Daniel 1

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs VC

Sair da comparação
VC Versão Católica
1 For di third year wey King Jehoiakim dey rule for Judah, King Nebukadnezzar for Babilon kon attack Jerusalem.
1 No terceiro ano do reinado de Joaquim, rei de Judá, Nabucodonosor, rei de Babilônia, veio sitiar Jerusalém.
2 God allow King Nebukadnezzar katch King Jehoiakim and e karry some of di tins wey dey God temple too. E karry Judah pipol as prisonas go Babilon and di tins wey e karry from Jerusalem, e put dem for en own juju temple.
2 O Senhor entregou-lhe Joaquim, rei de Judá, bem como parte dos objetos do templo, que Nabucodonosor transportou para a terra de Senaar, para o templo de seu deus: foi na sala do tesouro do templo de seu deus que ele os colocou.
3 Den di king kommand Ashpenaz wey dey guide di kourt sey make e choose some Israel men wey kom from royal house and from betta family:
3 O rei deu ordem ao chefe de seus eunucos, Asfenez, para trazer-lhe jovens israelitas, oriundos de raça real ou de família nobre,
4 yong men wey nor get any diziz for body; wey fine; wey dem don train and wey go fit learn kwik-kwik, so dat dem go dey serve and work for di king palis. E still sey make Ashpenaz tish dem di language and evritin for Babilon.
4 isentos de qualquer tara corporal, bem proporcionados, dotados de toda espécie de boas qualidades, instruídos, inteligentes, aptos a ingressarem {nos serviços do} palácio real; ser-lhes-ia ensinado a escrever e a falar a língua dos caldeus.
5 Di king still orda sey make dem give dem di same food and wine wey en and di oda pipol dey chop and drink evriday. E sey dem go train dem for three years and afta di three years, dem go kom serve di king.
5 O rei destinou-lhes uma provisão cotidiana, retirada das iguarias da mesa real e do vinho que ele bebia. A formação deles devia durar três anos, após o que entrariam a serviço do rei.
6 Di pipol wey dem choose from Judah na: Daniel, Hananaya, Mishael and Azaraya.
6 Entre eles encontravam-se alguns judeus: Daniel, Ananias, Misael e Azarias.
7 But di pesin wey bi guide di kourt kom shange dia names. E give Daniel, Belteshazzar; Hananaya kon bi Shadrak; Mishael kon bi Meshak and Azaraya kon bi Abednego.
7 O chefe dos eunucos deu-lhes outros nomes: a Daniel, o de Baltasar; a Ananias, o de Sidrac; a Misael, o de Misac; e a Azarias, o de Abdênago.
8 But Daniel kon decide sey e nor go chop di sweet food and wine wey dem dey serve for di king palis, bikos e nor won dey unklean. So e beg di pesin wey dey lead dem sey, en nor won chop di royal food or drink di wine.
8 Daniel tomou a resolução de não se contaminar com os alimentos do rei e com seu vinho. Pediu ao chefe dos eunucos para deles se abster.
9 So God kon make Ashpenaz mind soft and e gri with wetin Daniel tell am.
9 Este, graças a Deus, tomado de benevolência para com Daniel, atendeu-o de boa vontade,
10 So e tell Daniel, “I dey fear my masta di king. Na-im tok di kind food wey una go chop and wine wey una go drink; wot of if e sey yu dey tin and di oda yong men dey fat! Wetin I go tell am?
10 mas disse-lhe: Temo que o rei, meu senhor, que estabeleceu vossa alimentação e vossa bebida, venha a notar vossas fisionomias mais abatidas do que as dos outros jovens de vossa idade, e que por vossa causa eu me exponha a uma repreensão da parte do rei.
11 Den Daniel go meet di pesin wey Ashpenaz sey make e dey guide en, Hananaya, Mishael and Azaraya kon tell am:
11 Mas Daniel disse ao dispenseiro a quem o chefe dos eunucos havia confiado o cuidado de Daniel, Ananias, Misael e Azarias:
12 Abeg make yu test yor savants for ten days. Just give us vegitabol make wi chop and wota make wi dey drink.
12 Rogo-te, faze uma experiência de dez dias com teus servos: que só nos sejam dados legumes a comer e água a beber.
13 Afta di ten days, make yu kompare us with di odas wey dey chop and drink di king food and wota; den yu go judge us with wetin yu si.”
13 Depois então compararás nossos semblantes com os dos jovens que se alimentam com as iguarias da mesa real, e farás com teus servos segundo o que terás observado.
14 Di pesin wey dey guide dem so kon gri with wetin e tok and e test dem for ten days.
14 O dispenseiro concordou com essa proposta e os submeteu à prova durante dez dias.
15 Wen ten days don finish, dia body betta and dem get flesh pass di yong men wey dey chop and drink di royal food and wine.
15 No final deste prazo, averiguou-se que tinham melhor aparência e estavam mais gordos do que todos os jovens que comiam das iguarias da mesa real.
16 So di pesin wey dey guide dem kon remove di royal food and wine wey di king sey make dem chop, den dem kontinue to chop dia vegitabol and drink wota.
16 Em conseqüência disso o dispenseiro retirava os alimentos e o vinho que lhes eram destinados, e mandava servir-lhes legumes.
17 God kon give dis four men good sense; difren gift and wisdom. God give Daniel di gift to take tell pipol wetin vishon and dreams, mean.
17 A esses quatro jovens, Deus concedeu talento e saber no domínio das letras e das ciências. Daniel era particularmente entendido na interpretação de visões e sonhos.
18 Afta three years, Ashpenaz kon take all di yong men go meet King Nebukadnezzar.
18 Ao fim do prazo fixado pelo rei para a apresentação, o chefe dos eunucos introduziu-os na presença de Nabucodonosor,
19 Den di king follow dem tok. E nor si anybody wey bi like Daniel, Hananaya, Mishael and Azaraya. So dem kon bi memba for di king kourt.
19 o qual palestrou com eles. Entre todos os jovens nenhum houve que se comparasse a Daniel, Ananias, Misael e Azarias. Por isso entraram eles a serviço do rei.
20 Any matter wey koncern wisdom and knowledge wey di king ask dem, e dey si sey dia ansa betta well-well pass di ansa wey all di wise men, majik pipol and di pipol wey dey tok wetin go happen for future, dey give.
20 Em qualquer negócio que necessitasse de sabedoria e sutileza, e que o rei os consultasse, este achava-os dez vezes superiores a todos os escribas e mágicos do reino.
21 Daniel stay for di royal house until di first year wen King Cyrus start to rule.
21 {Assim} viveu Daniel até o primeiro ano do reinado de Ciro.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Daniel 1, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.