Colossenses 2
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARA
1 Pipol for Laodicea and doz wey neva si mi face-to-face, I wont make una know how I dey work for una rish.
1 Gostaria, pois, que soubésseis quão grande luta venho mantendo por vós, pelos laodicenses e por quantos não me viram face a face;
2 Wetin I wont bi sey, wen una don really undastand God sekret wey dey inside Jesus Christ, make una heart dey strong with love, so dat una go get evritin wey una wont.
2 para que o coração deles seja confortado e vinculado juntamente em amor, e eles tenham toda a riqueza da forte convicção do entendimento, para compreenderem plenamente o mistério de Deus, Cristo,
3 Bikos all di wisdom and knowledge wey God get, E hide dem inside Christ.
3 em quem todos os tesouros da sabedoria e do conhecimento estão ocultos.
4 I dey tok all dis tins, so dat nobody go dey deceive una with argument.
4 Assim digo para que ninguém vos engane com raciocínios falazes.
5 And even if I nor dey der with una, my spirit dey der and I dey happy sey una mind nor dey shange and una faith for Christ, still strong well-well.
5 Pois, embora ausente quanto ao corpo, contudo, em espírito, estou convosco, alegrando-me e verificando a vossa boa ordem e a firmeza da vossa fé em Cristo.
6 So, just as una asept Jesus Christ as una Oga God, make una kontinue to live una life inside am.
6 Ora, como recebestes Cristo Jesus, o Senhor, assim andai nele,
7 Make una dey strong for groun and dey grow inside Christ, so dat una faith go strong as wi dey tish una and una go dey tank God well-well.
7 nele radicados, e edificados, e confirmados na fé, tal como fostes instruídos, crescendo em ações de graças.
8 Make una take kare and nor let anybody fool una with wayo tok about human being wisdom and spiritual pawas wey dey rule di world, but make una dey do as Christ wont.
8 Cuidado que ninguém vos venha a enredar com sua filosofia e vãs sutilezas, conforme a tradição dos homens, conforme os rudimentos do mundo e não segundo Cristo;
9 Bikos na Christ dey show us evritin about God.
9 porquanto, nele, habita, corporalmente, toda a plenitude da Divindade.
10 And una dey komplete inside am; bikos na-im bi di head for all di pawas wey dey for heaven and eart.
10 Também, nele, estais aperfeiçoados. Ele é o cabeça de todo principado e potestade.
11 Dem sekonsaiz una inside am. Dis nor bi human being sekonsishon, but na di spirit own wey Christ dey do.
11 Nele, também fostes circuncidados, não por intermédio de mãos, mas no despojamento do corpo da carne, que é a circuncisão de Cristo,
12 Bikos wen dem baptize una, dem beri una with am and una follow am raiz-up thru di faith wey God pawa dey give and na dis God raiz am up.
12 tendo sido sepultados, juntamente com ele, no batismo, no qual igualmente fostes ressuscitados mediante a fé no poder de Deus que o ressuscitou dentre os mortos.
13 Even doh una bin don die inside una sin bikos dem nor sekonsaiz una body, God kon make una dey alive with am, bikos E don forgive una sins.
13 E a vós outros, que estáveis mortos pelas vossas transgressões e pela incircuncisão da vossa carne, vos deu vida juntamente com ele, perdoando todos os nossos delitos;
14 E don distroy doz bad-bad tins wey una dey do and wetin dem rite about awa debt wey fit kill us, God remove am kon nail dem for di cross.
14 tendo cancelado o escrito de dívida, que era contra nós e que constava de ordenanças, o qual nos era prejudicial, removeu-o inteiramente, encravando-o na cruz;
15 God disgrace wiked and evil rulers for publik, wen E win dem for di cross.
15 e, despojando os principados e as potestades, publicamente os expôs ao desprezo, triunfando deles na cruz.
16 So make una nor let anybody take food, drink, party, new moon or Sabat Day matter, take judge una.
16 Ninguém, pois, vos julgue por causa de comida e bebida, ou dia de festa, ou lua nova, ou sábados,
17 Bikos all dis tins na shadow for di tins wey go kom, but di really tin, na Christ!
17 porque tudo isso tem sido sombra das coisas que haviam de vir; porém o corpo é de Cristo.
18 Make una nor let doz wey dey pritend and woship angels judge una. Dat kind pesin dey tok anyhow about vishon wey e sey e si, but na yeye tins and sin full en mind.
18 Ninguém se faça árbitro contra vós outros, pretextando humildade e culto dos anjos, baseando-se em visões, enfatuado, sem motivo algum, na sua mente carnal,
19 Dat pesin nor dey with Christ wey bi di head. Bikos na Christ join di whole body togeda, as dem dey grow inside God.
19 e não retendo a cabeça, da qual todo o corpo, suprido e bem-vinculado por suas juntas e ligamentos, cresce o crescimento que procede de Deus.
20 Since una don die with Christ and e don free una from wiked pipol, den why una still dey bihave as pipol wey nor know God?
20 Se morrestes com Cristo para os rudimentos do mundo, por que, como se vivêsseis no mundo, vos sujeitais a ordenanças:
21 Wen dem sey, make pipol nor whole, chop or tosh some tins, e nor mean anytin.
21 não manuseies isto, não proves aquilo, não toques aquiloutro,
22 All dis tins dey yuzles as pipol dey use dem, bikos na human being make all dis rules.
22 segundo os preceitos e doutrinas dos homens? Pois que todas estas coisas, com o uso, se destroem.
23 E bi like sey dis tins get wisdom, bikos pipol dey woship angels; dey pritend sey dem good and dey sofa dia body, but dis wisdom nor get value, bikos e nor fit stop pesin make e nor do di yeye tins wey dey en mind.
23 Tais coisas, com efeito, têm aparência de sabedoria, como culto de si mesmo, e de falsa humildade, e de rigor ascético; todavia, não têm valor algum contra a sensualidade.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Colossenses 2, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.