdom don dey old, some part go strong and some part go weak.
42 Algumas partes serão fortes como o ferro, mas outras serão fracas como o barro.
43 Di san and iron wey mix togeda still dey show sey dis kingdom go try gada oda pipol join demsef thru marriage, so dat dem go dey strong, but dem nor go fit stay togeda just as iron and san nor fit mix.
43 A mistura de ferro e barro também mostra que esses reinos tentarão se fortalecer ao formar alianças entre si por meio de casamentos. Contudo, não permanecerão unidos, da mesma forma que o ferro não se une ao barro.
44 For di time wey dis kings go dey rule, God wey dey heaven go raiz one kind kingdom wey nor go ever end. Dem nor go fit distroy di kingdom and anoda pesin nor go rule am. E go distroy and skata all di oda kingdoms. But dis kingdom go stand forever.
44 “Enquanto esses reis estiverem no poder, o Deus dos céus estabelecerá um reino que jamais será destruído ou conquistado. Reduzirá os outros reinos a nada e permanecerá para sempre.
45 My king, yu si sey di stone kut komot from mountin, but nor bi human being hand kut am. E skata di iron, bronze, silva, klay and gold to pieces. God Almighty don show di king wetin go happen for future. I don tell yu yor dream and wetin e mean.”
45 Esse é o significado da pedra cortada da montanha, mas não por mãos humanas, que despedaçou a estátua de ferro, bronze, barro, prata e ouro. O grande Deus está mostrando ao rei o que acontecerá no futuro. O sonho é verdadeiro, e seu significado é certo”.
46 Den King Nebukadnezzar bow face groun kon sey make dem sakrifice and offa ofrin for Daniel.
46 Então o rei Nabucodonosor se curvou à frente dele e ordenou que o povo oferecesse sacrifícios e queimasse incenso diante de Daniel.
47 Di king sey, “Na yor God big pass among all gods! Na-im bi God of all kings and E dey show pipol wetin dey sekret and na-im make yu fit tok all dis tins so!”
47 O rei lhe disse: “Verdadeiramente, seu Deus é o maior de todos os deuses, Senhor dos reis e revelador de mistérios, pois você conseguiu revelar esse segredo”.
48 So di king give Daniel high post with many fine gifts. E gi-am pawa for evry aria for en kingdom kon make am leader ova all di wise men for Babilon.
48 O rei colocou Daniel em um cargo elevado e lhe deu muitos presentes valiosos. Nomeou-o governador de toda a província da Babilônia e chefe de todos os sábios.
49 Daniel beg di king make e promote Shadrak, Meshak and Abednego, so dat dem go dey handle some issues for Babilon. Daniel, ensef kon dey serve for di king palis.
49 A pedido de Daniel, nomeou Sadraque, Mesaque e Abede-Nego para cuidarem de todos os negócios da província da Babilônia, enquanto Daniel permaneceu na corte do rei.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Daniel 2, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.