Atos 6
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARA
1 As time dey go, wen di disciples don plenty, di Jew pipol wey dey tok with Greek language kon dey kworel with di oda kountry-men wey dey tok Hibru. Dem kon dey komplain sey, “Wen dem dey share food, di Hibru men dey sofa wimen wey dia husband don die.”
1 Ora, naqueles dias, multiplicando-se o número dos discípulos, houve murmuração dos helenistas contra os hebreus, porque as viúvas deles estavam sendo esquecidas na distribuição diária.
2 So di twelf apostles gada evribody kon sey, “E nor good make wi leave God word wey wi dey prish kon put hand for food matter.
2 Então, os doze convocaram a comunidade dos discípulos e disseram: Não é razoável que nós abandonemos a palavra de Deus para servir às mesas.
3 So make una look round kon choose among una, seven men wey una know sey dey bihave well; di Holy Spirit dey use well-well and wey get sense, so dat dem go do dis work for us.
3 Mas, irmãos, escolhei dentre vós sete homens de boa reputação, cheios do Espírito e de sabedoria, aos quais encarregaremos deste serviço;
4 So dat wi go fit put awa mind for prayer, as wi dey prish God word.”
4 e, quanto a nós, nos consagraremos à oração e ao ministério da palavra.
5 Evribody like wetin di apostles tok, so dem kon choose one man wey en name na Stefen, bikos di Holy Spirit dey use am well-well. Di odas wey dem choose, na Filip, Prokorus, Nikanor, Timon, Parmenas and Nikolas wey kom from Antiok and e dey serve God like Jew pipol.
5 O parecer agradou a toda a comunidade; e elegeram Estêvão, homem cheio de fé e do Espírito Santo, Filipe, Prócoro, Nicanor, Timão, Pármenas e Nicolau, prosélito de Antioquia.
6 Dem show dem to di apostles. Di apostles put hand for dia head kon pray for dem.
6 Apresentaram-nos perante os apóstolos, e estes, orando, lhes impuseram as mãos.
7 Na so God word start to spread and di disciples wey dey Jerusalem kon plenty well-well. And many priests kon bilive Jesus Christ.
7 Crescia a palavra de Deus, e, em Jerusalém, se multiplicava o número dos discípulos; também muitíssimos sacerdotes obedeciam à fé.
8 God bless Stefen well-well kon gi-am pawa to take do many wonders and mirakles among di pipol.
8 Estêvão, cheio de graça e poder, fazia prodígios e grandes sinais entre o povo.
9 But some men kon dey argue with am. Dis men dey woship God for one place wey dem dey koll “Di Freedmen Sinagog.” Some among dem kom from Alexandria, Sirene, Silisia and Asia.
9 Levantaram-se, porém, alguns dos que eram da sinagoga chamada dos Libertos, dos cireneus, dos alexandrinos e dos da Cilícia e Ásia, e discutiam com Estêvão;
10 But dis pipol nor fit stand di wisdom and pawa wey Stefen take dey tok.
10 e não podiam resistir à sabedoria e ao Espírito, pelo qual ele falava.
11 So, dem kon bribe some men make dem lie sey, “Wi hear wen dis man tok tins wey dey against Moses and God law.”
11 Então, subornaram homens que dissessem: Temos ouvido este homem proferir blasfêmias contra Moisés e contra Deus.
12 Dem lie for Stefen head, so di pipol, di eldas and di oga dem for di law kon hate am. So dem arrest Stefen kon karry am go di kansol.
12 Sublevaram o povo, os anciãos e os escribas e, investindo, o arrebataram, levando-o ao Sinédrio.
13 Dem bring pipol kon lie sey, “E don tey wey dis man dey tok bad-bad tins about Moses Law and dis Temple.
13 Apresentaram testemunhas falsas, que depuseram: Este homem não cessa de falar contra o lugar santo e contra a lei;
14 Wi hear wen e dey tok sey Jesus Christ wey kom from Nazaret go skata dis place and e go shange all di tradishon wey Moses give us.”
14 porque o temos ouvido dizer que esse Jesus, o Nazareno, destruirá este lugar e mudará os costumes que Moisés nos deu.
15 Evribody wey dey di kansol dey look Stefen kon si sey en face dey shine like angel own.
15 Todos os que estavam assentados no Sinédrio, fitando os olhos em Estêvão, viram o seu rosto como se fosse rosto de anjo.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Atos 6, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.