Atos 5
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARIB
1 One man wey dem dey koll Ananias with en wife Saffira kon sell dia land.
1 Mas um certo homem chamado Ananias, com Safira, sua mulher, vendeu uma propriedade,
2 Dem kon gri sey dem go keep some for di money for demsef. So Ananias take di remainin money go give di apostles.
2 e reteve parte do preço, sabendo-o também sua mulher; e levando a outra parte, a depositou aos pés dos apóstolos.
3 But Pita tell am, “Ananias, why yu allow Satan enter yor heart and yu kon dey lie give di Holy Spirit? Why yu keep some for di money wey una sell di land, for unasef?
3 Disse então Pedro: Ananias, por que encheu Satanás o teu coração, para que mentisses ao Espírito Santo e retivesses parte do preço do terreno?
4 Before una sell di land, nor bi una own propaty? Naw wen una sell am finish, di money nor still bi una own to spend as una like? Wetin make una get dis kind mind? Dis lie wey yu tok so, nor bi pesin yu do am to, but na God!”
4 Enquanto o possuías, não era teu? e vendido, não estava o preço em teu poder? Como, pois, formaste este desígnio em teu coração? Não mentiste aos homens, mas a Deus.
5 Wen Ananias hear di word wey Pita tok, e fall for groun at wons kon die. Dis tin make fear katch evribody wey hear wetin happen.
5 E Ananias, ouvindo estas palavras, caiu e expirou. E grande temor veio sobre todos os que souberam disto.
6 So di yong men wey dey der, take wrapa kover en body kon karry am go beri.
6 Levantando-se os moços, cobriram-no e, transportando-o para fora, o sepultaram.
7 Wen three hours don pass, en wife, Saffira waka kom, but e nor know wetin don happen to en husband.
7 Depois de um intervalo de cerca de três horas, entrou também sua mulher, não sabendo o que havia acontecido.
8 Den Pita ask am, “Madam, tell mi di trut. Na dis bi di prize wey una sell di land? Saffira ansa, ‘Yes, na-im.’ ”
8 E perguntou-lhe Pedro: Dize-me: Vendestes por tanto aquele terreno? E ela respondeu: Sim, por tanto.
9 So Pita tell am, “Wetin make yu and yor husband decide to try God Spirit like dis? Look! Na di pipol wey go beri yor husband dey kom so and dem go karry yu go beri too!”
9 Então Pedro lhe disse: Por que é que combinastes entre vós provar o Espírito do Senhor? Eis aí à porta os pés dos que sepultaram o teu marido, e te levarão também a ti.
10 At wons, di woman fall for groun kon die for Pita front. So wen di yong men enter inside di house kon si sey di woman don die, dem karry am go beri near where dem beri en husband put.
10 Imediatamente ela caiu aos pés dele e expirou. E entrando os moços, acharam-na morta e, levando-a para fora, sepultaram-na ao lado do marido.
11 Fear katch di pipol for di church and odas wey hear wetin happen.
11 Sobreveio grande temor a toda a igreja e a todos os que ouviram estas coisas.
12 Na dis kind mirakle and wonder God do thru di apostles for di pipol front and dem kon dey meet for Solomon Varanda.
12 E muitos sinais e prodígios eram feitos entre o povo pelas mãos dos apóstolos. E estavam todos de comum acordo no pórtico de Salomão.
13 Fear nor let anybody wey nor dey among dem go join dem anyhow and e kon make all di pipol dey respet dem well-well.
13 Dos outros, porém, nenhum ousava ajuntar-se a eles; mas o povo os tinha em grande estima;
14 But plenty men and wimen wey bilive Jesus Christ kon join dem,
14 e cada vez mais se agregavam crentes ao Senhor em grande número tanto de homens como de mulheres,
15 sotey dem even dey karry pipol wey nor well put for bed and mat for road, so dat as Pita dey pass, en shadow go heal dem.
15 a ponto de transportarem os enfermos para as ruas, e os porem em leitos e macas, para que ao passar Pedro, ao menos sua sombra cobrisse alguns deles.
16 Dem bring pipol well nor well and doz wey get evil spirit from all di town and village wey near Jerusalem and God heal all of dem.
16 Também das cidades circunvizinhas afluía muita gente a Jerusalém, conduzindo enfermos e atormentados de espíritos imundos, os quais eram todos curados.
17 But jealousy kon full di High Priest and di Sadusi pipol mind,
17 Levantando-se o sumo sacerdote e todos os que estavam com ele {isto é, a seita dos saduceus}, encheram-se de inveja,
18 so dem kon arrest di apostles put for prison.
18 deitaram mão nos apóstolos, e os puseram na prisão pública.
19 But for dat nite, God angel open di prison door kon bring dem kom out and tell dem,
19 Mas de noite um anjo do Senhor abriu as portas do cárcere e, tirando-os para fora, disse:
20 “Make una go stand for di temple varanda bigin prish God word wey dey give pipol life.”
20 Ide, apresentai-vos no templo, e falai ao povo todas as palavras desta vida.
21 Afta dem hear dis, dem enter di temple varanda for morning kon start to dey tish di pipol.
21 Ora, tendo eles ouvido isto, entraram de manhã cedo no templo e ensinavam. Chegando, porém o sumo sacerdote e os que estavam com ele, convocaram o sinédrio, com todos os anciãos dos filhos de Israel, e enviaram guardas ao cárcere para trazê-los.
22 But di savant wey dem send go, nor si dem for di prison, so dem go back go ripot sey,
22 Mas os guardas, tendo lá ido, não os acharam na prisão; e voltando, lho anunciaram,
23 “Wi si sey dem lock di prison well and all di sojas stand for di front, but wen wi open di gate, wi look inside, but wi nor si anybody.”
23 dizendo: Achamos realmente o cárcere fechado com toda a segurança, e as sentinelas em pé às portas; mas, abrindo-as, a ninguém achamos dentro.
24 So wen di soja oga wey dey di temple and di priest oga dem hear dis tin, dem sopraiz well-well kon dey wonder wetin happen to di apostles.
24 E quando o capitão do templo e os principais sacerdotes ouviram estas palavras ficaram perplexos acerca deles e do que viria a ser isso.
25 Na dat time one pesin kon tell dem sey, “Si o-o, di men wey una put for prison dey for di temple varanda dey tish pipol!”
25 Então chegou alguém e lhes anunciou: Eis que os homens que encerrastes na prisão estão no templo, em pé, a ensinar o povo.
26 So di soja oga wey dey di temple kon escort di savant go bring di apostles, but dem nor use force, bikos dem dey fear sey di pipol wey gada der, fit stone dem.
26 Nisso foi o capitão com os guardas e os trouxe, não com violência, porque temiam ser apedrejados pelo povo.
27 Wen dem don bring dem inside, dem kon sey make dem stand for di kansol front and di priest oga dem kon dey kweshon dem.
27 E tendo-os trazido, os apresentaram ao sinédrio. E o sumo sacerdote os interrogou, dizendo:
28 E ask dem, “Wi kommand una sey make una nor tish pipol about dis name, but si naw, di whole Jerusalem don full with di tins wey una dey tish. Una won put dis man blood for awa head?”
28 Não vos admoestamos expressamente que não ensinásseis nesse nome? e eis que enchestes Jerusalém dessa vossa doutrina e quereis lançar sobre nós o sangue desse homem.
29 But Pita and di apostles ansa, “Wi go must obey God instead of human being.
29 Respondendo Pedro e os apóstolos, disseram: Importa antes obedecer a Deus que aos homens.
30 Na di God wey awa grand-grand papa dem serve raiz-up Jesus Christ wey una hang for tree.
30 O Deus de nossos pais ressuscitou a Jesus, ao qual vós matastes, suspendendo-o no madeiro;
31 But God don promote am sey make e sidan for en rite hand kon gi-am big pozishon as Oga God and di Pesin wey go save di world, so dat Israel shidren go turn from dia sin kom meet God make e forgive dem.
31 sim, Deus, com a sua destra, o elevou a Príncipe e Salvador, para dar a Israel o arrependimento e remissão de pecados.
32 All of us know sey dis tin na true and di Holy Spirit wey God don give to pipol wey dey obey am, dey still bear witness sey, dis tin na true.”
32 E nós somos testemunhas destas coisas, e bem assim o Espírito Santo, que Deus deu àqueles que lhe obedecem.
33 Wen di priest oga dem hear dis tin, dem kon vex well-well and won kill di apostles.
33 Ora, ouvindo eles isto, se enfureceram e queriam matá-los.
34 Den one Farisee wey dem dey koll, Gamaliel, wey dey tish di law and wey di pipol dey respet well-well kon stand up tok, “Make una send dis men go outside first.”
34 Mas, levantando-se no sinédrio certo fariseu chamado Gamaliel, doutor da lei, acatado por todo o povo, mandou que por um pouco saíssem aqueles homens;
35 Den e kon tok to di kansol, “Una Israel oga, make una tink well before una do anytin to dis men.
35 e prosseguiu: Varões israelitas, acautelai-vos a respeito do que estais para fazer a estes homens.
36 Bikos na so Teudas still kom up before, dey tok sey en na pesin wey dey important and na about four hundred pipol follow am. Wen dem kill-am, all di pipol wey dey follow am skata and evritin kon end.
36 Porque, há algum tempo, levantou-se Teudas, dizendo ser alguém; ao qual se ajuntaram uns quatrocentos homens; mas ele foi morto, e todos quantos lhe obedeciam foram dispersos e reduzidos a nada.
37 Afta am, Judas wey kom from Galilee kom out wen dem dey do census. E push pipol to join am oppoz wetin dem dey do. Dem still kill-am and all di pipol wey dey follow am skata too.
37 Depois dele levantou-se Judas, o galileu, nos dias do recenseamento, e levou muitos após si; mas também este pereceu, e todos quantos lhe obedeciam foram dispersos.
38 Naim make I sey for dis matter so, make una remove una hand and leave all dis men, bikos if all di tins wey dem dey plan and do, na from dia mind, dem nor go susid,
38 Agora vos digo: Dai de mão a estes homens, e deixai-os, porque este conselho ou esta obra, caso seja dos homens, se desfará;
39 but if na from God, una nor go fit stop dem, escept una won fight God.”
39 mas, se é de Deus, não podereis derrotá-los; para que não sejais, porventura, achados até combatendo contra Deus.
40 So dem bring di apostles kom back kon tell dia savant make dem flog dem. Afta dem release dem, dem kon warn dem sey make dem nor use Jesus Christ name take prish again.
40 Concordaram, pois, com ele, e tendo chamado os apóstolos, açoitaram-nos e mandaram que não falassem em nome de Jesus, e os soltaram.
41 So di apostles komot from der dey happy well-well sey God don give dem di shance to sofa, bikos of Jesus Christ.
41 Retiraram-se pois da presença do sinédrio, regozijando-se de terem sido julgados dignos de sofrer afronta pelo nome de Jesus.
42 So evriday for di temple kompond and from house to house, dem kontinue to dey tish and prish di Good News sey, “Na Jesus Christ bi di Mezaya.”
42 E todos os dias, no templo e de casa em casa, não cessavam de ensinar, e de anunciar a Jesus, o Cristo.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Atos 5, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.