Atos 7
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARC
1 Di priest oga dem kon ask Stefen, “All dis tins wey dem tok about yu so, na true?”
1 E disse o sumo sacerdote: Porventura, é isto assim?
2 Stefen ansa, “My brodas and fada, make una listin to wetin I won tok so. Na wen Abraham, awa grand-grand papa dey for Mesopotamia, before e go stay for Haran, naim God wey get pawa, appear to am
2 E ele disse: Varões irmãos e pais, ouvi. O Deus da glória apareceu a Abraão, nosso pai, estando na Mesopotâmia, antes de habitar em Harã,
3 kon tell am sey, ‘Make yu leave yor kountry and yor pipol kon go di land wey I go show yu.’
3 e disse-lhe: Sai da tua terra e dentre a tua parentela e dirige-te à terra que eu te mostrar.
4 So Abraham leave Kaldean kountry kon go stay for Haran. Afta en papa die, God kon tell am make e stay for dis land wey una dey naw.
4 Então, saiu da terra dos caldeus e habitou em Harã. E dali, depois que seu pai faleceu, Deus o trouxe para esta terra em que habitais agora.
5 Dat time, God neva gi-am any part for di land and e neva born any pikin, but God promise am sey E go gi-am di land and en and en shidren go stay der forever.
5 E não lhe deu nela herança, nem ainda o espaço de um pé; mas prometeu que lhe daria a posse dela e, depois dele, à sua descendência, não tendo ele filho.
6 God tell am, ‘Di shidren wey yu go born go bi strenja for anoda kountry and di pipol for dat kountry go sofa dem kon use dem as slave for four hundred years.’
6 E falou Deus assim: Que a sua descendência seria peregrina em terra alheia, e a sujeitariam à escravidão e a maltratariam por quatrocentos anos.
7 But God sey, ‘I go ponish di pipol wey go use dem as slave and afta all dis tins, dem go komot for der kon woship mi for dis place.’
7 E eu julgarei a nação que os tiver escravizado, disse Deus. E, depois disto, sairão e me servirão neste lugar.
8 So God make kovenant with Abraham thru sekonsishon. Abraham kon born Isaak and sekonsaiz am afta eight days. Isaak born Jakob and Jakob born di twelf brodas, wey bi awa grand-grand papa dem.
8 E deu-lhe o pacto da circuncisão; e, assim, gerou a Isaque e o circuncidou ao oitavo dia; e Isaque, a Jacó; e Jacó, aos doze patriarcas.
9 Jakob shidren wey bi awa grand-grand papa dem, bikos dem dey jealous Josef dia broda, dem kon sell am as slave go Egypt, but God dey with am
9 E os patriarcas, movidos de inveja, venderam a José para o Egito; mas Deus era com ele.
10 kon save am from all en wahala and from Fero wey bi Egypt king, E gi-am favor with wisdom and Fero kon make am oga for di whole Egypt and ova evritin wey e get.
10 E livrou-o de todas as suas tribulações e lhe deu graça e sabedoria ante Faraó, rei do Egito, que o constituiu governador sobre o Egito e toda a sua casa.
11 Honga kon dey for di whole Egypt and Kanaan and awa grand-grand papa dem nor si food chop.
11 Sobreveio, então, a todo o país do Egito e de Canaã fome e grande tribulação; e nossos pais não achavam alimentos.
12 So wen Jakob hear sey food dey for Egypt, e kon send awa grand-grand papa dem go shek if na true.
12 Mas, tendo ouvido Jacó que no Egito havia trigo, enviou ali nossos pais, a primeira vez.
13 Wen dem kom di sekond time, Josef show ensef give en brodas and Fero kon know Josef family.
13 E, na segunda vez, foi José conhecido por seus irmãos, e a sua linhagem foi manifesta a Faraó.
14 Josef send message go give en papa Jakob sey make en and all di pipol wey dey with am kom Egypt and dem bi seventy-five wey go.
14 E José mandou chamar a Jacó, seu pai, e a toda sua parentela, que era de setenta e cinco almas.
15 So Jakob and awa grand-grand papa dem go Egypt and dem die for der.
15 E Jacó desceu ao Egito e morreu, ele e nossos pais;
16 Dia bone dey der till dem karry dem go beri for Shekem for di grave wey Abraham buy from Hamor shidren.
16 e foram transportados para Siquém e depositados na sepultura que Abraão comprara por certa soma de dinheiro aos filhos de Hamor, pai de Siquém.
17 “But as time dey near wen God go fulfil di promise wey e make with Abraham; Israel pipol kon dey many inside Egypt,
17 Aproximando-se, porém, o tempo da promessa que Deus tinha feito a Abraão, o povo cresceu e se multiplicou no Egito;
18 till anoda Fero wey nor know Josef kon dey rule.
18 até que se levantou outro rei, que não conhecia a José.
19 E deceive and sofa awa pipol sotey e force dem to leave dia shidren make dem die.
19 Esse, usando de astúcia contra a nossa linhagem, maltratou nossos pais, ao ponto de os fazer enjeitar as suas crianças, para que não se multiplicassem.
20 Na dat time dem born Moses and God kon like am well-well. Moses stay for en papa house for only three monts
20 Nesse tempo, nasceu Moisés, e era mui formoso, e foi criado três meses em casa de seu pai.
21 and wen dem trowey am for river, Fero dota kon take and train am as en own pikin.
21 E, sendo enjeitado, tomou-o a filha de Faraó e o criou como seu filho.
22 So dem tish Moses all di wise tins wey Egypt pipol dey do and e kon get wisdom for how e dey tok and wetin e dey do.
22 E Moisés foi instruído em toda a ciência dos egípcios e era poderoso em suas palavras e obras.
23 But wen forty years don rish, e kon tink am sey e good make e go visit en own Israel pipol.
23 E, quando completou a idade de quarenta anos, veio-lhe ao coração ir visitar seus irmãos, os filhos de Israel.
24 Wen e si one man from Egypt dey opress one Israel pesin, Moses kon defend and kill di Egypt man.
24 E, vendo maltratado um deles, o defendeu e vingou o ofendido, matando o egípcio.
25 E tink sey en own pipol go undastand sey God won use am take save dem, but dem nor undastand.
25 E ele cuidava que seus irmãos entenderiam que Deus lhes havia de dar a liberdade pela sua mão; mas eles não entenderam.
26 Di next day, Moses si two Israel men dey fight and e won try setol dem. So e tell dem, ‘My pipol, una bi brodas, why una kon dey fight unasef like dis?’
26 E, no dia seguinte, pelejando eles, foi por eles visto e quis levá-los à paz, dizendo: Varões, sois irmãos; por que vos agravais um ao outro?
27 But di man wey dey opress en broda kon sey, ‘Who give yu pawa to rule and judge us?
27 E o que ofendia o seu próximo o repeliu, dizendo: Quem te constituiu príncipe e juiz sobre nós?
28 Hope yu nor won kill mi di way yu kill dat Egypt man yestiday?’
28 Queres tu matar-me, como ontem mataste o egípcio?
29 Wen di man tok like dis, Moses run go Midian, anoda land where e stay as strenja kon born two boys for der.
29 E a esta palavra fugiu Moisés e esteve como estrangeiro na terra de Midiã, onde gerou dois filhos.
30 “Afta forty years don pass, one angel appear to am for inside wildaness for Mount Sinai, where one bush for dey burn.
30 E, completados quarenta anos, apareceu-lhe o anjo do Senhor, no deserto do monte Sinai, numa chama de fogo de um sarçal.
31 As Moses si dis tins, e sopraiz well-well and wen e waka near make e si am well, e hear God vois wey sey,
31 Então, Moisés, quando viu isto, se maravilhou da visão; e, aproximando-se para observar, foi-lhe dirigida a voz do Senhor,
32 ‘Na mi bi di God wey yor grand-grand papa Abraham, Isaak and Jakob dey woship.’ Moses start to shake and fear nor let am look too mush.
32 dizendo: Eu sou o Deus de teus pais, o Deus de Abraão, e o Deus de Isaque, e o Deus de Jacó. E Moisés, todo trêmulo, não ousava olhar.
33 But God tell am, ‘Make yu pul yor shoe komot from yor leg, bikos di place wey yu stand so, na holy Groun.
33 E disse-lhe o Senhor: Tira as sandálias dos pés, porque o lugar em que estás é terra santa.
34 I don si as my pipol dey sofa for Egypt and I don hear as dem dey kry, so I don kon save dem. Make yu kom, bikos I won send yu go Egypt back.’
34 Tenho visto atentamente a aflição do meu povo que está no Egito, e ouvi os seus gemidos, e desci a livrá-los. Agora, pois, vem, e enviar-te-ei ao Egito.
35 “Dis Moses wey dem rijet and ask sey, ‘Who make yu awa oga and judge’, naim God kon send make e bi oga and Savior thru di angel wey appear to am for bush.
35 A este Moisés, ao qual haviam negado, dizendo: Quem te constituiu príncipe e juiz? A este enviou Deus como príncipe e libertador, pela mão do anjo que lhe aparecera no sarçal.
36 Na dis Moses lead dem komot from Egypt. E still do plenty mirakles for Egypt, di Red Sea and inside di wildaness for forty years.
36 Foi este que os conduziu para fora, fazendo prodígios e sinais na terra do Egito, no mar Vermelho e no deserto, por quarenta anos.
37 Na dis Moses tell Israel pipol sey, ‘Na from among una God promise sey, E go raiz-up one profet wey go lead una.’
37 Este é aquele Moisés que disse aos filhos de Israel: O Senhor, vosso Deus, vos levantará dentre vossos irmãos um profeta como eu; a ele ouvireis.
38 Na dis same man dey with di pipol for wildaness; with di angel wey tok to am for Mount Sinai; with awa grand-grand papa dem and e kon receive God word for una.
38 Este é o que esteve entre a congregação no deserto, com o anjo que lhe falava no monte Sinai, e com nossos pais, o qual recebeu as palavras de vida para no-las dar.
39 But una papa nor gri obey am. Instead, dem nor ansa am, but dem shange dia mind sey dem won go Egypt back.
39 Ao qual nossos pais não quiseram obedecer, antes o rejeitaram e, em seu coração, se tornaram ao Egito,
40 Dem kon tell Aaron, ‘Make yu do juju for us wey go lead us bikos, wi nor know wetin don happen to Moses!’
40 dizendo a Arão: Faze-nos deuses que vão adiante de nós; porque a esse Moisés, que nos tirou da terra do Egito, não sabemos o que lhe aconteceu.
41 So dem make image wey bi like melu, sakrifice gi-am kon bigin serve di melu wey dem take dia own hand make.
41 E, naqueles dias, fizeram o bezerro, e ofereceram sacrifícios ao ídolo, e se alegraram nas obras das suas mãos.
42 “God leave dem make dem woship stars to make wetin Profet Amos tok, happen sey, ‘Israel pipol, una tink sey na mi una dey serve wen una dey sakrifice animal for inside wildaness for forty years?’
42 Mas Deus se afastou e os abandonou a que servissem ao exército do céu, como está escrito no livro dos profetas: Porventura, me oferecestes vítimas e sacrifícios no deserto por quarenta anos, ó casa de Israel?
43 ‘Na bikos of di house wey una build for “Molek and Refan”, wey bi una god and juju wey una dey woship, naim make mi send una go bi slave for Babilon.’
43 Antes, tomastes o tabernáculo de Moloque e a estrela do vosso deus Renfã, figuras que vós fizestes para as adorar. Transportar-vos-ei, pois, para além de Babilônia.
44 God give di Tabanako to awa grand-grand papa dem, di house where dem go for woship am, just as E sey make Moses build am.
44 Estava entre nossos pais no deserto o tabernáculo do Testemunho (como ordenara aquele que disse a Moisés que o fizesse segundo o modelo que tinha visto),
45 “Afta, awa grand-grand papa dem karry di Tabanako wey God give dem with Joshua kon drive all di oda tribes and take dia land till di time wey David bigin rule Israel.
45 o qual nossos pais, recebendo-o também, o levaram com Josué, quando entraram na posse das nações que Deus lançou para fora da presença de nossos pais, até aos dias de Davi,
46 God favor David well-well and e sey e go build house for God
46 que achou graça diante de Deus e pediu que pudesse achar tabernáculo para o Deus de Jacó.
47 but na Solomon en pikin kon build am.
47 E Salomão lhe edificou casa;
48 Wi know sey God nor dey stay for house wey human being build, just as di profet tok,
48 mas o Altíssimo não habita em templos feitos por mãos de homens, como diz o profeta:
49 “ ‘Heaven na my chair
49 O céu é o meu trono, e a terra, o estrado dos meus pés. Que casa me edificareis, diz o Senhor, ou qual é o lugar do meu repouso?
50 Nor bi mi make all dis tins by mysef?’
50 Porventura, não fez a minha mão todas estas coisas?
51 “Si how una sturbon! Just as una grand-grand papa dem bi, na so una still bi too, bikos una don make una heart strong to disobey God!
51 Homens de dura cerviz e incircuncisos de coração e ouvido, vós sempre resistis ao Espírito Santo; assim, vós sois como vossos pais.
52 E get any profet wey una grand-grand papa dem nor kill? Dem even kill di messenja wey tok before sey, ‘Di Raitious Man go kom and una go gi-am to wiked pipol and dem go kill-am.’
52 A qual dos profetas não perseguiram vossos pais? Até mataram os que anteriormente anunciaram a vinda do Justo, do qual vós agora fostes traidores e homicidas;
53 Na una receive God law wey E send thru en angels, but una nor obey am.”
53 vós que recebestes a lei por ordenação dos anjos e não a guardastes.
54 As di kansol membas hear all di tins wey Stefen tok, dem kon dey vex well-well.
54 E, ouvindo eles isto, enfureciam-se em seu coração e rangiam os dentes contra ele.
55 But Stefen, wey God dey use well-well, look strait go heaven kon si God glory and Jesus Christ wey stand for God rite hand.
55 Mas ele, estando cheio do Espírito Santo e fixando os olhos no céu, viu a glória de Deus e Jesus, que estava à direita de Deus,
56 Naim e shaut, “Look! I si heaven wey open and I si Jesus Christ, God Pikin, stand for en rite hand.”
56 e disse: Eis que vejo os céus abertos e o Filho do Homem, que está em pé à mão direita de Deus.
57 But di pipol klose dia ear bigin shaut and all of dem kon rush am.
57 Mas eles gritaram com grande voz, taparam os ouvidos e arremeteram unânimes contra ele.
58 Wen dem don drag am go outside for di temple, dem kon start to dey stone am, den dem kon pul all dia klot give one man wey dem dey koll Saul, make e whole.
58 E, expulsando-o da cidade, o apedrejavam. E as testemunhas depuseram as suas vestes aos pés de um jovem chamado Saulo.
59 As dem dey stone Stefen, e kon pray, “Oga God, Jesus Christ, make yu receive my spirit.”
59 E apedrejaram a Estêvão, que em invocação dizia: Senhor Jesus, recebe o meu espírito.
60 So e fall for groun kon shaut, “My Papa, abeg, make yu nor kount dis sin against dem.” Wen e tok so finish, e kon die.
60 E, pondo-se de joelhos, clamou com grande voz: Senhor, não lhes imputes este pecado. E, tendo dito isto, adormeceu.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Atos 7, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.