Atos 9
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs VC
1 As all dis tins dey happen, Saul still dey tell di disciples sey e go kill dem. E go meet di High Priest
1 Enquanto isso, Saulo só respirava ameaças e morte contra os discípulos do Senhor. Apresentou-se ao príncipe dos sacerdotes,
2 kon take pamishon to go Damaskus, so dat if e si anybody wey dey follow Jesus Christ wey bi di Way, weda na man or woman, e go arrest dem kom Jerusalem.
2 e pediu-lhe cartas para as sinagogas de Damasco, com o fim de levar presos a Jerusalém todos os homens e mulheres que achasse seguindo essa doutrina.
3 As e dey go, one lite from heaven kon shine round where e dey.
3 Durante a viagem, estando já perto de Damasco, subitamente o cercou uma luz resplandecente vinda do céu.
4 E fall for groun kon hear one vois wey koll en name, “Saul, Saul, wetin make yu dey ponish mi?”
4 Caindo por terra, ouviu uma voz que lhe dizia: Saulo, Saulo, por que me persegues?
5 So e ansa, “Oga God, na who dey tok so?” Di vois ansa am, “I bi Jesus Christ wey yu dey ponish!
5 Saulo disse: Quem és, Senhor? Respondeu ele: Eu sou Jesus, a quem tu persegues. {Duro te é recalcitrar contra o aguilhão.
6 Naw, make yu get up go inside di town and dem go tell yu wetin yu go do.”
6 Então, trêmulo e atônito, disse ele: Senhor, que queres que eu faça? Respondeu-lhe o Senhor:} Levanta-te, entra na cidade. Aí te será dito o que deves fazer.
7 Di men wey dey follow am travel, sopraiz dey look, bikos dem hear vois dey tok, but dem nor si anybody.
7 Os homens que o acompanhavam enchiam-se de espanto, pois ouviam perfeitamente a voz, mas não viam ninguém.
8 So Saul get up from groun, en eye open, but e nor dey si. En friends hold en hand kon escort am enter Damaskus.
8 Saulo levantou-se do chão. Abrindo, porém, os olhos, não via nada. Tomaram-no pela mão e o introduziram em Damasco,
9 E nor si at-all for three days and for dat time, e nor chop or drink anytin.Jesus tok to Saul for Damaskus Road|alt="Paul's conversion on di Damascus" src="WA03960b.tif" size="col" loc="ACTS 9:3-8" copy="Wade" ref="9:5"
9 onde esteve três dias sem ver, sem comer nem beber.
10 Dat time, e get one disciple for Damaskus and en name na Ananias. God koll am for inside vishon, “Ananias”, e kon ansa, “Na mi bi dis, Oga God.”
10 Havia em Damasco um discípulo chamado Ananias. O Senhor, numa visão, lhe disse: Ananias! Eis-me aqui, Senhor, respondeu ele.
11 God tell am, “Get up make yu go di street wey dem dey koll ‘Strait’ and wen yu rish Judas house wey dey der, make yu look for one man, en name na Saul and e kom from Tarsus. Yu go meet am dey pray for der.
11 O Senhor lhe ordenou: Levanta-te e vai à rua Direita, e pergunta em casa de Judas por um homem de Tarso, chamado Saulo; ele está orando.
12 I don show am for vishon sey one man wey dem dey koll Ananias go kom meet am and e go put hand for en head, pray for am, make e for fit si again.”
12 {Este via numa visão um homem, chamado Ananias, entrar e impor-lhe as mãos para recobrar a vista.}
13 But Ananias ansa, “Oga God, many pipol don tell mi about dis man and all di wiked tins wey e don do to yor pipol for Jerusalem.
13 Ananias respondeu: Senhor, muitos já me falaram deste homem, quantos males fez aos teus fiéis em Jerusalém.
14 E even kollect leta from di priest oga dem, wey e go take katch and trow pipol wey bilive yu, for prison.”
14 E aqui ele tem poder dos príncipes dos sacerdotes para prender a todos aqueles que invocam o teu nome.
15 But God tell Ananias, “Make yu go meet am, bikos I don choose am make e karry my name to Gentile pipol, kings and all Israel pipol.
15 Mas o Senhor lhe disse: Vai, porque este homem é para mim um instrumento escolhido, que levará o meu nome diante das nações, dos reis e dos filhos de Israel.
16 True-true I go show am how e go sofa, bikos of my name.”
16 Eu lhe mostrarei tudo o que terá de padecer pelo meu nome.
17 So Ananias go di house and wen e enter, e put en hand for Saul head kon sey, “Broda Saul, di Oga God wey show ensef to yu for road wen yu dey kom here, na en send mi kom meet yu, so dat yu go fit si again kon receive di Holy Spirit.”
17 Ananias foi. Entrou na casa e, impondo-lhe as mãos, disse: Saulo, meu irmão, o Senhor, esse Jesus que te apareceu no caminho, enviou-me para que recobres a vista e fiques cheio do Espírito Santo.
18 At wons, sometin wey bi like fish skale fall komot from Saul eye and e kon dey si. E get up and dem baptize am.
18 No mesmo instante caíram dos olhos de Saulo umas como escamas, e recuperou a vista. Levantou-se e foi batizado.
19 Afta e chop finish, en body kon strong again and Saul kon stay Damaskus for some days with di disciple.
19 Depois tomou alimento e sentiu-se fortalecido. Demorou-se por alguns dias com os discípulos que se achavam em Damasco.
20 At wons, e kon start to dey prish for di sinagog sey Jesus Christ na God Pikin.
20 Imediatamente começou a proclamar pelas sinagogas que Jesus é o Filho de Deus.
21 Evribody wey hear am kon dey sopraiz dey ask demsef sey, “Dis nor bi di man wey dey kill pipol wey bilive Jesus Christ? Wi tink sey e kom here kon arrest pipol karry go give di priest oga dem.”
21 Todos os seus ouvintes pasmavam e diziam: Este não é aquele que perseguia em Jerusalém os que invocam o nome de Jesus? Não veio cá só para levá-los presos aos sumos sacerdotes?
22 But Saul still dey prish with pawa. E dey show sey na Jesus Christ bi di Mezaya and di Jew pipol wey dey for Damaskus, nor fit ansa am. Ananias dey pray for Saul for Tarsus|alt="Ananias praying for Paul at Tarsus afta di Damascus experience" src="DN00504b.tif" size="col" loc="Act 9: 1-22" copy="Dunham" ref="9:22"
22 Saulo, porém, sentia crescer o seu poder e confundia os judeus de Damasco, demonstrando que Jesus é o Cristo.
23 Afta some days, di Jew pipol kon dey plan to kill-am,
23 Decorridos alguns dias, os judeus deliberaram, em conselho, matá-lo.
24 but Saul hear wetin dem dey plan. Some pipol dey wosh for di town gate day and nite make dem for fit kill-am wen dem si am.
24 Estas intenções chegaram ao conhecimento de Saulo. Guardavam eles as portas de dia e de noite, para matá-lo.
25 But one nite, di pipol wey dey follow Saul kon put am for basket, trow am down small-small from one small window wey dey near di town fence.
25 Mas os discípulos, tomando-o de noite, fizeram-no descer pela muralha dentro de um cesto.
26 Wen e rish Jerusalem, e kon try to join di disciples, but dem dey fear am, bikos dem nor bilive sey e don bi Jesus Christ disciple.
26 Chegando a Jerusalém, tentava ajuntar-se aos discípulos, mas todos o temiam, não querendo crer que se tivesse tornado discípulo.
27 So Banabas take Saul go meet di apostles, den e tell dem how Saul take si Jesus Christ for vishon wen e dey go Damaskus and how e bigin prish with boldness about Jesus Christ.
27 Então Barnabé, levando-o consigo, apresentou-o aos apóstolos e contou-lhes como Saulo vira o Senhor no caminho, e que lhe havia falado, e como em Damasco pregara, com desassombro, o nome de Jesus.
28 Saul stay and waka with dem for Jerusalem and e dey tok with boldness about Jesus Christ.
28 Daí por diante permaneceu com eles, saindo e entrando em Jerusalém, e pregando, destemidamente, o nome do Senhor.
29 E bigin dey tok and argue with di Jew pipol wey dey speak Greek, but some pipol kon dey try to kill-am.
29 Falava também e discutia com os helenistas. Mas estes procuravam matá-lo.
30 Wen di brodas know about wetin dem dey plan, dem kon take am go Caesaria and from der, dem send am go Tarsus.
30 Os irmãos, informados disso, acompanharam-no até Cesaréia e dali o fizeram partir para Tarso.
31 Dat time, di church wey dey Judea, Galilee and Samaria get rest and dis kon make dem strong as dem dey stay togeda, dey woship God with all dia heart and as di Holy Spirit dey tok to dem. So pipol wey dey di church kon dey plenty more-more.
31 A Igreja gozava então de paz por toda a Judéia, Galiléia e Samaria. Estabelecia-se ela caminhando no temor do Senhor, e a assistência do Espírito Santo a fazia crescer em número.
32 Pita dey travel from one place go anoda and e still go where di bilivers dey for Lydda.
32 Pedro, que caminhava por toda parte, de cidade em cidade, desceu também aos fiéis que habitavam em Lida.
33 E kon meet one man for der, en name na Aeneas wey nor fit waka since wen e bi eight years.
33 Ali achou um homem chamado Enéias, que havia oito anos jazia paralítico num leito.
34 Pita kon tell am, “Aeneas, Jesus Christ, wey bi di Mezaya, won heal yu naw. So make yu stand up, karry yor bed!” At wons, e get up kon karry en bed.
34 Disse-lhe Pedro: Enéias, Jesus Cristo te cura: levanta-te e faze tua cama. E levantou-se imediatamente.
35 All di pipol wey dey Lydda and Sharon si wetin happen and dem kon bigin follow Jesus Christ.
35 Viram-no todos os que habitavam em Lida e em Sarona, e converteram-se ao Senhor.
36 One woman dey for Joppa wey bi Jesus Christ disciple and en name na Tabita (wey mean Dorkas for Greek language). E dey do good tins and dey help poor pipol.
36 Em Jope havia uma discípula chamada Tabita - em grego, Dorcas. Esta era rica em boas obras e esmolas que dava.
37 E sick and e kon die. Wen di pipol don wosh en dead body, dem kon karry am put for one room for upstair.
37 Aconteceu que adoecera naqueles dias e veio a falecer. Depois de a terem lavado, levaram-na para o quarto de cima.
38 Bikos Lydda dey near Joppa, so wen di disciples hear sey Pita dey der, dem kon send two men go koll am sey, “Make yu kom meet us at wons.”
38 Ora, como Lida fica perto de Jope, os discípulos, ouvindo dizer que Pedro aí se encontrava, enviaram-lhe dois homens, rogando-lhe: Não te demores em vir ter conosco.
39 So Pita get up follow dem and wen e rish der, dem kon take am go di room for up. All di wimen wey dia husband don die stand near Pita dey kry and dey show am all di dress wey Dorkas make for dem, wen e dey with dem.
39 Pedro levantou-se imediatamente e foi com eles. Logo que chegou, conduziram-no ao quarto de cima. Cercavam-no todas as viúvas, chorando e mostrando-lhe as túnicas e os vestidos que Dorcas lhes fazia quando viva.
40 But Pita drive all of dem go outside, den e knee down kon pray. E turn face di dead body kon sey, “Tabita, get up!” Naim di woman open en eye and wen e si Pita, e kon sidan.
40 Pedro então, tendo feito todos sair, pôs-se de joelhos e orou. Voltando-se para o corpo, disse: Tabita, levanta-te! Ela abriu os olhos e, vendo Pedro, sentou-se.
41 Pita kon hold en hand stand up. E koll di bilivers and all di wimen wey dia husband don die, kon give di woman to dem.
41 Ele a fez levantar-se, estendendo-lhe a mão. Chamando os irmãos e as viúvas, entregou-lha viva.
42 Wen evribody for Joppa hear dis tin wey happen, many of dem kon bilive Jesus Christ.
42 Este fato espalhou-se por toda Jope e muitos creram no Senhor.
43 Pita kon stay for Joppa for many days with one man wey dem dey koll Simon, wey dey do leda work.Pita bring Dorkas kon mit di pipol afta e don wake from deat|alt="Pita show Dorkas to pipol afta e pray for am" src="cn01941B.tif" size="col" loc="ACTS 9:39-42" copy="Cook" ref="9:43"
43 Pedro permaneceu ainda muitos dias em Jope, em casa dum curtidor, chamado Simão.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Atos 9, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.