Daniel 10

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NVI

Sair da comparação
NVI Nova Versão Internacional
1 For di third year wen King Cyrus for Persia dey rule, God kon give Daniel (wey dem dey koll Belteshazzar) one message. Dis message na true, but e hard to undastand. Daniel undastand di message thru di vishon wey e si.
1 No terceiro ano de Ciro, rei da Pérsia, Daniel, chamado Beltessazar, recebeu uma revelação. A mensagem era verdadeira e falava de uma grande guerra. E numa visão veio-lhe o entendimento da mensagem.
2 Before dat time, mi, Daniel dey mourn for three weeks.
2 Naquela ocasião eu, Daniel, passei três semanas chorando.
3 I nor chop any good food, meat, drink wine or komb my hair until di three weeks komplete.
3 Não comi nada saboroso; carne e vinho nem provei; e não usei nenhuma fragrância perfumada, até se passarem as três semanas.
4 For di twenty fourt day for di first mont, I stand near di great river, wey dem dey koll Tigris.
4 No vigésimo quarto dia do primeiro mês, estava eu de pé junto à margem do grande rio, o Tigre.
5 I look up kon si one man wey wear linen klot: di belt for en waist na gold wey dem make from Ufaz.
5 Olhei para cima, e diante de mim estava um homem vestido de linho, com um cinto de ouro puríssimo na cintura.
6 En body bi like yellow jasper and en face dey shine like lite. En eye dey shine like tosh; en hand and leg bi like bronze wey dem polish. En vois alone bi like sey na many pipol dey tok.
6 Seu corpo era como o berilo, o rosto como o relâmpago, os olhos como tochas acesas, os braços e pernas como o reflexo do bronze polido, e a sua voz era como o som de uma multidão.
7 Na only mi, Daniel si di vishon. Di men wey follow mi nor si am. Dem run go hide, bikos dem dey fear.
7 Somente eu, Daniel, vi a visão; os que me acompanhavam nada viram, mas apoderou-se deles tanto pavor que eles fugiram e se esconderam.
8 Na only mi dey der wen I si dis great vishon. I nor get strent again and my face kon shange well-well and anybody wey si mi nor go know sey na mi.
8 Assim fiquei sozinho, olhando para aquela grande visão; fiquei sem forças, muito pálido, e quase desfaleci.
9 But I hear as e dey tok and wen I hear dis vois, I just fall face groun.
9 Então eu o ouvi falando, e, ao ouvi-lo, caí prostrado, rosto em terra, e perdi os sentidos.
10 Den one hand tosh and karry mi stand up well; but I still dey shake.
10 Em seguida, a mão de alguém tocou em mim e me pôs sobre as minhas mãos e os meus joelhos vacilantes.
11 Di angel kom tell mi, “Daniel! God love yu. Stand up make yu listin well-well to wetin I won tok naw, bikos na God send mi kom meet yu.” Wen e don tok finish, I kon stand up, even doh I still dey shake.
11 E ele disse: "Daniel, você é muito amado. Preste bem atenção ao que vou lhe falar; levante-se, pois eu fui enviado a você". Quando ele me disse isso, pus-me de pé, tremendo.
12 Di angel tell mi, “Daniel, make yu nor fear. Since di first day wen yu honbol yorsef kon dey pray for undastandin, naim God don ansa yor prayers. So I kom as ansa to all yor prayer.
12 E ele prosseguiu: "Não tenha medo, Daniel. Desde o primeiro dia em que você decidiu buscar entendimento e humilhar-se diante do seu Deus, suas palavras foram ouvidas, e eu vim em resposta a elas.
13 Di prince for Persia kingdom oppoz mi for twenty-one days. But Mikael, one strong angel for heaven kom help mi, bikos na only mi dey Persia.
13 Mas o príncipe do reino da Pérsia me resistiu vinte e um dias. Então Miguel, um dos príncipes supremos, veio em minha ajuda, pois eu fui impedido de prosseguir ali com os reis da Pérsia.
14 Naw, I don kom help yu undastand wetin go happen to yor pipol for di future, bikos dat na wetin di vishon dey tok-of.”
14 Agora vim explicar-lhe o que acontecerá ao seu povo no futuro, pois a visão se refere a uma época futura".
15 As di angel still dey tok to mi, I sleep for groun and I nor fit tok.
15 Enquanto ele me dizia isso, prostrei-me, rosto em terra, sem conseguir falar.
16 Den di angel wey bi like human being, appear kon tosh my lip. I open my mout kon start to tok. I tell am, “Oga God! Dis vishon don make mi weak and na-im make mi dey shake anyhow.
16 Então um ser que parecia homem tocou nos meus lábios, e eu abri a minha boca e comecei a falar. Eu disse àquele que estava de pé diante de mim: Estou angustiado por causa da visão, meu senhor, e quase desfaleço.
17 I bi like savant wey stand for en oga front. Naw, how I won take tok to yu? I nor get strent to even breath again.”
17 Como posso eu, teu servo, conversar contigo, meu senhor? Minhas forças se foram, e mal posso respirar.
18 Den di angel tosh mi again and my body kon strong.
18 O ser que parecia homem tocou em mim outra vez e me deu forças.
19 E sey, “Make yu nor fear, God love yu well-well! So nor let anytin worry yu. Make yu dey strong! Wen e don tok like dis, my body kon strong more-more.” Den I sey, “Oga! Yu don make mi dey okay naw.”
19 Ele disse: "Não tenha medo, você, que é muito amado. Que a paz seja com você! Seja forte! Seja forte! " Ditas essas palavras, senti-me fortalecido e disse: "Fala, meu senhor, visto que me deste forças".
20 Di angel sey, “Yu know wetin make mi kom meet yu? Naw, I won go fight Persia prince. Wen I don go, di angel wey dey guide Greece go kom.
20 Então ele me disse: "Você sabe por que vim? Vou ter que voltar para lutar contra o príncipe da Pérsia, e, logo que eu for, chegará o príncipe da Grécia;
21 “But I go first tell yu wetin dem rite for di book wey yu fit trust. (Nobody fit help mi against di prince, escept Mikael wey dey guide Israel.
21 mas antes lhe revelarei o que está escrito no Livro da Verdade. E nessa luta ninguém me ajuda contra eles, senão Miguel, o príncipe de vocês,

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Daniel 10, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.